MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 29 June 2014

3RD MAINLAND BRIDGE STILL STRONG KAKARAKA - GODWIN EKE

3RD MAINLAND BRIDGE
Di Federa Controla of Work for Lagos State, Mista Godwin Eke,don tok say,"make Naija calm down,3rd mainland bridge nor go kolaps bicos e dey strong kakaraka.he say na mentaynance dem dey do for di bridge nor bi say one tin one tin.
He say di last mentaynance wey dem do last year,naim stil kontiniu bicos many work stil full ground for di bridge bodi and e also tok say di main problem na di foundashon and dem don dey work on di foundashon bicos rain dey wash am troway.
He say to take kia of di eroshon wey dey wash di foundashon dey among di tins wey di kontrators Messrs Borini Poroni wey dey hando di work sign to do and na  Decemba 17, 2012 dem sign dat kontrat.
Mista Godwin Eke also tok say dem just finish one work for Eko bridge but pipo nor know.
Pipo dey buy gala and pure water,dem dey buy minera,dem dey buy wonut,dem even dey buy kpekere and grandnut for traffic on top Eko bridge but dem no know say govment don do one ogbonge work for unda Eko bridge.Na just 4 hours e take dem to do di repair for Eko bridge one quiet sunday.
For di work for 3rd mainland bridge,he say dem go close some part of di road for di piriod wey di wok go shele so dat dem go get space take complit di work but di trafic no go bad like last year own.
No forget say,3rd mainland bridge naim still be di longest bridge for Africa.

GOVERNOR UDUAGHAN DON CLEAR KEFEE HOSPITAL BILLS AND HER BODI GO SOON ARRIVE.

GOVANOR UDUAGHAN
Di bodi of Kefee,di branama queen,wey no rekova from di deep faint wey hapun to her for America,go soon enta Naija bicos di Govnor of her state,Emmanuel Uduaghan don clear all di credit for di Desert Spring Hospita,Las Vegas wia she for die for Amerika and he don also pay di moni wey dem go need to fly her come back to Naija.Na di Ogakpatakpata of di assosiashon of Naija pipo wey dey stay Las Vegas,Mista Festus Ebonka na complain say make Naija try come shift Kefee dead bodi back to Nigeria as many tins dey involve b4 di hospita go reliz her bodi to anybodi.


Na dis one kon make Govnor Uduaghan rush answa dem quik and clear all di debt.
Meanwhy,her husband,Teddy Don Momoh go fest come back to Naija so dat he go fit resiv her bodi akordin to Teddy tori pesin,Chilee Agunanna.
Teddy say akordin to di Urhobo tradishon,her family go bury am for her home town Okpara inland for Ethiope East for Delta state and di celibrashon service for Sapele go shele later.
Kefee die on di 13 of june,2014 for Amerika afta she no get hersef back afta di deep faint wey hapun to her for inside plane wey dey carri her go Chicago.

Saturday 28 June 2014

CHARLY BOY NO ALLOW GOVERNOR OKOROCHA OF IMO STATE TO YARN FOR HIM PAPA BURIAL

CHARLY BOY AND HIM PAPA BIFOR E DIE
Di area fada of okada assosiashun of Naija,Charly Boy don stop Govnor R ochas Okorocha to tok for im papa,Justice Chukwudi Oputa burial service for church yestaday.
Nor bi smol pipo gada for di church service to honor Justice Oputa.Big big men wit big name.men of timba and firewood like Pius Anyim wey represent president Goodluck Jonathan,di labor minista Chief Chukwuemeka Nwogu,aAbia state govnor Theodore Orji,Anambra Govnor Chief Willy Obiano,forma Govnor of Rivers state Peter Odili,Chris Ngige,Arthur Nzeribe and plenti odas.
All dis pipo naim see wetin Charly Boy do Okorocha as e drag di microfone take from e hand as di pastor of di day Bishop Kukah call di Govanor to come yarn smol.
Charly Boy say Okorocha kanot use im papa burial play politiks and sake of say di disgrace too much for Okorocha,naim e comot for di place wit all im bodi gaids.
Even di lawyers wey gada to join celibrate di life of dia ogakpatakpata for di bizness,justice Oputa,check out liv di place too.
Akordin to di tori wey we gada,dem say wetin make Charlie Boy vex bi say Okorocha lie say dem giv di family  20 milion naira for di burial arangement and meanwhy dem no see one kobo of di promise.
Gbagada badboy Charly Boy,di name wey we dey call am b4 e remove from Eko,don alreadi warn Govnor rochas Okorocha make e no near im papa burial or else im go disgrace am like smol pikin.
True true na exactly wetin di bobo do be dat

