MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 31 July 2015

I DON BE DANFO DRIVER BIFOR-AYO FAYOSE


One man mopol, Ayo Fayose,di Govnor of Ekiti State, don yarn membas of Road Transport Employers Association of Nigeria (RTEAN) on thursday July 30 during di swearing-in ceremoni of di new State Executive of the union for Ado Ekiti,say him don drive danfo bifor too just to fit pay skul fees to complit him HND for Ibadan politeknic.
He yarn all dis ones since dem don dey report di union drivers say kidnappas dey pay dem to kidnap pipo.
He say di rizin why him dey yarn dem all dis one be say, even tho u be driver,u can still hama big time for life,so diafor make dem comot hand for bad tins.
He also tank di union as dem stand gidigba for him back wen him enemies try to comotam as govnor of Ekiti state.

NO BE ONLY ME DON BREAK YVONNE NELSON HEART-IYANYA

Kukere masta,Iyanya,don talk e own side of why him and Ghana actress Yvonne Nelson frendship hit rock scata.
During di intaviu wit Ehis of Mtv Base,Iyanya say di real tin be say, ''him na popular guy,di geh na popular babe''
Who hard and who bam pass kon dey worry two of dem.
He say afta dem brake up,evribodi kon dey lookam like say naim be di bad pesin for di mata.
Iyanya say bifor u lookam wit bad guy eye,wot of oda bois wey dem brake her heart bifor di two of dem start dia kurukere love,dem nor bad?
Iyanya and Yvonne Nelson,di forma lovebirds romance, bin no get part two as dia love na talk of di town dat year bifor kasala buss.

Tuesday 28 July 2015

PHYNO: FROM MOHAWK TO HAWK-MO

Ndigbo numba one chief rappa,Phyno don surprise us as he don take down him mohawk hair style wey dem take know am.
Some pipo don yarn say na di forma haircut dem like pass why some say no way!
Na di new hair cut mature pass.
Anyway,see di new hair style for bottom hia.
Make u judge by yorsef

OBAMA VISIT: TIGHT SKIRT LOVER POLICE WOMAN DON RELEASE NEW PHOTOS

With dis kain ikebe wey Linda Okello di Kenyan police woman carry,she go fit make pipo obey traffic rules so?
or u feel say she go cause more accident?
Dis woman wey skata evriwia last year wen she wear baddest tight skirt,release new pictures wen Obama visit Kenya.
See more photos for bottom hia:
CORPORAL LINDA OKELLO POSE NEXT TO ONE OF DI CAR FOR OBAMA CONVOY

OH MY GASH!!! NICKI MINAJ AND DIS KENYA POLICE WOMAN DEY SHARE SOMETHING IN COMMON

With dis kain ikebe wey Linda Okello di Kenyan police woman carry,she go fit make pipo obey traffic rules so?
or u feel say she go cause more accident?
Nicki Minaj dey one side and we also get Linda Okello for di oda side.
Come O,
Linda and Nicki,why una dey look for trouble?
NICKI MINAJ
LINDA OKELLO WITHOUT POLICE UNIFORM

Monday 27 July 2015

UNA BYE BYE!!! I NO GO EVER VISIT SWEDEN AGAIN - SNOOP DOGG

America rappa,Snoop Dogg,don tell all him Sweden fans say make dem blame dia police pipo for di swear wey him swear say,him no go eva visit dia biutifu kontri again.
Snoop yarn dis wan on top twitta on sunday afta Sweden police stopam for road,arrestam go station and force am to piss for cup sake of say dem won do test wit di piss to know weda igbo(marijuana) dey him system.
Snoop bin go do show for di university town of Uppsala Stockholm,Sweden.
Snoop later yarn say na bicos him na black man naim make dem tritam like dat but di police pipo say na lie bicos na dia work dem just dey do. 
If u check and balance am,u go blame Snoop?
For police to arrest am go station from him car and force am to piss for cup and no be say dem catcham wit igbo,naim be  say dat wan pass opression.

