MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 31 May 2017

NEW SUPER EAGLES PLAYER, OLARENWAJU KAYODE,DON WIN BUNDESLIGA PLAYER OF Di YEAR FOR AUSTRIA


Forma Flying Eagles playa and now New Super Eagles playa,Olarenwaju Kayode,get plenti reason to selibrate as dem don choose am as di playa of di year for Di Austria Bundesliga League base on di way wey di bobo take paform for him club.
He score 17 league goals for hin club Austria Wien,5 Europa league goals,2 for di Austrian Cup and evritin total come be 24 goals.
Congratulations Kayode as we dey wait weda one big Europe club go come pincham take from Austria Wien.

Tuesday 30 May 2017

WITH 30K,YOU GO FIT BUY YOUR OWN HOUSE AND BECOME LANDLORD FOR NIGERIA NOW ACCORDING TO YEMI OSINBAJO,OUR ACTING PRESIDO


Politicians don come again and dis time around,na Yemi Osinbajo be dia piano.
Akordin to Osinbajo wey be our president until Buhari return from di sickness wey he go trit,if you get 30k,you fit be your own landlord bicos dem don dey save plenti money since to take make am appun.
He say dis one na big sikrit and dem don alreadi start dis 30k house mata for 11 states for Naija.
Osinbajo u for try mention di state so dat tori pipo go do dia investigation.
Di 5k for pipo wey nor get work wey una promise,I nor know anybodi wey don collect.
I hope say dis one no be craze man talk?

BARCA FANS,SEE UNA NEW COACH


Fc Barcelona of Spain don get new coach for dia next season.
Hin name na,Ernesto Valverde,forma Olympiocos and Valencia coach wey just step down as coach of  Athletico Bilbao last week.
Ernesto naim go handle all Barcelona football war wit oda teams from next season.
Di kain qualiti and serenren playas wey Barca get,if Coachee nor dey bench sef,dem go stil win cup.
Anyway,kongratulation to Ernesto Valverde.

PIPO WEY NO DEY DO KEREWA ALWAYS,SMALL TING LIKE DIS DEM DON PARA ACCORDING TO FORMA BIG BROTHER AFRICA MEMBA,BEVERLY OSU



Forma Big Broda Africa memba,Beverly Osu,don yarn on top her Snapchat page say,pipo wey no dey involve diasef for kerewa always dey always vex ova stupid tins.
Na wa o.
Dis babe don turn kerewa mathematician and adviser.

Monday 29 May 2017

PDP CHIEF BODE GEORGE,DON YARN SAY,TINUBU PUTAM FOR PRISON FOR NOTHING DAT TIME WEN HIM BE OGAKPATAKPATA FOR NIGERIA PORTS AUTHORITY (NPA)


Bode George,National PDP chief,don yarn tori pipo say,Bola Tinubu and some oda pipo troway am Put for prison for no reason.
Bode George wey also be forma khaki Gofnor of Ondo state say all di wahala wey him be di Oga of NPA,Tinubu dey among di pipo wey put fire.
He say although him and Tinubu no dey quarel but he just want make di young ones undastand wetin appun dat time so dat dem fit learn fromam.

Sunday 28 May 2017

AMERICA COURT DON TELL BURNA BOY SAY DEM NOR WON SEE AM COME SING FOR AMERICA AND CANADA AGAIN UNTIL HE SETTLE WIT PROMOTER WEY HE DISAPPOINT


One court for America don ban Naija singa Burna Boy say make dem no katcham dey sing for any wia for Canada or America afta he fail to show face for di show wey dem pay am to go play.
Vibesland Entertainment,LLC naim dem carry go court and dem claim say dem spend ova N8 million for di arrangement but Burna Boy nor fall dia hand.
Akordin to di court,until Burna Boy settle wit Vibesland,he nor fit paform for any wia for America or Canada.

Friday 26 May 2017

DAVIDO DON PUT ONE SMALL PIKIN FOR SCHOOL AND ALSO PROMISE TO TAKE CARE OF AM FOREVA AFTA HE HEAR DI BOY SING HIM SONG,'iF'


God favour don smile on one smallie for Ibeno,Akwa ibom afta one bros post him video of wen he dey sing Davido jam,if.
Davido don promise to train di boy foreva as di boy don alreadi start school.
Dis Davido use style good sha.

