MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 30 July 2014

GOVERNOR ROCHAS OKOROCHA DEY RIDE BICYCLE WITH POLICE ESCORT

GOVANOR ROCHAS IS RIDING A KEKE
Exercise good welwel for bodi.
E go make yor bodi strong kakaraka,e go make u no dey sick anyhow,e dey build yor muscles,e dey build yor brain,e fit make orobo turn lekpa,e dey make yor brain dey sharp welwel,e dey reduce stress,exercise dey drive sickness and do plenti oda tings for our bodi.
To dey ride keke na gud way to take do exercise,even kpakpa sef u fit use am make money bicos pipo like di Americana,Lance Armstrong,use keke-riding take make millions of dollars. 
Sake of bodi to dey gidigba naim make di Govanor of Imo state,Rochas Okorocha carry keke enta road go practice and do exercise in oda to keep fit and less im big belle.
Na for inside twitter naim Rochas put di pishor of how im dey exercise wit keke bicycle but one tin wey soprise pipo be say police escot van dey followam for yansh as e dey ride di keke.
Rochas yarn for twitter say "my pipo,my pipo,I dey kip mysef strong kakaraka,hope say una dey do exercise make una bodi dey kamkpe too?"
E be like say no be onli exercise Govnor Rochas dey do,I sure say im also dey practice to run for next year tour de france di nomba one keke race wey dey shele for France and maybe to sell ice cream wit keke wen him tenior don end as di Imo state ogakpatakpata nomba one.


Sunday 27 July 2014

BLESSING OKAGBARE DON GET BLESSINGS FROM USAIN BOLT PAPA AND MAMA TO SHINE FOR COMMONWEALTH GAMES.

OKAGBARE POSE WITH USAIN BOLT POPSIE AND MOMSIE

Wot eva love and blessings wey di world record holder for both 100metres and 200metres Usain Bolt get from im paale and maale wey make am dey tear race like okada,Naija runner Blessing Okagbare feel say she don resiv dat kain blessings from dem as she take pishor with di old boy and old geh wey bring Usain Bolt come dis world.
Okagbare meet Usain Bolt pileh and mileh for Scotland wia dis year commonwealth games for dey shele.
She put di pishor for her facebook page and she tok say she dey veri veri happy say di popsie and momsie of a big name, a legend,Baale of athletics Usain Bolt take notice of am.she say she dey veri proud and dis one na blessing to ram.
Naija put hope for Okagbare shoda welwel as na one pesin wey we biliv say he go make us proud espeshally as di main babe wey dey giv her headache Shelly-Ann Fraser Pryce no attend dis games.
BLESSING OKAGBARE
Okagbare go represent Nigeria for 100metre,200metre,long jump and relay for Glasgow,Scotland and she go try to follow di footstep of Mary Onyali for Victoria,Canada,1994 wey win 100 metre Gold,silver for 200metre and Gold for 4X100metres relay gold wit new commonwealth record of 42.99seconds.
If una rememba for Friday Novemba 9,2007,na Abuja naim Glasgow difit to host dis games.
Na 71 commonwealth memba kontris  vote for di join bodi wey dem do to announce di winna for Sri lanka.
47 kontris vote for Glasgow,Scotland why 24 kontris vote for Naija.
Di commonwealth games na for kontris wey England colonise and na evri 4 years e dey hapun.
Dis year games stat for July 23 and go end for 3rd August,2014.

SOUTH AFRICA DON CHOOSE SON OF THE SOIL EPHRAIM MASHABA AS DIA NEW COACH



 