UNA MUST PAY ME ONE BILLION NAIRA - KESHI DON TELL NFF


Super Eagles forma coach,Stephen Keshi wey Naija Futbol Assosiation sack sake of say him no value him job,don write dem leta to tell dem say na N1billion naira dem go arrange am as dem sackam.
He say dem do wrong to sackam as dem don robish him pesin base on di contract wey him sign as Eagles coach.
Akordin to one tori pesin wey know about di mata,he say NFF receive Keshi leta on friday from one Kaduna base lawyer compini.
Four months afta dem givam di job,NFF sack Keshi July 5 afta dem conclude say di coach no value him job as he apply to coach Ivory Coast di sametime wen he still dey unda kontrat wit NFF.

Thursday 23 July 2015

MAJEK FASHEK DON DEY WORK ON HIS TEETH SERIOUSLY


Naija answa to Bob Marley, Majek Fashek don see chomchin and he dey pass tru some deep issue.
Some even they say na spiritual problem why some say na drugs turn him life upside down.
Dis past few years no easy for Majek Fashek as many tins don go wrong for him life style.
One of dis problem na di color and di setings of he teeth wey don nearly scata finish.
If u know Majek Fashek bifor all dis plenti wahala start for him life, u go know say him teeth dem no be as dem be bifor.
Now,if Majek smile,you go shock if u see him teeth.

I no undastand weda na tabacco naim do am like dat but as somebodi wey don watch am live dey play him kpangolo style of miuzik. bifor, i no say dis man get koret teeth dat year.
Di good news be say Majek don start di re-arrangement of him life,starting from his teeth as he don carry waka go meet dentist(doctor for teeth mata).
Him friend Black Rice post for facebook di pictures of wen di teeth doctor dey work on Majek teeth.
Black Rice also write for facebook say "dem dey tank evribodi wey donate and kontriboot to see Majek stand gidigba again.
He say naija pipo kindness dey show wella and e dey work for Majek bodi.

NO BE ONLY BUHARI DEY DO MISTAKE AS VAN GAAL,CALL PLAYER 'MIKE', INSTEAD OF ''CHRIS''

During one join bodi siddon talk wit tori pipo,
Manchester united coachee,Louis Van Gaal,forget di name of him player and call am "Mike Smalling" instead of "Chris Smalling".
Pipo bin laff President Buhari welwell anytime wey he no call di name of any animal,place or ting corectli.
For example,Buhari won say Germany,he kon say West Germany.
He say ANPC instead of APC.
He supose say Chancellor Merkel but he kon say President Merkel of Germany.
Even our vice president name,Buhari call am Osunbade instead of Osinbajo during campaign but now we don know say it can appun to anybodi.
On tuesday for America wia Man U for dey train dey prepia for di new season,dia Coach Van Gaal follow tori pipo dey yarn about who him three captain dem be.
He kon misyarn say na 'Mike' instead of 'Chris' naim be di numba three captain.
Wayne Rooney naim be Manchester United captain.
Michael Carrick na numba two why Chris Smalling na di numba three captain akordin to Loius Van Gaal.

Wednesday 22 July 2015

TUFIAKWA!!!! BUHARI DON REJECT AMERICA GAY MARRIAGE OFFER

President Muhammedu Buhari don show say no be evritin Nigeria dey copy from obodo oyibo as he don reject gay marriage offer from America as he say na madness and he dey against our culture.
Di pesin wey dey represent di president for tori mata,Mr Femi Adesina talk say na true say di waka wey Buhari carry go America,dem sell di idea of make Naija agree make man dey marry man and make woman dey marry dem sef too.
But Buhari say tufiakwa! we no mumu reach like dat and dat kain tin no fit appun for hia.

