MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 30 September 2017

AFTA EEDRIS YABAM SAY HE DEY SING NONSENSE NAWADAYS,TIMAYA DON YABAM BACK SAY HIM NA FOOL! IDIOT AND DIRTY IGBO SMOKER!


First to do no dey pain,sekond to do fit giv high patenshon.
For two weeks now,rapa Eedris Abdulkareem don yab many miuzishans wey him feel say dey do anyhow for di industri.
Pipo like 2face,Mr Eazi,Davido,D'banj and even Timaya nor escape di yabis from Eedris.
Now Timaya don show us one video wia him for yab Eedris back and dis kain yabis fit make pesin blood boil.
Akordin to Timaya,Eedris na idiot,fool and dirty igbo smoker.
He say Eedris and dem 2face start di same time and till today,2face stil dey Hama but hin Own na to dey yarn puan on top intanet.
He say make Eedris go work and stop to yarn puan.
Timaya even yarn say,wen him dey do boyboy for Eedris,Eedris no even dey givam common transport money.
My guys Abeg una watch di video for bottom hia and see di way Timaya dey vex....


Friday 29 September 2017

TONTO DIKEH DON YARN TORi PIPO SAY,Di PAPA OF HER FORMER HUSBAND CHURCHILL OLAKUNLE,NA OBASANJO GARDEN HE DEY WORK BIFOR HE BECOME PREACHER MAN


Dem say wey pesin dey vex,he fit yarn anytin wey enta hin mouth.
Weda di tin na bad tin or gud tin,dat pesin fit talk am wen he dey vex.
Nollywood baddest babe Tonto Dikeh wey her marage to Churchill Olakunle jam rock about two months ago,don use vex take let us know say,Churchill papa na Obasanjo garden man bifor he turn preacher.
Dat is to say,na Obasanjo garden naim he dey work.
Tonto Dikeh yarn dis one during her vex vex reply to wetin tori babe,Azuka,talk about her and her marage to Churchill and oda tins.
She talk about how her forma hosband Churchill take bribe Azuka to dey write nonsense about her.
Di babe say Tonto Dikeh Own na just to talk bad tins about Churchill make pipo for feel say di bobo na bad pesin.
Dis one kon make Tonto vex say,if true true say she won spoil Churchill name,why she neva tell di whole world since say,Churchill papa na forma gadina to Obasanjo?
Na wa o.

Thursday 28 September 2017

PDP DON TELL GOVNOR FAYOSE SAY HE CANNOT BE PRESIDENT FOR 2019 BICOS ALL OF DEM DON AGREE FOR MEETING SAY,NA PESIN FROM NORTH DEM GO PRESENT TO BE PRESIDENT


PDP don advise one of dia memba wey be Ekiti state gofnor Ayo Fayose say,make he no dey waste him time,waste him money and waste him salaiva dey talk say he wan be Naija president.
Na PDP poblic seketri,Dayo Adeyeye naim yarn dis one on Wednesday.
He say even Fayose dey di meeting wey dem for agree say,na Hausa,Fulani or pesin from di north naim dem agree to choose president for 2019.
Tori wey fly enta our newsroom be say,Oga Fayose go finalli let Di whole world know him plan to bikom Naija president on Thursday.
Akordin to PDP,di only position wey open to politishans from south na,PDP Chairman so diafor,if Fayose won be chairman of PDP,wahala no dey but if na to be president naim dey hungry am,he dey disiv imsef.

Wednesday 27 September 2017

PORT HARCOURT FIRST SON DUNCAN MIGHTY,DON YARN TORi PIPO SAY,E NO GO BETA FOR ANY MAN WEY LOVE HIM WIFE OR GIRLFRIEND PASS HIM MAMA


Singa and Port Harcourt first son Duncan Mighty don remind us of di need to love our mama like mad afta he post pishor of two women wey sidon for back of bus wit dia cassava from farm.
Akordin to Duncan Mighty he say, E no go beta for any man wey love him girlfriend or wife pass him mama.
On top di pishor,he write say, "afta all dis suffer wey mama dem suffer make pikin for chop and make dem for pay dia school fees" some men go carry one yanga tolotolo woman put for house and kon forget dia mama.
Duncan tank him mama for di 9 months wey she carry am.
Akordin to di bobo,he say some men don still hama buy car but dia mama stil dey trek go market.
Too bad akordin to Duncan Mighty.

