MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 28 February 2017

NOLLYWOOD ACTRESS MERCY JOHNSON HUSBAND,DON CLEAR TORi PIPO SAY,HE NOR DEY LIKE WATCH HIM WIFE FILMS SO DAT HE NOR GO GET HIGH BLOOD PRESSURE


Akordin to di bible,di truth sha set you free.
Di hosband of one of Nollywood biggest name,Mercy Johnson,Prince Okojie,don clear tori pipo say,di reason why he nor dey like watch Mercy Johnson films be say,him nor wan get high blood pressure bicos of di lovey lovey part.
You know say anytin wey di director say make u act naim u go act.
And dem Mercy Johnson dey act all dis touching-bodi and lovey lovey part for inside all dis film.
To avoid heart attack or BP,Prince Okojie say him nor dey watch film wey him wife dey.

Monday 27 February 2017

OGAKPATAKPATA OF APC BOLA TINUBU DON YARN TORi PIPO SAY,HIM GO LIKE TO BECOME NAIJA PRESIDENT ONE DAY ONLY IF,BUHARI SEAT FOR ASO ROCK GET VACANCY


Who get ear make he hear.
Ogakpatakpata of APC home and abroad,Bola Ahmed Tinubu,don clear tori pipo say,he nor go mind to bikom president of Nigeria one day but dat na only wen vacancy dey.
He yarn dis one during di selibrashon groove to take swear in di new Ondo state Gofnor Rotimi Akeredolu.
Dat one konsign dem.
Di only tin wey me I know be say,many Naija pipo dey pray make God giv dem pesin wey him head koret to rule us not pesin wey go add join dia problems.

Sunday 26 February 2017

IF YOU BE ONE OF DIS PIPO WEY DEY SHOUT SAY BUHARI DIS BUHARI DAT,FORMA PRESIDO OBASANJO DON YARN SAY,WETIN HIM KNOW BE SAY,BUHARI GOVMENT NEVA DISAPPOINT AM


One man meat na anoda man poison.
Many pipo don dey yarn say Buhari nor dey try.
Dem even say we don enta one chance for dis Buhari gofment but one man don come out to defendam.
Forma Presido Obasanjo don yarn The Guardian Newspaper say Buhari neva Fall hin hand bicos di man dey try for di area were he for strong.
Areas like koropshon,fighting of Boko Haram.
Obj say he know say Buhari nor dey try for our ekonomi and obodo oyibo mata but he dey try for oda areas and di mata dipend on wich area u dey lookam from.
So diafor,Buhari neva disappointam.

Saturday 25 February 2017

POPULAR GHANA PASTOR MENSAH OTABIL DON YARN SAY,MAKE WE STOP TO EAT FUFU BICOS CHOPPING OF FUFU DON NEARLY KILL AFRICANS FINISH



Notin pesin nor go hear for dis small world wey we dey.
If dem tell me say one day sombodi go say chopping of fufu dey kill,I for no bilivam.
Dat na exactli wetin popular Ghana Pastor Mensah Otabil of di Intanashona Central Gospel Church for Ghana,don yarn we Africans.
Akordin to Mensah he say,first of all wia dem dey do dis fufu dey dey veri dirt and also,any food wey dey arrange dey punish yorsef join na ploblem.
Otabil say di one wey dey pain am pass be say,if dem dey pound di fufu na so sweat dey pour enta.
If di sweat enta,na so dem go mix di sweat togeda and bacteria from di sweat go kon go sidon for inside ya bodi.
Mensah Otabil say we dey die dey finish for Africa bicos of dis one but we nor know.
Dis kain advice from Pastor get as e be o.