Friday 27 June 2014

RONALDO ODESHI DON YEYE GHANA BABALAWO POWER

.
How far?How kpomo market mista Babalawo?
No surprise if dem burn di shrine of di Ghana babalawo,Kwaku Bonsam,wey say Ronaldo no go play dis world cup bicos him don alreadi use spirichua power condem Ronaldo leg or even tho CR7 go di world cup,di jazz no go allow ram play against Ghana.
No surprise if binu boys brake all im kalabash for im shrine and burn all di red pieces of cloth wey e tie for im shrine.
We even hia say Ghana fans drink all di bear for dia kontri finish just to celebrate di jazzman stori.wetin u expet for fans wey don drink bear full face?
No surprise if dem dragam go market square,put tire for im neck,turn fuel for im bodi and lite matchis for im bodi make e burn to ashes.
Why,bicosss...,of di fake hope wey im giv Ghana fans say Ronaldo no go play di world cup.
Mista Jazzman even say im kill 4 bingos take praypia di otumorkpor wey go destroy Ronaldo leg.
E get one time wey evribodi fil say di juju dey rili work for Ronaldo bodi bicos di bobo injor tire for portuga training camp but upon all di injuri,Ronaldo play all di match wey portuga play for dis world cup even tho dem comot for di tornament.
Nor be onli dat one o,di onli goal wey im skor for di world cup na against Ghana.
Dis one kon make our tori pipo enta town go intaviu pipo on wetin dem want make dem do mista Babalawo?
Dis na wetin diferent pipo tok for diferent area:,
We ask Okon Nsikak for Calabar and he say make dem fly Kwaku Bonsam come Calabar make dem use im bodi parts for pepe soup and edikan ikong soup,
Salisu Abubakar for Maiduguri say kai!shege barawo!bringam kom make we sendam go bringam firewood for Sambisa Forest,
Abaga Mike(M.i. for short) say bringam come plateau make dem addam join fish and putam for cold room make cold kilam for Jos,
Eze Okpara for Onitsha say make dem flyam come make dem use am praypia koret Nkwobi and beta Oha soup,
We phone Akpos for Warri and e say make dem barb im dada fest,brake all im teeth and make dem tie di jazzman brain join tree.
But if u ask me,i go say

make dem forgivam.e go repent one day.

Thursday 26 June 2014

SNAKES DON DEY KILL BOKO HARAM MEMBERS FOR SAMBISA FOREST


Wetin Nigeria army no fit do,na snakes kon dey do am.even kpakpa sef,wetin Amerika,Britico army and oda pipo wey dey hep Naija to find di Chibok skul gehs wey Boko Haram kidnap no fit do,snakes don dey do am.
Akordin to di tori wey we gada,snakes and bees don dey atack and bite Boko Haram membas for inside Sambisa Forest and some of dem don dey tear rase enta town kon hide.
Na some of dia membas wey di vigilante bobos,di 'civilian JTF' arrest for Mairi ward near Univasiti of Maiduguri,na dem make dis confeshon say spirichua snakes and bees dey use dem do shege and dem say anytime wey dis snakes bite dem,e no dey rich 24 hours di pesin must die.
Akordin to one of dem wey dem katch,Kolo Mustafa,e say if di snakes bite dem,dem go kon vanish like williewillie.
Dem say akordin to di tori wey dem hia for Sambisa forest,e be like say na Chibok pipo and di ghost of di pipo wey dem don kill,naim dey turn to snakes and bees dey show dem pepe.
For May last month,rumors enta town say,snake bite 2 of di chibok skul gehs and dem later die.
Akordin to Mustafa,some of dia lidas dey eskape enta Cameroon but dem wey to stay Maiduguri don masta,dem try to dodge enta di town back bicos na dia dem for born dem.
Dem say dem dodge enta Maiduguri for nite and kon hide for one uncompleted building.dem say e no take di 'civilian JTF'
2 seconds to arrest dem.
Dem say okpolo eye no bi open eye as di eyes of Boko Haram membas wey dem arrest don clear bicos now dem don dey beg in di name of Allah say make dem no kill dem,say,dem go repent.
Dem say na force dem force dem join Boko Haram  and dem know say na veri bad life dem dey liv and e no good at all.