Tuesday 26 September 2017

BRODAS WAR AS P SQUARE DEM THROW BLOW DURING MEETING WIT DIA LAWYER (VIDEO)


Di fight bitwin P Square don tie wrapa.
Paul togeda wit Jude dia sinior Broda and manager,dey fight Peter for di video wey no swit for eye at all.
I wish dem fit settle diasef,di ting for swit bicos dis twins don give us beta gbedu miuzik wey make us love dem.
E dey painful to see dem dey fight like dis.
If Mary Slessor wey stop di killing of twins for Naija still dey alive bifor,dis video no go giv her joy at all.
Watch di video for bottom hia...


NEPA UNA DON HEAR? LAGOS STATE GOFMENT DON BUY 120 GENERATORS GIVE POLICE MAKE DEM DEY USE FOR ALL Di POLICE STATIONS FOR Di STATE


Wen gofment wey sopose giv di pipo light vex enta market go buy generators make dia workas for see use for office,make you know say water don pass Garri.
Lagos state govment don buy 120 tear rubber 5KVA generators for di state police station make light wahala no be part of dia ploblems.
Mr Oye-Hassan Oyekale di Chairman of di Lagos state sikioriti Trust Fund (LSSTF) wey reprezent Govnor Akinwunmi Ambode for di hand ova serimoni for Ikeja,yarn say he dey impotant say dem give dem generators so dat dia work go dey izzi if NEPA take light.
Dat one sef join.

Monday 25 September 2017

SINGA AND RAPPER 'SKALES' DON YARN TORi PIPO ONE SiKRiT AS HE TALK SAY,WEN POVERTY PINAM DOWN,NA OLAMIDE DASHAM MONEY WEY HIM TAKE SHOOT 'SHAKE BODY' VIDEO




If u do good Na so so good go dey follow you Na so dem talk am.
Afta about 3 years,rapper Skales don yarn us one big sikrit wey konsign di good wey Olamide do foram..
Skales bin dey wit Banky W and Empire Mates Entertainment (EME) bifor he kon go hin own way.
During dis piriod,di bobo reliz one ogbonge miuzik 'Shake Bodi' wey skata evriwia for Naija but no money to shoot di vidio bicos poverty use blanket kovaram.
Akordin to Skales on top twita,he say he no fit hide am again as he yarn out di sikrit say,na Olamide naim dasham money wey him take shoot di vidio of Shake bodi.
He say afta dat vidio,him stori change to halleluya and jolliment and he kon thank Olamide for di good ting wey him do for him life.
Olamide don yarn for di mata as he say God dey alive for all of us.
He also yarn Skales say,but two of dem agree to kipam as sikrit na!
Skales kon telam say,no be lie bicoshe try to kip di sikrit but di sikrit no gree.

Sunday 24 September 2017

AFTA NIGERIA GOVMENT AND SOLDIERS CALL NNAMDI KANU AND IPOB TERRORIST BICOS OF BIAFRA,AMERICA DON TALK SAY DEM NO GREE SAY IPOB AND KANU NA TERRORIST


America gofment don finalli yarn somtin konsigning di fight bitwin Nigeria gofment and indigenous pipo of Biafra (Ipob).
If u dey follow up you go notice say two weeks ago,Nigeria army carry fight go meet Nnamdi Kanu and him Ipob soportas for Umuahia and Aba.
Dem kill many pipo and video of pipo wey soljas force to drink potorportor water even come out.
During dat same time,Naija army say Nnamdi Kanu and Ipob pipo na terrorist group.
Buhari sign law to ban dem and also,Federa high court come say dem don ban dem too.
Right now,America gofment don come out and talk say,dem no see Ipob as terrorist pipo but dem dey in soport of Nigeria unity.
Di tori pesin of American embassi for Naija,Russell Brooks naim yarn dis one on behalf of di America govment.
Federa Gofment bin don dey pressure America make dem rekognaiz Ipob as terrorist group but America now don yarn say,no record show say dem be terrorists.
Group of pipo wey no get any record of say dem don kill common fly,Una just hurry call dem terrorist.
Dis our govment sha,dem hurry pass hurricane.
Fulani malu men wey dey kill kill,nobodi call dem terrorist.
Akordin to tori wey we gada,in four years,fulani malu men don kill ova 6,000 pipo for Agatu,Benue state and Federa Gofment no do anytin or call dem names.