Friday 24 February 2017

SEE GOBE! OUR SENATE DON TELL POLICE MAKE DEM REMOVE ALL BEGGARS AND ASHAWOS COMMOT FOR ABUJA


On Thursday,di Nigeria Senate giv order to police make dem remove all ashawos and all beggars comot from di streets of Abuja.
Di chairmo of di senate komiti on top Abuja mata,Dino Melaye naim yarn all dis one.
Na wa o.
Wen dis senate go eva diskors how food go take Boku for dis kontri?
Wen dem go eva diskors palm oil ploblem wey 1litre don turn N1000?
Imagine fuel na N145 and Palm Oil na N1,000 per litre and dem nor dey yarn anytin aboutam.
Yeye dey smell.

CHAi! OJUJU KALABA DEY BUY ICE-CREAM AND ANODA ONE DEY SHACK STOUT






Di masquerade of nawadays dey soprise man.
Only dis week,we don see ojuju kalabar ey dey use laptop,we don see Di one wey dey use ATM and now dis ones dey buy ice-cream.
Akordin to my grammar brodas,dis one na masquerade re-defined.

Thursday 23 February 2017

9ice DON CLEAR TORi PIPO SAY,Di REASON WHY HIM VOICE DEY CRACK LIKE WHO SWALLOW FROG NA BICOS OF OLD AGE AND BAD SINGING EQUIPMENT FOR STAGE


Di Gongo Aso singa wey him miuzik skata evriwia one piriod don clear tori pipo say,wetin make you dey notice say him voice don crack for sometime now na bicos of bad equipment for stage and old age.
Akordin to 9ice wey play for Mandela baitday dat year,he say wen show organizers provide those kain bad equipment,he go kon dey shout anyhow and bifor you go know wetin dey appun,he voice go just dey crack like who swallow frog.
He say anoda reason again na old age.
9ice say you nor expect hin voice to sound di same way he dey sound wen he be 24 years.
He say him be 35 years now so make una nor dey look soprise for him crack voice.
Bad equipment + old age is equals to crack voice akordin to 9ice.

PDP DOGFIGHT: SHERIFF OR MAKARFI WHO YOU WANT?


PDP house wey fall afta APC difit dem for di presido election of 2015 bitwin Goodluck Jonathan and  Muhammadu Buhari wey di forma Khaki presido win,need new landlord to build di house.
Toda,Senator Ahmed Makarfi go say naim be PDP national chairman,tomorrow Senator Ali Modu Sheriff go claim chairman.
Wich one we go biliv?
Some days ago,one Federa High Court for Port Harcourt pass judgment say na Sheriff be di authentic chairman but many PDP Gofnors say dem nor go gree.
As dem talk am,two Captains cannot drive one ship.
So PDP folowas,who una go prefer make he be una Chairmo?
Sheriff or Makarfi?
Or me wey nor dey any parti?
Oya make we yarn.

Wednesday 22 February 2017

FUNNY ACTOR AND COMEDIAN,IMEH BISHOP a.k.a OKON LAGOS,DON EMPLOY POLICE AS BODI GUARD AND SiKiORiTi AFTA DEM KIDNAP AND ROBAM FOR WARRI SOME DAYS AGO


Dem say thunda nor dey strike twice.
Afta arm robbers show Okon Lagos pepper for Warri some days ago,di funny actor and komedian don use policemen take dey do bodi guard and sikioriti.
Some days ago,Okon Lagos wife post on top intanet say bad boys rob her hosband and now di bobo nor won hia anoda stori dat touch as he don di side to dey pay policemen to givam sikioriti.

Tuesday 21 February 2017

STARBOY AGAIN! TWERKING MADAM MILEY CYRUS,TO FEATURE WIZKID FOR HER ALBUM


Miley Cyrus Di twerking madam,go soon join R.kelly,Drake,Tinnie Tempa,Justine Skye as miuzishan wey don fichor Wizkid.
Akordin to tori wey enta our yard,Miley Cyrus go joinbodi wit Starboy do one jam take pepper dem.
Wizkid mata dey pure evri now and den.
Baba God get hand for Starboy mata.
Pure niceness.