Thursday 25 May 2017

DIA FRENDSHIP DON END AS KCEE DON TALK SAY,WEN HE WIN Di STAR QUEST SINGING COMPETITION,HARRYSONG STILL DEY VILLAGE DEY FORM LOCAL CHAMPION


Today quarel,tomorrow dem settle,next tomorrow anoda quarel.
Dis na how two frends Kcee and Harrysong mata don be nawadays.
Dem be spend good times togeda for Five Star music but evribodi don dey cane hin own line afta Harrysong bodi language show say him mind no dey wit five star music again as he don form hin own kompini,Alter plate Records.
As if di mata neva rish,Kcee don yab Harrysong say,wen he win star quest singing show,Harry still dey village dey form local champion.
He yarn Moet Abebe on top one radio show all dis ones and right now we dey wait for wetin Harrysong ansa go be like.

Wednesday 24 May 2017

ONE IKORODU COMiNiTi FOR LAGOS,DON TIE JUJU FOR NEPA POLE SO DAT NEPA PIPO GO FEAR TO CUT DIA LIGHT


Wetin remain to see again for dis world?
Pipo don dey provide answer to nepa madness on dia own as some pipo for Oluodo kominiti for Igbogbo,Ikorodu,Lagos don tie juju for nepa pole so dat dem no go carry ladder to cut light for dia area again.
Na Ikeja Electric Plc na dem post di pishor on top dia Facebook page.
No mata how nepa man chop belleful rish,fear no go let dem climb dat pole.
Na dis one dem dey call real sef defense.
Trust nepa,I know say dem no go give dem light again for dat area until dem remove di juju.
God hep us.

CHECK OUT Di SOUTH SUDAN BABE WEY HER SKIN COLOUR NA PURE CHARCOAL BLACK


Black as dem talk am,dey veri veri biutifu.
Africa don produce some wondafu models and di latest wey dey trip pipo right now na Southern Sudan model Nyakim Gatwech.
Di babe black nor be small and di world dey on her mata siriosli.
Her blackness dey veri dark sotay,she rezembo biutifu night.
Check out more of her photos for hia..

Tuesday 23 May 2017

MINISTA OF PETROL IBE KACHIKWU,DON YARN SAY,HIM GO RESIGN IF NIGERIA STILL CONTINUE TO BUY FUEL FROM OBODO OYIBO AFTA 2019


Ibe Kachikwu di minista of petrol,don yarn tori pipo say him go run live him office and resign if we kontiniu to import fuel from abroad afta 2019.
During di joinbodi intaviu wey him do wit BBC world service program,Hardtalk,wit Stephen Sackur.
Akordin to di minista,he say gofment dey do efritin posibo to make sure we no dey buy fuel from outside Nigeria again.
Dis our politicians too like wahala talk.
Wen 2019 reach now,him go say he no talk say him go resign,na we nor hear well.
Na dis same Kachikwu announce di inkrizment of fuel from N86 to N145 and he also yarn say afta six months fuel price go start to come down.
One year afta dat announcement,many petrol station don even dey sell fuel for N150 and above.
Make God no let una sell dis kontri one day.

NEW TORi: GOVERNOR FAYOSE OF EKITI STATE DON BUY HUMMER JEEP DASH HIM BROTHER ISAAC AS BIRTHDAY GIFT


Ekiti pipo wia Una dey?
Una gofnor Ayo Fayose don buy hummer jeep for him broda Isaac as birthday gift.
I hope say nor be una millions he use take buy am?
Nice one.
Di same Fayose share 10 10 naira cheese balls give shidren last month afta dem shout him guy name 'oshoko'.
We also hear say he share bag of rice give some pipo some months ago.
Wen famili gift large pass di state pipo gift,naim be say water don pass garri.

Monday 22 May 2017

WIZKID DON BECOME Di FIRST NIGERIA MAN TO WIN BILLBOARD MUSIC AWARD AS HE WIN FOUR AWARDS WIT 'ONE DANCE',THE JOINBODi SONG WIT BIG NAME RAPPER,DRAKE


Wizkid don bikom di first Nigeria man(di first Africa man) to win Billboard music award.
He win four award wit di song 'One dance' wey he joinbodi do wit Kyla and Drake.
Dis boy awards go soon full drum.
Dem choose 'One dance' for seven katigori but e still manage to win four award.
Wizkid first intanashona album 'Sounds from the other side', go drop by June akordin to tori wey we gada.
Congratulations Baba nla on top dis ogbonge Billboard awards wey you win for obodo oyibo.