Saturday 23 September 2017

CONFAM BREAK UP AS PAUL OF P SQUARE DON RELEASE HIN OWN MIUZIK 'NAGODE' AFTA HIM EVRi YEAR QUAREL QUAREL WIT PETER DON START AGAIN DIS YEAR


Evri year naim P Square dey break up nawadays.
Peter and Paul break up two years ago Dem settle, dem break up last year dem settle and now e be like say dem don break up again dis year.
Last week naim dem bigin disturb us again wit dia wahala and from di way wey di mata dey go,e be like say dis twins don finalli skata as two of dem don write on top intanet about dia wahala.
Even Paul don yarn say na peter wife be di famili ploblem.
But now we dey confam give una dis morning say,Paul don reliz him pasona miuzik wey him call,Nagode to take show say ploblem dey true true.
Una beta skata if una won skata bicos if una comeback nobodi go take una sirios again.

Friday 22 September 2017

COURT FOR IBADAN DON FINALLY ANSWER Di PRAYERS OF FORMA SUPER EAGLES COACH,ONIGBINDE,AS DEM DON END Di 30 YEARS OLD MARRIAGE BITWIN HIM AND HE WIFE


Customary Court for Mapo,Ibadan,don finally end di marage bitwin Super Eagles forma coach Festus Onigbinde and him wife Anne.
Onigbinde bin drag Anne go court say he don tire for di marage bicos she be trouble maker.
Di president of di court,Ademola Odunade give order make Onigbinde give him wife N5,000 make she take transport her load comot for di house.
Di 79 years old Onigbinde say him don tire to die in silence bicos di woman na big bone for him neck.
Onigbinde say her evriday wahala don tire ram.

Thursday 21 September 2017

THANK GOD AS NNPC DON NEARLY FINISH PLANS TO DEY GET OIL FROM SOKOTO


Di Nigeria National Petroleum Corporation NNPC,don dey niali finish plans make dem dey dig and get oil from di Sokoto basin.
For di joinbodi tori wey Malam Imam Imam di tori pesin to Sokoto govnor Aminu Tambuwal sign,he say,di Group managing director of NNPC Maikanti Baro naim yarn dis one afta di gofnor visitam for Abuja.
He say e don tay wey dis oil mata dey ground and veri soon dem go dey get oil from Sokoto basin.
We pray make dem start quick so dat pipo go stop to say na only malu and groundnut north get.

Wednesday 20 September 2017

FARIDA NABOUREMA FROM TOGO,DON BLAST YEMI ALADE SAY SHE DEY SOPORT BAD GOVMENT AFTA SHE COLLECT MONEY PLAY SHOW FOR TOGO PRESIDENT WEY DEM DEY VEX FOR


One of di voice against any bad behavior and bad rule by govment for Togo,Farida Nabourema,don blast Yemi Alade afta she go play show for Togo presido Faure Gnassingbe wey many Togo pipo dey para for right now.
Farida say Yemi Alade disapoint dem as she no fit use her selibriti name take fight for good.
She also yarn say bicos Dem pay Yemi some dollars,she deny her konshens.
Yemi Alade afta tori pipo tell her wetin di Togo woman talk don yarn say,she no be politishan,na show she go play.
Oya watch her video for bottom hia...


Tuesday 19 September 2017

SWEEET VOICE SINGER,SIMI,WEY JUST RELEASE HER ALBUM SOME DAYS AGO,DON YAB NAIJA MEN SAY DEM NO SABi PLAY LOVE AND DEM NO DEY ROMANTIC


One of di biggest babe wey dey faint naija pipo wit good miuzik,don yab naija men from left,right and senta.
Her name na Simi di Jamb Question singa.
During one joinbodi intaviu wit tori pipo afta dem askam say naija men dey romantic or not?
She no waste time to tinkam as she say kapita NO! naija nor dey romantic at all.
Akordin to Simi,Naija men dey feel say dem to much and dem get right to efritin.
She say lot of di men grow up for dis kontri and dem dey feel say no need to dey romantic.
Simi I feel you but me I know many bobos for dis kontri wey get romance full bodi.
I fit giv you dia nombas.

