MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 28 February 2019

FEDERAL GOVMENT DON SHARE N610.36BILLION NAIRA GIVE FEDERAL SERVICE, STATE AND LOCAL GOVMENT AREAS FOR Di MONTH OF FEBRUARY


If you be civil servant and dem neva arrange your salary give you,naim be say tori don dey enta be dat.
Why be say,federal gofment don share N610.36 billion give both state and local gofments plus even the federal service too.
No need to fear sha as I biliv say di money go reach evri evri.

Wednesday 27 February 2019

PRESIDENT BUHARI DON FLAT ATIKU ABUBAKAR TO PIECES TO CONTINUE AS PRESIDENT FOR ANODA 4 YEARS FOR THE PRESIDENTIAL ELECTION RESULT WEY INEC RELEASE


President Muhammadu Buhari of APC don win Atiku Abubakar of PDP for di preidential election afta INEC announce say Buhari score 15,191,847 to win Atiku wey score 11,262,978.
Dat na ova 4 million votes naim Sai Baba take win Atiku but as e be so,PDP don come out dey spit fire say,na pure magomago naim APC do to take win dis election.
E be like say na court go end am as dem don reject di result.

Saturday 23 February 2019

2 SECONDS AS DAY BREAK,ELECTION DON START TODAY TO TAKE CHOOSE PIPO WEY GO RULE NIGERIA FOR Di NEXT 4 YEARS ESPECIALLY WHO GO BECOME PRESIDENT


Afta dem postpone di election from last Saturday to today,finally Nigerians don dey vote for who go rule dem for di next four years.
Today ns elections for house of reps,senate and presidential election.
Report wey dey enta our tori room be say,crowd rili come out to vote.

Friday 22 February 2019

FORMA SUPER EAGLES PLAYER 'OSAZE ODEMWINGIE' DON YARN TORi PIPO SAY,70% OF AFRICAN PLAYERS BILIV IN JUJU POWER


Forma Super Eagles winga Osaze Odemwingie don yarn say 70% of football players wey be Africans biliv say juju na evritin for football.
 He say Africa players biliv juju sotay if dem injure,dem biliv say na juju man medicine naim go cure dem.

Tuesday 19 February 2019

Monday 18 February 2019

GUN MEN DON KILL APC CHAIRMAN BONIFACE OKOLOHO OF IHIMINI LOCAL GOFMENT AREA FOR BENUE STATE


Elections neva rili start but killings don start.
APC chairman for Ihimini local gofment area for Benue state don die just like dat afta gun men kpai am.

Saturday 16 February 2019

DAVIDO TO WIZKID: YOU DEY JEALOUS ME BICOS I DEY MAKE PLENTi MONEY PASS YOU


Friends today enemies tomorrow,dat na di relationship wey Davido and Wizkid dey kip.
Afta dem settle dia quarrel ova a year ago,e be like say dem don wake dia beef up again.
If u dey follow up,you go don notice say Davido dey chook bodi for politiks nawadays since him uncle Senator Adeleke fight to be gofnor of Osun state.
Just last week,Davido join PDP big boy Atiku go campaign for Port Harcourt.
Unto dis kain selebritis campaign for politishians,Wizkid non yarn some days ago say,make naija pipo use dia own brain choose who dem biliv say,na beta leader wey we go need.
He say make una no do follow follow bicos selibritis don kolet politishians money put for pocket and bigin shout upandan.
Davido no kuku waste time to yab Wizzy back as he say bodi go pepper Wizkid die.
He say Wizkid dey jealous am bicos he dey make beta bar passam.

Friday 15 February 2019

THE SHORT BLACK BOY 'M.I ABAGA DON YARN TORi PIPO SAY, WIZKID REJECT VERi BIG MONEY DURING ONE JOINBODi MEETING WEY DEM ENTER WIT POLITICIANS WEY DEY FIND VOTES


Chocolate city and one of naija best rapper 'M.I' don yarn say,Wizkid reject one stupid big money wey politicians promise am.
He say for dat joinbodi meeting,him dey dia,Olamide and Wizzy dey plus oda pipo.
M.I say during di meeting na only Wizkis reject di big money wey dem promise.

Wednesday 13 February 2019

WIZKID DON ADVICE NIGERIANS SAY,MOST CELEBRITIES DON COLLECT POLITICIANS MONEY PUT FOR POCKET,MAKE U NO LET DEM DECEIVE U INSTEAD VOTE FOR WHO U BILIV SAY GO MAKE NAIJA BETA


Wizkid don call most of him fellow selibritis scam bicos dem don kolet politicians money put for dia big pocket to support dem.
Now he don dey beg fans of those kain selibritis make dem no jonz for di election mata wey dey ground and make dem no do follow follow but instead make dem vote for candidates of dis choice wey dem biliv say go make naija beta.
He say time don reach for us not to dey do follow follow but to use our brain.
Beta yarns Wizzy.

Tuesday 12 February 2019

NEWS WEY DEY REACH OUR TORi ROOM NA THE RUMOR SAY,2FACE AND ANNIE MARRIAGE DON DEY GROW K-LEG


Di way wey 2face dey write and delete tings for twitter konsigning marriage yarns don dey give him fans sleepless nights.
As if dat one no reach,even Annie Idibia him wife dey join dey write some kain tings wey dey worry dia fans.
Rumors dey come say dia marriage get problem but we Neva rili know weda truth dey di mata.

