MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 30 June 2017

Di MAMA OF Di SMALL BOY,UTIBE,WEY DAVIDO DEY BUILD HOUSE FOR,DON DIE





Life dey dey veri wicked some times.
Imagine di small boy Utibe wey Davido put for school and also dey build house for,don loose him mama to death.
Just wen di mama sopose to enjoy life,death say na lie.
If you rememba,Utibe sing Davido song,'if ' and wen Davido siam and listen for intanet,he dey veri hapi.
Wen Davido find out say di boy no dey go school and he dey stay wit him mama for mud house,he decide to build house and put di boy for school.
Rest In Peace mama.

Thursday 29 June 2017

SUPER EAGLES PLAYER JOHN OGU WEY BASE FOR ISRAEL DON TALK SAY,PIPO NO KNOW SAY NA ANODA EAGLES PLAYER,ONAZI,NAiM BUY TICKET FORAM ENTA EUROPE GO LOOK FOR CLUB



Dis na sikrit wey many of us no know bifor as Super Eagles playa John Ogu don yarn on top twita say,na Super Eagles assistant captain Ogenyi Onazi,naim buy am ticket to enta Europe go hussle for club.
He don take time pour praise on top Onazi say make God bless am.
He say he stay wit Onazi for Italy wen di bobo stil dey play for Lazio bifor tings kon pure foram.
Today,him don bikom champion for Israel wit Hapoel Beer Sheva.
He don even play for many clubs for Europe.
Onazi no kuku use am boast bifor today say him don epp dis one and epp dat one.
Pipo wey dey use dia church mind nor dey hard to know.

Wednesday 28 June 2017

GAME OVER AS TONTO DIKEH PAPA DON FINALLY RETURN Di BRIDE PRICE WEY CHURCHILL PAY FOR HIM DAUGHTA TO CHURCHILL FAMILY


Afta many months of fighting bitwin Tonto and Churchill,dem don finalli end dia marriage as Tonto Dikeh papa don return di bride price wey Churchill pay for daughta head.
Two of dem don dey sing di same divorce song as dem don tire for demsefs.
Tonto bin pack comot for di guy house afta she yarn say Churchill dey sleep wit him pasona seketri,Rosaline Meurer.

Tuesday 27 June 2017

NNAMDI KANU Di BIAFRA LEADER,DON YARN SAY LIKE SAY NA PATIENCE JONATHAN NAIM BE PRESIDENT OF NIGERIA,E FOR BETA PASS GOODLUCK BICOS Di MAN NOR TRY AT ALL AS PRESIDENT


Di leader of di Biafra movement Nnamdi Kanu,don yarn one ogbonge one for ground.
He say forma presido Goodluck Jonathan,nor sopose to be president at all bicos as president he weak pass dodo.
Akordin to Kanu he say,like say na Uncle Jona wife Patience naim rule Nigeria,she for try pass her husband.
As I enta street dey ask some pipo how dem see dis mata,many gree say na truth while some say make Nnamdi Kanu go sidon for wia contain am.
Di tin be say he don yarn how he feel,we dey wait for wetin Jona go yarn for di mata.

Monday 26 June 2017

DAVIDO DON KONTINIU HIM GOODNESS AS HE DON BUY BIG TANKER MOTOR FOR HIM OLD TIME FREND TO USE FOR HIM OIL AND GAS BIZNESS




Just some few ago,Di banana fall on you singa Davido,show us di house wey him dey build for dat smallie ,Utibe.
Now he don do follow up to dat niceness as he don buy truck give him old time frend for him birthday to take soport him oil and gas bizness.
He say dem don be frends since wen him be 12 years and di bobo always dey talk say di oil and gas bizness dey him blood.
So diafor,Davido don use him church mind arrange di tanker give di guy to take plasta.
Dis boy don try no be small.

