MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 31 October 2018

THE NIGERIA LABOUR CONGRESS,NLC, DON DEY DRAW NAIJA PIPO EAR SAY,MAKE DEM BUY 'FOOD FULL HOUSE' BIFOR NOVEMBER 7 BICOS,SERIOUS STRIKE DEY COME


Akordin to di Nigeria Labour Congress NLC, di strike wey go start on Novemba 7,go  sirious pass high fever.
And dem don advice say buy rice,buy beans,buy onions,buy any food wey go last you bicos, di strike wey won start by next week go tie wrappa and wear agbada on top.
For some time now,NLC don dey beg gofment make dem inkriz workers salari wey oyibo dey call minimum wage from 18k to 56k.
Dem don dragam tire wit gofment sotay dem don say make govment dey pay workas 30k but di govnors now dey yarn say na N22,500 salary dis pawa reach and na dis one make NLC dey draw our ears say,dis time around di strike go carry high current so diafor,buy food for house.

Tuesday 30 October 2018

BIG FISH 'CRISTIANO RONALDO' DON BREAK ANODA RECORD AS HE DON BECOME Di PESiN WIT THE HIGHEST NUMBER OF FOLLOWERS ON TOP INSTAGRAM FOR Di WORLD


Juventus and Portugal soccer star Cristiano Ronaldo don kontiniu from wia he stop as he don kontiniu to tumble more records.
He don break records tire for field and now di records don kontiniu to fall on top sosha midia.
Just yestaday,Ronaldo break di Instagram records as he bikom di pesin wit di highest numbers of followers on top Instagram.
Bifor we enta our tori room,di bobo don get over 144 million three hundred and somtin followas.
Na America singa Selena Gomez bin dey wit di record since 2016
She bin take ova from anoda singa Ariana Grande.

Monday 29 October 2018

SEE GOBE! OLAMIDE AND WIZKID CONCERTS GO HOLD FOR THE SAME DAY (DECEMBER 23RD,2018) AND LAGOS BALLERS DON DEY DIVIDED ON WHICH PESIN OWN DEM GO ATTEND



Di Made in Lagos show wey Wizkid dey do for Eko hotel and di OLIC4 wey Olamide wan do for Eko Atlantic,go appun for di same day wey be December 23,2018.
Dis na problem for fans for Lagos as dem dey konfiuz on which pesin own dem go attend.
See gobe!

Sunday 28 October 2018

RAPPER 'YCEE', DON YARN TORi PIPO SAY,FOR Di INDUSTRi DiS YEAR,NOBODY DESERVE THE 'MUSICIAN OF THE YEAR' PASS BURNA BOY



Omo Alhaji and Jagaban rappa 'Ycee' don choose Burna Boy as him miuzishan of di year.
He postam on top him twita account and e be like say him no joke about am.
Afta he yarn am,many pipo wey yarn concerning di mata gree say,dis year belong to Burna Boy.
True true di boy dey on fire afta he bless di industri wit him 'Outside Album' early dis year.
If you dey follow up,you suppose know say about two years ago,naija intanashona singa 'Jidena' yarn tori pipo say,Burna Boy na confam talent and we nor know di talent wey God bless us wit yet.
And true true di Port Harcourt propati neva disappoint.

Saturday 27 October 2018

OBA OF LAGOS DON YARN TORi PIPO SAY,IF PRESIDENT BUHARI WIN THE 2019 ELECTION AGAIN,HIM GO ADVISE AM TO CLOSE OUR BORDERS MAKE OBASANJO NO ESCAPE



Di Oba of Lagos Rilwan Akiolu don kontiniu him fight wit forma khaki and sivilian presido Olusegun Obasanjo.
He say instead of Obasanjo to face naija problems dat time wen he win election for 1999, na as he won take kapchor Lagos naim he pursue for him first four years.
Di good ting akordin to di Oba be say him no givam dat chance.
He say Obasanjo no be beta pesin and if President Buhari win next year election, him go make sure say him advise am make he close down our borders make Obasanjo for no eskape.
Di Oba go selibrate him 75 years birthday few days from now.
I go siddon for fence dey watch wetin Obasanjo get to yarn for dis mata and imidiateli he ansa di Oba,una go ridam hia.

