MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 31 August 2016

FACEBOOK OWNER,MARK ZUCKERBERG,Di 5th RICHEST MAN FOR Di WORLD,DON CARRY WAKA ENTA NIGERIA YESTADAY TO EXPAND HIM BIZNESS



Di man wit di simpo looks Mark Zuckerberg wey be di owna of Facebook,don carry waka enta Nigeria since yestaday.
Dis guy arrival to di kontri be like miuzik to many pipo ears.
For inside dis waka,he go folow bizness men parli on top teknologi mata.
Mark Zuckerberg soprise evribodi as he enta Nigeria like tiff.
Nobodi know say di bobo dey come.
Dis na di 32 years old first visit to Africa as he land for Lagos for bizness tins.
Di first place wey di young billionaire visit na di Co-creation Hub Nigeria (CcHUB),Yaba,Lagos.
Chai! Dat bobo nor dey wia plenti clothes.
Polo, jeans and slippers,di mata don end.
If na by to pack load for bodi,Derenle,Charly Boy and Terry G for be bastard billionaires but nor be so.


FOR OVA 25YEARS WEY SAM ALLARDYCE OF ENGLAND DON DEY COACH,HE SAY NA JAY JAY OKOCHA BE Di BEST CAPTAIN WEY HE DON EVER SEE


Forma Bolton wanderers coach Sam Allardyce,don yarn tori pipo say,na Okocha be di best captain wey he don see for hin life.
Jay Jay Okocha play unda Sam Allardyce for Bolton from 2002 to 2006 and di coach make di masta dribbla Bolton captain two years bifor he remove.
Allardyce say,during dat piriod,Jay Jay show am say him na beta lida for inside and outside field.
He say Okocha sabi talk sense enta di players head and he sabi give dem mind.
Sam Allardyce wey be di new England coach say,apart from say Okocha na wondafu captain,he say Okocha kon rili sabi tap di leather like mad.
Talent na water,skills full hin bodi like say dem create am spesha.

WHO I OFFEND! KELECHI IHEANACHO SALARY NA N34 MILLION NAIRA A WEEK



Super Eagles and Manchester City midfielder,Kelechi Iheanacho,don bikom naija highest paid footballer for England as Manchester City don inkriz hin salary to £85,000 pounds a week.
For Nigeria money dat na over N30 million naira a week.
Earli dis month,Kelechi sign new kontract wit Manchester City and di bobo even konfess say,hin new salary
He money don long pass evri oda naija playa for England inkluding super eagles new captain Mikel Obi.
Mikel dey kolet £70,000 a week for Chelsea,
Ahmed Musa raba na £60,000 a week for Leicester City,
Victor Moses salary na £50,000 for Chelsea,
Odion Ighalo osusu na £25,000 a week for Watford.
And my salary wit ogakpatakpata nor rish N500,000 naira for a month.
Baba God who I offend?
I DEY beg for forgiveness.

Tuesday 30 August 2016

KATSINA STATE GOFNOR DON TELL FORMA PRESIDO GOODLUCK JONATHAN TO SHOW Di WORLD WETIN HE DO FOR HIM PIPO FOR NIGER DELTA


Forma speaker for di House of Representatives and di prezent Katsina state gofnor,Aminu Bello Masari,don call out South south lidas espeshali Goodluck Jonathan make he show us wetin he do for Niger Delta for di six years wen he dey power.
He say make uncle Jona show us wetin he do for hin own pipo bicos,market price for oil na ova $100 dollars and money dey yanfuyanfu for dat piriod.
Nor worry yorsef Masari,even small pikin wey dem born today,know di ansa to yor queshons.

Monday 29 August 2016

ANODA FEATHER TO WIZKID CAP AS INTANASHONA MIUZISHAN,DRAKE,DON PICK Di OJUELEGBA BOY TO APPEAR FOR ONE YANKEE FILM


Wizkid mata na ezampo of wetin God chook hand put.
Di man wey dey behind Wizkid rise for di intanashona market,Drake,don put Wizkid name join di pipo wey go act one film, "Please forgive me ".
Dem go reliz dis film for Septemba 30.
Dis film go hep boost Drake latest album 'views' and nor be di first wey hin dey reliz film to take soport him album.
Di Canada born bobo,reliz one short 14 minutes film 'jungle' togeda wit hin last album and e don set to bring out di anoda one.
Make we dey wait Septemba 30 weda na waka pass part Wizkid go act for inside.
Any wich way,we go stil klap foram.
Wizkid mata nawadays,na klap dey end am.