Monday 18 September 2017

Di PIKIN OF HIGHLIFE KING,OLIVER DE COQUE,WEY DIE 10 YEARS AGO,DON TALK SAY,WEN HIM PAPA DEY ALIVE,HE DEY SPEND N30,000 EVRi WEEK TO MAINTAIN HIM BEARS FOR HIM FACE

Oliver de Coque
Darlington alias Safin 

If you talk about di history of highlife miuzik for Nigeria and you no menshon Oliver De Coque name,naim be say dem need to school you.
One of di biggest highlife miuzishan for Nigeria wit ova 70 albums,Oliver de Coque die ova 10 years ago wen he sick.
But one of him pikin,Darlington don tell tori pipo some of him papa sikrit.
One of di tins wey he yarn about him papa be say,di papa like to dey buy plenti clothes.
Akordin to Darlington,he say Oliver de Coque he spend beta money to take maintain imsef so tay,di papa dey spend N30,000 just to maintain him bia-bia.
He say he dey go saloon two times evri week just to arrange and take kia of di bia-bia and mustache for him face.
30,000 just to take of bia-bia?
Naim be say he go reach 50k if he barb hin hair join.
Anyway,naim money sha,Notin like your own.

Sunday 17 September 2017

AFTA HE BLAST 2FACE SAY HE NO COME OUT TO PROTEST AGAINST BUHARI,2FACE DON TELL CHARLY BOY SAY, "BROS LIVE ME ALONE,NOR BE ME BE NIGERIA PROBLEM!"


If u dey follow up,Charly Boy a.k.a Area fada,oganaiz and stage di 'Resume or Resign' protest last month for Abuja against dis Buhari gofment.
Di reason for di protest wey Charly Boy also call #OurMumuDonDo be say,Buhari don spend almost 4 months for London dey trit sickness and meanwhy tings no dey alright for Nigeria.
He call oda selibritis and supastars to join am for dis protest.
Some come out and many like 2face no come out and Area Fada kon blastam ontop Instagram.
2face imsef don tell tori pipo say make Oga Charly Boy livam alone bicos no be him be Nigeria ploblem.
He also yarn he go talk to di pipo wey be Naija ploblem.
Nobodi fit lie right now say naija no get ploblems and we all need voices like 2face and di rest to speak out.
Now 2face don finish plans to do him 'Buckwyd and Breathless Show' for Lagos and he don dey beg Nigerians alreadi make dem turn up.
Turn up for WOT?
If you no fit add ya voice join on how Naija go take beta,why u kon dey worry Nigerians make dem pack kon ya show?
Pipo sopose come togeda to make dis kontri beta.

Saturday 16 September 2017

NOLLYWOOD BAD BABE COSSY ORJIAKORLK SAY,E DEY VEXAM AS PIPO DEY TALK SAY SHE GET FLAT YANSH AND NOW SHE DON READY TO DO Di OPERATION WEY GO MAKE AM BIG



Cossy Orjiakor one of di baddest babe for nollywood and di entatayment industri for Naija,don talk say,e dey pain welwell as pipo dey say her yansh flat.
So diafor,she dey plan to do yansh operation wey go make di yansh big.
But wait o,
Who tell dis Cossy say,life na all about big yansh?
Well na she know.
If anytin appun make she no call my name.

Friday 15 September 2017

OLD SKOOL RAPPER EEDRIS ABDULKAREEM DON TALK SAY,WEN DAVIDO BIKOM MAN,HE GO REGRET SAY NA DIFERENT WOMEN BORN CHILDREN FORAM


Old skool rapa,Eedris Abdulkareem,don yab Davido again.
Dis time around he say,Davido go regret say,diferent women naim born foram.
Davido don get two pikin from two diferen girls wey he give belle and Eedris don dey telam say wen he grow to bikom man,he go regretam bicos,di shidren fit kill demsefs wit jealousy just bicos no be di same mama born dem.

Thursday 14 September 2017

ACCORDING TO LAGOS STATE GOVNOR AKINWUNMI AMBODE,ONE DAY ONE DAY AND VERY SOON,LAGOS STATE GO PRODUCE Di FIRST WOMAN GOVNOR FOR Di STATE


Lagos state gofnor,Akinwunmi Ambode,biliv say veri veri soon woman go bikom govnor of Lagos state one day.
He yarn dis one wen he resiv di Lagos state govnor for only one day Miss Zuffon Bukola,her assistant and sekond for command Miss Rosemary Ogidan plus oda membas of her team.
Evri year,Lagos dey get one day Gofnor from sekondri school.
Dem select dis two girls as govnor and assistant govnor afta dem carry first and sekond position for di spelling kompetishon.
Bicos of dis one,Govnor Ambode say for two girls to carry first and sekond for di konpetishon show say veri veri soon woman go soon bikom govnor for di state.

