MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 30 January 2018

SAD NEWS AS OLAMIDE DON ANNOUNCE SAY HIM MAMA DON DIE,Di SAME DAY WEY OLAMIDE CELEBRATE HIM SON 'MAXIMILIANO' BIRTHDAY


Naija nomba one Science Student,Olamide,don lost him mama today as dis one troway shock enta di entatayment industri.
Olamide mama die today wey be di 30 day of January di same day wey Badoo selibrate him pikin Batifeori Maximiliano Adedeji nomba three birthday.
If you dey follow up,Olamide papa die for 2015 bifor dis one kon appun today.
We still dey try gada di news of how he take appun and we go bringam to una as e drop.
Rest In Peace Mama Badoo.

SOUND SULTAN SENIOR BRODA 'BABA DEE' DON YARN SAY,HIM SURPRISE FOR Di LEVEL OF POVERTY WEY HIM SEE FOR ONE WHITE MAN COUNTRY 'ESTONIA'


Baba Dee wey be di sinior Broda to Sound Sultan don talk say,wen him travel go 'Estonia' for Northern Europe,him shock to see say dem poor like us too.
He say for a kontri of white pipo,him surprise say dia poverty level high welwell.

Monday 29 January 2018

E TAKE AIYEGBENI 10 YEARS TO SCORE 8 GOALS FOR ENGLAND FA CUP BUT IHEANACHO DON BREAK Di NAIJA RECORD AS HE DON SCORE 9 GOALS IN JUST TWO YEARS


Forma Manchester City player Kelechi Iheanacho of Nigeria don break record for England FA Cup as he score him nomba 9 goal for di konpetishon afta him club Leicester City win Peterborough 5-1 on Saturday.
Iheanacho score two goals out of di five to pass Yakubu Aiyegbeni wey bin dey hold di record of all Naija playa wey don score pass for di England FA Cup.
Iheanacho don score 9 goals for 9 matches in two years,Aiyegbeni score 8 for 20 matches and he take am 10 years to score dem,Victor Moses dey 6 goals from 29 matches and Kanu Nwankwo score 6 goals from 24 FA Cup matches.

Sunday 28 January 2018

I GET 13 PRESIDENT PHONE NUMBERS.. DAT NA WETiN DAVIDO TELL TORi PiPO YESTADAY


Davido go always yarn wetin some pipo go see as shakara and pride but no lookam like dat, na just him style.
Evribodi wit dia own karata and Dis na di difrence bitwin some pipo and oda pipo.
Akordin to Davido wey plasta evri evri for 2017,him say him get 13 Presidents phone numbers and if he call dem,dem dey pick one time.
Bobo you try,e no easy but no be only u get dia nombas,some selibritis fit get like 20 President nombas but dem no wan just yarn.
Anyway as Davido talk am e no bad bicos talk like dis dey inkriz pesin GP for do industri.
Like me now,I get 14 Presidents nombas but I no just won talk yet.

Saturday 27 January 2018

"MAKE UNA STOP TO DEY DRINK GARRI" IMO STATE GOVNOR,ROCHAS,DON TELL IMO PIPO AFTA LASA FEVER KILL 3 PEOPLE FOR Di STATE


Na rat spit or shit dey cause Lasa Fever espeshali bicos dis rats like to dey play for inside garri and even tiff garri eat.
Many pipo don get dis lasa fever and many don die from am.
Tori wey rish us be say,three pipo don die from dis lasa fever for Imo state and Na dis one kon make di govnor of di state Rochas Okorocha dey beg dem make dem stop to drink garri.
Imo pipo ova to una.
Una Gofnor say lasa fever dey town so diafor,make una avoid garri.

Friday 26 January 2018

ALL 'MAN U FANS' AND CORRECT FOOTBALL FANS,WERE UNA DEY? IN CASE YOU NOR KNOW,TODAY NA JOSE MOURINHO BIRTHDAY


Big name and top coach for world football Jose Mourinho birthday na today.
Dem born am January 26 for 1963 and he don turn 54 years today.
If you dey follow up,you go know say,Mourinho don win many trophy for him coaching karia.
He win Champions League wit Porto of Portugal and Inter Milan of Italy.
He don also win many cups wit clubs like Real Madrid and Chelsea.
Naim be di coach of Manchester United right now since 2016 and he don alreadi win two cup for dem.
Some dey call am di 'No Nonsense Coachi' but him nickname imsef di 'Special One' dat year wen he still dey Chelsea.
We for Ogakpatakpata dey wish you Happy Baitday Sir.
You go resiv ya baiday gift today from us if night nor quick rish.