Sunday 28 August 2016

NAIJA OLD SCHOOL MIUZISHAN FELIX LIBERTY SAY,DAT TIME WEN HE NEWLY MARRY,HIM DEY SHOOK LEG FOR OUTSIDE AND CARRY MANY WOMEN


Old skul lala!Nor go there o.
Ifeoma,ifeoma,ifeoma,ifeoma,..I want to marry you,gimme yor love....
Nor be small tin dat time wen dat Felix Liberty jam dey reign skata evriwia for dis kontri.
Di old skul miuzishan don yarn now say,dat time wen he newly marry and wen devil dey control hin brain,him nor dey use eye see woman.
He say he wife be like disturb toram and he kon be like say him dey regret who sendam enta early marage.
Felix Liberty say him dey carry gehs anyhow but later,him kon undastand say na robish him bin dey do dat time.
Now he dey respect hin wife like God.

Saturday 27 August 2016

BIFOR PSQUARE STORi CHANGE OVANIGHT,PETER NA SALES BOY FOR SUPERMARKET,WHY PAUL NA ELECTRICIAN


Make we pray make Baba God put hand for our mata so dat we go get Tori to yarn like evri oda susesful pesin.
Psquare,di singing twins wey don hama today thru dia miuzik,get stori to tell too.
Tins bin roff for dem welwell wen dem dey grow.
Inshot,e get di time wey six of dem dey stay one room.
Nor be only dat one o,e roff sotay,Peter kon turn sales boy and Paul kon dey learn electrishian work.
But today,dem don turn landlords and dem dey travel around di world.
Respet God not man bicos na only am fit change yor stori ovanight.

Thursday 25 August 2016

WHO WANT TO BE A MILLIONIA PREZENTA,FRANK EDOHO SAY,HIM HATE CELEBRiTi LIFE BICOS HE NOR DEY MAKE AM LIVE NORMAL LIFE AGAIN


Popular program, 'who want to be a millionia' prezenta Frank Edoho,don yarn tori pipo say,him hate di popular life of selibritis bicos e nor dey make pesin live normal life again.
He say bicos say him be selibriti and he popular,na so pipo go dey look for any small mistake or error to bringam down.
Edoho say,make we forget about di swit tins and di serenren wey populariti dey bring.
Di bad part tins wey e dey bring too nor make di tin dey ova swit.

DAVIDO DON FINALLY GIVE Di GUY WEY DEY WORRY AM LIKE TSETSE FLY ON TOP TWITA,N10,300 TO BUY HND FORM



Di new style wey pipo take dey beg naija selibritis now,dey work wondas for dem.
Dem don beg Kcee Limpopo,di oda day Funke Akindele buy KEKE NAPEP for one bobo wey begam for twita.
Davido don do for many pipo too and resentli he dash one bobo wey dey worry am N10,300 for HND form.
Who be di next pesin wey go cook stori for our selibritis?
Weda na fake stori or true stori,we dey wait.

DIS PICTURE GO MAKE YOU KNOW SAY,SUFFER PASS SUFFER


Dis life,na wen u neva know wetin God do for u naim u go dey konplain.
You see food eat two times a day,u konplain,pipo dey wey nor see anytin grob dat day.
You see paste use take brosh teeth u dey find oyibo Maclean.
Pipo dey wey dey go bush go cut wood to use as chewing stick for dia teeth bicos dem no get money for close-up.
Look di round concrete ring for dis foto veri well,u go see one bobo fold mattress for inside and na dia he dey sleep.
See make I nor yarn too mosh,if I hear say u nor thank Baba God for yor life ehn,I go do am make you see yor house dey run.

OMOTOLA PIKIN, CAPTAIN E,DON DRAG HIN MAMA JOIN Di DABBING MADNESS




Na small small pipo take dey kraze.
If dis dabbing tin neva make one billion pipo kraze,we nor go stopam.
I know how many pipo don craze thru dabbing for my area and now Nollywood big name Omotola,don join di dabbing crew.
She say her pikin Captain E wey selibrate hin betday some days ago,dey tish her how to dab.
Omosexy say although she prefa her scorpion dab.
Make unu kontiniu.