Wednesday 13 September 2017

MINISTA OF WOMAN MATA,AISHA ALHASSAN WEY TALK SAY SHE NO GO SUPPORT BUHARI FOR 2019 ELECTION,GO SIDDON FACE TO FACE WIT BUHARI AND OTHERS FOR FEC MEETING TODAY


Minista of women mata for Nigeria,Aisha Alhassan last week talk say for 2019 election na Atiku Abubakar she go soport instead of her present Oga.
Akordin to Aisha she say,na Atiku be her politika God fada.
She say her present Oga President Buhari wey she dey work right now,no be di right pesin for 2019 President elections.
For Di first time afta she reject Buhari,dem go sidon face to face today for di FEC meeting togeda wit oda ministas to diskors about Nigeria.

Tuesday 12 September 2017

FOR SOUTH AFRICA, 5 LIONS DON ESCAPE FROM WiA DEM KIP DEM AND DIA GOVMENT DON WARN PIPO ABOUT NIGHT WAKA SO DAT Di LIONS NO GO USE DIA BODY DO FOOD


For Guateng province for South Africa,One giant lion and four small ones,don eskape from wia dem kip dem.
Di govment for dia don dey draw ear dey warn pipo about nite waka if not,di five lions go use dia bodi take drink garri.
Dinsafety pipo wey dey try to arrest di lions,see for nite as dem busy dey chop one malu wey dem kill but to pin dem down for nite go hard so diafor,dem don warn pipo for di area make dem dey inside dia house jejeje bicos,lions no dey waste time to kill.
In case u nor know,na Lions be di kings of di jungle.

WOW! WATCH WETIN DIS BABE USE 15 OLAMIDE SONGS DO FOR INSIDE 60 SECONDS (VIDEO)



Wen you see beta talent,na 2 seconds e go take you to rekognaiz am.
Big Broda Naija winna Efe,don dey do miuzik afta di Big Broda show and many pipo dey shout say miuzik no be him calling.
Now anoda Efe don boss out!
Dis time around na girl dis one be.
Her name na Efe Oraka and di babe do magic wit 15 Olamide songs in 60 seconds.
Watch di video of di babe Efe for bottom hia weda miuzik na her calling or not.
No long talking.
Oya kliq and watch...


Sunday 10 September 2017

TEETH DOCTOR OKIKE SUNDAY,DON ADVICE RAPPER PHYNO,MAKE HE DO SOMETHING ABOUT HIM YELLOW TEETH BICOS NA BAD TING FOR SUPER STAR LIKE AM TO GET YELLOW TEETH


One teeth doctor Nebeokike Sunday don advice rapper Phyno to take kia of him teeth wey yellow like Mtn rice.
Di teeth doctor yarn dis one on top twita and he say he no want make anybodi bring insult enta di mata.
He say to make pipo teeth to look white and pure naim bizness no be say he just won yarn for yarning sake.
Akordin to di teeth doctor,yellow teeth no be crime but supastar like Phyno sopose get white teeth so diafor,him readi to hep Phyno.

Saturday 9 September 2017

ANNA BANNER,Di MOTHER OF FLAVOUR NABANIA SECOND PIKIN DON YARN SAY,Di LOVE WEY SHE GET FOR FLAVOUR NO BE ORDINARY LOVE BICOS SHE STILL LOVE Di BOBO SCATTER


Hip Highlife king for Naija Flavour second baby mama Anna Banner don tell TORi pipo say di love wey she get for Flavour no be odnari love.
She say she don alreadi turn star bifor she meet Flavour so diafor anybodi wey dey feel say she just use style carry belle for supastar Flavour,dey wrong.
She say na real love make her do am.