Thursday 25 January 2018

POLICE DON ARREST OGOGORO PROPHET 'PROPHET TITO' FOR TANZANIA AFTA PICTURE OF WEN HE DEY KISS HIM 'WIFE AND HOUSE GIRL' COME OUT



Dis one weak me like dodo o.
Afta pishor of one Tanzania prophet, Prophet Nabii Tito of wia he for dey kiss him wife and house girl for public come out,police don arrestam.
Nor be just odnari kiss o,na beta ashawo kiss naim Di prophet kiss him wife and house geh for public and na di prophet imsef use him own hand dey post di pishors for intranet.
Akordin to dia police,dem say no be only Di kissi kissi pishor be Di ploblem.
Dem say anoda reason why dem arrestam na di alcohol wey him dey shack anytime he dey preach.
Di tin vex Tanzania pipo and dem kon ginja police to arrest di prophet base on say as man of God wey he claim,dat kain karata no good,dat kain karata na bad example.

Wednesday 24 January 2018

ONE OF Di BIGGEST MUSICIAN FOR Di WORLD RIGHT NOW 'ED SHEERAN' DON TALK SAY, HIM GO FORGET ABOUT MUSIC IMMEDIATELY HE START TO BORN CHILDREN


Akordin to Ed Sheeran one of Di most respected miuzishan for Di world right now,him go stop miuzik imidiatli him and him woman start to born pikin.
I no know how miuzik take konect getin shidren but well,naim life.
If he say he wan pack go moon go sidon,diaris notin we fit do about am.

Monday 22 January 2018

FULANI HERDMEN AND MALU BOYS DON BURN DOWN Di FARM OF OLU FALAE Di FORMA SEKETRi OF FEDERA GOVMENT AND MINISTA OF FINANCE


Afta dem bury 75 pipo wey dem kill for Benue state,dis Malu boys and Fulani herdsmen don kontiniu to kill and destroy pipo farm.
News wey dey rish our tori room dis morning be say,Fulani herdsmen don burn down Di farm of Olu Falae.
If you dey follow up bifor today,you go don know say Olu Falae na forma seketri to federa gofment and also minista of money mata bifor bifor.
Plenti pipo don dey ask queshon say,wetin Falae do dis Malu boys bicos ova two years ago,na so dem kidnapam bifor dem later relizam.
Now dem don burn him palm oil,yam and kasava farm and meanwhy,Buhari gofment just quiet dey look dis nonsense wey dis boys dey do.

Sunday 21 January 2018

TIMAYA FORMA GIRL FRIEND 'EMPRESS NJAMAH' DON TALK SAY,E DEY PAIN AM ENTA HER BONES ANYTIME WEY SMALL SMALL BOYS DEY TELL HER TO BE DiA LOVER


We bin hear say age na notin but nomba but nollywood babe and Timaya forma geh frend 'Empress Njamah' don talk say,she hate make small boys dey spinam and tell her about touching bodi.
She say many pipo dey feel say she be twenti somtin years old babe and di truth be say she be tarti 30 plus already.
She say wen 20 years old boys dey tell her to be dia lova,di ting dey pain am for bodi.

Saturday 20 January 2018

WIZKID DON YAN SAY HIM LIKE TO BE LIKE Di KING OF REGGAE MUSIC 'BOB MARLEY' AFTA HE LISTEN TO PLENTi OF HIM MUSIC

Wizkid and Bob Marley Pikin,Damian Marley
Mention pipo wey dem name go last forevavfor dis world, Bob Marley name must dey among and I no dey sorprise wey Starboy Wizkid say,him like to be like do reggae miuzik king.
Marley die almost 37 years ago but do koret jamming jamming wey di man sing bifor he die still dey skata evriwia til today.
And WizKid listin to some of Marley song,he kon yarn say,true true him like to be like Bob Marley.
Watch do video for hia...


Friday 19 January 2018

EFCC DON DEY LOOK FOR WHO HIDE $500 MILLION WEY DEM REKOVA FROM ABACHA AND HIM FAMILY ACCOUUNT


Di $500 million wey Sani Abacha and him famili tiff from our kontri don get K-leg akordin to Efcc afta oyibo kontris send di money give us back.
Di money wey di banks for obodo oyibo send give Nigeria nobodi no wia di money enta right now as EFcc dey use torch and candle dey find am.