KESHI


 Dem say di devil u know is beta dan di angel u don't know as South Africa futbol assosiashun,SAFA, yestaday don choose di angel wey dem know Ephraim Mashaba and scata di hope of Stephen keshi to coach di bafana bafana.
Keshi as many tori pipo don report for di past 3 months dey eye di hot seat for Sauti as e imsef don even yarn say e dey posible say e fit leave di super eagles job and go work for South Africa.
But yestaday,SAFA choose Mashaba wey e guy name na "Shakes".
Mashaba don coach Bafana bafana 3 diferen times b4 and naim be di present coach of dia Under 20 nashona team wey dey Mali presently for training wit di team.
No be onli Keshi South Africa bin dey eye for di post bifor as forma Manchester united assistant to Alex Ferguson and di present Iran coach,Carlos Queroz naim get di brightest chance pass for di job but di salary wey him want big pass wetin SAFA get to pay.
Di gud news for Keshi be say,although him kontrat don finish wit Super eagles afta di world cup for brazil,but NFA executive comiti don announce for di small join bodi meeting on Monday for Abuja wey dem take impich and sack dia chairman,Aminu Maigari,say dem go soon stat to negoshate wit Keshi to renew im kontract.

Wednesday 23 July 2014

SORRY ARSENAL FANS,LIONEL MESSI NEARLY PLAY FOR ARSENE WENGER LAST SEASON.



If you like call Arsenal 'Top 4 team' but di tin be say 4 time world futbola of di year and di best playa for Brazil 2014 world cup akordin to FIFA,Lionel Messi don tok say,Barcelona get luck,im for sign for arsenal last year.
He say like say Barca kontiniu dat dia shakara not to inkriz im salary,notin for make am no sign for Arsenal futbol club akordin to VOZPOPULI one ogbonge website wey dey for inside Spain.
Yes o!akordin to VOZPOPULI,Messi beg forma Arsenal captain,Cesc Fabregas make he yarn him agent,Darren Dein to arrange him waka to Arsenal but e be like say Barcelona hia di rumor naim dem quik quik giv Messi di salary wey di soca magician ask for.
Arsenal bank account for hear nwhi bicos di money wey Barcelona put for Messi head na 197 million pounds if u won buy am and na smol tin all di moni wey Arsenal don spend for dia history take pass dat moni.
But as di mata be now sha,di small engine big motto for world futbol,Lionel Messi dey on a salary of 16 million pounds a year kontract for Barcelona.

Thursday 17 July 2014

OJUJU CALABAR DON CAUSE DI DEATH OF ONE 5 MONTHS OLD PIKIN.


 
 No be small tin o,as one masquarade don cause di death of one pikin for  Amakohia Ubi, Owerri West Local Government Area of Imo State.

As di masqurade dey pursue one 10 years old geh wey carry di pikin,she kon run enta backyard but eye of fear,naim di geh trow di 5 monts old pikin for inside 'mama put' pot of soup.
Akordin to Chika,one woman wey see evrytin as e take hapun,she say as di ojuju man see say di pikin don draw for di geh hand enta put of soup,naim e take yawa race.even di geh wey carry di pikin,fall yakata for near fire and na smol tin remain fire for roast her like corn and ube.
Although sha,di villagers try to reskiu di pikin but as dem rusham rich hospito,dokita kon tell dem say di baby don already kpeme.

Sunday 13 July 2014

MESSI NEVA PLAY ANY BETA BALL FOR DIS WORLD CUP-GARY LINEKER OF ENGLAND

LIONEL MESSI




One of di stars of Italia '90 world cup,Gary Lineker of England don yan say 4 times world futballar of di year,Lionel Messi of Argentina neva play any beta futbol for dis world cup wey go end for Brazil today.
He say tho Messi and Argentina don qualify to play Germany for today final but di bobo neva impress at all apart from di bigining of di world cup wen dem play Bosnia,Iran and Naija.
Lineker say im na Messi nomba one fan and e neva see pesin wey get swit talent richam since afta Maradona.
Gary say he chop plenti colanut make sleep no katcham and e shine im eye welwel watch Messi for dia semi final match against Holland and di only time wey Messi leg toch ball for di goalkipa area na wen e play penarity.Lineker say no be di Messi wey him know be dat.
He say tho Messi don skor 4 goals wen di world cup fest stat but all di smol beta tins wey Argentina play for di match against Holland,Messi no dey involve for any one.
He say anyway sha,if Messi win di world cup e go hepam for di argument of who beta pass bitwin Messi and Maradona.
GARY LINEKER

Gary Lineker also tok say na Maradona be di best playa wey im don play against wen im stil dey tap leather.Lineker say as Maradona shot rich,di kain chocolate futbol wey di guy play no be here .




