MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 31 May 2014

BRANAMA QUEEN,KEFEE DON COLAPSE FOR INSIDE PLANE FOR AMERICA BUT SHE DEY OK NOW



Di rumors wey dey go round for evri wia now,bi say,Kefee dat fine babee wey sing Branama and Kokoroko,Don kolaps for inside plane as she dey travel go Chicago for America.
Di Sapele water singa,Kefee, neva rich wia she dey go b4 di pilot kon stop for carlifonia make dem for fit carry her go hospita.
Di tori now bi say,di sikness dey veri sirios as pipo say na brain problem naim she get.
But make e no bi like say i dey spread rumors wey I no know weda na true,naim I kon call her phone weda she go pick.but na one guy wey say he name na Kevin naim pick di col.
He tell me say,Kefee travel out of di kontri wit her husband.
Naim i kon askam say,wetin dey do am bicos I dey hia some kain rumors wey no sweet mi for ears.di bobo kon tell me say,na true say she get some problem b4 but she don dey veri ok now.
We pray by God grace say na so e go be.
Kefee don win many award for di miuzik wey she dey play.she just bring one new miuzik come out last week wey she call "Dem go talk"

Kefee and Teddy Don Momoh marry for 2012 and na two of dem naim go one skul wey dem dey call,Chicago Access Network for America last year wia dem for  len how to direct and do koret vidio.na April last month dem come bak togeda from America as dem finish for di skul.

BOKO HARAM DON DEY THIEF VILLAGERS FOOD AS DIA FOOD DON FINISH FOR BUSH.





Report wey dey rich us bi say hunga don dey blow Boko Haram membas as dem don dey come out from bush to town come tiff food.
Dem don kill all di antelope,all di monkey,all di animals for Sambisa forest chop finish and now dem don dey enta town to tiff pipo meat,rice,beans,kpomo,tomatos,bread and even gala wit force.
Even kpakpa sef,Last Sunday,Boko Haram block one bus wey carry bread,kill di driver and di motto boys and dem kon drive di bus face Sambisa Forest.di motto dey come from Gwoza and e dey go Polka but dem kon waylay dem for Wallaba village,kill dem and take di motto.
Tori wey our Tori team gada be say,di food wey dem get nor dey rich dem eat not to tok of di one wey di ova 180 gehs wey dem kidnap go chop.na since April 14 dem kidnap di gehs dem from dia skul for Chibok and Naija army don dey look for di gehs but dem neva stil see were Boko Haram hide dem.oda countries wey join bodi to find dis gehs na,America,Britain,France and Britain.
Akkordin to some of di villagers wey dey stay wia Boko Haram dey go tiff food,dem say,if u see di kain red eye wey dem take dey pack all dia food,somtin go tell u say,e be like say dem won use some of di food take feed di gehs.
But di bad tin be say,akkordin to one man wey dey stay Kamuyya village,afta dem don tiff food and malu finish,instead make dem carry dia wahala go jejeje,na lie!
Dem go kon dey kill pipo,dem go burn down dia shops,burn down dia motto and burn down dia house.
Some of di villa wey Boko Haram dey go tiff food na Limankara, kirenowa,Kamuyya, Kirenowa, Kimba,Makor.

Friday 30 May 2014

DEM DON CHOOSE ORITSE FEMI, PATORANKING, DON JAZZY, DERELE, GENEVIEVE, TIWA SAVAGE FOR DI 2014 NIGERIAN ENTATAYMENT AWARD "NEA"

Di families of Oritsefemi,Orezi,Pato Ranking,Cynthia Morgan and plenti oda stars don join dem dey tank Baba God and sing "haleluya,hosanna,,,praise da Lord,O singO singO...praise da Lord" as dem don choose dem among di people wey fit win prize for di Nigeria Entatayment Award wey go shele for August 31,2014 for Skirball Centre Performing Arts for Newyork,America.
Oritsefemi get 4 chance to win for,4 diferen catigori,Wizkid get for 3 catigori ,Tiwa Savage(3),Chidinma(3),Olamide(
2)...
To know di miusishans and oda pipo wey dem choose for dis Award,make u checkam for bottom dis place:

Best Actress in a lead role

Nse Ikpe-Etim (Journey to self)
Funke Akindele in Agnetta (O’Mpa)
Damilola Adegbite (Flower Girl)
Chioma Chukwuka Akpotha (Accident)
Daniella Okeke (Lagos Cougars)

Best Supporting Actress

Rita Dominic (Finding Mercy)
Patience Ozokwor (After the Proposal)
Tamara Eteimo (Desperate Housegirls)
Genevieve Nnaji (Half of a Yellow Sun)

Bikiya Graham-Douglas (Flower Girl)
Best Director

Tope Oshin-Ogun (Journey to Self)
Sadiq Mafia (Maja)
Desmond Elliott (Finding Mercy)
Teco Benson (Accident)
Biyi Bandele (Half of a Yellow Sun)

Best Music Video of the year (artist & director)
 Jaiye Jaiye – Wizkid & Sesan
P-Square- Personally
Rands&Naira (Emmy Gee & Nick)

Music producer of the year

Duncan Daniels
Dtunes
Don Jazzy
Blaq Jerzy
Pheelz
Del B
Maleek Berry

Best Rap Act of the year

Olamide
Phyno
Ice Prince
Eva
Show Dem Camp
Reminisce
Cynthia Morgan

Best Picture

Journey to Self
Maja
Accident
Half of a Yellow Sun
Murder at Prime Suites

Best Supporting actor

OC Ukeje (Half of a Yellow Sun)
Rabilu Musa Ibro (Maja)
Desmond Elliott (Finding Mercy)
Yomi Fash-Lanso (Omo Elemosho)
Shawn Faqua (Lagos Cougar)

Hottest Single

Surulere – Dr. S.I.D ft. don Jazzy
Eminado – Tiwa savage Ft. Don Jazzy
Touching Body – J Martins ft. DJ Arafat
Pull-Over -Kcee ft. Wizkid
Double Wahala- Oritshe Femi
Aye-Davido
Caro – Starboi feat Lax & Wizkid

African Artist of the year (non-Nigerian)

Sarkodie
Mafikizolo
Shatta Wale
Micasa
Fally Ipupa
Uhuru
R2Bees
Diaspora Artist of the year
 Stlyzz
Wale Bils
L.A.X
Lola Rae
Mr. 2Kay
Emmy Gee

Best Collaboration –

Daddy-Reminisce/Davido
Solid Star ft Flavor – Oluchi
WanDaMo – Burna Boy ft. Dbanj
Oh Baby – Chidinma Ft Flavour
 Emergency – Wizzy Pro Ft. Runtown, Skales & Patoranking
Gallardo – Runtown Ft. Davido
Allubarika – Patoranking ft. Timaya

Best Actor in a Lead Role

Chitewel Ejiofor (Half of a Yellow Sun)
Kanayo O. Kanayo (Apaye)
Tope Tedela (A Mile from Home)
Joseph Benjamin (Murder At Prime Suites)
Nkem Owoh (Maja)

Best Album of the year

Baddest Guy Ever Liveth – Olamide
Once Upon A Time – Tiwa Savage
Takeover – Kcee
 L.I.F.E – Burna Boy
Jagz Nation, Vol 1: Thy Nation Come -Jesse Jagz
Journey – Sean Tizzle
Blessed – Flavour

Best New Act of the year

Orezi
Patoranking
Runtown
Charass
Tekno Miles
Oritshe Femi
Skuki

Male Artist of the Year

Kcee
Davido
Iyanya
Wande Coal
Wizkid
Oritse Femi
Patoranking

Female Artist of the Year

Tiwa Savage
Yemi Alade
Seyi Shay
Cynthia Morgan
Eva
Chidinma
Niyola

World DJ

DJ IK Nigeria
DJ Shinski Houston
DJ Cuppy UK
DJ Flexx Nigeria
DJ Tunez New York
DJ Spinall
DJ Xclusive

Best R&B artist of the year
Praiz

Tiwa Savage
Wande Coal
Ayoola
Banky W
Chidinma
Harry Song

Entertainment Executive of the year

Efe Omorogbe
Don Jazzy
E-Money
Illbliss
Ayo Animashaun
Steve Babaeko
Okwudili-umenyior