Thursday 18 January 2018

NOBODY KNOW NIGERIA RAPPERS FOR SOUTH AFRICA, DIA SABi END FOR INSIDE NAIJA ACCORDING TO SOUTH AFRICA RAPPER CASSPER NYOVEST


Na South Africa hip hop be nomba one for Africa right now akordin to South Africa rappa Cassper Nyovest.
He also yarn say na inside naija here our rap end as nobodi know our rappas for South Africa.
Akordin to Cassper he say,no be yab he dey yab us but na di truth he dey yarn.

Wednesday 17 January 2018

HARRYSONG Di SAMANKWE KING DON TALK SAY,ANYTIME WEN HIM TRAVEL GO OBODO OYIBO NA FOR BIZNESS NOR BE TO GO COUNT BRIDGE OR CATCH GROOVE


If you don dey make some kain money,to dey travel go obodo oyibo to rest and katch groove na normal ting for some pipo.
But one man wey God don ansa him prayer and by God grace dey make kool money for imsef na Harrysong.
Di tori for ground be say,di bobo don yan say,anytime wen he travel go obodo oyibo,him no dey go count bridge or katch fun for yonda.
He say na bizness dey carry am go nor be groove.
Dat one sef dey.

Tuesday 16 January 2018

NOLLYWOOD SUPASTAR 'MERCY JOHNSON' DON TELL TORi PIPO SAY,SHE TRUST HER HUSBAND 100% BiCOS HER HUSBAND CAN NEVA SLEEP WIT ANODA WOMAN


Wia you?
If you neva hia di new meaning of trust,Oya Read dis tori.
Home vidio and nollywood big name Mercy Johnson don yarn tori pipo say,her hosband 'Prince Okojie', can neva cheat on am bicos she trust am 100%.
She say her hosband can neva see anoda woman pant no mata how di cold strong rish.
So if you be woman and you dey eye her hosband you dey waste ya time akordin to Mercy.
But my only fear be say make any of dis slay queens wey full evriwia nor come out one day say,Mercy Johnson,I get vidio of wen me and ya hosband dey do kerewa afta una marry.
Tufiakwa!

Monday 15 January 2018

GOSPEL MIUZISHAN 'NATHANIEL BASSEY' DON TALK SAY,ALWAYS DEY WATCH BARCELONA MATCH IF YOU WANT MAKE YOUR BRAIN DEY WORK LIKE COMPUTER


Di starta of Halleluyah challenge and gospel singa Nathaniel Bassey don yan say,if you dey watch Barcelona football club match steadi,e fit make ya brain dey reason fast like konputa.
He yan dis one ova di wikend afta Barcelona trash Real Sociedad for di match wey dem play.
For ova ten years now Barcelona don dey play champagne football and wit playas like Lionel Messi,Iniesta,Suarez and even dia new bobo Paulinho,Barcelona still dey play swit and biutifu champagne football like say na champagne village dem come from.

Sunday 14 January 2018

LAGOS STATE GOVERNMENT DON CARRY COMEDIAN AY AND DAVIDO GO COURT BICOS DEM NO DEY PAY DiA TAX


Very soon you go hia wetin oga judge for court go talk konsigning di dodge wey Ay and Davido dey dodge to pay dis tax to Lagos internal revenue Service, LIRS except say di case no come up again.
For now akordin to Lagos state gofment,Davido and Ay dey make millions for Lagos and dem no dey free pay tax.
Di tori wey we gada now be say,Davido dey claim say him dey pay him tax to Osun gofment bicos na dat state him come from why Ay di komedian also claim say him dey pay tax to Ondo state too bicos na wia him come from be dat.
How dis mata go end laslast,we go let una know as e drop.

Saturday 13 January 2018

TONY TETUILA Di BOBO WEY SING DAT SONG 'YOU DON HIT MY CAR' DON CRY OUT SAY,KWARA STATE GOVNOR NEVA STILL GIVAM Di POLITICAL APPOINTMENT WEY DEM PROMISE AM


If you call Tony Tetuila name,pipo wey dey follow up go tell you say naim sing dat song 'you don hit my car' wey skata evriwia dat year.
During di last elections, many selebritis kontest for vaykant positions akross di kontri.
One of such pipo na Tetuila and now di bobo don cry out say,di promise wey di Kwara state gofnor Abdulfatah Ahmed promise am neva still come.
He say wen he loose di election, di gofnor say dem go givam appointment but today him don wait tire and now he don decide to come back to miuzik wey him sabi make hunga no go killam.
Akordin to Tetuila him spend and loose plenti money for di election but him like di expirience wey he gada.