NAIRA DON KONTINIU TO FOOL IMSEF FOR WiA DOLLAR DEY AS PIPO CHANGE ONE DOLLAR TO N520 naira


Wetin dey appun to dis kontri?
Abi devil don finalli relocate finally from Babylon to Naija?
Di free fall of naira for wia dollar dey don turn to laffing mata.
Yestaday dollar change for N520.
Di only tin wey 20 naira fit buy you na one pure water satchet but if you get 20 dollar,you fit use zam arrange two pot of wicked soup wit bokotor,chaki,kpomo,cowleg,goat meat,prawns,fresh fish and even sef di money fit rish to add bush meat join.
God epp us.

Monday 20 February 2017

ZIMBABWE PRESIDENT ROBERT MUGABE WIFE,GRACE MUGABE,DON YARN TORi SAY,EVEN IF HER HUSBAND DIE,PIPO GO STILL VOTE FOR HIM DEAD BODi


Hmm,na wa o.
92 years old Robert Mugabe wey be di president of Zimbabwe don get soport from him wife ova di ruling of dat kontri.
Grace Mugabe di wife of Robert Mugabe,don yarn tori pipo say,bicos of di love wey pipo get for her hosband,even if he die today and dem prezent him dead bodi,pipo go stil vote foram.
She say di pipo wey dey plan to take ova from her hosband na pipo wey don old too like her Oga.
She say since all of dem start politics wit her hosband di same time,make dem forget about to smell dat position.
51 years old Grace Mugabe also yarn say,na pipo like her wey neva old sopose to dey prepia to take ova from her hosband.
Tori wey dey rish our backyard be say,she don dey do evritin posibo to take ova from her hosband.
We go bring una all di drama.

Sunday 19 February 2017

2 DAYS AFTA DAVIDO ATTEND REDEEMED CHURCH OF GOD,CITY OF DAVID,VICTORIA ISLAND FOR LAGOS LAST SUNDAY,DEM DON SiAM DEY SMOKE iGBO


If you dey folow up,u go don hear say,Davido attend Redeem church,City of david for Victoria Island for Lagos last Sunday.
Di bobo kon promise to serve God all di rest days of him life.
Nice one.
But di tori wey dey fly like kite for evriwia now be say,two days afta Davido go dat church,dem Don siam don smoke igbo as he rest bodi for him new motor wey he buy.
Na wa o.
Some pipo Don alreadi dey argue say,smoking of igbo nor be sin bicos na God krate di grass.
Me I nor know about dat one o.
Na him and God go judge dat one.

Saturday 18 February 2017

ONE OF Di OGA SIR FOR NOLLYWOOD,PETE EDOCHIE,DON TALK SAY Di REASON WHY HE NEVA APPEAR FOR GHANA FILM FOR 18 YEARS NOW,NA BICOS DIA STORYLINE NOR DEY TRIP AM


Pete Edochie one of di biggest name for Nollywood,don yarn tori pipo di reason why him neva act for any Ghana film for ova 18 years na bicos dia stori line nor dey tripam.
I nor know how di industri for Ghana go feel for dis kain yarns wey dey come from Pete Edochie.
Although Edochie don agree to act for one Ghana movie by Kofas media.
Akordin toram,di film stori dey mature and Kofas production dey come out veri tight.

Friday 17 February 2017

NO MORE VALENTINE AS PAKISTAN,ONE MUSLIM COUNTRY FOR ASIA DON BAN VALENTINE DAY


You know say bifor on Tuesday February 14,court for Pakistan ban valentine day celebration for dat kontri?
Yes o,dem ban am.
Na one man Abdul Waheed submit one annoyance letter say,valentine day selibrayshon dey against muslims lifestyle.
Afta di court look into di mata,dem agree wit di man and later pass judgment wey ban all types of valentine selibrayshon.
So all Romeo and Juliet,if una won visit Pakistan to enjoy valentine,tink twice,make dem no go use sharia law do una strong tin.