Saturday 12 July 2014

CRISTIANO RONALDO BEAT LIONEL MESSI

CR7
Messi fit don qualify to play for di final of dis year world cup for Brazil but Messi moni dey learn for wia di kain moni wey Ronaldo resiv last year for all mata like adverts,salary and all oda gbogboyen.
Akordin to Forbe richest list of sports pipo,one ogbonge magazine wey di hole world dey respet,na only one bobo naim im moni long pass Ronaldo own and dat bobo name na Floyd May Weather Junior.
May Weather na one wicked boxer wey no dey use eye see im felow boxer for inside boxing ring.im blow plenti boxers face swell up and blood even dey rush for some nose and dia eyes.di true tori be say nobodi don defeatam once since e stat to fight. 



FLOYD MAYWEATHER


If u won know di list of di richest sports bobo for di hole of 2013,checkam for bottom hi

  RankNamePay
  #1Floyd Mayweather$105 M
  #2Cristiano Ronaldo$80 M
  #3LeBron James$72.3 M
  #4Lionel Messi$64.7 M
  #5Kobe Bryant$61.5 M
  #6Tiger Woods$61.2 M
  #7Roger Federer$56.2 M
  #8Phil Mickelson$53.2 M
  #9Rafael Nadal$44.5 M
  #10Matt Ryan$43.8 M.

NA ME GIVE MY SINIOR SISTER BELLE BUT NA BY MISTAKE-SHAMSU ISA


One bobo don enta big wahala for kano as e dey tochlite im sinior sista website steady and dis tochlighting don result to belle.
Shamsu Isa,one 25 years old man for Kano don yarn say she giv im sinior sista belle but na by mistake and di handwok of di devil.
Isa tok dis one for court for di mata wey one area fada of Takalmawa quatas report to police on july 4,say e suspect say Isa dey tochlite im sista website.
Isa nor drag all di tins wey dem accuse am of for court as im gree say na true say im giv im sinior sista belle and she dey carry dia baby but im be no mean to giam belle,na one smol tinrinrin mistake e take hapun.
Akordin to di tori,Isa Shamsu sinior sista wey her name na Naima Isa,get smol skonskon for head.she get fish brain and her mind weak finish.she no too complit for tinking and Isa kon take advantage of her fish brain dey sleep witam anyhow.
Di pesin wey dey incharge of di case,Corporal Ibrahim Abdulrazak kon beg court make dem postpone di case so dat police go fit complit di investigashon.
Di judge of di court,Ummi Sani Kurawa,say make dem stil kip Isa Shamsu for prison til wen dem go siddon for di mata again for court on August 4.

BURNA BOY DON SACK HIM MAMA AS HIM MANAGER.

BURNA BOY AND HIM MAMA
Burna boy one of di miuzishan wey dey reign scata for Naija right now,don yarn anoda one again.
Di bobo wey sing dat crazy jam"Like to party" wey plenti bobos and malawis love finish,don announce on top twitta say time don rich for him mama to chill to enjoy di fruit of her labor.
Burna boy mama,Mrs Bose Ogulu wey be him manager since di bobo show face for Naija miuzik,naim dey take kia of how much pipo go pay to fit carry him pikin for show,look for bizness for her pikin,market her pikin,run di day to day bizness and oda mata wey manager dey do.
But now Burna Boy don say"Ha! Mummy dis wok dey make pesin dey quik old,just chill for house and enjoy yor sweat,u don try welwel.anytime wey I won suck breast I go come house,u are my Sweet Mama for life".
Dis bomboy from River state Burna Boy tok say,witout him Mama,im for neva rich wia im dey today.
Di Afro dancehall reggae miuzishan also tok say time don rich for im manager to be im manager and time don also rich for im mama to remain as im mama.
He say from now on,if u won bookam for any show or any oda impotant mata,make u richam for dis address burnaboybookings@gmail.com and just 2 weeks ago di bobo just release one new muzik wey im call Don Gorgon.

