MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 27 May 2015

WIZKID POSE WITH HIN N8 MILLION POWER BIKE

Money good o
See Wizkid dey flenjor wit hin pawa bike wey dem say na 8 milion naira dem dey selam!
Starboy tins.
Expensive abi?
Dis him expensive pawa bike showface some few days afta Wizkid release him new miuzik,'Expensive Shiit'.
But wait o!
Dis pawa bike no too big for dis bobo so?
We no won hia tori afta about dis ovaload  bicos na so my broda dey complain plenti years ago say hin pawa bike dey fall press am evritime.
Nobodi tell my broda say 'okokobioko' na noun bifor he rush selam troway.
I go siddon dey look.
I wish him and he new dog luck.

.

Thursday 21 May 2015

CHINEKE!!! SEE AS OBAMA TAP HIM WIFE YANSH!

Di most pawafu man for di world,America presido,Barrack Obama no send anybodi message o!
Check out dis pishor below as he tap him wife,Michelle yansh for public.
No be say e concern me sha o but i just say make i let my pipo know wetin dey pipeline.
But come o,
Wetin Obama bin dey tink?
He feel say he wife yansh na drum wey dem dey beat?
Obama you be drummer boy or drama boy?



Wednesday 20 May 2015

MY WIFE NA VIRGIN BIFOR I MARRY AM - OSHIOMOLE


Govnor Oshiomole of Edo State wey just marry one new sugar peperenpe,don kontiniu to tell di world some secret wey nobody askam.
Di forma NLC presido yarn say,him new wife, Lara Fortes, na virgin and nobodi don visit her website bifor he meet di shenkez.
He yarn all dis one for di wedding thanksgiving service wen he dey teach and talk sense enta di head of di youth membas of di church make dem no dey use dia John Thomas and tomato do bad tin bifor dem marry.
He also teach dem make dem run far from anytin corruption.
During dis yarnings,Oshobaba boast say,naim be di fest pesin wey torchlight hin new wife website and he want make di youth dem learn how to keep dem sef holy until di time don reach instead make dem enta town dey sleep around.
Make i tell una sometin.
Na rumors Ooo!
Rumors wey dey reach our tori room be say,dem say Oshiomole buy di girl Palleh and Malleh private jet make dem take jolly sake of say,dem train dia pikin veri well and dem no allow anyboy dance awilo near her website.

Tuesday 19 May 2015

DAVIDO DON GET HIM FIRST PIKIN


Naija star,Davido,don welcome im first pikin and di pikin na baby girl.
Alltho, as at wen dis tori enta our news room, Davido neva talk anytin concerning dis baby or di babe,Sophie Momodu wey born di pikin.
Di pesin wey first talk and congratulate Davido,na Dele Momodu di owner of Ovation magazine.
Dele Momodu and Sophie Momodu na cousins and Dele kon send congratubia message to him cousin and Davido for dia new born pikin for inside instagram thru enjoygram.
Di question wey pipo dey ask now be say,so, Dele Momodu dey happy now say small boy Davido,give him cousin,Sophie belle witout bride price and marriage? 
Davido na 22 years and Sophie na 28.
For naija nowadays,our miuzishans no send marriage again even wit dia plenti moni as na baby mama dem dey get now.
Wizkid get baby mama,Ice prince get mama,Flavour Nabania get babay mama and rumors wey we dey hear now be say anoda girl,forma miss Nigeria,19 year old Anna Banner, don carry belle for Flavour too.
Chai!
Badoo,Olamide,get baby mama,May d get baby mama,2face nko?
He get plenti baba mama bifor he kon finally marry one of dem,Annie Macaulay.
And now Davido don join di baby mama owners club of Nigeria.
I go siddon dey wait to hear wetin Davido  go talk.
Weda he go deny di pikin and di mama or him go gree say dem be him propati.
Sidon look na dog name.

Tuesday 12 May 2015

CHAi !!! NIGERIA DEBT DON HIT N12 TRiLLiON NAIRA


Di money wey Nigeria dey owe thru borrow borrow,even kakulator no fit kakulate am again.
Di kakulator wey my oga try to use for office to konvat di N12.062 trillion to dollar,explode for hin hand and katch fire!
If u be pesin wey dey follow Naija mata welwell,u go know say for di 1990s,our debt no plenti at all.
Wich way democracy?
Dis 12 trillion naira,na money wey Naija dey owe as at march 31,2015 and i know say e go don rise welwell by now.
We stil dey wait for di latest data from the Debt Management Office (DMO) for di month of April and dis month to know how much he don enta.
My queshon now be say,
Wetin dem borrow all dis money take dey do?
Our refineries no dey work.
even student no dey gree carry excursion go our refineries again bicos notin dey appun for dia.
No good roads,potholes,potholes full evriwia, school fees dey inkriz evriday, our doctors dey strike anyhow,Agege bread sef don cost.
Kpomo wey plenti pipo take dey see front even tho say e no dey give anytin for bodi,don cost die.
Na yahoo-yahoo most of our graduates dey do afta school bicos no work.
Di ones wey gofment manage give job,dia salaries dey smell bicos e no reach pinch.
NEPA dey one side dey crase dia own.
No need to talk about fuel skasiti bicos,to look for needle wey fall for inside river, dey easy to see, dan to see fuel buy for filling station nowadays.
Na wa o govment.
Wich way Naija?

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...