Sunday 21 May 2017

REVEREND DONALD TURAGHA OF Di ANGLICAN CHURCH,DON GIVE OGBONGE ADVICE SAY,IF YOU MARRY ONLY ONE WIFE,YOU GO ENJOY LONG LIFE


No be evri time u dey see pipo wey dey give koret advice o.
Reverend Donald Tulagha of di Anglican Church wey get 11 shidren from different women,don advice pipo make dem marry only one wife if dem won enjoy long life.
Di Bayelsa state born man,yarn tori pipo dis one as him dey selibrate him 80 years birthday.
He say bifor he turn Christian,he dey sleep wit diferen woman and dat is why oda women born foram.
Afta he kon get sense,Di wife wey him marry born seven shidren for di marage.
Di reverend say dis tins no gel as you fit die quick bicos of too much wahala if you marry plenti wifes.

Saturday 20 May 2017

BIG BROTHER NAIJA MEMBA,TBOSS,DON SWEAR FOR PIPO WEY DEY CURSE HER MAMA SAY DEM NO GO EVER GET PIKIN BICOS HER MAMA NO DO DEM ANYTHING


Wetin I neva undastand be say,why norma human being go wake up dey curse anoda pesin mama for notin on top intanet just bicos oyibo teknologi don do am make we fit dey run tings for Facebook,Twita and even Instagram.
Forma Big Broda Naija babe Tboss wey Efe win to gbask di N25milla,don swear for girls wey dey insult her mama say dem no go eva bikom mother.
For di boys wey join dey curse her mama,Tboss say dia sperm no go eva give dem shidren.
If you rememba,last week during di Mother's Day selibrashon,Tboss getam hot wit one bobo wey dey  insult her mama.
Too bad.
Wetin her mama do dem?
Useless shidren.
Watch di video for bottom hia...


Friday 19 May 2017

PATIENCE OZOKWOR A.K.A MAMA G,DON TELL TORi PIPO SAY,DEM FORCE HER TO MARRY WEN SHE BE 19 YEARS OLD


Pipo dey call her witch and wicked mother for nollywood but for real life if u neva hear,Patience Ozokwor alias Mama G na sirios Christian.
She dey even go diferen diferen places go preach now.
Right now she dey Kumasi for Ghana and she folow do, one joinbodi intaviu wit Ghana television station,RTV wia she yarn plenti tins.
One of di tin wey she yarn dem be say,her paleh and maleh force her marry wen she be 19 years.
She say di way wey dem train am be say,u must obey orders so diafor she nor get choice as she just kuku enta marriage.
Tank God for open eye and awianess.
Nawadays na babe dey choose who dem like.
E hard to hear about forcement.
Forcement nor dey reign again.
Na only for nollywood and pure village you fit hear dat kain tori.

Thursday 18 May 2017

GOODLUCK JONATHAN SIX YEARS OPORTUNiTi AS PRESIDENT NA WASTE TO Di IJAW NATION ACCORDING TO BAYELSA STATE GOVNOR SERIAKE DICKSON

Jonathan and Dickson 
Bayelsa state gofnor Seriake Dickson don finalli yarn di sikrit wey him dey kip make he no go burst for him belle.
For di sikrit,Gofnor Dickson blast forma president and him pasona pesin Goodluck Jonathan.
He say di six years wey Uncle Jona rule Nigeria na waste to di Ijaw pipo and na opotuniti wey just waste troway.
Dickson yarn dis one wen youths and leaders gada during di evri year selibrashon of Ijaw hero, Major Adaka Boroh for Yenegoa,Bayelsa.
He also yarn say,all di Ijaw ministas and oda ijaw pipo wey work wit Jonathan nor givam beta advice on how dem sopose take develop Ijaw land.

AFTA ADEKUNLE GOLD LIVE OLAMIDE,HE DON ANNOUNCE HIM NEW BAND GANG (PHOTOS)



Wen one road close anoda one go open.
Ybnl Oga Olamide and Ybnl artiste Adekunle Gold nor dey work togeda again afta Adekunle contract end.
Di bobo don dey do hin own ting now and he don get new band gang wey him go dey run tings wit.
Di name of di band na,the 79th element and naim be di leader of dis gang.