Wednesday 9 July 2014

ETIM ESIN SAY MAKE MIKEL GO WATCH ORIGINAL NUMBER 10 "JAY JAY OKOCHA" VIDIOS TO LEARN FOOTBALL

MIKEL OBI
Forma Nigeria intanationa futballer Etim Esin don yab crase comot for Mikel head bicos of di pregnant woman futbol wey di bobo play for dis year world cup for Brazil.
He say for dis Brazil world cup,Mikel na big disgrace to imsef and di numba 10 jesee bicos he dey run like confuse man for fid and he wonda why dem dey allow ram wear nomba 10.Weda na Akara Mikel go fry for Brazil or na ground nut he go select we nor kon know.
Nowadays goalkeepers dey close dia eyes if Mikel hold ball bicos dem know say he canot skor.
Etim Esin say yor name must be Mikel if as a nomba 10 u no fit try goalkeeper wit shot sometimes or even kpakpa sef skor goal.
Etim say check out No 10s from oda kontris like Messi,Sneider from Holland,Neymar and even sef dat smol rat from Colombia James Rodriguez wey skor 6goals for dis world cup and Mikel no even try any keeper oddnary one shot.even kpakpa sef Abedi Pele pikin,Andre Ayew skor 2goals out of 3 match wey Ghana play but Mikel own tire ram.
ETIM ESIN




Etim Esin say Mikel try for South Africa 2013 nations cup but he fool imsef welwel for Brazil.
He say im no get anytin against Mikel o bicos im dey among di fest pipo wey praise Mikel wen he stat to play for Nigeria say,he go bicom a veri wondaful player but rite now he sorprice say Mikel just dey play robish.
He also tok say wen Osaze and Musa dey busy dey take freekicks and kona kicks,Mikel own na to dey trek for field.
Etim Esin kon give Mikel one advice say make e try go watch di vidio kaset of Jay Jay Okocha and Henry Nwosu and even im sef to learn how numba 10 dey play ball.

Tuesday 8 July 2014

ARM ROBBERS DON ROB 5.8 BILLION NAIRA FROM SAMSUNG FACTORY FOR BRAZIL

Apart from futbol skill,Brazil pipo don show say dem get arm robbery skills full bodi and dem don show say dem dey multi talented for plenti tins.
Just yestaday for Brazil,20 arm robbers break enta Samsung phone factory, tiff ova 40,000 fones,laptops and oda eletronics.
All di tins wey dem tiff full seven trailers.
Dem say if u dey dia,u go fil say na action film dem dey shoot but film trik no dey dis one.
Na 12 midnite naim di Jankolikos take brake enta di factori wey dey sampinas near Sao Paolo and tiff propatis of ova Five point eight billion naira(5.8billion naira).
Akkordin to di police for di area,wen di arm robbers enta di place,di fest tin dem do na to use dia Ak 47 guns bail up and soranda all di gate men and ova 200 workas and take dem sleep for ground say, "if dem try any robish or move,dem go kill all of dem like fowl".
Di robbers dress like di workas and kon even put  di Samsung company id badge for dia shirt take do cova up enta di factory.
Di operashon last for ova 3 hours and di way wey di jankolikos take know wia dem kip all di phones and laptops make pipo dey suspect say somebodi wey dey work for dia,na informa to dem and he know about dis operashon.
Samsung tok say nobodi die for di operashon sha and nobodi injor and di company dey corprate wit police for di investigashon.
Brazil na one place wey poverty take hand toch ground welwel and majoriti of di pipo gada togeda and protest against di big moni wey govt spend for dis year FIFA world cup wey dey shele for dia kontri rite now and go soon end.
Brazil go play Germany and Argentina go play Holland for di Semi Finals to know who go play for di final for july 13,2014.