MANCHESTER UNITED COACH JOSE MOURINHO PAPA FELIX MOURINHO,DON DIE AT Di AGE OF 79


Man U coach Jose Mourinho don papa don kpai some few hours ago as we don konfamam.
He die at di age of 79 and hin name na Felix Mourinho.
Him na forma goalkeeper and also coach.
Naim hand Mourinho imsef for learn di coaching job.
De burial go take place for Setubal for 11 O'Clock on Tuesday.
May his soul Rest In Peace.

DEM DON JAIL NAIJA RAPPER 'SAUCE KID' FOR 2 YEARS AFTA HE USE WURUWURU THIEF OVER 5 MILLION NAIRA FOR YANKEE WIT PIPO ATM AND CREDIT CARD


Wetin dey soprise me be say,dis boys go carry 419 for head like lakpalakpa without tinking say,what if dem katch me?
If u be pesin wey dey follow naija hip hop industri you go don hear of Sauce Kid some years ago but for sometime now,di bobo enta wahala for America ova credit card ,ATM ploblems.
Akordin to di tori,he use wuruwuru tiff $15,000 dollars wey be ova 5 million naira for Naija money.
Afta judgement,di law for Yankee don find am guilty as dem don sentensam to two years for prison.
Tori neva rish us yet weda dem add hard laybor join di two years.
If u rememba,about three weeks ago,Fuji pop singa Dammy Krane also enta dis kain wahala for yonda but him case still dey for court.
Naija,make una learn lesson.

Sunday 25 June 2017

PRAISE GOD! AFTA MANY YEARS OF LOOKING FOR PIKIN,FUNKE AKINDELE A.K.A JENIFA,DON FINALLY DEY PREGNANT WIT TWINS ACCORDING TO HER HUSBAND


No problem wey u dey pass tru wey too big for God to solve as Funke Akindele Jenifa stori don show us.
She don dey look for pikin but her marage to Jjc skills Bello don give her beta news.
Jjc skills naim brake Di good news as he post say him wife dey pregnant wit twins.
Di God of Elijah wey dey ansa prayers by fire go make her diliva safely.
Congratulabia as we dey wait for di safe arrival of di ejima.

Saturday 24 June 2017

ARSENAL PLAYER,KELECHI NWAKALI ENTA DIA VILLAGE FOR HOLIDAY AND HE NO DO SHAKARA AS HE SIDDON NEAR FIRE AND HELP HIM MAMA FRY GARRI


Arsenal football club player,Kelechi Nwakali wey play on loan last season wit MVV Maastricht for Holland,dey holiday right now and he travel go see him family for Village.
Now di bobo don post pishor of wen he dey epp him mama fry garri and he say he enjoy di work welwell.
Dis one na beta pikin.

Friday 23 June 2017

HARRYSONG AND HIM BABE DON WELCOME TWINS,ONE BOY AND ONE GIRL


Samankwe singa and Alter Plate Oga,Harrysong,don welkom ejima,twins for America wit him Abuja base bizness babe.
One bouncing baby boy and one bouncing baby girl naim God take bless dem.
Harrysong name di boy PEREZ wey mean richness for Ijaw language,why he name di babe TARELA wey mean love.
Congratulations to dem.

FUNNY MUSICIAN,FALZ THE BAHD GUY,DON ADVICE HIM FELLOW MUSICIANS MAKE DEM STOP TO PRAISE 419 AND YAHOO-YAHOO BOYS FOR DIA MUSIC


Di new teknika adviser of di association of Naija miuzishans,Falz,don advice miuzishans make dem stop to praise yahoo yahoo boys and 419 for dia songs.
Of resent,pipo don yab 9ice welwell afta he praise yahoo yahoo for him new song 'Living things' and di way wey di mata kon be,e be like say na 9ice be di nomba one pesin wey him dey talk to.
Akordin to Falz he say dis kain ting nor good for di young ones to grow wit.
Nice one Falz but you for advice Davido too wey curse Oga Dele Momodu for yor song wey him and Olamide joinbodi follow you sing.
Abi cursing of elders na good tin for di young ones?