Friday 26 October 2018

TIWA SAVAGE DON TALK SAY,IF THE 'GUM BODY' WEY SHE AND WIZKID DEY DO..DEY GIVE ANYBODY HIGH BLOOD PRESSURE, MAKE Di PESiN CHARGE HER TO COURT



The pipo of di moment,Tiwa Savage and Wizkid friendship,don dey give wahala big problem.
Some pipo don dey call Tiwa Savage names since dem take dia gumbodi go di next level espeshali afta she fichor for Wizkid record breaking video 'Fever' wey don turn di world upside down.
Some say she be Olosho,some say she be afta one',some say she be old mama youngie wey dey fool hersef for small boy Wizkid.
Mama Jamjam hersef don come out yarn say,anybodi wey get ploblem wit she and Wizkid kemistri,get right to charge di mata to court.
One ting for di mata be say,pipo dey forget say dis pipo na entatainas and dem get right to push dia karia to di next level wit all manners of stunt.
If you dey follow up,you go don notice say dis dia joinbodi don fetch dem records.
Dem win award last year for di best colabo wit Tiwa song 'Malo' and Tiwa sef don yarn say dis na just di beginning of dia friendship.

Thursday 25 October 2018

MANY AFRICANS DON DEY PRAISE LIBERIA PRESIDENT 'GEORGE WEAH' AFTA HE DECLARE FREE EDUCATION FOR ALL PUBLIC UNIVERSITIES FOR Di KONTRi


Weda di free education for univasitis wey di 1995 World footballer of di year and Liberia president 'George Weah' declare go last or not,Africans don show say dem no wan know.
Di only ting wey dey dia head right now be say,foram to statam at all,dem dey veri hapi as many Africans still dey shawa praises on di man of di moment afta he say,no more school fees for Liberia public univasitis .
Dat kontri dey live on low budget and even for one year dem no fit make di kain money wey Nigeria dey make for one day but yet,our leaders dey fall our hand.
We need freedom for dis kontri.

Wednesday 24 October 2018

FEDERA GOVMENT DON DEY WORK ON PLANS TO ANNOUNCE Di NUMBER OF CHILDREN WEY MAMA DEM GO DEY BORN ACCORDING TO FINANCE MINISTA 'ZAINAB AHMED'


Akodin to di minista of finance Zainab Ahmed, di eva inkrizing population for Nigeria dey affect di Ekonomy Recovery and Growth Plan (ERGP) of federa gofment.
She say di only way wey dem go take hep di situation na to kontrol di nomba of shidren wey Nigeria mama dem go dey born.

Tuesday 23 October 2018

THE FEDERA HIGH COURT FOR ABUJA DON DIRECT THE NIGERIA POLICE FORCE TO PAY CHARLY BOY N50 MILLION NAIRA AFTA DEM ATTACK AM LAST YEAR BICOS OF BUHARI



If tori wey dey reach our newsroom na anything to follow,naim be say,Charly Boy go dey N50 million naira richer afta Di Federa High Court for Abuja don pass judgement say make  Di Nigeria Police Force,Inspector General of Police Mr Ibrahim Idris and Di Komishona of Police Abuja Command  pay am di 50 Milla.
If you dey follow up,you go rememba say last year Charly Boy gada him fans go do peaceful 'Resume or Resign protest' for Unity Fountain for Maitama Abuja against President Buhari medical waka waka for almost four months.
But Las Las di Nigeria police use tear gas and big big dogs take chase Charly Boy and him pipo comot for di ground and na dis piriod Charles take faint.
Him lawyer wey carry di Mara for head na Inibehe Effiong.

Monday 22 October 2018

WIZKID FORMA BEAUTIFU GIRLFRIEND 'TANIA OMOTAYO', DON FINALLY MARRY RESTAURANT OWNER 'SUMBO' YESTERDAY FOR LAGOS


Afta she wait tire for Wizkid hoping say dia friendship go see light,di starboy forma girlfriend 'Tania Omotayo' don las last marry Lagos restaurant owna Sumbo' for dia traditional marriage yestaday for Lagos.
Tania and Wizkid na big item for about 3 to 4 years until di supastar give two more girls belle afta him first baby mama don born him first son foram.
Wizkid don get three boys from three different women and Tania don carry her life face wia she feel say she get future.