DI GIRL WEY DEM CLAIM SAY DIE FOR EJIGBO PEPPER TORTURE MATA,NEVER DIE

EJIGBO TERRORISTS













Dat geh Juliana Agoma wey di hole world report her stori of how dem take pour grinded pepe for her website for Ejigbo,Lagos,no die aftarol.
If u rememba,di vidio of how market agbero take torture Juliana and her sista and her mama,come out for intanet and plenti pipo watcham.
Dis vidio wey nor swit for eye at all at all,hapun for Oba Morufu Market for Iyana Ejigbo,Lagos last year Febuary but na dis year January naim evritin wey hapun,come out.
Di lida of one assosiashun wey stand on dia own witout govament soport,Joe Okei-Odumakin,wey di name of her assosiashun na ''Women Arise For Change Initiative'' naim carry di mata for head say govment must arrest di pipo wey giv di gehs dem and dia mama beta beating and also put plenti pepe for dia website.
Many tins don hapun since di day wey dis mata hapun til today as police don arrest 8 pipo including one woman di Iyaloja of Iyana Ejigbo Market and di mata don dey court alreadi.tho sha dem stil dey find four pipo wey get hand for di mata.
But di new tori now be say,di geh wey dem put almost 200 naira pepe for her website no die even tho na wetin tori pipo report bicos na wetin dem hear be dat.
Akkordin to one family memba,he say dem force dem make dem tok say,dia sista don die from di injuris wey she get from di beating.
Di pesin wey dey represent police for tori mata,Frank Mba,tell tori pipo say,govment send policemen from the Federal Special Anti Robbery Squad go her town for Tchaada community for Ifaguin area of Benin Republic but dem no see wia dem tritam wit native merisin bifor dem claim say she die and even her grave sef dem no see.dem also visit di police stashon for Tchaada but her dead bodi file and statement no dey dia.
No be onli dia dem waka go as dem also carry waka go meet di tradishona rula,di Baale of Juliana town and di Baale kon confirm say Juliana stil dey alive.
Di Baale kon even invite Juliana twin broda kon palace for intaviu and di broda kon confirm say truetrue say her sista dey alive and she dey stay anoda nearby village.
Mr Mba say dem go dey disiv demsef,disiv di pipo and di law if dem charge di 8 pipo go court for killing and meanwhy no evidence of dead bodi.
Now sha ,Mba say dem go take dem go court for "trying to kill pesin'' and dat one sef na heavi offense.

Saturday 5 July 2014

GOTV DON SIGN JOHN OKAFOR AKA "MR IBU" AS FACE OF GOTV


MR IBU
Big name for home vidio mata,Mr ibu John Okafor don hama anoda one again as GOTV di ogbonge cable tv pipo don make am dia korect bobo nomba one.
JOHN OKAFOR
Mr ibu di Nollywood mumu,don use im mumu take dey put plenti korect food for im table and put plenti moni for im bank account why many guy men wey dey form fine boi no pimples,dey drink garri sleep witout shuga and milk.
So if na shit u dey pack make u packam well,if na gutta u dey dig make u digam well.if na kponkpo u dey carry make u carryam well bicos anytin can hapun.
Akkordin to di kontrat wey Mr Ibu sign with GOTV,he go dey appia for dia adverts,dia party and any impotant join bodi wey dem won do.
Di rison why GOTV appointam akkordin to di  General Manager of GOtv Nigeria, Elizabeth Amkpa, bi say di bobo sabi make pipo laff welwel and he fans plenti welwel bicos dem bilivam finish for di wok wey im dey do.
GOTV also biliv say dem go gada plenti costomas wit im face and dia bizness go dey grow.
No be only GOTV don sign dis kain kontract wit Mr Ibu as GLO signam too for june to be dia persona pesin.
Naija,una no biliv say Ibu need manager wey go hepam dey manage dis moni?



BRAZIL WONDA BOY,NEYMAR,NO GO PLAY FOR DI WORLD CUP AGAIN.