TIWA DON BORN BOUNCING BABY BOY

Di first lady of mavin records,Tiwa Savage along her husband,Tee Billz,don welcome dia first pikin togeda.
Ogakpatakpata for Mavin records imsef Don Jazzy naim break di good news for twitter and Tee Billz imsef don confam di tori as he post photo of wen he hold di pikin hand.
Congratulabia!

Tuesday 21 July 2015

GABON PRESIDENT TURN TO MESSI DRIVER

Lionel Messi spend last saturday for Gabon wen he go hep lay foundation of one new stadium wen dem won build.
Di stadium go contain 20,000 pipo wen dem build am finish and na di president of Gabon Ali Bongo Ondimba naim hostam.
Akordin to di president,wen he visit Barcelona some years ago,Lionel Messi promise to visitam for Libreville,Gabon one day.
He say Messi na man of him words as he honor di waka.
Tori wey dey reach our table be say na N1.6 billion naim Ali Bongo pay Messi bifor he agree to carry waka come Gabon.
So wich one be dis one wey dis president dey yarn say Messi promise to visitam?
Ova to una pipo of Gabon.
Messi don dey eat from una national cake.

'MONKEY' FALL FROM PALM TREE,BREAK SPINAL CORD BICOS OF N300

For Mkpuma Agbaja in Izzi local government of Ebonyi State last weekend, one bobo, Mr Egede Nwofe, wey he nickname na 'monkey' fall from palm tree and break him spinal cord.
Akordin to Mr Nwamimi Okwuta, di man wey get di palm trees, he say for di past five years naim he don dey hire Nwofe to helpam harvest palm fruit and dat kain tin neva appun bifor.
Wen tori pipo carry waka enta dia village go hear from dem,Mr Nwofe yarn say, di money wey him dey make from di palm tree climbing,naim he take dey feed im family.

He say na N500 him dey collect for tall palm tree and N300 for short one.
For dat day, Mr Nwofe don alreadi climb three trees.
He say as he dey climb di numba 4 tree,naim him bodi start to dey shake like shakespeare, Cold kon enta him.
Bifor he say Jesus! him don reach ground break him spinal cord.
Spinal cord wahala no be small pikin problem.
We wisham goodluck as he dey recover.

Monday 20 July 2015

KWEKE!!!! BUS DRIVER VEX NAKED HIMSELF TO PREVENT LASTMA TO ARREST HIM BUS

Wen some pipo don make up dia mind say dem go die for some kain mata,nobodi fit change am.
Dis na exactly wetin one bus driver do dis afernoon for Allen Avenue for Ikeja as LastMa seize him bus sake of say he break traffic law.
Bifor u say siddon look is a noun,di driver don naked imsef one time and tanda gidigba for front of him bus dey shout say, make Lastma kukuma jamam die instead of dem to arrest him bus wey dey give am im daily bread go dia office.
Leave mata for mathias.
To carry last nowadays no dey anybodi dictionary.

SHUOoooo!!!! OBASANJO ABEG LEAVE JONATHAN ALONE - AYO FAYOSE

Some days ago if u dey follow up,u go don hear wen Obasanjo yarn say, pipo from Niger Delta go suffer tey bicos of di way wey Jonathan take rule.
Akordin to OBJ,he say Uncle Jona no use di oportuniti wey him get to rule dis kontri well at all.
Him say so diafor,to pick anoda pesin from dat area go hard.
Bifor di presido elections for April wey Buhari win,Obasanjo withdraw all im suport for Jona.
Earlia today, di Govnor of Ekiti state,Ayo Fayose don release statement say make di grand Palle of Naija politiks Olusegun Obasanjo, stop to attack forma presido,Dr Goodluck Ebele Jonathan from left,right and centre bicos no be di man be president again.
Ayo Fayose di one man mopol of PDP,say make he try leave Jona make he leave him private life jejely since he don give Aso Rock chance.