Wednesday 25 June 2014

MADMAN DON KILL THE MAN WEY DEY CURE iM CRASE

MENTA PIPO
Make di gud wey u dey do no kill u for dis life wey we dey.
No bi smol ting as one man wey dey kolo for Idanre for Ondo state don kill di 60 year old man wey dey cure im crase.
Di 24-year-old mad man wey im name na Iijisakin Ayoola, break bottle kon shuk di baba for neck.the traditiona hila wey im name na  Alfa Iliasu Waheed,later die as e no fit survive di shuking bicos he loose plenti blood.
Akordin to tori pipo,b4 di baba kick bucket,e dey stay nomba 9 Isanwo Ijigbokin Street, Idanre but he come from Osun State why im wife come from Idanre.
Afta di madman kill di baba,di madness kon enta im head welwel as e try to burn di house down but area pipo kon ovapower ram.
Akordin to im neighbours wey dey dia wey di ting hapun,dem say wen di baba dey tink,dey crack im brain on how e go take cure im costomas crase,naim di kolo stabam for throat.
Dem rush di baba go hospita but b4 dem rich,e don alreadi die.
As u dey read dis stori,police don alreadi gbask di madman put for prison.
Police dey try to open case on top di madman head for court but only if dem don check im brain to know weda im brain koret b4 im kill who dey tritam.

Monday 23 June 2014

KESHI DON SIGN TWO YEARS CONTRACT TO COACH BAFANA BAFANA OF SOUTH AFRICA.

Dem say dia is no smoke wit out fire.na ova 3 monts ago naim dis rumor don dey blow say Stephen Keshi go stop to coach Super Eagles afta world cup to go také ova di empti sit for South Africa.
South Africa don alreadi sack dia coach Gordon Igesund last mont bicos dem fil say unda im regime,South Africa dey play nyama nyama futbol.
We hia say na aeroplane wey dey go South Africa naim Okechukwu Keshi go enta imidiateli afta world cup.
We even hia say,di salari wey e go dey resiv go rich to také buy private jet.dem say di salari go long like Ted Mainland bridge.
South Africa say dem dey veri hapi wit di kain gud gud result and gud wok wey Keshi don do wit Naija. Akordin to di tori we gada,ova 12 oyibo coach don sumit dia paypas to NFA to bicom Super Eagles coach if Keshi agree to coach Sauti.
E neva clear sha if all dis rumors later bi true,weda NFA go hire obodo oyibo coach to také ova from Keshi or weda dem go giv anoda naija coach di work.
Many futbol lovas don alreadi dey say if dem go giv any naija coach di job at all,e fit be Amokachie turn since di bobo don dey do asistant coachee for almost ten years wit Super Eagles and e don get expirience plenti.
Dia argiument bi say,e don stay tey wit di team and e don know di team welwel bicos for di past 23 years e don dey wit dem as a playa and later as a coach.
If Keshi rilirili bicom Bafana Bafana coach,naim bi say e go try to make Naija no qualify for di 2015 nations cup bicos Super Eagles and Bafana Bafana go play each oda for di same grup to know who go qualify for di Africa cup of nations wey go shele for Morocco.
Na Super Eagles bi defending champion nations cup as dem kpokpo evribodi plus Burkina Faso for di final and winam for 2013.  

RICK ROSS THE PLENTI BIA BIA MAN, DON SLIM DOWN LIKE PENCIL

THE NEW RICK ROSS
Dis one no bi film trik or drama o,no bi magic and no bi beans o, bicos if u know dat Amerika rapper,Rick Ross b4,u no go know am again as di bobo don trim down welwel.
RICK ROSS OF BIFOR BIFOR
E bi like say only rapping money no rich di guy again as e don slim down so dat all dis modelling companis go sign am.
Wen Rick Ross come Naija for 2012 kon do one show,as im listen to dat Lynx jam"suck belle make shirt fine",naim di bobo swear say,if e enta yankee back,notin go make am no work on di belle.
Di plenti biabia man and di big belle man,Rick Ross,don drink oyibo agbo and kon do operashon to comot plenti robish from im belle.now di bobo naim bi di latest bobo in town.
Doctors don comot plenti nyama nyama from inside im belle and e no dey carry chop again.dem say di space for im belle don smol welwel.
Rick Ross fit chop five naira (N5)biskit and one bottle of seven up for one full day and he go dey ok.