Wednesday 24 August 2016

ADEKUNLE GOLD SAY IF YOU ASKAM Di FIVE PIPO WEY HIM GO LIKE WORK WIT FOR Di iNDUSTRi,HIM GO PICK..ASA,ASA,ASA,ASA AND ASA


Ybnl singa,Adekunle Gold,don yarn pipo say,if dem say make he pick five miuzishans for di industri wey him go like work wit,he go pick dem one time witout wasting time.
He say di five pipo na..Asa,Asa,Asa,Asa and Asa.
Yes o,you ridam well.
Adekunle say na Asa in five pesins.
He say him na big Asa fan.
Dat is to say,if na Asa miuzik go turn am to madman,hin readi to be dat madman.
I wonda how dia collabo go be.
Adekunle Gold album wey him call 'GOLD',dey do wondas right now for di industri.

ENEMIES FOR NEWSPAPER BUT FRIENDS FOR AFTERNOON..SEE AS ROTIMI AMEACHI AND PATIENCE JONATHAN DEY LAUGH TOGEDA


I dey pity for dose pipo wey dey kill demsef bicos of politishans.
If pesin yarn u say forma First Lady,Patience Jonathan and forma Rivers state gofnor and minista of transport,Rotimi Ameachi go dey laff afta Ameachi join comot dem for Aso Rock,u go biliv?
Infact na Ameachi start di fight to remove Uncle Jona from Aso Rock until dem Tinubu kon join am.
Uncle Jona and hin wife kon join Gofnor Wike to seize Rivers state power from Ameachi.
Nor be small tin.
But yestaday for di burial of Ojo Madueke wey be forma transport minista,our politishans show us say,dem be frends for nite,frends for aftanoon and frends for morning.
Dem show us say nobodi send una weda una dey kill unasef bicos of dem or not as Ameachi and Mama Peace dey shine dia 32 wit each oda.
Who nor len lesson naim him know.

Tuesday 23 August 2016

TIWA SAVAGE DON YARN TORi PIPO SAY,SHE BLAME HER PARROT MOUTH AS SHE DON TOO LET Di WORLD KNOW ABOUT HER PRIVATE LIFE


Wen yor brain link you say na u responsibo for yor own downfall,naim be say u be gud advisa to yor sef.
Tiwa Savage,mama jam jam,don tell Tori pipo say her biggest regret na di way wey she don too yarn her sikrit to di publik.
She dey blame her parrot mouth now afta all di plenti tins wey she don yarn about her life.
If you rememba some months ago,her forma hosband Tee Billz tell us say Tiwa Savage nor be beta wife and also say,she don sleep wit Don Jazzy,Dr Sid and 2face.
Tiwa Savage later reply Billz and leak many sirios sikrit wey we nor know about bifor.
Now Tiwa don yarn tori pipo for South Africa say she don len her lesson not to dey talk too much about her private life again.

SEE AS KLINT da DRUNK' JOIN HIN WIFE REST HEAD FOR ANODA BABE BIG 'BAKASSi'


E be like say one of di most funny comedian for naija,Klint da Drunk and him wife don mix small 'kain kain' for dia system.
You nor fit get enof of di ogogoro karata wey comedian Klint Da Drunk take dey entatain us.
He don drag hin wife joinbodi for di madness.
See as di drunken masta plus hin wife,rest dia head on top one babe big bakassi.
Klint imsef naim post dis pishor for Instagram and he write on top say,playing wit hin wife enta old age,naim sure pass.
Guy man head on top dis kain bakassi,fit cure any kain headache.
Nor soprise to see dis two pipo carry dia madness enta stage togeda one day.
E go nice die.

Monday 22 August 2016

NAIJA RAPPER,YUNG6IX DON YARN ON TOP TWITA SAY NA FORMA PETROL MINISTA,DAN ETETE PIKIN,DAVID ETETE,NAIM TRY TO KILLAM SOME DAYS AGO


Some days ago yung6ix konplain on top twita say somebodi try to kilam troway but e nor give us di name of di pesin.
But dis wikend,di rappa don finalli tell us di name of di bobo wey try to shootam.
he say na forma petrol minista,Dan Etete pikin naim try to kilam.
David Etete wey hin nickname for raping na P.R.E,naim Yung6ix say nearli kpai am troway.