Sunday 21 October 2018

ONE TIME GHANE BASE NAIJA SINGA 'MR EAZI' DON YARN SAY,E NO GET ANYTIME WEN HIM TALK SAY,GHANA MUSIC BETA PASS NAIJA MUSIC


Wen dem say make pipo try dey dey kiafu bifor dem yarn some kain tings,e go be like say you no want di pesin progress.
Now,naija singa 'Mr Eazi' wey blow wen he dey Ghana,don dey explain tire say him no yarn say Ghana miuzik beta pass naija miuzik.
He say he no get anytime wen him use di word 'beta pass' say na pipo dey put word for him mouth.
If you dey follow up,you suppose rememba about 2 years ago wen naija twita users battle Mr Eazi afta he say Ghana miuzik dey influence naija miuzik.

Saturday 20 October 2018

WIZKID BODYGUARD 'ROY' SAY MANY PIPO BIN ADVICE AM SAY WIZKID GO USE AM DO YEYE BUT TODAY,WIZKID DON GIVAM JOY AND PUT SMILE FOR HIM FACE



Roy Emmanuel, di pasona bodyguard to Wizkid don yarn tori pipo say,Syarboy don put smile for face and givam unlimited joy since 2012 wey him dey bodyguard am.
Akordin to Roy he say many pipo bin dey advice am make he live Wizkid say Starboy go use am do yeye but him say today,Wizkid don prove dem wrong as him dey veri hapi to dey work witam.
He say Wizkid na God sent.

Friday 19 October 2018

ANAMBRA VILLAGE SCHOOL CHILDREN DON MAKE 'GENERATOR' WEY DEY USE WATER INSTEAD OF FUEL




Imagine say di Anambra village school children wey don make generator wey dey use only water na obodo oyibo children dem be.
Trust me,dia govment go make sure say dem hep dem develop dis kain generator until di world go know about am and bigin make beta money inside di mata.
No be only generator wey dey use water dis Anambra school children make.Dem also make Torchlight wey dey use potato as battery,rocket laucjer and waste digesta.

Thursday 18 October 2018

THE NIGERIA 'SENATE' DON TELL CBN MAKE DEM ALLOW PEOPLE FIT DEY USE DiA ATM CARD WITHDRAW N40K AT ONCE FROM ATM MACHINES


Di Nigeria Senate don come out wit new order as e take concern naija pipo and banks.
Dem say unnecessary banks charges must stop.
Charges like ATM maintenance fee and some other ones na wuruwuru charges.
Di senate also tell Central Bank of Nigeria CBN make dem direct banks to make am posibo for pipo to fit dey use dis ATM cafrd widraw N40k at once from ATM machines instead of di 20k wey dem fixam put bifor.
Di senator wry sponsor dis bill na Gbenga Ashafa wey dey represent Lagos East.

Wednesday 17 October 2018

FOR ONDO STATE,POLICE DON ARREST Di MADMAN WEY RECEIVE N1.5 MILLION ALERT FOR HIM PHONE DURING WEN DEM BIN DEY ASKAM QUESTIONS


Madman wey dem see as kidnappa don enta more wahala afta N1.5million naira alert enta him phone.
Di alert  enta him phone wen police arrestam dey askam question for oda offence.
All dis one appun for Ondo state.
Akordin to di tori wey we gada,wen police dey askam queshon naim alert enta him phone.
immediately di alert enta him phone, di madman draw di phone take from dia hand and use am nack ground skata so dat dem no go see di alert.
Police for Ondo now don yarn say,dem go repair di phone and see di tings wey di madman dey try hide.

Tuesday 16 October 2018

POLICE DON SEIZE GUN FROM MAVIN RECORDS AND DON JAZZY DJ 'DJ BIGN' AFTA DEM SEE AM WIT Di GUN WEN HIM AND SOME PIPO DEY FIGHT FOR LAGOS


DJ BigN,di DJ to Mavin records don invite kasala enta him own bodi afta police seize gun from him hand.
He appun for Lounge38 for Surulere,Lagos.
Akordin to di tori  wey we gada,fight broke out bitwin BigN friend and anoda guy.
Even Dr Sid try to settle di fight but he no fit.
Bifor we know wetin dey appun,DJ BigN rush go back of him white car and bring out gun.
No be only dat one o,as dem say he fire some shots on air.
Police no hapi wit wetin dem see as dem seize di gun from am.
Weda na license gun or not,na dat one we neva know but we go bring una more tori wen e drop as e take concern BigN.