Friday 20 June 2014

PLENTI GEHS DEY DIE FOR ARM ROBBER FOR FACEBOOK

Wetin man nor go see?Wetin pesin nor go hear?
Dis bobo wey u dey see im pishor so,
JEREMY MEEKS
na one heavy criminal for Amerika but di big tori bi say,plenty plenty gehs say dem go die for di bobo mata as dem see him pishor wey police put for facebook.
Na ova forti four tausand(44,000) pipo don like di bobo pishor for facebook imidiately ekelebe putam make evribodi see.
Na im foto plus 3 oda tiff dem wey dey shoot and tiff pipo propati and also di way wey dem dey giv pipo worriment for Stockton for inside Carlifonia and oda area.
Police even say di 30 years old bobo wey he name na Jeremy Meeks,na one of di most wicked criminal for dat Stockton area.if he dey kill,dem say he no dey look back. in shot,dem say only look wey di guy go look yor pocket,yor phone don lost bi dat.dem even say he shoot pass Rambo and Comando and e sabi tiff pass Anini.
But many gehs don say police fit call am tiff if dem like but dia own bi say,dem no mind to pay di moni to také bail am bicos di bobo too fine and e too sexy and dem ready to marry am for free.
Di guy man,don cause heavy kasala for facebook as diferen gehs say naim bi di 'finest criminal eva liveth'.
one of di gehs write say'make her mama no vex o,say she don fall in love wit criminal.
Dis na wetin some oda gehs also write:
"u be model or u be criminal?fine bobo of life,
"Michie sim C say "as she see di foto,her pant don fall from her waist,
Nicole Seba Lorena Elena say "Oh my God!abeg come love mama,
"Make dis bobo kidnap me anyday...kidnap me sef even if i say No!"na so Jessica Gutierrez write,
Melissa Stiles see di foto naim she shout "Hottttt bobo!
Police also put di rest tiff foto for facebook but nobodi send dem as na only Jeremy Meeks pipo gbadu say na 'complit sexy bobo wit sexy blue eyes'.
True true dem tok say wondas shall neva end.

YAYA TOURE AND KOLO TOURE BRODA,IBRAHIM,DON DIE

Di junior broda of Yaya and Kolo Toure of Ivory coast,Ibrahim,don die for Manchester.
Na leather naim Ibrahim Toure dey tap too like im brodas and di bobo wey be 28 years old bin dey suffa from cancer and na one hospital for di city of Manchester,England were doctors dey tritam naim e for die.
Toure Oyala Ibrahim die on thursday di same day wey Toure Gnegneri Yaya,Kolo Abib Toure and di Elephants of Cort d'voire loose to Colombia for di FIFA world cup wey dey shele for Brazil.
 
But sha,na some hours afta dia match wit Colombia naim Ivory coast footbol asosiashun president tell dem.
Di president also tok say,for dis kain sad time,all Ivory coast playas and evribodi wey folow dem dey Brazil,dey show dia suport to di Toure brodas and dia hole family and he say make all Cort d'voire pipo put evritin for prayers.
B4 Ibrahim die,all im life he play as striker and d bobo last club na Al-safa sc of Lebanon.
Ibrahim don play for oda clubs like ASEC Mimosas, Metalurh Donetsk, OGC Nice, Al-Ittihad Aleppo, Misr Lel Makasa and Telephonat Beni Sweif but although sha,he nor play for Ivory Coast nationa team.

Tuesday 17 June 2014

RIHANNA DON DEY LOVE SEXY GHANA PLAYER,KEVIN PRINCE BOATENG BADLY!



Rihanna don show say dat miuzik, 'America Boy' wey Estelle sing for 2008 take  dey praise American bois,no be bicos of her as American boys mata don tire ram rich neck.
During di match bitwin USA and Black Stars of Ghana on monday nite for di world cup wey dey shele for Brazil,Rihanna tok for twitter say,she fit die for #GHANA mata bicos of Prince Boateng.
She say, chai! di bobo too fine no bi smol,she say forget mata,di bobo sexy finish.
She even say yeye Chris Brown and yeye Drake show her yeye love for America,now she biliv say real love na Africa  bois bodi she go getam.
She no fit sleep til day brake bicos of say she dey tink of di Sexy Prince from Ghana.
Di tori wey our tori pipo gada bi say,she don dey husle to get Boateng nomba like rat wey dey husle for fish to chop but di bad news for Rihanna bi say,Prince Boateng malawi get belle foram right now.
Anyway sha,wot eva di scores bitwin Rihanna and Kevin Prince Boateng be,we go let una know.

Friday 13 June 2014

YEKPA! E BE LIKE SAY GHANA BABALAWO JUJU DEY WORK FOR RONALDO BODI o!

Una rememba di ogbologbo babalawo for Ghana wey tok 2 wiks ago say im go make sure Ronaldo no go go world cup?na wa o! E be like say di man juju dey work wit style o.
Ronaldo fans don stat to dey celebrate di World best playa say di bobo injuri wahala don finish as CR7 play 66minits for di frendli match wey dem play against Ireland for America on Tuesday.
But just yestaday wen Portugal playas dey train for Brazil were di world cup for dey shele,naim Ronaldo injor he left knee again afta 20minits for field.inshot,na ice block naim dia doktor tie for di leg as water nearly comot for di bobo eye.
Di fear now bi say,Ronaldo fit nor well quik b4 dem go play against Germany on Monday for dis year world cup.
E get how di leg go worse rich,Ronaldo fit miss dia match against USA and against Ghana and even kpakpa sef he fit miss di world cup.
If e hapun like dat,naim bi say,di Babalawo,Mr Nana Kwaku Bonsam juju don work bi dat.he bi tok say Ronaldo leg kanot smell di world cup or kpatakpata e go injor bifor dia match wit Ghana.
If all dis e Otumokpor work for Ronaldo bodi,we dey veri sure say di President of Ghana John Mahama Dramani go make Bonsam "Di Minista of Juju tins for Ghana".
But make wi stil dey watch how di mata go end.