Thursday 22 June 2017

BISOLA,ONE OF Di MEMBA OF BIG BROTHER NAIJA WEY JUST END,DON YARN SAY,NO BE SAY SHE NO TRY TO GO UNIVASiTi BUT JAMB USE HER EYES SEE PEPPER



Who go biliv Say Bisola of Big Broda Naija dat babe wey talent full her bodi nor go univasiti?
Yes she no go school like many of di housemates but she know book pass almost all of dem.
Now she don yarn tori pipo say,no be say she nor write jamb to fit enta school but evri time wey she write jamb,jamb always dey jam her.
Nor be only dat one.
She say dat piriod wey she dey fight to enta school,to get money hard am no be small.
So tay she try to enta Lagos state univasiti some bad pipo play am 419 chop her money.

Wednesday 21 June 2017

TONTO DIKEH HUSBAND CHURCHILL,AFTA MONTHS OF KEEPING QUIET,DON FINALLY YARN SAY,HIM MARRIAGE WIT TONTO DIKEH DON END


Wen di ting dey swit Tonto Dikeh and Churchill,plenti pipo bin jealous dem but now di tori be say,di marage don skata.
Two of dem bin get kwanta and Tonto kon pack comot from house.
Now Churchill imsef don tell tori pipo say,di marage don crash.
Akordin to Churchill,he say e get one piriod wey Tonto dey vex break plates,glass and evritin breakable for di house and as him mama try to stop her,she push her fall yakata.
Tonto say she don tire for di marage and now Churchill say she don tire too,barracks don close.

Tuesday 20 June 2017

NNPC DON BRING DOWN DIESEL PRICE TO N175 AFTA MANY FILLING STATIONS SELL FOR N300 SOME WEEKS AGO


Akordin to di Nigerian National Petroleum Corporation NNPC,dem don crash diesel price to N175 afta Di ting bin inkriz to N300 some weeks ago.
Akordin to NNPC tori pesin,Dr Ndu Ughamadu,he say na since January Dem dey do evritin to make sure Di price crash.
Nice one sha but no be to reduce Di price for newspapers and tori page,I hope say filling stations go sellam for N175?
I nor trust our karata for dis kontri.
To talk easy,na make e work bicos our politicians don use our head tire.
Dem go yarn one today,tomorrow na anoda tin you go see.

Monday 19 June 2017

WIZKID AND DAVIDO DON START DIA FIGHT OF WHO SABi SING PASS AND AFTA DAVIDO YABAM,WIZKID DON YABAM BACK SAY,HIM NA LOCAL CHAMPION SO MAKE HE STOP TO JEALOUS


Today frends,tomorrow enimis,today peace,tomorrow war naim be di case of Wizkid and Davido.
Wetin start dia new quarel still dey wonda me.
Some days ago,Davido use style yab Wizkid wey him new intanashona album "Sound from the other side" go drop for July 7.

Trust Wizkid as di bobo sef kuku get bad mouth.
On top twitter he say,Since you fail for intanashona and him succeed for intanashona,e beta make di guy remain local instead of am to dey yarn puan.

Sunday 18 June 2017

WIZKID AND DAVIDO DON START DIA FIGHT OF WHO SABi SING PASS AND AFTA DAVIDO YABAM,WIZKID DON YABAM BACK SAY,HIM NA LOCAL CHAMPION SO MAKE HE STOP TO JEALOUS


Today frends,tomorrow enimis,today peace,tomorrow war naim be di case of Wizkid and Davido.
Wetin start dia new quarel still dey wonda me.
Some days ago,Davido use style yab Wizkid wey him new intanashona album "Sound from the other side" go drop for July 7.

Trust Wizkid as di bobo sef kuku get bad mouth.
On top twitter he say,Since you fail for intanashona and him succeed for intanashona,e beta make di guy remain local instead of am to dey yarn puan.