Thursday 16 February 2017

TONTO DIKEH DON TELL ONE OF HER FAN SAY,SINCE SHE COMOT FOR HER HUSBAND HOUSE BICOS OF DIA QUARREL,DI HUSBAND NEVA CALL HER TO ASK OF DIA PIKIN


If u dey follow up,u go know say Tonto Dikeh marage to Churchill don get k-leg.
She kukuma don carry her bag and propati comot for di house.
Afta one fan write her letter on top Instagram concerning dia marriage,she reply di bobo say,e good say di bobo ask and she kon clear di guy one sikrit.
She say,since she remove from her hosband house,di guy neva for once call to know how dia pikin dey do.
She say although,na she block her line make her hosband nor fit rish her but if di bobo rili care,he for don call dia house hep and oda pipo wey him get dia nomba to ask of dia son.
Na wa for dis mata.
Make God epp di two of dem make dem fit settle dia gbege.

Wednesday 15 February 2017

MAJEK FASHEK MANAGER DON TALK SAY,DEM GO CARRY TIMI DAKOLO GO COURT FOR N100 MILLION SINCE HE GADA MIND GO SING MAJEK SONG 'SEND DOWN Di RAIN' WITHOUT PERMISION


Majek Fashek and him manager Don readi to go to war wit Singa Timi Dakolo afta di guy go sing Majek wonda song 'send down di rain' witout dia pamishon.
Although sha Timi Dakolo say him take pamishon from di manager but we neva know di manager wey him dey talk about.
Majek manager Uzoma Day Omenka say,wen dem rish court,he go tell Oga judge wich manager Timi  take pamishon and pay to.
Na 100 million Dem dey plan to make Timi pay if he dey guilty.

Monday 13 February 2017

SENATOR OLAMILEKAN ADEOLA WEY DEY REPRESENT LAGOS WEST FOR SENATE,DON YARN TORi PIPO SAY,HIM NOR DEY USE SOAKING GARRI WIT FRIED FISH JOKE


All soakers in di building,Raise yor hand up if u nor dey use ijebu garri joke?
Una don get one baddest memba for una club o.
Him name na,Senator Olamilekan Adeola wey dey reprezent Lagos West Senatorial district for National Assembly.
Di guy yoyo say him nor dey use garri and fried fish joke at all.
If you want make Oga Senator dance like masquerade wey shack palmwine for you just givam cold water to punish di garri.

Sunday 12 February 2017

ONE ZIMBABWE WOMAN,MAPFUMO,DON GIVE HER DAUGHTER AS TITHE TO CHURCH FOR HER KONTRi


Siddon look na adjective,wondament is a verb.
Notin we nor go hear for dis world.
One woman for Zimbabwe wey her name na Conviction Mapfumo from Sally Mugabe Heights for Zimbabwe,don use her daughta as tithe for church.
She say na her own way to take tank God be dat afta four miscarriage.
Akordin to her,she also yarn say,na afta di lida for Holy Baptist Apostolic Church pray foram,naim God ansa her prayers for her life.
Now God don blessam wit three daughtas and na dis one make her use one of dem as tithe.
Di pikin go dey assist and go message for di church.
Wondament.

UNA DON TOO CALL PATIENCE OZOKWOR WINCH FOR NOLLYWOOD..NOW SEE HER NEW DEEPER LIFE LOOKS


Most Nigerians dey forget say na film Patience Ozokwor a.k.a Mama G dey act.
Nor be her fault say movie produsas don see say her talent dey for wicked woman roles.
Na wetin sell her be dat.
But di good tin about Mama G be say,she don turn born again kristian as she dey preach from church to church.
She don even start to dress like deeper life church membas.
At list now una go start to look am wit saint eyes.