Monday 11 February 2019

SAD SUNDAY FOR CHELSEA FANS AS MAN CITY NEARLY BURY CHELSEA WIT GOALS AS DEM WIN DEM 6 KONDO


Manchester City don show say dia rise to di top of England football no be by luck as dem nearly use goals take spell Chelsea name.
Dem score Chelsea 6 wicked kondo and none of di goals sef be penariti. 
I no know wen Chelsea fans go rekova  from dis trashing bicos all Di players dey play like say dem soak dia legs for portorportor. 
Weda chairman Abrahimovic go tell him seketri to type sack letter today or he go sorry for Sarri wey be di coach, na dat one we neva know.
For now, make I go sidon for fence dey monitor my malam radio weda I go hia  any tori as e take konsign dis London club. 

Sunday 10 February 2019

APC NATIONAL CHAIRMAN ADAMS OSHIOMOLE DON YARN TORi PIPO SAY,BUHARI NA Di ONLY NAIJA PRESIDENT WEY NO PRIME MINISTER FOR BRITAIN DON CALL THIEF


Forma Edo state gofnor and prezent APC national chairman Adams Oshiomole don blast PDP say koroption dey dia blood.
He say na only Buhari naim all di prime ministas wey Britain don get neva call thief.
Akordin to Oshiomole PDP no dey dis class of beta leaders.

Friday 8 February 2019

HURRAY!!! AFTA THREE MONTHS,ASUU DON FINALLY CALL OFF DIA STRIKE MAKE UNiVASiTi STUDENTS FIT GO BACK TO SCHOOL


Di Academic Staff Union of Univasitis,ASUU don finally chop beans and rice for di same plate wit federa gofment as dem don call off dia strike.
Di union presido Biodun Ogunyemi naim announce dis one for Abuja yestaday afta dem settle dia money fight wit gofment.
Thank God,at lis our students fit dust di cobwebs wey don dey gada dem brain and go back to class and learn book.

Wednesday 6 February 2019

PDP MAN ATIKU WEY DEY TRY TO BE NAIJA PRESIDENT FOR NEXT WEEK ELECTION,DON CALL DAVIDO THE KING OF NIGERIA MUSIC


Abubakar Atiku di man wey dey try to bikom una president for next week election, don yarn tori pipo say, Davido naim be king of naija music.
He say wen him young him leg no dey comot for Fela shrine bicos Fela na di nomba one dat time but for now, na Davido dey wear di crown.
Davido imsef don thank Atiku as he call am di king.
Although many pipo don come out to say dem no surprise since Davido and Atiku na PDP dem two dey,dem get right to dey famz dem sef.

Tuesday 5 February 2019

FEDERAL GOVERNMENT DON ANNOUNCE SAY,BIFOR Di END OF THE YEAR, DEM GO STOP TO IMPORT OBODO OYIBO TIN TOMATOES ENTA NAIJA


Federal gofment don dey harsh anoda plan as e take konsign tomato farming mata.
Di minista of agriculture Mr Audu Ogbeh don yarn tori pipo during him visit to Dangote tomato processing firm for Kadawa,Kura local govment area for Kano state say,bifor di end of 2019,dem go stop to import obodo oyibo tin tomatoes enta di kontri.
Did one na to enkorage our own tomatoes wey we get for hia.
For di world,naija na numba two for tomato production.

Monday 4 February 2019

TUNDE TDOT,ONE OF THE MEMBAS OF THE GBEDU SQUAD 'STYL PLUS' DON YARN TORi PIPO SAY,GIRLS WEY GET BIG BAKASSI NO DEY TRIPAM



If you dey follow up,you sopose know the gbedu group 'Style plus' wey skata evriwia wit dia koret jams in those years wey gbedu wit yankee touch start for naija.
One of di memba of dat squad Tunde Tdot don yarn tori pipo say,di kain woman wey him like must get bakassi wey no too big and no too small.
He say girls wit big yansh no dey tripam at all.
Di bobo say,even bifor him marry him wife for 2010,he don dey avoid girls wit big ikebe like acid.
I biliv say Tunde dey speak for him sef not evribodi.
I know plenti guys wey fit die for big yansh mata.

Sunday 3 February 2019

IPOB OGA 'NNAMDI KANU' DON TELL TORi PIPO SAY NA CAMEROON ATIKU COME FROM BUT ATIKU IMSEF DON SAY NA BIG LIE


Nnamdi Kanu di IPOB Biafra oga,don yarn tori pipo say,PDP presidential pesin Atiku Abubakar na Cameroon man.
Nnamdi Kanu say di area wey Atiku come from for Adamawa state na inside Cameroon e dey.
But Atiku imsef don come out to say make Kanu shut up say y na big lie di man dey lie for him head.

Friday 1 February 2019

GHANA STAR ACTRESS 'YVONNE NELSON' DON SWEAR SAY,NOTHING GO MAKE HER RUN FOLLOW NAIJA MAN AGAIN AFTA IYANYA TAKE HER HEART ROB GROUND


One of Ghana top actress Yvonne Nelson don swear say ova her dead bodi say she date Nigeria man again afta wetin she don pass thru for dia hand.
Di mother of one say she dey find new boyfriend and she go prefa Ghana man.
If you dey follow up,you go notice say no be small ting iyanya use di girl heart see as he break her heart afta di girl don fall in love witam.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...