Saturday 17 June 2017

FEDERA GOVMENT WAN SERIOUS WIT Di LAW WEY SAY,IF DEM CATCH YOU DEY SMOKE FOR PUBLIC,YOU GO PAY FINE OF N50,000 PLUS SIX MONTHS FOR PRISON


Smoking Cigar of N10 fit make you spend six months for jail plus N50 tausand naira fine if dem catch you dey smoke am for public.
Akordin to di Federa Gofment,dem won take dis law sirios so dat pipo go dey live long,
Nor be say dis law no dey since but dem say from now on dem won make sure anybodi wey brake dis law go hear nghwi.
Na di Federa Gofment tru di ministry of health naim yarn dis one.
Fly wey no hia word naim dey follow deadbodi enta grave.

Friday 16 June 2017

BIG NAME FOR AFRICA FOOTBALL DIDIER DROGBA,DON PRAISE DAVIDO OVA Di HOUSE WEY HE DEY BUILD FOR UTIBE,Di SMALL BOY WEY HE ALSO PUT FOR SCHOOL AFTA Di BOY SING HIM SONG


Africa football legend Didier Drogba don praise Davido on top twita for di good ting wey him do for dat smallnboy Utibe and him mama.
If you rememba some weeks ago for Ibeno,Akwa Ibom state,di video of Utibe wey dey sing "if" by Davido enta evriwia and Davido kon decide to epp put di boy for school.
Nor be only dat,he also don dey build house for di boy and him mama afta he diskova say na sandsand house dem dey stay.
Di ting dey buss Drogba head as he don join tausands of pipo tank Davido for him goodness.

Thursday 15 June 2017

DAVIDO PIKIN MAMA,SOPHIE MOMODU,DON YARN SAY ANYTIME WEN POOR BOYS SEND AM LOVE MESSAGE,Di TING DEY VEXAM ENTA BONE




Davido baby mama Sophie,don yarn on top her Snapchat say,anytime wey fine boys,broke boys and poor boys send am love message on top Snapchat,Facebook or any oda link,di ting dey make her para.
If u nor get money and u dey form fine boy for wia she dey,she say u dey waste ya time.
She also yarn say who fineness don epp?
Davido don spoil her wit money,why she no go yarn puan?

Wednesday 14 June 2017

ROTIMI AMEACHI Di MINISTA OF TRANSPORT DON YARN TORi PIPO SAY,GOODLUCK JONATHAN NO DO ANYTHING FOR IBO PIPO UPON SAY DEM VOTE FORAM FOR 2015 ELECTION


Transport minista and forma Rivers state gofnor,Rotimi Ameachi,don kontiniu di yabis against forma presido,Goodluck Jonathan as he yarn say,di man no do anytin for Ibo pipo.
He say for 2011,Ibo pipo use all dia life vote for uncle Jona but yet,di man nor gree do wetin he promise dem like di 2nd Niger bridge.

Tuesday 13 June 2017

CHURCH MUSIC SINGA,ATORISE DON YARN SAY,HE BEG HIM WIFE AND SHE DON FORGIVE AM FOR Di PIKIN WEY ANODA WOMAN BORN FORAM OUTSIDE DIA MARRIAGE


Popular gospel miuzishan,Lanre Teriba a.k.a Atorise don yarn tori pipo say,him wife don look up,look down and forgivam for di away match wey him go play wit anoda woman.
For dat away match,di woman get belle and she born pikin for Atorise and akordin to di popular miuzishan,him wife don forgivam for dis chukuchuku wey him do outside dia marage.
Atorise say,as far as pipo wey dey close toram don undastand and as far as him wife don forgivam,him nor care about pipo wey dey call am ashawo man.
He say most pipo wey dey do worse tins for backyard sef,join dey call am bad names and di tin dey wondaram why pipo nor fit just forget wetin don appun for bifor bifor.