Sunday 21 August 2016

MERCY JOHNSON DON TELL AMEBO PIPO WEY DEY CHECK WEDA SHE DON CARRY ANODA BELLE SAY,IF SHE LIKE SHE GO BORN FOOTBALL TEAM,NA HER LIFE


Nollywood actress Mercy Johnson,don blast Di pipo  wey dey check her belle weda her hosband Don put anoda pikin inside.
She say dose kain pipo dey waste dia time bicos she go must add anoda pikin join di three wey she don born alreadi.
Di funny actress say if she like she born football team, na she get her life.
Mercy Abeg take am izzi O.
And dis change briz neva blow reach yor side?

MERCY JOHNSON DON TELL Di JOBLESS PIPO WEY DEY MONITOR HER BELLE SAY

Saturday 20 August 2016

COMEDIAN BASKETMOUTH DON BUY HIN WIFE OGBONGE HOUSE AND SHE DEY VERi HAPPY AND SURPRISE SAY E HAPPEN FOR DIS HUNGA PIRIOD

Big name comedian Basketmouth, don buy him wife, Elsie one ogbonge house.
Elsie hersef naim share di gudnews as she write on top instagram say, u go know say our God na koret God wen u resiz big gift like dis espeshali for dis kain hard kondishon.
Di babe kon use di opotuniti tank her husband welwell.
Abeg Basketmouth, incase una won re-sell di
house, make una lemme know o.
Cargo divide by four, at list e go cheap.

Friday 19 August 2016

AMERICA MIUZISHANS DEY FEAR TO WORK WIT ME..NA SO BADDEST MIUZIK PRODUCER,DON JAZZY TALK


Mr Don Jazzy a.k.a Don baba j,don yarn tori pipo say American miuzishans dey fear to work witam bicos dem dey fear make dia sound nor go change.
He say most of di Americana wey him don work wit neva readi for di miuzik change.
Jazzy say,wen he give dem beat wey go make dia miuzik break enta oda part of di world,dia leg go dey shake and dem go want make he add salt and maggi make di beat for sound like dia own.
Don Jazzy say him nor undastand why dem stil dey fear to try new tings.
Pipo like Drake don comot fear for eye,add small Africa style join hin miuzik and di result wey him get,don brake many record for di world.
On top di jam 'one dance' wey don giv Drake plenti halleluyah,di Canada born bobo,fichor our own Wizkid,wey carry Africa sound for head like lakpalakpa.

Thursday 18 August 2016

RADIO PREZENTA,YAW OF WAZOBIA FM,DON YARN SAY,FIGHT,ENiMiTi,MALICE AND QUARREL BITWIN MIUZISHANS DEY MAKE MIUZIK SELL


Afta Don Jazzy and Olamide start di new year wit kworel,many selebriti espeshali miuzishans follow dia footstep.
Wizkid and Tori queen,Linda Ikeji kworel dia own too but di one wey we for see blood na di fight bitwin Wizkid and Dammy Krane.
Afta Dammy akiuz Wizkid of tiffing hin songs,na fight naim later end am.
For Quilox nite club for Lagos,Wizkid stone Dammy Krane head wit glass cup.
Di bobo injor as blood stain all hin polo.
Now Wazobia Fm prezenta,actor and komedian,Yaw,don yarn Tori pipo say,all dis kasala bitwin miuzishans and selibritis dey make dia miuzik sell.
Di bobo say wen dem reliz miuzik during di piriod of dia fight, fans dey rush to buy dia songs.
Yaw say all dis kain gbege good for di industri.
E dey make tori pipo say somtin write to kip dem busy.
He say as Tori pipo dey report di tori,di miuzishans dey popular more and dia market dey sell.