Wednesday 17 May 2017

ONE OF Di BIGGEST NAME FOR PDP RIGHT NOW,GOVNOR FAYOSE DON YARN SAY,HIM GO COMOT FOR PDP IF SUPREME COURT JUDGEMENT CONFAM MODU SHERIFF AS DIA CHAIRMAN


Many pipo prayer right now na make Supreme Court still konfam Ali Modu Sheriff as PDP chairman instead of Ahmed Makarfi so dat di tin go pepper Ayo Fayose for bodi.
Many pipo wan see di party wey he go win join if Sheriff kontiniu as chairman.
Gofnor Fayose don yarn say,anytin wey make di court new judgement favor Sheriff,him go carry him load and run live PDP.
Politicians and dia wahala,make una no kill una sef sha.

Tuesday 16 May 2017

TIMAYA SAY WEN HE SEE WOMAN BACKSIDE,Di TING DEY GIVAM GINGER AND INSPIRATION TO WRITE BETA SONG


If you ask miuzishans since wen dem start to sing be say,many go say,since wen dem dey dia mama womb.
If u ask who dey give dem Inspiration to sing many of dem dey say,na God dey give dem inspirashon.
But di Egberipapa 1 of Bayelsa Timaya don shock many pipo wen dem askam di same question.
He yarn tori pipo say,na woman yansh dey givam Inspiration to write songs.
Anytime wen he look woman big bakassi Na so him go start to write good miuzik.
Afta him go dey sing say him na memba of MFM,Mountain of Fire and Miracle Ministries.
Di Ogakpatakpata of MFM Dr Olukoya,must hear dis.
Di boy need dilivrance.

Monday 15 May 2017

OSAMA BIN LADEN PIKIN HAMZA,DON YARN SAY HIM GO BOMB AND ATTACK AMERICA FOR Di WAY WEY DEM TAKE KILL HIM PAPA


Na beg I dey beg evribodi wey dey give dis world bad name,make dem try cool down.
Hamza,di son of Osama Bin Laden di king of Islamic kasala,wey America kill some years ago,don tell America say,him go show dem pepper afta dem kill him papa.
Wen him papa die,Hamza na 22 years dat time.
Naim be say now na matured bobo he don turn and na only God know di nombas of bombs wey him go don buy hide.
Donald Trump Abeg no take dis boy as joke o.

Sunday 14 May 2017

COMEDIAN I GO DYE DON BUY VERY BIG BIUTIFU HOUSE FOR HIM MAMA AND NA ONLY FOR DREAM SOME OF US FIT SEE DAT KAIN FINE MANSION



Wen pipo bin dey say diaris heaven on earth,I dey tink say na joke.
Comedian I go dye don troway any doubt wey bin dey my head say heaven no dey dis earth.
Di kain big mansion wey I go dye build for him momsi no get part two.
Just to dey talk for stage naim dis guy take arrange dis kain bunk for him mileh,guy I dey enta street go talk for drum.
I just dey imagine di kain appiness wey go dey him mama mind now.
Mama banga rice dat year don dey enjoy di fruit of her labor.
I go dye you be man.
You don inspire crowd.

Saturday 13 May 2017

NA OSHODI BRIDGE LAWYER 2FACE GET,DEM NO FIT DO ME ANYTING-BLACKFACE


Wen dis two Benue boys,Blackface and 2face fight go end sef?
Yestaday we bin yarn una say,2face lawyer,don write leta to Blackface say make he tell 2face sorry for all di tins wey him don yarn or else dem go carry am go court afta 7 days.
Blackface don reply 2baba say,na Oshodi undabridge lawyer him get bicos di man no sabi book naim make am dey write robish.
Di bobo say make dem do anytin dem like him no dey fear dem.
Di black one say on top say 2face tiff him miuzik,dem stil want make he say sorry,sorry for what?
Blackface say,apart from African Queen,2face also tiff 'Let somebody love you'.
2face na true?