Friday 8 September 2017

PROPHET T.B JOSHUA DON FINALLY READY TO BUILD Di BEST UNiVASiTi FOR ONDO STATE AND HIM GO ALSO BUILD WERE PRIVATE JET,HELICOPTER AND NAVY SHIPS GO DEY LAND AND PARK


Di Synagogue Church of All Nations founder,Prophet T.B Joshua,don finally agree to build him univasiti for Ondo state,Nigeria.
Many Churches and dia pastors get univasitis for Naija and many pipo don dey ask say,wen T.B Joshua go get.
No ask again as di man of God don finalli get one big land for Ondo state wia him go build di school put.
Apart from say dem won use $1billion build am,he go also get airfield and helipad wia private jets,helikopta go dey land and park put.
Also navy ships sef go dey park for dia too just to give easy life to di Navy school for Imeri,Ondo state.
Akordin to tori wey enta our newsroom,if dem build di school finish,naim go be di first of is type for di hole world.
Nice one Oga T.B Joshua.

Wednesday 6 September 2017

ACCORDING TO FEDERA GOVMENT,BIFOR ANYBODI WEY DEY STUDY AGRICULTURE FOR UNIVERSITY GRADUATE,HE MUST GET FARM


Federa Gofment don yarn tori pipo say bifor any student wey dey read agriculture for univasiti go leave di school,he must get farm for somwia.
Dis kain ting na wa o.
Who no get land to farm don enta one chance be dat o.

Monday 4 September 2017

LIE ON TOP MY HEAD NO WAHALA,CURSE ME NO WAHALA BUT IF YOU TOUCH MY WIFE,I FIT KILL YOU..DAT NA WETIN PASTOR ADEBOYE OF REDEEM CHURCH TALK


Pastor E.A Adeboye,The General of Redeemed Christian Church Of God,don yarn say,if you really love your wife you must readi to die foram.
He yarn dis one wen he dey preach for RCCG Redeem headquarters,Throne of Grace for Ebute Metta,Lagos.
Papa Adeboye say you fit insult am,slapam,lie on top him head but if anybodi touch him wife,he go kill di pesin.
Meaning say he go pray to him papa for heaven and di pesin fit sleep nor wake up.


Sunday 3 September 2017

OUR OGBONGE SUNDAY TORi FOR TODAY BE SAY,Di GOVMENT OF CHINA DON BAN CHILDREN MAKE DEM NO DEY GO CHURCH AGAIN AND DEM SERIOUS ABOUT AM


Wetin man no go hear for dis world?
China don ban shidren make dem no dey go church again.
Nor be today dis mata start as dem don dey even stop churches make dem no put Jesus Christ cross for dia building for Zhenjiang province.
Today dis kain law don dey enta evriwia for dat kontri as China don say,dem no won see any pikin for church again but instead,make young pipo bigin study and take science sirios.
Di same China bin put law say, make pipo no dey born pass one pikin.
Now,if papa and mama wey no get house girl won go church,who dem go live dia pikin for?

Saturday 2 September 2017

DANGOTE DON TELL THE PDP PIPO WEY WANT MAKE HE BE NAIJA PRESIDENT FOR 2019 SAY MAKE DEM LIVAM ALONE BICOS NA BIZNESS MAN HIM BE NOR BE POLITICIAN


Aliko Dangote,baddest billionaire for Africa,don tell all di PDP membas wey dey begam to run for president election for 2019 say,dem dey waste dia time bicos na pure bizness man him be.
Dangote say him no wan mix bizness wit politiks bicos politiks nor dey him dikshonari at all.
So if you dey plan to force am to spend money on top 2019 president election,your name na sorry bicos di man don yarn tori pipo say,no juju fit change him mind.

Friday 1 September 2017

D'BANJ DON YARN SAY,HIM USE ROLEX WRISTWATCH TAKE SIGN DAVIDO FOR 2014 BUT DAT TIME,HIM PAPA NO GREE BICOS HE WANT MAKE DAVIDO FINISH SCHOOL FIRST


D'banj,forma Don Jazzy main man,don yarn U.K. tori boys say,na Rolex wristwatch him bin take sign Davido for 2014 but afta him hold small joinbodi meeting wit Davido papa,di papa kon say,he want make Davido finish school first.
But today akordin to D'banj,Davido don turn one of di biggest miuzishan for Africa and he can afford to many Rolex share giv pipo.
But come to tink of am.
2014?
As at 2014,Davido don large pass D'banj for miuzik.
Maybe he make mistake for di year wey him givam Rolex.
Anyway,stil watch di video wia D'banj for talk am for bottom hia...


LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...