MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 28 March 2015

LIST OF NIGERIA CELEBRITIES WEY GO VOTE FOR JONATHAN OR BUHARI

For all ova di world,pipo wey dey contest for election always dey want make superstars and celebrities support dem bicos of di kain respect and mouth wey dis stars get for dia area and di world and di mata no differen for naija as many of dem don declare dia support for eida APC or PDP.
Some of dis celebrity fit just on dia own start to support dis candidates bicos  dem feel say di pesin go deliver if dem vote foram or sometimes most of dem fit don collect heavy raba and wen dia pocket don swell,dem go begin sing di praise of di pesin and if posibo sef dem go even dey yarn dust join.
Some of dis Celebrities go turn Yeyebrities if di candidate of dia choice no win.
Anyway sha dat one na tori for anoda day.

For naija,make I give una di list of superstars wey go vote for eida Goodluck Jonathan and PDP or General Muhammadu Buhari and APC today for who go bicom Naija Presido for di next four years as all dis celebrity don earlier declare for public rallies and ameboristic site like facebook,twitter,instagram and oda gbogbonye site who dem want.



#CelebritiesForGoodluckEbeleJonathan

Rita dominic,Sammy Okposo,Omawunmi,Oc Ukeje ,Mike Ozuronye,Oritsefemi,Afrocandy,
Ramsey Noah,Patience ozokwor,Gordons,Ini edo,Daddy Showkey,Mercy Johnson,Bovi,Toyin Aimakhu,Mochedda,Ibinabo Fiberesima, Onyeka Onwenu, Kate Henshaw,Monalisa Chinda, Joseph Benjamin, Femi Ogedemgbe, Joseph Yobo
Onyeka Onwenu, Fred Amata, Daddy Showkey, Ben Murray Bruce, Funke Adesiyan, Ruggedman, Essence, Segun Arinze, Joseph Benjamin, Fidelis Duker, Omoni Oboli, Femi Ogedengbe, KCEE, Monalisa Chinda, Eedris Abdulkareem, Zaaki Adzee, Harrysong, Majek Fashek, Omo Baba, Patience Ozokwor, Zeb Ejiro, Charles Novia, Naeto C, Omawumi, Ini Edo, Toyin Aimakhu, Emem Isong,Obesere,Saheed Osupa.





#CelebritiesForGeneralMuhammaduBuhari

Desmond Elliot,Tony One Week,Dayo 'D1'Adeneye,Olamide,Kenny St Brown,Don jazzy,9ice,Funke Akindele,Ice prince,M.I,Uti Nwachukwu,Banky W,Yemi Alade,Tiwa Savage,M.I,Ice Prince,Fathia Balogun, Muyiwa Ademola,Sanyeri,Adebayo Tijani, Wasiu Ayinde KWAM1,Femi Adebayo,Weird MC, Banky W, Funke Akindele, Yemi Alade, Muyiwa Ademola,Yomi Fash Lanso, Dammy Krane, DJ Jimmy Jatt, Flavour, Saidi Balogun, Ronke Oshodi Oke, Femi Adebayo, Lola Idije, Dayo Amusa, Sola Kosoko, MC Kirikiri, Shola Shobowale, Muyiwa Ademola,General Pype, Femi Adebayo, top celebrity stylist Swanky Jerry, Sanyeri Afonja, Kamilu Kampo, Odunlade Adekola, Adebayo Salami, Lagbaja, Mercy Aigbe, Yinka Quadri, Fathia Balogun, Foluke Daramola.



WHO YOU WANT AS NAIJA FIRST LADY?

Di office of di first lady na one office wey di Nigeria constitution and law no recognise at all and even tho say the late Maryam Babangida di wife of di forma Khaki Presido,General Ibrahim Badamasi Babangida add style and efizzi to di First Lady life style,dis one neva still make di law recognise di office.
Nigeria First Ladies mouth nowadays sharp pass parrot mouth.
If u nor know di role of di President u go tink say na dia wives be President bicos of di way wey dem don use dia hand arrange dia office to get beta respect. 
Anybodi wey win today election to bicom Naija Presido,automaticalli him wife go bicom di First Lady of The Federa Republic of Naija.
So area!
As dia husband don enta battle field today to know who go win di gbege wey dey ground,who you want to bicom your First Lady for naija?
Shey na di defending champion,Patience Jonathan or Aisha Buhari?
Shey na Mrs Chekwas Okorie or Mrs Onovo or Mrs Kelani or Mrs Sam Eke?
Or even kpakpa sef,Abi na di only woman wey dey contest with di men dem today to bicom Presido,Mrs Comfort Sonaiya husband, naim u won see as Naija First Man?
Oya make u yarn yor own...