Friday 12 May 2017

2FACE LAWYER DON GIVE BLACKFACE 7 DAYS WARNING TO SAY SORRY TO 2FACE FOR ALL Di BAD TINGS WEY HIM DEY YARN ABOUT 2FACE OR DEM GO CARRY AM GO COURT


Di kpalava bitwin 2face and Blackface neva show sign of slowing down as 2face lawyer don serve Blackface warning paper say dem go carry am go court if he no tell 2face sorry for di bad bad tings wey him don dey yarn about am.
If you rememba,Blackface yarn some few weeks ago say 2face and him manager don tiff him song 'Let somebody love you' again  he tiff di first one 'Africa Queen'.
Di same song wey 2face take hama.
Now 2face camp don giv Blackface 7 days to say 'sorry' or else,two of dem go enta di same shokoto for court.
Dis ting don dey pass be kiafu o.
Una start as frends so make una try settle unasef bicos,2pac and Biggie famili still dey miss dem till today.
We nor won hia tori.

Thursday 11 May 2017

BAYELSA STATE PRIMARY SCHOOL TEACHERS DON STRIKE BICOS DIA GOVMENT DEY OWE DEM 9 MONTHS SALARY


Bayelsa state primary school tishas don down tools say dem no dey tish again until di gofment for dat state pay dem dia 9 months salary wey dem dey owe dem.
I pity for dis kontri.
Bayelsa na only 8 local govment dem get and some states get over 20 local govment but dem nor owe dia tishas salary.
Dem dey kolet ova 9 billion naira for Federa Gofment hand evri month but dem nor fit pay tishas salari.
Meanwhy tishas from states like Anambra,Ogun wey dey resiv below 9 billion evri month nor dey konplain.
Dis kontri na real one chance.

Wednesday 10 May 2017

DAVID ADELEKE A.K.A DAVIDO,DON BLESS ANODA DAVID ADELEKE FOR TWITA HIM NAMESAKE AFTA Di BOBO COMPLAIN OF MONEY TO ATTEND ONE JOINBODi MEETING FOR YANKEE



Davido don tell one bobowey be him namesake for twita make he sendam message make he arrange somtin foram base on say di bobo dey beg.
Di boy,David Adeleke wey also dey bear di same name wit Davido,need di money to take go Yankee for one joinbodi workshop for Yale univasiti.
As Davido siam,naim he telam say no shakement I go plasta,aftaraw u be my namesake.

Tuesday 9 May 2017

NICKI MINAJ DON PROMISE TO PAY Di SCHOOL FEES OF SOME OF HER FANS WEY DEY UNiVASiTi


No be bad idea at all wen u give back to di Pipo wey dey support your karia.
Nicki Minaj bin dey do konpetishon on top twita wit her fans and Di plan Na to reward dem.
One fan kon tell Nicki say,she go prefa make she pay her school fees.
Nicki agree as she also agree to pay Di school fees for many oda fans too.
Nice one Nicki.
Life nor be only to dey naked and show us your yansh on top Instagram and twita.

Monday 8 May 2017

YEMI OSINBAJO DON TURN TO PRESIDENT AGAIN AFTA BUHARI HAND OVA POWER TORAM BICOS HE TRAVEL GO LONDON FOR ANODA TRITMENT


Wen we dey play monkey post dat year for area,dem go say,two corners make one penariti.
If to say di nomba of times wey Yemi Osinbajo don be president anytime wey Buhari go for tritment dey count like di penariti ting,o boy di vice presido for don be di real president once and for all espeshali now wey Buhari don travel again to trit di sickness wey dey him bodi.
Rememba say president Buhari come back from London for March afta he spend two months go trit imsef for dia.
Yestaday Oga Buhari don travel again but dis time around nobodi no wen he go come back.
Well,I pray say bifor he go come back,make my frends wey dey stay Abuja no go sell dis kontri troway take buy kpof kpof share give hungri pipo.

Sunday 7 May 2017

AFTA ALL Di BEATING WEY CHRIS BROWN BEAT AM IN THOSE DAYS,RIHANNA DON STILL PHONE CHRIS BROWN AND TELL AM SAY,"I LOVE YOU" DURING Di GUY BIRTHDAY


Dis tin call love ehn,e be like juju.
If e don catch you,e don catch you be dat.
All di black eye wey Rihanna get wen she dey frend Chris Brown and upon say court settle di mata say make Chris stay away from her,e don clear say she neva fit remove di guy from her mind.
Chris Brown selibrate him birthday on Friday and akordin to pipo wey dey di birthday groove,di bobo resiv call from Rihanna to wisham hapi betday.
Dem also yarn say Chris Brown dey veri hapi as di babe call am.
Di last word wey come out from riri mouth wen she call na,'I love you' to show say she still dey kolo for Chris.
Chris selibrate him 28 years old birthday on May 5.
Na anoda new chapter dis pipo won use sense open so o,
We dey watch.