POLICE DON RELEASE Di OKRIKA SELLER WEY NICKNAME HIM DOG BUHARI FROM PRISON


One dog wey dem nickname Buhari,don put di owna for wahala for Ogun state.
30 year old Joe Fortemose Chinakwe spend sometime wit criminals for inside prison as him Niger republic neighbour,Musa,arrange wit Hausa police to arrestam bicos he dey call hin dog Buhari.
Akordin to Joe,he say wetin pain am pass na Musa,hin neighbour from anoda kontri,wey come cause ploblem for naija sake of say hin name he dog Buhari.
Joe wey be say na okrika bizness he dey do,na from Niger Delta and dis one kon make di policeman inkriz di suffer.
If nor be association of pipo wey show concern,maybe Joe for rotten for cell.
He say dem handcuff and chain him and hin dog go station and di Hausa police sergeant even threaten am say he go die for prison.
Wetin kon save Joe,na wen dem carry am go di police headquarters for Sango-Ota as di comishona of police and oda orfisas kon vex say why dem carry dat kain small mata come headquarter.
As dem reliz Joe Fortemose,hin kon dey para tell tori pipo say,di foolish Musa nor even know why he name di dog Buhari.
He say e don tay wey him like Buhari.
Akordin to wetin he yarn,he say na since 1983 wen Buhari take be khaki head of state naim he take like am.
He say di likeness kon still kontiniu as Buhari comeback as sivilian president last year.
He say he like di way wey hin take dey fight koropshon wey don damage our ekonomi.
Joe say dis one naim make am name di dog afta him hero,Buhari but he nor know say na offense to like Buhari.

Wednesday 17 August 2016

UNA DON HEAR? WIZKID DON YARN SAY HIM NOR BE CHEAP MIUZISHAN AS HE REJECT N17,000 MILLION NAIRA TO PLAY SHOW FOR OBODO OYIBO


Wizkid don reject £50,000 from show promotas wey want make he play for dia show for obodo oyibo.
If dis Wizkid of a boy na my broda,di slap wey I go givam afta he reject £50,000 go make hin ears get ploblem for life.
Since he don dey role and see fit big money wey dem dey give dem Drake and Chris Brown,e be like say water don enta he brain.
How normal human being go reject £50,000 wey be N17,000 million for Nigeria money?
He sopose dey gada all of dem bicos he know di mad kontri wey hin come from.
Wetin dey pain me for di mata be say,dem won give you N17,000 million just to jump and shout for stage for less than one hour and Wizkid reject di money.
Na u first turn intanashona miuzishan.
Ojuelegba boy wey dey use palm kernel soak garri bifor,don dey craze all of a sudden.
Well,naim life.
E get right to craze but as he craze,make he nor craze remain for us o.

Tuesday 16 August 2016

JAPAN DOCTOR DON PROMISE TO GIVE N10 MILLION NAIRA TO EACH OF OUR U-23 PLAYERS IF DEM WIN GOLD FOR OLYMPICS FOR BRAZIL


One Japan dokita,Katsuya Takasu,don promise to give our U-23 team $30,000 each if dem win GOLD for di Olympics wey dey appun right now for Brazil.

Monday 15 August 2016

SIX YEARS AFTA DiA QUARREL BICOS OF TONI PAYNE,RUGGEDMAN AND 9iCE DON FINALLY SETTLE


Na to forgive and forget naim sure pass.
Nor be small kworel 9ice and Ruggedman don kworel for ova six years now all bicos 9ice say Ruggedman dey sleep wit him forma wife,Toni Payne.
Nor let anybodi tell u say na rumors dis fight be o bicos,two of dem later sing dey curse demsef during dis piriod.
For inside songs like,'Talk I dey listin' and 'One word dey enuff for di 9ice', dem sing to insult demsef just to confam dia kworel.
But now,e be like say dem don settle dia kasala as dem don readi plans to reliz dia new song togeda wey dem call,Religion.
One of di song wey dem reliz togeda bifor 'Ruggedy Baba', skata evriwia dat year.

MR IBU DON YARN HIN WIFE SAY: BABY,I NOR FIT STOP TO LOVE YOU



Di king of mumu acting for nollywood,John Okafor a.k.a Mr Ibu,don send strong lovina message to hin wife.
He share him wife and son pishor make pipo see hin sugar peperenpe.
He kon sama di pishor wit some biutifu yarns.
Mr Ibu on top di pishor say,di only tin wey dey make am hapi na wen he look hin wife face and see her smile...
Baby I nor fit stop to love u oooo,na so Mr Ibu kon take end am.
See love.