KEFEE THE BRANAMA QUEEN DON DIE FOR AMERICA.

Kefee di babe wey don win many many award for inside music,don die dis morning for America for inside di hospita wey she for dey resiv tritment for di deep faint wey hapun to her for inside plane wen she dey travel to Chicago for bizness.
Kefee naim sing dose popula miuzik like Branama and Kokoroko wey Timaya join bodi do witam and Kefee win plenti award wit dis miuzik dem.
Last 2 wiks wen di tori of di deep faint hapun to her,I col her phone but na one bobo wey he name na Kelvin tell me say Kefee get smol sikness but she don dey ok.
But wetin I len for wetin Kelvin tok bi say,he just tok say Kefee don dey ok make di pressure and tenshon for dey less even tho she no fit sorvive di sickness.
Akording to di tori wey we gada,e be like say she get belle bifor di sickness attackam.
Doktos for di hospita bin tok say e go dificult for Kefee to sorvive from dat deep faint wey hapun to her.
We pray to Baba God make her soul Rest in Peace.

Thursday 12 June 2014

ASARI DOKUBO DON SAY NA BINGO BE THE NEW EMIR OF KANO.

ASARI DOKUBO
Di King of gbege biforbifor for inside Niger Delta, Asari Dokubo don
col di niu Emir of Kano,Sanusi Lamido Sanusi bingo. Na for inside im
facebook e for tok dis one and di bobo even put pishor of bingo wey
tie hijab for head and e kon write for di bottom of di pishor say,'so
bingo stil fit bi Emir of Kano?Na wa o and e kon laff and kongratulate
APC and di Govnor of Kano,Rabiu Kwankwaso for di choosement of Sanusi
as di New Emir. 
Asari even say im dey sure say  Sanusi and di rest pipo wey dey eye di
sit get hand for di death of di Emir of Kano wey die last wik.
Sanusi wey bi di forma govenor of Central Bank,always dey tell
jonalist say im dream na to bicom Emir of Kano one day.but weda na God
answa im praya or na Devil,na dat one we no know.
Asari Dokubo also tok say if Goodluck Jonathan no win election to
remain as di president of Nigeria for 2015,im go kos heavy gbege wey
even water no go fit quench.

Tuesday 10 June 2014

MIKEL AND EMENIKE DEY QUAREL SIRIOSLY FOR SUPER EAGLES CAMP

Na smol ting remain Mikel Obi and Emmanuel Emenike for nearly throw blow for dia training camp for America wia dem dey prepare for di world cup wey go stat for Brazil on Torsday.
Dem say dis quarel don dey ground since last year and di tori bi say Mikel no get respet for di rest playas as dem say e too dey kari sholda go up.dis one kon dey vex some playas but na only Emenike kon gada heart telam say,"Mikel wetin u dey fil like? u bi God?
Di tin kon make Mikel para kon tell Emenike say,'Go to Hell!who u be?

And anoda tori wey wi hear bi say,during di frendly mash wey we play wit Greece and USA,dem say Mikel too dey guard ball and he no dey like pass ball wen dem expetam and dis one dey add join Emenike anoyance.
Supa Eagles coach Stephen Keshi naim kon act as dia papa and eldaly man to setle di mata for front of all di 23 playas wey im selet for di world cup.he tell dem say to dey fight is not gud at all.
As Keshi dey setle di mata,naim one of dem kon dey show imsef and e kon dey shout.
Dis one kon make Keshi  vex and telam say,'Sharaaaaaaaaaaaarap!! u no get respet for sinior man for una village?u know no say dis una quarel dey make us dey play robish for field?and Naija pipo don dey col us Supa Chickens again instead of Supa Eagles?erm!wot nonsense!
Keshi kon also warn dem say,if dem no stop dis dia quarel,he go giv dem red card and he go also put dem for bench.
Imidiately Mikel and Emenike hia dis one,naim dem setle quikquik,shake dia hands,hug demsef and kon even say,"DI DEVIL U ARE A LIAR! we are one family.
Shola Ameobi as di sinior playa for camp kon tell all di playas for di meeting say,make dem try copurate just like rice and pot and just like bread and butter so dat dem go make Naija proud for Brasil.
Di Supa Eagles go play dia fest match wit Iran on di 16 of dis month.