Saturday 11 February 2017

Di ABANDON MUDA LAWAL STADIUM FOR ASERO ABEOKUTA,OGUN STATE WEY DEM NAME AFTA Di LATE SUPER EAGLES LEGEND WEY DIE 25 YEARS AGO,DON TURN TO TRAILERS PARK

Wen Naija gofment sef go get sense?
Abandon project evriwia for dis kontri.
Imagine na trailers Dem dey park now for di Muda Lawal Stadium for Asero,Abeokuta,Ogun state.
Dem name dat Stadium afta di late Green Eagles wonda player wey die for July,1991.
Di Ogun state gofment nor fit just use dia church mind konplit dis Stadium for dis national hero sake.
No wonda many pipo nor won die for Nigeria mata again.
If na lie,ask Sam Okwaraji famili.

Friday 10 February 2017

GOD IS GOOD: ONE GOOD SAMARITAN DON PROMISE TO RENT HOUSE AND OPEN BIZNESS FOR Di CRIPPLE WEY SOLDIERS NEARLY BEAT DIE FOR ONITSHA


Dem don arrest di two soldiers wey niali beat dat cripple die for Onitsha sake of say dem siam wear di kolor of dia khaki.
Akordin to Nigeria army,dem say dem go show di two sojas shege.
I still biliv say dat na stori until dem show us dia face and do open trial for dem make di whole world see.
But di good news wey rish our tori room be say,one Good Samaritan Mr Kokun of Kokun Foundation  don promise to rent house and open bizness for di cripple.
God nor dey sleep.
Nice one Mr Kokun,God bless you.

Warning!

In case you neva watch di video wey sojas for dey beat di cripple,watch am for bottom hia...but Rememba say, Dis video nor good to watch for eye sha


Thursday 9 February 2017

ACTRESS YVONNE JEGEDE,DON BEG NAIJA PIPO MAKE DEM KONTiNiU TO BUY RECHARGE CARDS FROM PIPO WEY DEY HAWK INSTEAD OF FROM BANKS SO DAT HUNGER NOR GO KILL HAWKERS


Nawadays,u can wake up for 2 O'clock midnite and buy recharge card from your phone tru ya bank account.
You nor need to wait make daybreak and go buy for shop if u get impotant call wey u wan make.
But Nollywood actress,Yvonne Jegede,don beg Naija pipo make dem nor stop but kontiniu to dey buy recharge cards from hawkers hand and pipo wey dey sell for shops instead of to dey buy online or from banks.
Akordin to Yvonne,she say hungri go beat dis hawkers if banks drive dem from bizness so diafor,make we kontiniu to helep dia bizness grow.
E nor go easy sha.
Wot if u get impotant call teakettle for mid nite and u need recharge card?

GOD FORBID! NAIJA SOLDIERS NEED EDUCATION AS DEM NEARLY BEAT CRIPPLE DIE FOR ONITSHA

If you carry 10 billion dollars gimme make I do wetin Nigeria sojas do dis cripple for dis video,I go still reject di money.
Dem beat di cripple niali die for Onitsha sake of say dem siam wear dia colour of dress.
Bifor dem start to beat am,dem first troway him wheelchair.
Wen I dey hear about devil devil,I feel say na joke but dis sojas make me biliv say tru tru devil get followers.
If Dem see Boko Haram dem go run but wen dem see innocent sivilians,dia dada go stand.
Dis video nor good to look for eye but if u won watch am,look am for bottom hia...


SEE FINISHING! DEAD OR ALIVE,NIGERIANS SUFFER NA STILL Di SAME UNDA BUHARI AKORDIN TO 'FINANCIAL TIMES' DAVID PILLING


London newspaper 'Financial Times' writer,David Pilling,don write say,weda Buhari dey alive or not,e nor change anytin for how Naija mata dey go.
He say for 20 months wey di forma General dey rule Nigeria,diferens nor dey bitwin enjoyment and suffer.
Well,we dey wait to hear from our gofment officials like Femi Adesina and Lai Mohammed to ansa David Pilling of Financial Times.
My hand nor dey.