Funniest Comedian of Year

Bovi
Bash
Funny Bone
Ajebo
Akpororo
Helen Paul
Chi Girl

Indigenous Artist of the year

Oritshe femi
Reminisce
Sean Tizzle
Jaywon
Flavour
Timaya
Mc Galaxy

Entertainment Personality of the year

Toolz
Liz Yemoja Adams
Toke Makinwa
Denrele – Channel O
Lami – Nigezie
IK Ogbonna

Gospel Artist of the year

Tim Godfrey and Xtreme Crew
Frank Edwards Flo
Segun Oluwayomi
Niki Laoye
Sabina Proverbs

Most Promising Act to Watch-

Di’Ja
Ayo Jay
Elphlex
Koko J
Sna-Z
Brain
DJ Mo






D'BANJ DON WIN OGBONGE PRIZE FOR WORLD MUSIC AWARD


All of una wey dey yarn say,since D'banj liv Don jazzy and Mohits rekord,na so so opata and rubish e dey sing,di oganaizas of one Ogbonge award wey dem dey call 'Di World Music Award,tok say,na big lie una lie as dem chuz D'banj as di Africa nomba one!
For di award wey dem do for Monte Carlo,Monaco, for inside France,dem say di Eja nla,D'banj, naim bi di nomba one miuzishan wey he miuzik dey sell pass for di hole of Africa,so diafor,if bad belle pipo wan to hug transforma,dem dey veri free.
Di Kokomasta win oda Africa miuzishans like Banky W,Fally Ipupa,wizkid and Davido.
Even kpakpa sef,D'banj paform for stage for di award.oda miuzishan wey paform dat day na Miley Cyrus,Jason Derulo,Mariah Carey and plenti odas.

TO KNOW DI MIUSISHAN WEY WIN AWARD DAT DAY,  CHECKAM FOR BOTTOM DIS PLACE:

World-s best-selling Recording Act – One Direction
Worlds Best Male Artist as voted on by fans – Han Geng
Worlds Best Group – One Direction
Worlds Best-selling recording Act – One Direction
Worlds Best Pop Act – One Direction
World’s Best Pop Rock Male Artist – Justin Timberlake
Worlds Best Pop Rock Female Artist – Miley Cyrus
World’s Best Rock Act – Imagine Dragons
World’s Best R & B Act – Beyonce
World’s Best Rap/Hip Hop Act – Eminem
Worlds Best Alternative Act – Lorde
Worlds Best Alternative Group (voted by the fans) – Fall Out Boy
World’s Best EDM Act – Daft Punk
Worlds Best EDM Artist (voted by the fans) – Avicii
Worlds Best New Artist – Lorde
Worlds best Video – Miley Cyrus

LEGEND AWARDS

Greek Legend – Sakis
Latin Legend – Ricky Martin
Outstanding Contribution to Dance Music – Flo Rida
Icon Award – Mariah Carey
Best selling singles artist in America – Mariah Carey

Best female as voted on by fans Miley Cyrus

NATIONAL BEST-SELLING ARTISTS

Best-selling American Artist – Eminem
Best-selling Australasian Artist – Lorde
Best-selling Azerbaijan Artist – Emin
Best-selling Benelux Artist – Stromae
Best-selling Canadian Artist – Michael Buble
Best-selling Chinese Artist – Chris Lee
Best-selling British Act – One Direction
Best-selling French Artist – Daft Punk
Best-selling German Artist – Helen Fischer
Best-selling Indonesian Artist – Anggun
Best-selling Italian Artist – Ligabue
Best-selling Korean Act – EXO
Best-selling Latin Artist – Shakira
Best-selling Japanese Artist – AKB48
Best-selling Philippines Artist – Sara Geronimo
Best-selling Portuguese Artist – Tony Carreira
Best-selling Russian Artist – Grigory Leps
Best-selling Scandinavian Artist – Avicii
Best-selling Spanish Artist – David Bisbal
Best-selling African Artist – D’Banj