Thursday 16 July 2015

MAJEK FASHEK: I GO CURE MY CRAZE AFTER I RELEASE MY NEXT ALBUM


Reggae miuzishan,Majek Fashek, don yarn afta he carry waka go one church say make dem no force am go place like Uselu, wia dem for dey cure pipo craze or pipo wey small nut don loose for dia head.
He say him spirit go dey low if dem force am.
If you rememba three weeks ago,di whole intanet scata wey dem say Majek dey beg ogogoro waka nowadays and dis one kon make Area Fada,Charly Boy beg naija pipo make dem join am to hep di reggae star.
Pipo also dey yarn say,di ting wey putam for dis problem na bicos, di ganja farmers product wey him dey smoke no good for him bodi.
Majek say him know how he take dey escape dis tritment bicos God don givam differen differen knowledge like orisha and babalawo knowledge.
He say naim ancestors knowledge he dey use right now and him dey drink akpeteshie (ogogoro) wit di orisha idea wey him get.
Di Rain maker wey him jam,"Send Down The Rain" reign scata dat year say, him go take di tritment afta he release him next album.
HIS ROYAL FRESHNESS,MAJEK
His Royal Freshness,one of Majek Fashek guy name some years ago bicos him skin fresh finish like fresh vegetable in dose days yarn say, he no want make him spirit dey low bicos na Jesus be him hero,Lord and Saviour and naim don carry am reach dis level.
Majek say make pipo calm down afta di album bicos he no won enta hospital now bifor somebodi go givam bad injection.


GHANA MUSICIAN,STONEBWOY DON REJECT GLO N18 MILLION

STONEBWOY
Ghana miuzishan of di moment,Stonebwoy and him team don tell GLO make dem kip dia N18 million naira wey dem won take make am ambassador for dia network.
Di bobo say di raba too small foram and di conditions for di contract no favor ram.
For example,he no go fit play for any shows wey oda network like Mtn and Etisalat organize.
Di BET Awards winna wey also win Ghana artiste of di year,don study di kontrat and conclude say,him level don big pass dat money wey GLO dey offaram.
We hope say he no go regret dis action sha bicos dem talk am say,a bird in di hand even tho e fit shit for yor hand, beta pass 20 birds for inside bush.

Wednesday 15 July 2015

EEDRIS TO DAVIDO: WHY YOU GO DO VIDEO ABOUT COCAINE


Pipo don dey shook mouth put for di kwanta wey buss out bitwin NDLEA and Davido as
Naija supastar,Eedris Abdulkareem don blast Davido for di cocaine part for him latest video.
For some days now,di National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, don dey investigate why Davido go use him korokoro eyes dey do sabisabi about cocaine mata for di video of "Fans Mi".
Akordin to NDLEA,dem say na veri bad example from Davido as he nor teach pipo any beta ting apart from say he dey advatise cocaine.
Dem say if to say na arrest dem arrest pipo wey dey do cocaine bizness for di vidio,dem for even congratulate am for a good job and even enta partnaship and do bizness witam.
For di same mata, Eedris don blast Davido say why he go use cocaine for him vidio?
He yarn dis one for inside HipTv news.
He say America rappas fit dey do drugs vidio for dia side but we no supose dey copy dem.
Di Nigeria jagajaga singa say,make pipo use dia office take do beta tin.
He also yarn say miuzik nor be only about to dey show naked gehs wey dey shake yansh but also to pass beta message to educate and inspire shidren.

Wednesday 8 July 2015

SEE AS TEACHER BULALA Di YANSH OF STUDENT WITH 100 STROKES (WARNING; Di PHOTO NO GOOD FOR EYE)

One tisha for one of the most popular school for Delta State,Government College,Ughelli,don fall him hand as he scata di yansh of him student with cane.
He flog di poor boy 100 strokes sake of say di boy follow him fellow student fight bicos of him own spoon.
If u see di yansh of Ebikabowei Daniel,di boy wey di tisha flog,you go feel say dem forget di yansh for fire.
Why wicked pipo plenti pass good pipo for dis world?
If na yor pikin or broda dem bulala im yansh like dis,wetin u go do to di tisha?

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...