Friday 12 January 2018

DEM DON ARREST DAVIDO PADDi 'KAYODE' WEY BEAT UP AIRPORT OFFICIAL AND WORKER FOR LAGOS INTERNATIONAL AIRPORT


Wahala no dey pay and some pipo no won wise.
Police don arrest Davido paddi Kayode afta he beat up airport official for Lagos airport.
Dis one appun just bicos di man ask di bobo of di tag of di loads and bag wey dem sopose clear.
Di mata dey police hand and we go bring una more tori of how di mata dey go as we getam.

Thursday 11 January 2018

FOR EXAM MATA,NA ONLY 24 STUDENTS FOR ZAMFARA STATE NAiM PASS Di 2017 NECO EXAM AFTA NECO RELEASE Di RESULTS


E don show say tings dey go backward for dis kontri too fast.
Evritin just dey rotten.
Fuel no dey,food no dey,light no dey and now students just dey fail exam anyhow like say tomorow no dey espeshali for north.
For di latest results wey NECO reliz for dia 2017 exams,na only 24 students naim pass di exam for 24 state.
Di state wey dia student try pass na Ogun state and na 4,766 students naim pass di exam.

Wednesday 10 January 2018

GOVNOR AJIMOBI OF OYO STATE DON YAN TORi PIPO SAY,NA DEAD BODi HIM WASH FOR 8 YEARS TO TAKE TRAIN iMSEF FOR SCHOOL FOR OBODO OYIBO


Gofnor Abiola Ajimobi of Oyo state don tell us one big sikrit of how him take dey wash dead bodi for abroad to take sorvive and train imsef for school afta he travel out for 1963.
Akordin to Ajimobi,he say,wen he dey school for abroad na only $30 dollars im papa fit sendam thru out.
He say if no be dead bodi wey im kon dey wash for yonda,e for red foram and he for no fit finish school.
Ajimobi also yan say,anytime wey him rish house like dis and if he rememba di dead bodis wey him wash to sorvive,him go just start to cry.
He also yan say Wetin make am dey talk like dis be say,na to enkorage di youths dem to hustle to sorvive instead of to dey look Uche face.
He yan all dis one during di joinbodi South-West area meeting wey appun for Oshogbo,Osun state.

Tuesday 9 January 2018

GHANA IMMIGRATION SERVICE(GIS),DON STOP TO GIVE PIPO WEY GET STRETCH MARKS AND PIPO WEY DEY BLEACH WORK


To dey bleach skin nor be beta ting at all.
Fela talk am pipo wey get sense talk am I talk am.
As you dey read dis tori,I want make you know say for Ghana,Di Ghana Immigration Service GIS,don stop to give work to anybodi wey dey bleach or wey get stretch mark.
Dia reason be say,blood fit just carry dey comot for such pipo bodi wen dem dey do exercise.
Dis law also affect pipo wey carry dada for head,pipo wey draw tattoo for bodi and pipo wey get bow legs.
Many pipo don dey vex for di Immigration Service as dem say dat kain law no gel.
Ghana Immigration Service resiv ova 84,000 applications for only 500 job wey dey available.

Monday 8 January 2018

DEM DON JAIL ONE MAN MR. CHRISTOPHER HAUPTMANN FOR AMERICA,AFTA HE DO WAYO TAKE MARRY MAMA AND PIKIN Di SAME TIME


America wondament naim be dis one o.
One man wey come from Pennsylvania for America,Mr Christopher I. Hauptmann don use hin own hand put imsef for prison for two years akordin to di court judgement.
Di 44 year old Hauptmann marry 43 years old woman and also marry di woman 18 years old daughter di same time.
Di mama and pikin website too switam,he no kon no dey one to choose as he kukuma marry dem two.
Di ploblem now be say akordin to di law be say,he marry di pikin wen he nor even divorce di mama and dis one naim landam for jail.
Make pipo try len dia lessons from pipo mistake.