Thursday 29 May 2014

NOLLYWOOD OGA,CHARLES NOVIA,DON FINISH TIWA SAVAGE WITH CURSE


 One of di big Oga for film and home vidio mata for
Naija,
Oga Charles
Novia,don finish Tiwa Savage and her husband Tee
Bills wit curse just di
way wey Ajegunle musishan,Nico Gravity,take finish
Timaya with curse for 2011.na for inside twitta he for curse dem afta im watch di vidio for di
new miuzik wey Tiwa Savage just bring come out.
One of Nollywood oga,Charles Novia say,sake of say
Rihanna and Beyonce dey
open yansh and breast for Tv,Naija gehs won open
dia own too.he say,fear nor fit allow pipo put on dia Tv again to watch
Nigezie,Soundcity,hip
Tv,Music africa and oda Naija miuzik stashon sake
of say,Naija miuzishan
dey do like say na blue film dem dey do nowadays
for inside dis miuzik wey dem dey play.
Novia also tok say,im na big fan of Tiwa Savage,but
for dis her new miuzik
wey she bring come out so,she no try at all bicos say
she just dey torch
her website anyhow and she kon dey wine body (like) mamiwater and ashawo.he
say Maheeda crase dey learn for wia Tiwa own dey
and even tho Tiwa won
crase,she supose to crase for dia bedroom for only
her husband.
Akordin to tori wey we gada,Charles Novia also tok say,if to dey open John
Thomas and Website for evribodi to dey see na gud
tin,den,make dem no wear
dia pikin any clothes for bodi and make dia shidren
dey naked go skul.

Di Oga kpata kpata for Manchester United, Malcolm GLazer, don die


Di man wey get Manchester United Malcolm Glazer
don die for im house for
Rochester for inside New York,America.
Glazer buy Man U for 2005 and for dis period dem
win 5 primia lig 4 England
and one champions lig 4 Europe.Naim also get di America football lig
team,Tampa Bay Bucaneers.he don get stroke since
2006 and he kon die today
at di age of 85.
Even united later bring out yarns say dem dey
veriveri sad say di man die but e death no go stop Man u to kontiniu to exist as
im pikin,Joel and
Avram Glazer don even dey run di club since as Vice
Chairmen for ova 9
years now.
But sha o,b4 Glazer die,e no eva visit Old Trafford.weda na to come wash
mash o, or to come grit di playas o,e no go dia
anytime.
Old Trafford naim bi di field wey Man u for dey play
all dia home mash.

Wednesday 28 May 2014

NAIJA SOJAS SAY DEM DON LOCATE Di KIDNAP CHIBOK SKUL GEHS



Di Ogakpatakpata 4 securiti mata for Naija,Air Chief Marshal Alex Badeh,tok say dem don see di place wia dem hide di Chibok skul gehs wey Boko Haram kidnap.he tok dis one wen he dey kul di mind of di crowd down wey carry protest come he office.he say na sense dem take dey katch monkey,so diafor, Naija sojas nor go use force to free di gehs make e no go kos big wahala sake of say,if dem use force,di gehs dem fit die since Boko Haram don alreadi soranda di gehs dem wit bigbig guns and dangerous wipons.
Dis tori,go giv di gehs dem mama and papa smol hope but Chief Badeh say dem nor go fit tell anybodi wia di gehs dem dey for now since na di sikrit wey dem go take kontiniu to dey work and look for di gehs.
Tori wey our tori team also gada be say,President Goodluck Jonathan don cancel di plan wit Boko Haram to free di gehs.di plan b4 bi say,federa govment sopose to free about 100 Boko Haram membas wey dey prison,den,Boko go come free di Chibok skul gehs.but Jona phone from France wia he go do one join bodi meeting wit im felow ogakpatakpata from oda kontris about dis Boko Haram wahala,say,make dem put fulstop to dat deal.
Di rizin bi say,if dem do dis kain bizness wit Boko Haram,e go giv dem high spirit to kontiniu di kidnaping,di killing and do more wickedwicked tins.
Di konclushon now bi say,since Naija sojas no won use force, federa govment don deside to borow sense from all di monkey for inside bush,make dem use am take free and #BRINGBACKOURGEHS.

Monday 26 May 2014

TWO REAL MADRID FANS DON DIE FOR LAGOS.