INJURED NEYMAR
Di golden boy of Brazil footbol,Neymar no go play at all again for di remaining match wey Brazil go play b4 di world cup go end on di 13 of july,2014.
Colombia playa,Juan Zuniga,naim brake Neymar back bone wit im kung fu fotbol durin di quata final match bitwin Brazil and Colombia for dis year FIFA world cup wey dey shele for Brazil gon gon gon.
Neymar don alreadi skor 4 goals for dis tonament as im skill don let dem quolify for di semi final but dem get to beat Germany to fit enta di final.
NEYMAR
Among di kontris wey remain for di world cup,na onli Holland and Costa Rica naim neva win di world cup b4.Brazil don winam 5 times,Italy don winam 4 times and Germany don winam 3 times.

Friday 4 July 2014

PHYNO SAY MUSIC LANGUAGE NA "GET UP AND DANCE"

PHYNO
Di King of ibo rapping,Phyno,don yarn say miuzik no dey hear italo,e no dey hear urhobo,e no dey hear ibibio,e no dey hear portuguese.e say di onli language wey miuzik dey hear na 'get up and dance' espeshiali if e sweet welwel.
For all ova di world plenti pipo fit die for makossa miuzik mata even tho dem no dey hear wetin dem dey tok but dem dey enjoy di melody.
Phyno tok say di South Africa jam, 'Khona' wey Mafikizolo sing,na one of di most popula jam since last year enta dis year and Naija pipo no dey hear dia language and dem no dey hear wetin dem dey sing about but we like di miuzik die.he say na di way u dropam naim mata.
Phyno don sing many beta jamming jamming wey make plenti pipo like am for Naija.many aboki like am,pipo for Benue like im miuzik,for Jos nko?dem like im miuzik,for minna dem like am.
Most of dis pipo no dey hear ibo but dem dey enjoy di way wey di bobo take dey rap fire.
Phyno say,make e no lie sha,im fear di fest fest time wen he stat to rap for ibo language,but now God don ansa im prayer.evrytin don sengemenge.
Di bobo don sing plenti beta miuzik like Parcel,Alobam, street miuzik,Obago, Man of the Year,Ghostmode wey im join bodi do wit Olamide and di one wey illbliss putam 'AmachiKwanu'
Rite now,Phyno and Olamide dey collabo to do one album togeda and dem go soon finish di wok.
Shay u trust dis bobos say dem go diliver?

Wednesday 2 July 2014

MARADONA SAY ONAZI ENEMY,MATUIDI, WORSE PASS SUAREZ THE BITER.

STUPID TACKLE
Maradona don blast FIFA,Pele and Beckenbauer  say,as Matuidi don injor Ogenyi Onazi for ground,shay dem don quiet dia mouth like say dem use evostic gum dia mouth.he say dis dis two old papa and FIFA get big mouth to tok robish evritime but wen dem sopose yarn dem no go hear dem yarn.
Maradona say di kick wey di bobo wey dey man France midfield,Blaise Matuidi troway give Onazi worse pass di bite wey Luiz Suarez bite Giorgio Chielini during di world cup match wey Italy and Uruguay play for Brazil.
Many pipo curse Suarez welwel bicos dis nor bi di fest time wey Suarez dey bite since e stat to play profeshona futbol.dem even say e be like say na di same skul im and Clifford Orji attend.
MARADONA

Now Maradona don say make pipo forget Suarez bite,even tho FIFA ban am for 4 months,na Matuidi kick naim bi di real crimina offense and dem soppose to givam beta ban.
He say Matuidi nor go for di ball at all.di way wey im take go for Onazi leg just be like say na grasscutter naim e won kill.robish futbol!
Upon di wicked kick on Onazi,na ordinary yellow card naim di Ogogoro referee from Amerika giv Matuidi and dis one vex Maradona welwel.
Matuidi don alreadi apologise to Onazi say make e no vex say na di handwork of di devil.
France go play Germany for quatafinal as dem later beat Nigeria for di match 2 kondo afta Onazi injor.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...