Saturday 7 June 2014

DAVIDO,TIWA SAVAGE,FLAVOUR,CLARENCE PETERS DON MAKE NAIJA PROUD FOR MTV MAMA AWARDS,2014




DAVIDO
Like play like play all di award wey Davido don win since e stat to sing go soon full one drum as di bobo just win 2 award for di Mtv Mama Award wey shele for Kwazulu Natal,South Africa dis nite.di award dem na,di Miuzishan of di year for Africa and di Best miuzishan among all di bobos for Africa.
Dat tok wey oyibo pipo always dey tok say Naija pipo too get long throat kon show esef for di place as dat Sexy Mama,Tiwa Savage no allow eni geh use hand toch di award for di best miuzishan for di baby dem.Long throat!

TIWA SAVAGE

As Davido win di one for di bobos,Tiwa Savage kon grab di one for di baby dem.
Nor bi only two of dem put Naija name for map as Flavour Nabania,win di miuzishan wey sabi display pass for stage.
Di last Naija boi wey win award na Clarence Peters and na di Transform today by absolut award e win.

To know evribodi wey win award for di Mtv Mama Award,checkam for bottom hia:



 MIUZIK KATIGORI
Best Male:
Anselmo Ralph (Angola)
Davido (Nigeria) [Winner]
Diamond (Tanzania)
Donald (South Africa)
Wizkid (Nigeria)
Best Female:
Arielle T (Gabon)
Chidinma (Nigeria)
DJ C’ndo (South Africa)
Efya (Ghana)
Tiwa Savage (Nigeria) [Winner]
Best Group:
Big Nuz (South Africa)
Mafikizolo (South Africa) [Winner]
Mi Casa (South Africa)
P Square (Nigeria)
Sauti Sol (Kenya)
Best New Act:
Burna Boy (Nigeria)
Heavy K (South Africa)
Phyno (Nigeria)
Stanley Enow (Cameroon) [Winner]
Uhuru (South Africa)
Best Live Act:
2face (Nigeria)
Fally Ipupa (DRC)
Flavour (Nigeria) [Winner]
Dr Malinga (South Africa)
Zakes Bantwini (South Africa)
Best Collaboration:
Amani ft Radio and Weasel – ‘Kiboko Changu’ (Kenya/Uganda)
Diamond feat Davido – ‘Number One’ (Remix) (Tanzania/Nigeria)
Mafikizolo feat May D – ‘Happiness’ (South Africa/Nigeria)
R2bees feat Wizkid – ‘Slow Down’ (Ghana/Nigeria)
Uhuru feat DJ Buckz, Oskido, Professor, Yuri Da Cunha – ‘Y-tjukutja’ (South Africa/Angola) [Winner]
Artist of the Year:
Davido (Nigeria) [Winner]
Mafikizolo (South Africa)
Mi Casa (South Africa)
P Square (Nigeria)
Uhuru (South Africa)
Song of the Year:
Davido- ‘Skelewu’ (Nigeria)
DJ Clock feat Beatenberg – ‘Pluto’ (Remember Me) (South Africa)
DJ Ganyani feat FB – ‘Xigubu’ (South Africa)
DJ Kent feat The Arrows –‘Spin My World Around’ (South Africa)
Dr Sid feat Don Jazzy – ‘Surulere’ (Nigeria)
KCee – ‘Limpopo’ (Nigeria)
Mafikizolo feat Uhuru ‘Khona’ (South Africa) [Winner]
Mi Casa- ‘Jika’ (South Africa)
P Square – ‘Personally’ (Nigeria)
Yuri Da Cunha -‘Atchu Tchu Tcha’ (Angola)
Best Hip Hop:
AKA (South Africa)
Ice Prince (Nigeria)
Khuli Chana (South Africa)
Olamide (Nigeria)
Sarkodie (Ghana) [Winner]
Best Pop:
Danny K (South Africa)
Fuse ODG (Ghana)
Goldfish (South Africa)
LCNVL (South Africa)
Mathew Mole (South Africa)
Best Alternative:
Gangs of Ballet (South Africa) [Winner]
Michael Lowman (South Africa)
Nakhane Toure (South Africa)
Parlotones (South Africa)
Shortstraw (South Africa)
Best Francophone:
Arielle T (Gabon)
Espoir 2000 (Ivory Coast)
Ferre Gola (DRC)
Toofan (Togo)
Youssoupha (Congo)
Best Lusophone:
Anselmo Ralph (Angola) [Winner]
JD (Angola)
Lizha James (Mozambique)
Nelson Freitas (Cape Verde)
Yuri Da Cunha (Angola)

NON MIUZIK KATIGORI
Personality of the Year:
Chimamanda Adiche (Nigeria)
Omotola Jalade Ekeinde (Nigeria)
Trevor Noah (South Africa)
Lupita Nyong’o (Kenya) [Winner]
Yaya Toure (Cote d’Ivoire)
Transform Today by Absolut
Anisa Mpungwe (Tanzania)
Clarence Peters (Nigeria) [Winner]
Leti Arts (Ghana)
Rasty (South Africa)