Monday 12 June 2017

FOR SAUDI ARABIA,15 YEARS FOR PRISON DEY WAIT FOR YOU IF DEM CATCH YOU WEAR BARCELONA JERSEY FOR DAT COUNTRY


Two kontris Saudi Arabia and Qatar nor dey agree at all as di two kontris get sirios quarel.
Now di Saudi gofment don put law say,u go pay fine of £135,000 wey be ova N67 million naira  if dem catch u wear Barcelona jersey bicos na Qatar Airways dey sponsor di jersey.
Nor be only dat one o,if you wear any Barcelona jersey wey carry di Qatar Airways logo,dem fit put you for prison for 15 years.
Fly wey no hear word naim dey follow dead bodi enta grave o.
For those of una wey won travel go Saudi Arabia and you get plan to wear Barcelona jersey,try buy cotton bud and use am klin ya ear.

Sunday 11 June 2017

PLENTY RESPECT TO DAVIDO AS HE DON BEGIN TO BUILD HOUSE FOR Di SMALL BOY WEY SING HIM NEW SONG SOME WEEKS AGO

Davido don win evri part of my soul, 30 billion times for di good tin wey him do for di smallie wey use play play sing him song.
Some weeks ago,davido put Di boy for school and promise to take kia of am foreva.
Now Davido don soprise even my sleeping spirit as he don skata Di boy mama mud house and bigin to build block house for dem.
Di Kain record wey Davido dey sef wit miuzik and outside miuzik,no get part two.
We as a pipo espeshali Di wicked rich pipo,must learn from dis Davido kindness.

Saturday 10 June 2017

FOR CAMEROON,LANDLORD DON USE FORCE CARRY TENANT POT OF CHICKEN SOUP BICOS HE NEVA PAY HIM RENT FOR 6 MONTHS


Tenant,landlord wahala no dey eva get ending.
Di latest news wey enta our tori room be say,one landlord for Cameroon don seize him tenant pot of chicken soup sake of say,he dey owe six months rent.
Dis one appun for Doula,Cameroon.
Di landlord wey don tire to ask for him money,carry him tenant pot of chicken soup.
Oda tenants joinbodi to beg di landlord make he givam di pot of soup back but di landlord nor gree.
Akordin to di landlord,he say wetin make am dey para be say,him tenant get money to cook correct pot of chicken soup but he nor get money to pay house rent.
He say anytime wen he ask of him rent,Na so di man go dey make mouth say,di law go hollam if he try to drive am from di house if he no givam two months quit notice,
Na wa o.
Landlord and tenant drama nor be small tin o.

Thursday 8 June 2017

AKWA IBOM STATE GOVMENT DON GIVE 31 DAYS WARNING TO TRADERS TO REDUCE Di PRICE OF GARRI,TOMATOES,VEGETABLES AND OTHER FOODSTUFFS OR ELSE DEM GO ENTA GOVMENT WAHALA


Dollars inkriz price of foodstuff go up,dollar rate come down,foodstuff dey inkriz more more.
Akordin to tori wey we gada,Akwa Ibom Own worse as unions dey kill dem for yonda.
For example,garri union for Akwa Ibom state put law say,if you nor pay N500,000 you no fit carry garri enta di state to sell and dis one kon make price of garri and oda tins go up.
Now di state gofment don open chapta reach dem and give di union 31 days warning to use dia church mind or gofment go show Dem pepper.
Di special assistant on traders mata to Govnor Udom Emmanuel,Idorenyin Raphael,naim yarn dis one on top di radio program 'Superior Performance '.
Idorenyin yarn say,for Akwaibom right now,bag of garri dey sell bitwin N22,000 and N30,000 but for outside Akwa Ibom bag of garri dey sell for 17k and N18k.
He say if u no dey dia union and u carry bags of garri come market,dem go seize am.
He say bicos of dis madness,crayfish sef don cost.
Aba pipo dey come Akwa Ibom to buy crayfish and dem dey sellam cheap pass pipo wey dey sell for Akwa Ibom bicos of union kpalava.