Wednesday 8 February 2017

GORDONS DON YAB 2FACE AS Di ONLY MUSICIAN WEY NOR GO SCHOOL BUT SABi SING AND NA DAT SINGING HE SUPPOSE TO TAKE FIGHT BUHARI INSTEAD OF TO DEY FORM VOLTRON




Afta 2face high pipo spirit say him go lead protest against Buhari gofment on February 6,sake of say hungry don too much for di land,di bobo kon cancel Di protest for last minute.
Since den,many pipo don dey call am names.
Some say him na coward,some say him na Mumu,some say him na paper tiger,some say him na woman,some even say naim be di real Africa queen.
Now Komedian Gordons,don giv 2face yabbing of di year as he call 2face di only illiterate wey sabi sing correct miuzik and na dat miuzik he sopose use take fight Buhari instead of am to dey form actor.
Since Gordons call 2baba illiterate,nor be small insult him don resiv from 2face hand.
Watch Gordons for di vidio wia him for blast 2face for bottom hia...


Tuesday 7 February 2017

DANFO DRIVERS MAKE UNA START TO PLAN UNA LIFE AGAIN BICOS LAGOS STATE GOVNOR AMBODE,DON TALK SAY,HIMGO REMOVE ALL Di YELLOW DANFO BUS FROM LAGOS ROADS DIS YEAR




I no go soprise if I see miuzishans Mad Melon and Mountain Black a.k.a Danfo Drivers,lead protest of 'we nor go gree' against Gofnor Akinwunmi Ambode plan to ban danfo bus from Lagos.
If u still dey Read dis tori wit sleep eye,try wash yor face bicos Ambode don yarn tori pipo for one joinbodi meeting yestaday say,him go remove all those yellow danfo buses from Lagos roads and replace dem wit beta transport buses.
My only advice to my frend Ambode be say,make he plan dis mata well bifor he ban danfo drivers hustle.
I nor won hia say,arm-robas start to give pipo yawa for Lagos.

Monday 6 February 2017

Di RUGGED GOFNOR OF EKITI STATE,AYO FAYOSE,DON TELL TORi PIPO SAY,HIM GO BE PRESIDENT OF NIGERIA ONE DAY BUT MAKE ANYBODi NO ASKam HOW E GO TAKE HAPPEN


Buhari nomba one enimi,Ayo Fayose of Ekiti state and PDP,don yarn say one day,him go be Naija president.
He say God don sign am say him go enta Aso Rock one day not as visitor but as president.
Akordin to di rugged Gofnor,he say him nor know how e go take appun but e go appun.
Afta he rule di first four years as Ekiti Gofnor,him talk say him go come back and true true he don come back and now he don yarn dis one again.
Ok o,we dey wait.
Pastor Chris Okotie don yarn dis kain tin bifor of how God take telam say him go bikom Nigeria president.
Till today,na only di president of him church for Ikeja naim he be.

Saturday 4 February 2017

BREAKING NEWS!!!! 2FACE DON CANCEL Di FEBRUARY 6th PROTEST AGAINST BUHARI GOFMENT


Nigerians wey rili want make di February 6 protest against Buhari gofment take place,go wake up to hear say,tubaba don run enta hin comfort zone back afta all di noise.
Akordin to Tubaba for di vidio wey him reliz,he say nobodi life worth to put on line for dis protest.
Wetin we neva know now be say,weda dem put gun for 2face head wey make am change mouth.
We go bring una more tori konsigning dis mata as we getam.