Thursday 5 June 2014

BABALAWO FOR GHANA SAY E GO USE WINCH AND JUJU TO STOP CRISTIANO RONALDO NOT TO GO WORLD CUP





One Babalowo for Ghana don say,forget mata!Ronaldo leg can neva smell di world cup wey go stat for Brazil nest wik.
He say im get di best Otumorkpor and naim bi di nomba one babalawo for di hole world.im dey fly korokoro for aftanun,im can fly for early momo and e fit also fly to America go folow Obama chop food for im dining table and Obama no go see am. inshot e can hold NEPA high tenshon wire for 5 hours and nortin go do am.
Dis babalawo wey e name na Nana Kwaku Bonsam,don tok dis tok b4 last Decemba say he go send one wicked injury to Ronaldo and e go shoot am itagba wey go make am miss d world cup or at list wey go make am no play against Ghana for di world cup.
Bonsam tok say,today na knee,2morow na leg,nest 2morow na big boil for him eye,even Ronaldo sef go fear fear for di kain problem wey e go get.
Nana Kwaku Bonsam,wey he name mean 'Devil of Wednesday' tok all dis one wen one radio stashon ,Angel Fm,intaviu am for Kumasi for inside Ghana.
He say im dey veriveri sirios for dis mata,even kpakpa sef,e enta town last wik go look for,4 bingos and na dis dog dem im take prepare di otumorkpor wey him call "Kahwiri Kapam" to take finish Ronaldo leg wit injuri. He say he don alreadi mix one spesha powda wit leaves plus konkonshun togeda,and e kon putam near Ronaldo image wey dem kav.
He say na dis one bi di final one wey e go take finish Ronaldo for ground.
He also tok say if Portuga like make dem kari Ronaldo go mit TB Joshua,or kariam to di best hospita for di world or if Ronaldo like make e use Odeshi,nobodi go fit cure dis injuri bicos e dey spirichua.
Ghana,Portuga,America and Germany naim dey d same group for di world cup wey go shele for Brazil.
Di World cup go stat nest wik and Ghana and Protuga go play each oda for June 26 .
So make we dey watch weda dis Nana Kwaku Bonsam juju go work.

BIAFRA OGA SAY MAKE EVRiBODi FOR NAIJA GO BUY COFFIN IF DIS KONTRI NO DIVIDE BY 2015.

ODUMEGWU OJUKWU


NNAMDI KANU
Di new oga of igbo pipo wey dey fight to get dia own kontri 'Republic. Of Biafra'for inside Naija,Mista Nnamdi Kanu,don tok say Naija go tie wrapper if we nor divide by decemba 2015.he say di kain bombs,guns,sword,bow and arrow,knife and cutlass wey dem go use,even America nor use am for iraq.he say,di mata go red!pure red.
Kanu tok say dem no go rest for dis mata until govament giv igbo pipo Biafra.he tok dis one for one join bodi wey e do wit dia membas and some ol' sojahs wey fight for di war wey dem take stat dis stroggle.
Na for Ngwo,Enugu naim dis meeting for apun and na to mark di fest edition of di rememberanse of Biafra day on May 30 and evritin wey shele for 1967 wen di Ogakpatakpata,Late Mista Chukwuemeka Ojukwu Odumegwu stat dis strogle for di Republic of Biafra.
Kanu wey bi di diretor of Radio Biafra,use di oportuniti comishon di statue to rememba di pipo wey die for di war.
He kon blast all di govament wey don rule naija afta di war stop for 1970 and also blast di present Jonathan govment say,all of dem dey mad bicos dem dey treat all igbo pipo like mumu and dem dey suffer and push dem go one kona.
He say e no know wetin dat oyibo man,Lord Lugard smoke wen im take go join north and south Nigeria togeda for 1914.
He say make all koret pipo of igboland for all ova di world join dem for dis fight to form dia own kontri.
He say no amount of join bodi meeting go fit solve Nigeria problems,so di best way na to divide Nigeria into pieces or into six.
Nnamdi Kanu say,if dem no divide Naija and giv dem Biafra by decemba 2015,dem go kill and turn evribodi to dead bodi and say e beta make evribodi go buy dia coffin for ground.
Akkordin to di tori wey our tori pipo gada,kanu also tank Ojukwu and evri oda pesin wey sakrifice dia lives for dis strogle. 