Monday 15 October 2018

IF YOU DEY FOLLOW UP, TODAY SUPPOSE BE Di BIRTHDAY OF Di OGAKPATAKPATA OF AFROBEAT MUSIC 'FELA' IMSEF AS HE CLOCK 80 YEARS TODAY


Happy 80 years birthday to di Ogakpatakpata of Afrobeat miuzik 'Fela Anikulapo Kuti'.
Today suppose mark him 80 years birthday like say him dey alive.
Dem born Fela for October 15,1938 and He die on the 2nd of October,1997.
Evribodi know am as a fearless man wey dey sing about di rubbish karata of gofment.
For di record,Fela na di most respected miuzishan weda dead or alive wey Nigeria don produce.
Rest on Ebami Eda of Africa.

Sunday 14 October 2018

SUNDAY TORi: FOR SEPTEMBER ALONE,MERCEDES BENZ DON SELL OVER 200,000 CARS WORLDWIDE


One of di strongest car brand for di world Mercedes Benz,don sell over 200,000 cars for di month of September for di world.
Dem sell 202,819 cars for only September for kontris like America,Australia,Turkey,Japan,Portugal,France,U.K. and other kontris wey dey follow big time for car mata.

Saturday 13 October 2018

JAMAICA BORN BRITISH SINGER ''STEFFLON DON'' DON DEY CELEBRATE SAY SHE DEY VERi VERi HAPPY SAY MOSQUITO DON BITE HER FOR Di FIRST TIME




Mosquito bite you you dey hapi you dey selibrate,e don red be dat.
Well,British singer Stefflon Don don dey sing alleluya hosanna onto say mosquito don finalli bite her for di first time for her life.
Di British born Jamaica singa postam di pishor for her insta story and tori pipo don carry di news enta town.
But wait to,dis girl na from Jamaica and she go don visit her kontri even tho say na England she dey stay.
I don also watch some of her video wey she shoot for ghetto.
So mosquito no dey all those place?
Well,she try to avoid all di mosquitos sha or maybe dem dey fumigate di ghetto area bifor she travel go dia.

Thursday 11 October 2018

THE STRIKE WEY WORKERS FOR Di LOCAL SIDE OF THE MURTALA MOHAMMED AIRPORT LAGOS STRIKE, DON DEY AFFECT BIZNESS SERIOUSLY FOR THERE


Airline operators don dey find new ways to take arrange dia bizness for di local side of di Murtala Mohammed airport 2 for Lagos afta di airport workers strike.
Dia biggest problem now na how to dey carry dia passengers go diferen diferen area.

Wednesday 10 October 2018

Tuesday 9 October 2018

32 YEARS OLD UGANDA WOMAN 'LULU JEMIMAH', DON VEX MARRY HERSELF BICOS OF TOO MUCH PRESSURE FROM HER FAMiLi UNTO SAY DEM WANT MAKE SHE DO MARRY



Dis na di Queen of all wondament as one Uganda woman don surprise even her famili.
Lulu Jemimah wey be student of one of di ogbonge school for di world 'Oxford Univasiti' for UK don vex marry hersef unto say di pressure too much from her popsi and momsi.
Oboy,I weak finish o!
See tori.

Monday 8 October 2018

FEDERAL GOFMENT DON PROMISE NAIJA WORKERS SAY,DEM GO SOON SMILE BASE ON Di NEW SALARY PACKAGE WEY DEM DEY PLAN AFTA WORKERS COMPLAIN SAY,N18,000 TOO SMALL


Akordin to Olusegun Adekunle di pamanent seketri wey represent Buhari seketri Mr Boss Mustapha for di Choir Anniversary wey di Christ Apostolic Church of God headquarters for Abuja arrange,he say,federa gofment go soon make naija workas smile.
Di Nigerian Labour Congress NLC bin strike say make dem inkriz dia salary from di 18k wey dey bicos he no dey rish to even take kia of famili for one week.
NLC say dem want N56,000 but govment neva still ansa dem.