Sunday 14 August 2016

ACTOR PETE EDOCHIE a.k.a OKONKWO,DON YARN SAY,HIM NOR DEY FACEBOOK SO DIAFOR,MAKE PIPO STOP TO USE HIN NAME DO WURUWURU


Nollywood Oga,Pete Edochie a.k.a Okonkwo don yarn tori pipo say,him nor DEY Facebook or twita but pipo don open diferen diferen account wit hin name.
He say for exampo,as him dey house dey watch football now,u go soprise say pipo don enta Facebook dey put word for hin mouth.
Pete Edochie say,na so dem dey use hin name for Facebook dey talk politiks,quote different proverbs and many oda tori.
He say na so one woman dey soprise as him telam say nor be him dey yarn all dose tins for Facebook and twita.
Akordin to di home vidio big name,he say na so dem formulate one pishor and tori of wen him take tell Mourinho say,di gods dey vex for di coach.
Edochie say anoda one wey pain am pass na wen dem go dey carry rumor say hin don die.
He say for dia korchor,anybodi wey dey wish u death,na you go later attend di pesin funeral.

Saturday 13 August 2016

IF ANY BABE GIVE YOU CONDOM TO USE,MAKE YOU REJECT AM..NA SO SEAN TIZZLE TALK


Wen singa Sean Tizzle yarn tori pipo say, if babe bring condom out say make u use take piaska,wia my mind first go na ritual tins.
But Sean Tizzle get why he talk am.
Akordin to di Sholee singa,he say many babes dey put hole for di condom so dat dem fit carry belle for you.
Di bobo say na babe telam dat sikrit wey some gehs dey use so diafor,he beta make u use yor own condom to avoid storis dat touch.
Sean Tizzle also advice boys wey neva readi for baby mama wahala say,make dem dey kiafu bicos wen di tin don enta yor head,u go just won use any condom wey u see.
So if babe give u condom,make you run 440 akordin to Sean Tizzle.

Friday 12 August 2016

MIKEL OBI DON SAVE NAIJA FROM DISGRACE AS HE PAY $4000 DOLLARS TO SAVE OUR FOOTBALL TEAM FROM HOTEL DEBT FOR OLYMPICS


You for don hear say our unda 23 team sleep for inside rain for di olympics wey dey appun for Brazil if nor be Mikel Obi wey save Dem.
For di hotel wey dem dey,our gofment Neva stil pay for dia hotel bills as di hotel owners don readi to troway dia propati for outside until Mikel Obi kon pay di $4000 wey dem dey owe.
Wen we go eva learn?

Thursday 11 August 2016

E DON HAPPEN! 18 YEARS OLD OBAMA DAUGHTA DON JOIN "SMOKERS CLUB FOR AMERICA" AS DEM CATCH HER DEY SMOKE iGBO WIT BAD GANG



How long I won form good girl?
Na di queshon wey dey run for Malia Obama mind be dat as she don cut rope enta town just to show her true kolor.
Di 18 years old Obama daughta don join bad gang dey smoke igbo.
For inside dis vidio wey I put for hia,dem dey one groove dey dance but she dey busy dey smoke.
Now her papa nor fit open hin mouth to advice anybodi again bicos dem go telam say make he shut up since he nor fit train her daughta.
Now dis babe don put words for Donald Trump mouth.
Trump na her papa nomba one enimi and he dey contest for election to replace Barrack Obama as president later dis year.
Oya Klik and watch di vidio for bottom hia...


KENYA ASHAWO DON DESTROY DI CAR OF CUSTOMER WEY REFIUZ TO PAY HER





Congil na bastard!
Pray make e nor hold you espeshali di kain kongi wey go put u for ploblem.
If e try to get you,na how u fit take giam chance or manage di situation naim make u man.
Watch wetin dis Kenya okpongbo do to di car of di customer wey nor pay am.

Oya watch am hia...