Sunday 7 January 2018

MR ISSA AREMU WEY BE STRONG MEMBA OF Di NIGERIA LABOUR CONGRESS NLC,DON YAN SAY,MAKE WE JOINBODi TOGEDA AND FIGHT ANY GOVMENT PLAN TO INKRiZ FUEL PRICE AGAIN


One memba of Di National Labour Congress NLC,Mr Issa Aremu don yan naija make dem fight any wicked plan of gofment to inkriz Price of petrol again.
He say make we no live di fight for only dem alone and he yan dis one during one joinbodi gada for Ilorin,Kwara state.

Friday 5 January 2018

AKORDIN TO NEWS WEY DEY REACH OUR TORi ROOM,FEDERA GOVMENT FIT INKRiZ FUEL PRICE FROM N145 TO N180


Pipo dey get kontri naim we say make we get too.
But e be like say our own don turn curse.
Abi our lidas dey serve juju?
No food,no money,no light,no fuel to use take plasta.
If you rememba,Buhari gofment say make dem inkriz fuel once and for all from N87 to N145 so dat dem no go boda to inkrizam again.
As u dey read dis tori like dis,rumors don come say dem dey try to inkrizam again to N180.
I pray make e be say na just stori.
If na sell dis kontri make dem sell,make pesin mind for rish ground.

Thursday 4 January 2018

LAGOS PIPO MAKE UNA THANK BUHARI IF NOT,BOKO HARAM FOR DON BOMB LAGOS SKATA..DAT NA WETIN ADEBAYO SHITTU Di MINISTA OF COMMUNICATION TALK


Di minista of kominikayshon Adebayo Shittu don talk say,make me and you klap for President Buhari base on di good work wey him don do to take fuck Boko Haram style up.
Akordin to Shittu he say,if no be Buhari,Boko Haram for don enta Lagos and  bomb evriwia skata.
Oga we don hear you.

Wednesday 3 January 2018

E DON RED O! ISRAEL DON GIVE NIGERIA PIPO AND OTHER AFR!CANS 3 MONTHSMONTHS TO COMOT FOR DiA COUNTRY OR ELSE,DEM GO CARRY ALL OF DEM FOR PRISON


I dey wait to hear wetin world leaders go talk for dis kain yeye ting wey Israel won do to Nigeria and Africa pipo.
Di Israel govment don give Africans now til April to komot for dia kontri espeshali di ones wey no get papers to stay.
Di only pipo wey dem go free na old pipo,shidrens,pipo wey suffer for slave mata.
Dem say dem go dash each pesin wey don readi to komot $3,500 dollars to take start life again.
Di United Nations Refugee Agency don alreadi kondem dis nonsense  and also tell dem say dis kain plan dey against intanashona and Israel laws.
Dis ting no be big deal.
Drive any Israel pesin go back to dia kontri too and close down dia embassy for all Africa kontris.
Dat one go touch dem too.

Tuesday 2 January 2018

OONI OF IFE DON YARN SAY,IF YOU BE RICHMAN AND YOU GET PLENTi MONEY BUT YOU NO DEY REMEMBA TO HELP POOR PIPO,NAiM BE SAY YOU BE YEYE PESIN


Ooni of Ife don reliz new year message to all di pipo wey dia hand don touch beta money,those pipo wey rich.
akordin to di king,he say if you get pepper and you no fit hep di poor just see yasef as a madman.
He say if you rich you sopose to dey hep poor pipo wey no get.
Nice message Ooni of Ife.
I hope say our rich men go get sense and take ya advice.

Monday 1 January 2018

NICE ONE AS Di BUHARI GOVMENT DON TELL ALL HOSPITALS FOR NAIJA MAKE DEM NO DEY REJECT BUT TREAT ANYBODi WIT GUNSHOT INJURY FIRST BIFOR DEM ASK ANY QUESTION


One of di best ting wey we hear for dis President Buhari gofment mouth for 2017 wey just finish so, na di new law wey dem just wan put for ground.
Dem don arrange law wey go make sure say hospitals go trit any emagensi gunshot injuri wey dem carry enta dia hospital.
Bifor,if u carry pesin wey dem shoot go hospital, no doctor go tritam bicos dem dey fear weda na arm-roba di pesin be or maybe dem want money bifor dem trit di pesin.
Now gofment don say,if dem carry pesin wey dem shoot come ya hospita, you must tritam first bifor you ask queshon.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...