Two Real Madrid fans don kpeme for Lagos on saturday nait bicos say Real Madrid no quik equalize di goal wey Athletico Madrid score dem for di Champions Lig final wey shele for Lisbon,Portugal.No bi di fest time wey dis kin tin dey hapun be dis.some men don throw dia wife down from upstair bicos dia team lose mash,some don stab dia frends die bicos of mash,some even kpakpa sef don comit susaid bicos dia clob wey dem dey suport no win mash.
Baba God for Heaven go dey wonda sef say,why pipo kon take futbol mata sirios like dis!
For dat nite wey dose 2 bobo die,Athletico fil say dem don win di mash finish ontil Real Madrid kon skor and equalize for di last minit.Madrid kon still skor anoda 3 gols to put sansan for Athletico Madrid garri.di bad ting bi say dem no even dey alife to no weda dia clob later win di mash.
Di 2 men names wey die na Mista Olusoga Ogunbanjo.im na 39 years and na fridge he dey repair.di oda man name na Mista Bambo Sholeye wey dey work wit LAWMA and na 42 years old.di 2 of dem na Lagos Island dem dey stay.
Akkordin to tori wey we gada,Olusoga go one salun for im area go shave im biabia and kon use di oportuniti to wash di mash.e no too tey naim d guy faint as Madrid dey play sanya like say dem be 11 pregnant women.di bobo wey get di salun,Danku tok say dem rush am go Genera hospito and na dia im for die.di oda man,Sholeye,vex comot for wia im dey wash di mash as e no fit bear di kind futbol wey im club dey play as dem dey strawgo to equalize.na front of im house wey he sidon dey complain about di mash,na dia im faint b4 dem rusham go hospito.doctors try dia best to tritam but dem say im don already kpeme.
Di bad tin bi say,dis 2 men no dey alife to join Real Madrid celibrate and jolificate as evritin kon turn around and Madrid kon later win di mash 4-1 for xtra time.










Sunday 25 May 2014

GTB DON WIN BANK OF Di YEAR AGAIN FOR AFRICA.

GUARANTY TRUST BANK PLC


Gtb don show di world again say dem bi baba for bank mata for inside Africa as dem don win di award as di nomba one bank for 2014. Incase u no rememba,na dem naim winam for 2013 too.
Dis award hapun for di join bodi meetin of di asociashun of banks for Africa wey dem do for Kigali on Wednesday May 21,2014 for inside Rwanda.one hotel wey dia name na kigali Serena hotel naim dis award for shele.
Africa bankas Magazine awards na dem bi one of di ogakpatakpata pipo wey dey klap for all di betabeta tins wey banks dey do.
Na plenti tings dem use take make GTB di winna of dis award.Nomba one na d way wey dem take dey frendly to dia costomas and d way wey pipo and bigbig compinis dey take do bizness wit dem witout complain.
Kunle Sonola di ogakpatakpata for all GTBANK for Kenya,naim kolet di award for GTB worldwide and he kon tok say dis award na di reward for di power,smiling face and klin heart wey all di staff and ogakpatakpata dem, take dey do dia wok.
And he also tok say dem go kontiniu to dey do dia best to give pipo hapiness for bank mata for inside Africa.

Saturday 24 May 2014

2BABA DON HAMMER AS HE WEAR N1MILLION NAIRA GOLD CANVASS FOR VIDEO SHOOTING


Baba God don continiu to dey bless 2face idibia for dis sing sing mata as di bobo wear 1million naira gold shoe go shoot one jammin jammin muzik video wey im join bodi do wit  T.W.O(Tunde and Wunmi Obe).


di name for dis jammin jammin wey T.W.O won sama pipo na GREEN WHITE GREEN and na muzik to take remind naija why we supose live as one pipo like brodas and sistas.Na Shina Peters pikin Clarence Peters naim dey do di video.
2baba and him wife Annie Idibia naim folow buss out for dis join bodi.

ETO'O SAY MOURINHO DEY BEHAVE LIKE DON BABY


Chelsea and Cameroon Futballer SamuEl Eto'o don blast im coach Jose Mourinho say im character worse pass donbaby own.
Eto and mourinho gbege bi like,yanga wey dey sleep jejeje and trouble go wake am,bicos,na Mourinho fest yarn for one join bodi tok for france say Eto go don pass 32years wey he dey claim.
Eto'o kon vex call am fool 2 wiks ago.as if dat one neva do,he kon tell di confederashon of Africa football website yestaday say im be 33years but he play ball pass many smolly wey neva old like am,so,make pipo no mind di opata wey dat donbaby(Mourinho)dey yarn about him age.
Eto skore 12 goals for chelsea dis sizin and im say he neva thru wit football for europe and he stil get 2 world cup to stil play.