Sunday 7 October 2018

NOLLYWOOD NEW LOVA BOY 'NINO B' DON YARN TORi PIPO SAY,HIM NA STRONG CHRISTIAN BUT HE NEVA ENTA CHURCH ONCE SINCE DEM BORN AM



Bolanle Ninalowo di bobo wey many don see as di new lova boy for di naija movie industri,don yarn tori pipo one ogbonge sikrit.
Di guy say,even tho say him na strong Christian,him neva enta church once since him papa and mama born am come dis life.
Bolanle Ninalowo a.k.a Nino B say,although dem born am enta Muslim famili but naim diside to be Kristian.
He also yarn say,bicos you no dey go church no mean say you no be Christian as na pasona race bitwin you and God.
Akordin to Nino B he say,make your heart pure naim mata.

Friday 5 October 2018

Di NEW LAW WEY GOVMENT DON ARRANGE NOW BE SAY,IF DEM CATCH ANYBODi DEY SPRAY NAIRA FOR PARTY, DAT PESIN GO PAY FINE OF 50K OR SERVE 6MONTHS FOR PRISON



Di new law wey govment don konclude plan to bring come for naija be say,if dem match anybodi dey spray money for party,dat pesin go see pepper.
Di bankers komiti naim dem yarn dis one on Thursday.
Akordin to the Central Bank of Nigeria CBN tori pesin,Mr Isaac Okoroafor,di ministry of Justice and di Nigeria police go dey involve so dat di law go fit work.

Thursday 4 October 2018

REGGAE LEGEND 'LUCKY DUBE' BEAUTIFU DAUGHTA 'BONGI DUBE' DON ESCAPE DEATH AFTA SHE STEP ON TOP NAKED WIRE WEN SHE DEY PERFORM FOR STAGE




Di Dube famili don eskape sad news as electric shock niali kill 'Bongi Dube' di biutifu daughta of reggae king Lucky Dube.
Bongi take afta her papa footstep as a miuzishan and na wen she dey stage electric niali shock her die.
As she enta stage to sing,she mistakeli step on top naked wire.
She post di pishor for her Instagram page of how di accident take injor her for leg and her hand as she no fit dey waka or drive for now.
Her husband sef join dey trit her right now bicos him na doctor.
Eleven years ago,bad guys kill her papa 'Lucky Dube' for Rosettenville near Johannesburg for South Africa.

Wednesday 3 October 2018

GHANA RAPPER 'KWESI ARTHUR' DON TELL TORi PIPO SAY,DEM RECOGNISE NAIJA MUSIC FOR INTERNATIONAL STAGE WELWELL PASS GHANA MUSIC


In case you neva hear,Ghana rapper Kwesi Arthur don put naija miuzik 
on top as he say Nigeria miuzik don go intanashona but Ghana miuzik still dey ground dey crawl.
Akordin to Kwesi he say,sometime ago,him dey Yankee and di only Africa miuzik wey pipo dey play for diferent joint na NAIJA miuzik.
He kon urge Ghana miuzishans say,make dem no give up to climb di ladder like naija miuzishans..

Tuesday 2 October 2018

UNTO SAY APC OGA 'TINUBU' YARN SAY HIM NO WANT 'AMBODE' AS GOFNOR OF LAGOS STATE AGAIN,OLAMIDE DON TANDA GIDIGBA FOR AMBODE BACK AS HE SAY Di GOFNOR MUST WIN AGAIN


If you dey follow up,you go don hear dat song 'Fada Fada' wey Olamide join bodi sing wit Phyno and inside di song he sing say,since him papa die naim Govnor Akinwunmi Ambode of Lagos state don dey act as him new papa.
Now di same Olamide don dey drum support for Ambode say di man must rule Lagos for aboda for years even say di man wet bring Ambode to be gofnor 'Bola Tinubu' don yarn say Ambode must go.
Di new pesin wey Tinubu dey support now to win Ambode na Sanwo Olu.
Dis Lagos state election,anybodi wet no get balls no fit play am.

Monday 1 October 2018

SUPASTAR WRESTLER 'JOHN CENA' WON QUIT WRESTLING JUST BICOS HIM WIFE BREAK HIM HEART



Afta John Cena yarn on top twita concerning him ex-babe,e no take time for pipo to judge say di guy won quit wrestling sake of say di babe knock am.
We dey wait to know wetin dey sup.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...