Wednesday 10 August 2016

JESSE JAGS DON YARN ALL MIUZISHANS SAY NOBODi AND NO BAGA SABI DO MIUZIK REACH HIM AND HIN BRODA M.I


Baddest rapperJesse Jagz don add boasting join him yarns as he don tell tori pipo say nobodi sabi rap and do miuzik reach him and him broda M.I.
Di rappa wey dey selibrate hin betday today yarn say,een nor kia wich family u come from,him and m.i combine togeda,nor get rival.

Tuesday 9 August 2016

BUHARI NA F9 AND TOTAL FAILURE AKORDIN TO APC CHIEF,HUSSAINI MAIRIGA FOR KANO STATE


Chairman of one of di different joinbodi groups of APC wey dey for inside Kano,Hussaini Mairiga,don blast President Muhammadu Buhari as presido wey don fail for class.
He yarn Tori pipo say,di way wey tins be now,Buhari don fall evribodi hand wey soportam during di elections.
Mairiga yarn say nor be joke and film trick di way wey pipo dey shout of hunga for di kontri.
Di APC bobo say,many pipo nor dey even chop once a day bifor dem sleep for nite.
He also yarn say for dis one year wey Buhari don dey pawa,di poverty level for dis kontri don inkriz like mad.
Mairiga say bag of rice na 16k now and oda foodstuffs don inkriz like say dem swear for us.
Last last,he kon advice Buhari make he stop to disiv us say naija pulse don dry.
He say dat na big lie as we dey make plenti money evri month for dis kontri.
Yawa dey.

EVEN AS A A STRONG KRISTAIN NOW,IF DEM SAY MAKE I ACT ASHAWO PART FOR FILM,I GO STILL ACT AM-EUCHARIA ANUNOBI


Eucharia Anunobi di Nollywood actress wey don also turn to pastor,don yarn us say,she stil readi to act ashawo part for home vidio if dem say make she do am.
Wen dem ask her weda she fit stil accept ashawo script,she say yes of course.
One tin wey she say  she nor go do for di film na smoking bicos she nor dey smoke for real life.
She say she nor go also drink for di film if dem say make she drink but she fit act like who don drink 20 bottles.
Eucharia also yarn say she nor go wear close wey go show her breast or laps bicos she won act like ashawo.
Na wa o.

Monday 8 August 2016

ACTOR JIDE KOSOKO SAY,HIM REGRET SAY HE MARRY PLENTi WIVES BUT NOW,HE DEY ADVICE HIN ENiMiS TO MARRY ONLY ONE WIFE


Nollywood actor,Jide Kosoko,don yarn say hin regret say he marry more dan one wife.
Oga Kosoko wey don loose three of hin wives to death say, him nor go advice even hin enimi to marry plenti wives.
Three of hin wives naim don die remain one.
Di last one sef go dey live in fear now but nor fear mama as God go kip all of us enta old age.
Di 62 years old Kosoko don get ova 12 shidren.

Sunday 7 August 2016

IF YOU BILIEVE SAY I DON GO BACK TO PDP,NAiM BE SAY YOR MAMA NOR BE WOMAN-NA SO OBASANJO YARN


Forma khaki and sivilian presido,Olusegun Obasanjo,don yarn tori pipo say him nor dey go back to hin vomit.
Three days ago,rumors come out say Obasanjo attend PDP new komiti joinbodi.
But baba don come out to yarn us say,anybodi wey biliv dat stori,make di pesin also biliv say him mama nor be woman.
Obasanjo say wetin him go dat area go do na di invitation wey him get from Comodities Association Stakeholders wia he for put mouth join di 'Zero Hunger Naija' mata for di Shehu Musa Yar'adua senta.
He say he dey he own jejeje for Musa Yar'Adua Centre wen some PDP pipo come gritam.
If you rememba 18 months ago,baba tear hin PDP membaship card to pieces.
Akordin to OBJ dat time,he say di party don fall yakata and dem nor get direction.
He say wetin he tell di world last year be say,hin don quit 'bodi jam bodi' politiks and di quitting na final.
Baba say dem just wan fool am and make hin vex.
OBJ say dat time wey PDP dey united and dat time wey dem dey bubble wit life,him live dem,not to talk of now wey dem dey strogle to breathe and now wey dem dey divided like one minus one(1-1).
Baba pasona pesin for tori mata,Kehinde Akinyemi,naim sign dis baba tori.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...