Thursday 22 May 2014

POLICE DON ARREST DIPLOMATIC OPJ BICOS E PISS FOR GUTTA

POLICE DON ARREST DIPLOMATIC OPJ BICOS E PISS FOR GUTTA



Ekelebe don arrest Opute Pius Junior A.K.A 'Diplomatic OPJ' of wazobia fm bicos say im piss for gutta for marwa bustop for Lekki,Lagos.Wazobia Fm na one veri popula radio stashon for Naija.di guy bin show im muscle smol as e take police men time to fit arrest am and di mata kon cause heavy go slow for lekki Epe espressway.
The policeman wey carry di mata for head,Sajent Daniel Ighodalo,tok say na offence for Envaromenta sanitashon law of Lagos to bring out your John Thomas for public and piss for anywia u like.
Di mata dey court now as we dey tok and na 2 offence dem say he comit.nomba one bi say he piss for gutta and nomba 2,he show im muscle and power to police say im na boxer.
As dem carry OPJ go Tinubu jojment court for Lagos,di lawya wey joj di mata,Missis Olaitan Ajayi,gree make dem bail OPJ wit 20,000 naira and dem also make sure say im bring pesin wey sign shortee foram and stand for di case wey go continue on di 18 of june,2014.


Wednesday 21 May 2014

WETIN SEF!ANODA BOMB BLAST DON KILL PLENTI PIPO FOR JOS AGAIN!


WETIN SEF!ANODA BOMB BLAST DON KILL PLENTI PIPO FOR JOS AGAIN!

Bomb wey some wicked pipo hide for inside two bus and shoe market for Murtala Mohammed way,don blow for diferen place and kill plenti pipo for Jos on Tuesday may 20,2014.One of the bomb blast happen 3pm for inside jos main market wey dey around di railway and Jos univasity tishing hospital area.
Na so pipo dey cry,some dey shout,blood dey rush from some pipo nose and bodi as di agent wey dey manage emagenci mata for Naija(NEMA) and Red cross don count and pack about 118 dead bodi alreadi.
We neva sabi di pipo wey do am as nobodi or groop don come out say na dem plant dis bombs but everibodi know for di world say,Naija nomba one enemi,Boko Haram don kill ova 11,000 pipo wit dangerous wipon and plenti bomb for di past 3 years.
Tori wey dey rich us bi say Plateau State governor Jonah Jang and President Ebele Jonathan don condem dis kin nonsense wey hapun for Jos as dem don promise Nigeria say dem go try gbaskele di pipo wey do dis kin wicked tin.













Tuesday 20 May 2014

YAWA!BRITICO PLANE WEY DEY COME FIND Di GEHS WEY BOKO HARAM KIDNAP DON SPOIL.


Quin Eliza and di Britico prime minista David Cameron go don squiz dia face as Di spy plane wey dem send dey come Naija to come find di chibok skul gehs wey Boko Haram Kidnap since april 14 don kaput for sky.dis one kon make dem do emagenci landing for Senegal.
Some pipo don dey ask weda na Chico plane or Tokunbo plane dem bin dey send come Naija?but anyhow sha dem don dey repair di plane for Senegal as we dey tok.
Dis Royal Air Force Jet bin don take off from Waddington,England dey go Accra for Ghana were dem won base b4 dem notis di folt.
If una rememba last week,Britico Prime Minista David Cameron tok say he go borrow Nigeria sojas and di plane make dem asist to find di ova 200 skul gehs wey Boko Haram siz for Chibok.
Expat pipo from America,France,Britain,Israel don join bodi enta Naija some weeks ago to hep find dis gehs for inside bush.more kontris like Japan,Canada,Australia dey promise to hep fait Boko Haram.



Friday 16 May 2014

BOMB BLAST FEAR DON CATCH TRADERS FOR BALOGUN MARKET.