Wednesday 7 June 2017

SOME JOINBODI GROUP WEY INCLUDE AREWA YOUTH FORUM FOR NORTH,DON GIVE IGBO PIPO 3 MONTHS TO PACK COMOT FOR DIA AREA AND MAKE DIA OWN PIPO COMOT FROM EAST TOO


Wich kain wahala dis Arewa joinbodi group AYCF won start for dis kontri so?
On Tuesday,some joinbodi group wey also include di Arewa youth forum,give igbo pipo three months to pack comot for north if not,kasala burst.
Dem also tell dia Own pipo make dem pack comot for east and come back to dia land.
Di national president of dis AYCF group Yerima Shettima naim yarn dis one for kaduna yestaday.
Na small small e take dey start.

Tuesday 6 June 2017

GOVNOR NYESOM WIKE OF RIVERS,DON RUN GO COURT TO STOP POLICE TO SEARCH HIM HOUSE FOR ABUJA AND OTHER PLACES


Na wah o!
Wen all dis kain tori go dress comot for dis Gofnor Wike head sef?
Today naim and Rotimi Ameachi,tomorow naim and police,next tomorow naim and Benue state govnor.
Today tori wey we gada be say,Gofnor Nyesom Wike,don carry EFCC,State Sikioriti Service,SSS and inspector general of police,(IGP) Ibrahim Idris,go court so dat dem go allowram drink water put cup for ground.
He dey pray right now thru him lawyer make court stop all dis pipo from searching him house for Abuja and oda places.
Gofnor Abeg pity for dem,allow dem to search if na dia work dem kon do.
If u nor get skeleton for cupboard no need to shake.

Monday 5 June 2017

KENYA SHAKARA BABE,HUDDAH MONROE,DON YAB NAIJA MEN SAY,WE BE BABA FOR ENJOYMENT BUT WE NO GOOD FOR MARRIAGE


Chai!
Naija men,Una don suffer.
Kenya shakara babe Huddah Monroe,don finish una for ground as she say,Naija men nor good for marriage but dem be ogakpatakpata of enjoyment.
Huddah yarn dis one on top Instagram wen one of her Naija fan beg her make she try marry Naija bobo so dat she go dey enjoy koret Naija jollof rice and moin moin.
Her reply to her fan don soprise many pipo as she say,she don follow many Naija men and dem sabi flex to pieces but she nor trust dem for marriage.
My queshon be say,she don marry Naija bobo bifor?
Her reply don make some Naija men dey grumble alreadi.

Sunday 4 June 2017

AFRO FUJI SINGA DAMMY KRANE,FIT GET UP TO 40 YEARS FOR AMERICA PRISON ACCORDING TO Di TORi WEY WE GADA AFTA DEM ARREST AM BICOS OF 419


I won enta private jet,I won show my pictures for Instagram,I want make pipo See say pepper rest,I want make di girls dem dey craze for my mata.
All dis one naim put Afro Fuji singa,Dammy Krane for wahala so.
Yestaday we bring una tori of how he take do gibiti and wayo for America as he use anoda pesin credit card take book private jet.
Afta dem arrest di guy,Di owners of di private jet company,Tapjets,don talk say,Dammy Krane get case to ansa for court.
For di level of crime wey he komit,di informate wey we gada be say,Dammy fit spend up to 40 years for prison afta court judgement if he nor get luck.
I pity for him mama and di pains wey she dey pass thru right now.

Saturday 3 June 2017

NICKI MINAJ DON SHOW WIZKID LOVE FOR INSTAGRAM


I nor know weda e get any man wey go see Nicki Minaj wicked shape and figure 8 wey no go trip.
Di guys wey dey line up to enta Nicki Minaj heart if space dey,go reach like 50 million.
One of such pipo wey dey trip for di sexy Nicki,either for her fineness or for her talent,na Wizkid.
Nor be today Wizzy don dey shout and like di babe pishors on top Instagram.
And now Nicki Minaj hersef don press di like button on top Wizkid foto.
For botom of dis pishor,Wizkid write say, "Ghetto yuth on top" and Nicki no waste time to press like to show soport to di young Africa legend.
1,1, na draw.
Like me,i like you God no go vex.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...