Saturday 6 May 2017

NO BE BY FORCE TO TAKE CARE OF YOUR PAPA AND MAMA WEY BORN YOU ACCORDING TO GAYMAN,BISI ALIMI



Notin pesin no go hear for dis kpangolo world wey we dey.
Gay craze,Bisi Alimi,don yarn tori pipo say no be by force to take kia of di papa and mama wey bring you come dis world.
Wetin you dey expect from pesin wey fit yarn say him nor biliv in God.
Pesin wey choose not to love woman but to love him fellow man,wetin remain for dat kain pesin brain?
If I choose to helep my momsie and popsie,na my life Abeg craze enta one corner wit yor yarns.
Yeye dey smell.

Friday 5 May 2017

MAN U COACH,JOSE MOURINHO,DON HAIL MARCUS RASHFORD AS PLAYER WEY DEY IN LOVE WIT FOOTBALL



Wen your coach kontiniu to sing your praises,make you know say,e get wetin you dey do right.
Jose Mourinho di coach of Manchester United,don praise him 19 years old playa as sombodi wey dey in love wit football afta di bobo score Di only goal wen dem play di first leg Europa league match wit Celta Vigo for inside Spain last nite.
Rashford bend one wicked free kick like Beckham enta di net for di 67 minute as dem give CeltaVigo one kondo.
Mourinho say make dem forget age for Rashford mata bicos di boy get mature heart to dey pepper difendas.
He say wen evribodi don dey go house afta dem train finish,Rashford go stil kontiniu to dey train.
Akordin to Mourinho he say,di boy dey work,work and work and na dis one make am say,Rashford dey in love wit football.

Thursday 4 May 2017

FORMA ENUGU STATE GOVNOR SULLIVAN CHIME,DON YARN SAY,PDP DON DIE AND DEM DON BURN TO ASHES


Forma Enugu state gofnor Sullivan Chime,don yarn say him forma party PDP,don die and dem don burn to ashes.
Sullivan talk dis one wen he dey follow tori pipo yarn for Enugu.
Akordin to di forma Gofnor he say,di rizin why him enta APC na bicos,many pipo dey look up toram for direction and APC na di only party wey fit giv you good life.
He say him pray say wetin appun to PDP make he no appun to APC.
Politicians una well done.

Wednesday 3 May 2017

NAIJA AND GHANA BORN ACTRESS YVONNE OKORO,DON TELL TORi PIPO SAY,WHY SHE NOR GET BOY FRIEND FOR TWO YEARS NOW NA BICOS GUYS DEY FEAR TO TELLAM ABOUT LOVE


Nollywood and Ghollywood actress Yvonne Okoro don yarn say di reason why she dey single for two years now na bicos guys dey fear to tell her about love.
She yarn dis one for one intaviu wen dem dey launch di Glam Magazin for Accra,Ghana.
She say di rizin why boys dey fear her be say,dem dey feel say she don alreadi get boyfriend.
Dis week as guys don know her sikrit,di toasting for dis babe go cause traffic.
Yvonne,which nomba I dey?
You go like my lyrics.

Tuesday 2 May 2017

BREAKING NEWS!!! PROPHET TB JOSHUA DON YARN SAY HIM DON DEY MAKE ARRANGEMENT TO CARRY HIM SYNAGOGUE CHURCH GO ISRAEL SINCE DEM NO VALUE AM FOR NAIJA.


Prophet TB Joshua wey be di founda and owna of di Synagogue Church of All Nations for Ikotun,Lagos,don dey make sirios arrangement to take carry him Church to Israel veri soon.
He say na dia him papa from heaven come from.
Akordin to di prophet him say,dem no value am for Nigeria so diafor make he go were dem go valuam.
He say him Synagogue Church naim dem hate pass for di world and pipo wey hate am akordin to TB Joshua,naim own pipo,Africa pipo.
Di prophet also yarn say,him don yarn wit three big names for yonda..di mayor of Jerusalem,Tiberians and di Jordan Valley and dem don even promise to givam land to build him Church.
Hmm,we dey watch.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...