Nor bi small yawa race naim shele for around di centra mosk for Nnamdi Azikiwe strit and Tinubu square for Balogun market yesterday as one man wey just dash beggars moni raze alarm say him see one tin wey be like bomb for front of one compini yard for di area.
Nor bi smol tin o,as pipo come dey col dia frends,col dia family say make dem no near dat area for any bizness bicos of di bomb rumor.
Na policemen for bomb mata wey rush come there kon kam di pipo down say make dem no fear say no be bomb di tin be.di bomb expats say di tin na wetin dem take dey patch bodi of ship wey dey leak or ship wey hin bodi don rost.
The pesin wey lead police for dis tok tok na Ngozi Braide.he say di tin no bi bomb at all say wey dem testam,so make dem relax dia mind.Ngozi Braide kon praise di area pipo say dia teeth complete and dem too mosh bicos dem put dia eye for ground to make shor bad bad tins no hapun for dia area.
Too many bomb blast don hapun for Naija for ova 4 years now.di last one na di Nyanya bomb blast for Abuja wey kill ova 77 pipo for garage.
Repot wey dey rich us be say dem don arrest one of di bobo wey plan di bomb attak for Nyanya garage.
Him name na Aminu Sadiq Ogwuche.Na for Sudan dem arrestam and federa govment don dey wok on di paypas make dem fit sendam back to Nigeria to answa him papa name.

OSAZE ODEMWINGIE WIFE DON BORN DIA SECOND PIKIN.






It is a goooooooooooooooal!!!
Shap shoota Osaze Odemwingie don score again!
Him and he wife don dey sing Halleluyah Hossana..as dem don welcome di arraival of dia second boi pikin wey dem name THEO.
Dem don fest get one boi pikin for January,2013 wey him name na NOAH and na ezactly two years since dem marry.
Osaze naim do di braking news by himsef for twita say plus himsef,him wife Sarah,dia fest pikin Noah and di niu bobo,Theo,dem don bicom 4 for di family and he kon tank evribodi for dia congratulashon mesage.
Osaze Odemwigie dey among di playas wey Super Eagles coach Stephen Okechukwu Keshi dey expet to make Naija proud for di world cup wey go shele for Brazil dis june.
Osaze dey play ball for Stoke City for England and he score 7 goals insaid dis season.
As him and he wife don score pikin nomba 2,we pray say he go score plenti goals for us for di world cup for Brazil.

Thursday 15 May 2014

SKELEWU!!! BET DON CHUZ DAVIDO AND TIWA SAVAGE FOR DIA AWARD FOR OBODO OYIBO.







Omo babolowo,Davido and Shenkes of life,Tiwa Savage get evri rison to dans Skelewu and tank Baba God dis morning as Black Entatayment Telivishon, BET don selet dem among di miusishan wey fit win di Best intanashona catigori(Africa) wey go shele 4 insaid yankee on sunday june 29,2014 for Nokia Theatre  for Los Angeles,Califonia,America.Chai!
Di oda miusishan wey dem go folow drag dis award na Diamond Platnumz of Tanzania,Mafikizolo of south africa,Sarkodie from Ghana,Toofan From Togo.
Ice prince win dis award for 2013,Sarkodie and Wizkid winam togeda for 2012,2face and D'banj nko?dem share dis trophi togeda for 2011.
We for ogakpatakpata.blogspot.com dey wish Davido and Tiwa Savage plenti luck.

Dis na di list of all di miusishan wey dem selet for diferen catigori for 2014

Best International Act: Africa
Davido (Nigeria)
Diamond Platnumz (Tanzania)
Mafikizolo (South Africa)
Sarkodie (Ghana)
Tiwa Savage (Nigeria)
Toofan (Togo) 

Best International Act: UK
Dizzee Rascal
Ghetts
Krept & Konan
Laura Mvula
Rita Ora
Tinie Tempah 

Best Female R&B/Pop Artist
Beyoncé
Janelle Monáe
Jhené Aiko
K. Michelle
Rihanna
Tamar Braxton

Best Male R&B/Pop Artist
August Alsina
Chris Brown
John Legend 
Justin Timberlake
Pharrell Williams