PATIENCE JONATHAN


AISHA BUHARI

PATIENCE JONATHAN

Thursday 5 March 2015

SKILLACHI ! COMMOT FOR ROAD OKOCHA,OBASANJO NA Di NEW MARADONA FOR FIELD

If u no dey di MKO Abiola stadium for Ogun State yestaday,naim be say u miss welwell as Baba Iyabo show some kain skills for field wen he play football match wit him friends and Govnor Ibikunle Amosun of Ogun State to celebrate im 78 years baitday.
If u see baba di way wey baba be for inside jersey and boot dat day,u go fear fear.
Pipo feel say dem go use ambulance carry baba comot for field but who sai! 
Baba dey fit finish and he show say im get stamina pass dem John Terry and Lukaku.
Obasanjo naim be skippo for him Presidential Library team and he skor two goals why di Special Assistant to the governor for Special Duties mata,skor di only goal for Govnor Amosun team.
If no be say OBJ miss many skoring chance dat day he for skor reach ten goals.
Picture no dey lie.

Check out di pictures for bottom hia:






Wednesday 4 March 2015

WHY WE DEY KILL OURSELVES OVER NAIJA POLITICS WEN BODE GEORGE PIKIN DEY LIVE EASY LIFE FOR OBODO OYIBO(PHOTOS)

Why we dey kill oursef ova notin?
Why we dey allow politicians use our head dey play kalokalo and our politicians shidren dey abroad dey flenjo?
Dis na one question wey our politicians no dey want make you ask bicos u no go eva get any beta answer from dem.
So diafor,no mata how u ask dis question reach,u are on a long tin.
Take for example,one of di PDP godfather of naija politics,Oga Bode George model pikin,Yinka George just release some kain picture wey go make some gehs dey say,chai!see suntin!see fine bobo!
Talk true,bitwin me and u,u see di bobo like who go put im life for ground and ready to die for PDP,APC mata?
A word don do for di wise,so wise up naija pipo.

Check di bobo pictures yorsef for bottom hia:







YINKA PAPA,BODE GEORGE



CAMEROON ARMY OGA DON YARN SAY BOKO HARAM MEMBERS PLENTY PASS SOLDIER ANTS

Colonel Joseph Nouma,Commanda of operation ALPHA,di millitary operation wey Cameroon govment form to take fight Boko Haram don yarn CNN say,Boko Haram membas plenti welwell no bi small.
He say di more dem dey kill dis terrorist,di more dem dey germinate like fresh vegetable.


He also talk say,e be like say Cameroon pipo sef don dey Join Boko Haram.
Akordin toram,he say boys and men bitwin di ages of 10 to 45 years from many Cameroon villages wey dey around Nigeria border,don dey join Boko Haram.
Anoda Cameroon army oga,Colonel Jacob Kodji,di interim commanda of di 4th millitary region, also yarn say,as dem dey kill Boko Haram na so dem dey recruit new membas too.
He say dis kain development dey make tins dey difficult for dem.

I GO RESIGN IF NFA EMPLOY KESHI-PAUL BASSEY


E be like say di tin wey dey delay di Nigeria Football Federation,NFF from announcing Stephen Keshi as Super Eagles coach go still continiu if NFF take wetin dia memba Paul Bassey yarn yestaday,sirios.
Memba of di NFF technical Commiti,Paul Bassey don yarn say im go resign if NFF appoint Keshi as Eagles coach.
Bassey say di tin dey buss im brain and e dey pain am reach im bone say dem still dey discuss weda to renew Keshi contract or not.
He say di day wey im hear say NFF announce Keshi name as Naija coach,na dat day im go resign.
He also yarn say him don work wit Keshi for good four years and he don find out say di coach nor get anytin new to offer us again. 
Paul Bassey say di illa,Delta State born coach na legend for our football but if na for coach mata,Keshi no biam at all bicos akordin toram,di big boss know wia im coaching skills end but he dey form like say he sabi welwell.
He say we need new coach wey go bring fresh tactics and fresh tins enta di mata so make Keshi go siddon one place.
Stephen Keshi contract end last year and NFF kon sackam afta Super Eagles win Sudan 3-1 for Abuja for one nations cup qualifier but President Goodluck Jonathan say make dem call am back to handle di remaining matches and yet him no fit qualify Naija for di nations cup wey just end for Equitorial Guinea as na only draw instead of win naim dem play against di Bafana Bafana of South Africa.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...