Tuesday 3 June 2014

JAY Z AND BEYONCE WON BREAK UP BICOS OF CORNER CORNER AND KELEKELE LOVE



E be like say di rumors wey we dey hear no bi joke o!
Dem say Jay Z don dey para say,e bi like say,im wife, Beyonce don dey do konakona love,kelekele love and touching bodi wit her bodiguard,Julius de Boer.
Julius De Boer don dey work and guard Beyonce bodi for 5 years now.
Dis nor bi di fest time wey dis kain ''na u dey play me ojoro" rumors dey come out for dis 2 ogbonge miuzishans life.pipo dey tok say,Jay Z dey veri sure say,Julius de Boer dey play rich Beyonce website.
If u rememba,na dis same Julius naim stop Solange and Jay Z not to fight last month for inside lift for dat vidio wey lick come out. Solange,na Jay Z inlaw and Beyonce junior sista but dem get gbege for lift afta dem go groove for one parti for New York.
Di rumor stil dey go say,Jay Z dey fil say,di way wey Julius De Boer take dey cot eye for im wife anytime all of dem comot togeda enh,u go know say,sometin,dey pipeline.
Di two of dem don born one pikin wey her name na Carter Ivy.
Papa ivy,even want make dem sack di bodiguard last February,but Beyonce say she go kill hersef if Jay Z sack Julius.
Well,nor be only Beyonce di olofofo and aproko pipo dey blame o,in short dem say Jay Z sef dey BULALA oda malawis apart from Beyonce.
So,dem say wetin Beyonce dey try do,na...,do me,i do you,God no go vex.
Anyway we go just siddon dey look weda dis kelekele love rumor go scata dia marrage or dem go settle di mata once and for all.

STEPHEN KESHI DON DROP NATIONS CUP ORIGINAL BOMBOY,SUNDAY MBA AND SIX OTHERS FOR WORLD CUP.


Di bobo wey score di only goal wey Naija take win di nations cup last year,Sunday Mba,nor go get di chance to show im skills for World Cup wey go stat for Brazil in 10 days time.
He dey among di 7 playas wey keshi drop dis morning.although sha di bobo enta camp late bicos say im paypers and passport get smol problem.weda naim make Keshi dropam nobodi kon know or na bicos im liv Warri Wolves wey he dey play gud futbol for jejeje,kon go sign for divishon 3 club for France or even kpakpa sef,weda na maybe he don loose form,nobodi still know.na only Keshi naim know y he dropam.
Oda playas wey dem drop na Daniel Akpeyi,Nnamdi Oduamadi,Joel Obi,Obinna Nsofor,Ejike Ozoenyi and Nosa Igiebor.
I ask some pipo for some strit dis morning say,how dem see di list?and many of dem tok say,dem no supose karry Chigozie Agbim bicos di bobo no sabi keep at all.one guy kon even tok say Agbim worse pass Agbonibasket.
Among all di 23 playas wey Keshi chuz,na only Joseph Yobo,Osaze Odemwingie,Vincent Enyeama and Elderson Echiejile,don go world cup b4.

To see di list of all di playas wey Keshi selet,checkam for bottom hia:

GOALKEEPAS:
Vincent Enyeama
Austin Ejide
Chigozie Agbim

DEFENDAS:
Joseph Yobo
Elderson Echiejile
Juwon Oshaniwa
Godfrey Oboabona
Azubuike Egwuekwe
Kenneth Omeruo
Efe Ambrose
Kunle Odunlami

MIDFIELDAS:
John Mikel Obi
Ogenyi Onazi
Ramon Azeez
Michael Uchebo
Reuben Gabriel

STRIKAS:
Osaze Odemwingie
Ahmed Musa
Shola Ameobi
Emmanuel Emenike
Babatunde Michael
Victor Moses
Uche Nwofor.

Monday 2 June 2014

TUFIAKWA!!! MY PIKIN, DAVIDO,NO SUPPOSE BE MIUZISHAN.

Omobabolowo,Davido dat young but mighty miuzishan wey bi 21 years old,don tok say Mr Adeleke,di man wey be im papa,bin no want make im do miuzik bicos he fil say miuzik na for pipo wey nor sirios and many pipo wey don chuz to dey sing no achiv anytin for inside.
But sake of say he no giv up for wetin Baba God don sign for im life,now,im papa sef naim bi him nomba fan.
E get one stage wey di mata kon rich,im papa just want make he hamma for anytin wey Davido chuz to do.weda na to dey swim he chuz o,or to dey run 100 metre and play table tenis or even kpakpa sef,to dey do bricklayer work,e papa just want make e suceed.
Wen tori pipo kon askam say,among all im miuzik,wich one im like pass?di bobo kon tok say ha!e no easy to chuz o!
Even tho say pipo like all im gbedu like Dami duro,Skelewu,Aye,All of you,e get di way wey Skelewu dey totori am for bodi anytime wey im hearam.
Davido don win plenti award.even as we dey tok so,dem don chuzam for pipo wey fit win Mama award dis wikend,B.E.T award for America for June 29 and N.E.A for August.




LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...