Best Group
A$AP Mob
Daft Punk
Macklemore & Ryan Lewis
TGT
Young Money

Best Collaboration
August Alsina f/ Trinidad Jame$ - I Luv This
Beyoncé f/ JAY Z - Drunk In Love
Drake f/ Majid Jordan - Hold On (We're Going Home)
JAY Z f/ Justin Timberlake - Holy Grail
Robin Thicke f/ T.I. & Pharrell Williams - Blurred Lines
YG f/ Jeezy & Rich Homie Quan - My Hitta

Best Male Hip Hop Artist
Drake
Future
J. Cole
JAY Z
Kendrick Lamar

Best Female Hip Hop Artist
Angel Haze
Charli Baltimore
Eve
Iggy Azalea
Nicki Minaj

Video of the Year
Beyoncé - Partition
Beyoncé f/ JAY Z - Drunk In Love
Chris Brown - Fine China
Drake - Worst Behavior
Pharrell Williams - Happy

Video Director of the Year
Benny Boom
Chris Brown
Colin Tilley
Director X
Hype Williams

Best New Artist
Ariana Grande
August Alsina
Mack Wilds
Rich Homie Quan
ScHoolboy Q

Best Gospel Artist
Donnie McClurkin
Erica Campbell
Hezekiah Walker
Tamela Mann
Tye Tribbett

Best Actress
Angela Bassett
Gabrielle Union
Kerry Washington
Lupita Nyong'o
Oprah Winfrey

Best Actor
Chiwetel Ejiofor
Forest Whitaker
Idris Elba
Kevin Hart
Michael B. Jordan

YoungStars Award
Gabrielle Douglas
Jacob Latimore
Jaden Smith
KeKe Palmer
Zendaya

Best Movie
12 Years a Slave
The Best Man Holiday
Fruitvale Station
Kevin Hart: Let Me Explain
Lee Daniels' The Butler

Subway Sportswoman of the Year
Brittney Griner
Lolo Jones
Serena Williams
Skylar Diggins
Venus Williams

Subway Sportsman of the Year
Blake Griffin
Carmelo Anthony
Floyd Mayweather Jr.
Kevin Durant
LeBron James

Centric Award
Aloe Blacc - The Man
Jennifer Hudson f/ T.I. - I Can't Describe (The Way I Feel)
Jhené Aiko - The Worst
LiV Warfield - Why Do You Lie?
Wale f/ Sam Dew - LoveHate Thing
KELEWU!!! BET DON CHUZ DAVIDO AND TIWA SAVAGE FOR DIA AWARD FOR OBODO OYIBO.

Wednesday 14 May 2014

YEKPAA! KASALA DON BUSS FOR INSPIRATION FM AS DEM DON SAY BYE BYE TO DAN FOSTER.

Inspiration Fm for inside Lagos don diside to put fullstop to di Kontrat wey dem get wit di Americana,Dan Foster since on Torsday 8 of may,2014.
Dan foster fest wok for Cool Fm b4 inspiration Fm kon tiffam take to wok for dem.
Di tori wey rish us bi say dem forsam to resign instead make dem sackam so dat di mata go get smol respet. Inspiration Fm lidas wey dia Ogakpatakpata na Mr Erastus Akingbola fil say Naija blood and karata don enta him head so him dey denge pose and he nor take di wok serios again.
Dem say di Bobo dey wok like Jakki wen he fest stat di wok but weda na bicos he don drink Naija water or na too mosh generator noiz don change am,we nor kon know.bicos America were him com from, na only farmers dey use generators for inside bush.with generator noiz,anytin can happen.
Akkordin to one worka for di radio station wey say make we nor menshon he name,Dan Foster dey resiv close to 2million naira evri mont if u join all him allawance togeda and yet dem no dey fil him wok again.
Naim dey resiv di bigest salari for di hole of Naija out of all di pipo wey dey work for radio.
He get one time wey evribodi tink say he go marry him forma babe LiNDA iKEJi,one popular Tori writa but he Kon brake di baby heart and marry one banker wey her name na Lovina.Dan and Lovina Don born 3 shidren togeda.2gehs and one Bobo.
No mata how u look di mata rish,plenti of him fans go misam for inspiration fm.
We for Ogakpatakpata.blogspot.com dey wisham gudluck.



LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...