FORMA PRESIDO OBASANJO,DON YARN SAY,NA 12 TIMES BAD BELLE PIPO CARRY RUMOR SAY HIM DON DIE AND ANYBODi WEY DEY WISH BUHARI DEATH NA WICKED PESIN


Obasanjo a.k.a Obj,don yarn tori pipo say na about 12 times bad belle pipo carry rumor say him don kpeme so nor be new tin.
He yarn dis one just bicos some pipo dey carry rumor say Buhari don kpai.
Akordin to OBJ,he say instead of dat kain wish,e beta make pipo dey pray for Buhari bodi to dey kamkpe so dat he go fit come back strong and rule well.
Obj also yarn say na wicked pipo go dey wish anoda man death.
If u rememba,since Buhari go London two weeks ago for holiday,rumors enta town say di man don kpai for yonda.
We nor know wetin to biliv again as some say he dey alive and Dem Siam dey play table tennis wit Queen Elizabeth for London last week.

Friday 3 February 2017

NO MORE ARGUEMENT AS AMERICA COMPOSERS ASOCIATION DON GIVE WIZKID OGBONGE AWARD AS Di PESIN WEY WRITE 'ONE DANCE' FOR DRAKE,Di BIGGEST SONG FOR Di WORLD LAST YEAR




Wen Seyi Shay tell Onstage TV for Jamaica one sikrit say,na Wizkid write 'One dance' by Drake,di biggest song for di world last year,na Wizkid first tell her to shut up and stop to talk wetin she nor know.
But today,di same Wizkid don thank Drake wey allow ram write and be part of di song afta he kolet award on top di song head.
Wizkid post di award wey America Society of Composers,Authors and Publishers(ASCAP) givam for writing di song wey skata evriwia last year.
If na me be Wizkid,i go call Seyi Shay and tell her make she nor vex base on say he nor want make di world know di sikrit yet.
Anyway,Ogakpatakpata dey kongratulate Oga Starboy Wizkid,on top dis ogbonge award wey America pipo carry givam.
More fire!

Thursday 2 February 2017

YEMI OSINBAJO,ASO ROCK NOMBA ONE MAN FOR NOW UNTIL BUHARI RETURN FROM HOLIDAY,DON SET UP COMITEE TO REDUCE Di PRICE OF GARRI,TOMATOES,FISH AND OTHER FOOD STUFF


Di way wey food stuff take cost for market now,don finally start to dey giv our lidas white hair join di one wey dem get bifor.
Acting presido,Yemi Osinbajo don form one komiti to find how dem go take reduce di price of food stuff wey dey inkriz evriday like say dem swear for naija.
Among pipo wey dey dis 7 man komiti na,Audu Ogbeh,Chris Ngige and Rotimi Ameachi.
Make we dey watch weda dis one go work bicos I know say gofment sabi promise and fail welwell.

Wednesday 1 February 2017

POGBA AND LINGARD OF MANCHESTER UNITED DEY BUBBLE TO WIZKID NEW SONG (VIDEO)


World most expensiv footballa Paul Pogba and hin Manchester United team mate Jesse Lingard enta bubble mood for Man U dressing room as dem dey bubble to Naija supastar Wizkid new song Hush up the Silence(Come Closer).
Meanwhy,Sony Music wey get Wizkid miuzika propatis for now,don remove di song online as dem say dem neva reliz di song yet.
Dem say di one wey pipo don get na likage and illegal.
But wait o,so Man U,abi na Pogba and Lingard rush download di song?
Naim be say dem nor buy am.
Anyway na Wizkid be di winna for di mata as di bobo don blow enta evriwia.
Watch for botom hia,wetin dem use di song do for dia dressing room...


BURNA BOY DON YARN SAY HE NOR TOO LIKE SCHOOL WEN HE DEY GROW UP BUT HE DON ADVICE ANYBODi WEY WON TAKE MUSIC AS HIM CAREER TO GO SCHOOL AND GET DEGREE FIRST


Like to party singa Burna Boy don advise boys and girls wey won take miuzik as dia karia,make dem go school and get degree first bifor dem tink miuzik.
Di bobo yarn dis one on top Instagram as he also yarn say,him nor too like school wen he dey grow but he nor want make u follow him footsteps.
Good advice from di River state born bobo.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...