MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 31 December 2017

NNPC DIRECTOR MAIKANTI BARU DON TALK SAY,NA WICKED AGENTS AND MARKETERS BE Di CAUSE OF Di FUEL PROBLEM BICOS DEM DEY BUY FUEL CHEAP AND SELLAM COST


Group managing direktor of NNPC Maikanti Baru don tell Nigerians say,na marketas be Di problem of did fuel skasiti as dem don plan wit devil to make Nigerians suffer for nothing.
Akordin to Baru he say dem dey sell fuel for N133.38 kobo to marketas and dem sopose to dey selam for N145 but instead dem dey sell for N250 or more.
He say him no undastand why human bins go dey do human bin like am dis kain wickedness make dem for no enjoy di Christmas and New year selibration.

Saturday 30 December 2017

CHURCHES AND MOSQUES GO SOON START TO PAY TAX FOR LAGOS AS Di STATE HOUSE OF ASSEMBLY DON DEY ARRANGE Di LAW WEY GO MAKE AM POSSIBLE


If di plan wey Lagos state house of assembly dey arrange work,naim be say churches and mosques go soon start to pay tax for di state.
Dem won try amend di Land Use Charge Law of 2001 wey go make churches and mosques start to submit and remit enta di Lagos state bank akaunt.
Akordin to di speaker of di House of Assembly Mudashiru Obasa,he say dem want make di state bigin make more money to take arrange tings for di state.

Friday 29 December 2017

VERY BAD AS WICKED MAN DON SHOOT AND KILL RIHANNA BRODA ON BOXING DAY JUST ONE DAY AFTA RIHANNA SPEND CHRISTMAS WITAM


Big name miuzishan Rihanna..and her fans dey veri sad right now afta one guy wey no know imsef shoot her cousin broda die on disemba 26 for di street of Barbados wey be her kontri.
Min why,dis na di same boy wey Rihanna spend Christmas day wit bifor dem kilam on boxing day.
Di cousin name na Tavon Kaiseen Alleyne and nobodi don know di sin wey di bobo komit wey make dem shootam.
Min why,police don bigin do investigatement.

Thursday 28 December 2017

Wednesday 27 December 2017

YES,AFTA Di FINAL ELECTIONS YESTADAY,GEORGE WEAH Di FORMA WORLD FOOTBALLER OF Di YEAR,DON WIN ELECTION TO BIKOM LIBERIA PRESIDENT


George Opong Weah don win Di present vice president Joseph Boakai to bikom Di new President of Liberia.
For di election wey dem do yestaday,George Weah win Joseph win plenti votes.
If you dey follow up,Weah naim be di only Africa player wey win FIFA 1995 world best player of di year.

Tuesday 26 December 2017

CHRISTMAS LOVE AS 'PRINCESS MAYA' GRADUATE OF NASARAWA STATE UNiVASiTi,DON DEY FEED 5,000 PIPO BIFOR DECEMBER 31..SHE DON FEED 4,500 PIPO ALREADY


Na beta manya naim Princess Maya don dey give Naija across all Naija states as she don dey arrange wack give 5,000 pipo.
Akordin to di tori wey we gada,she don feed 4,500 pipo alreadi for di iFeed5000people waka wey she dey arrange bifor Disemba 31 just to take put smile for pipo face.
Koret babe,beta pikin.
God bless you plenti.

Monday 25 December 2017

NO MORE WAR,NO MORE FIGHT AS WIZKID AND DAVIDO ENTA STAGE SING TOGEDA DURING Di WIZKID GROOVE FOR EKO HOTEL LAGOS LAST NIGHT


Afta dia fans don curse demsef tire on top Facebook, Instagram and twita,WIZKID and Davido don finalli settle dia fight.
Some of dia fans even throw blow and fight demsef but yestaday,dis two supastars shock all of us as dem sing togeda for stage for Eko Hotel Lagos for Wizkid show last Nite.
Afta una make many pipo fight for una mata,now una don settle,DAT na wetin some fans dey talk.
Some even say dem no go gree make dem settle bicos do kworel dey swit dem.
Oya watch di video for bottom hia...


Sunday 24 December 2017

Saturday 23 December 2017

NO BE SMALL THING AS FUEL WAHALA DON MAKE PLATEAU STATE GOVNOR SIMON LALONG PARK CAR FOR CORNER GO BUY FUEL FOR BLACK MARKET



Nigeria mata just dey foolish dey go evri sekond, evri minit and everyday by day.
We call our sef oil kontri,yet fuel scarce pass tomatoes.
Imagine our leaders wey evritin dey wit,yet dem dey konfiuz on how to move dis kontri forward.
Plateau state gofnor Simon Lalong pack him car for kona kon dey buy black market fuel to fill him car and camera boys make sure dem snap him car foto.
Meanwhy,our sekond name na 'Oil' and we be nomba oil produsing kontri for Africa,yet we dey suffer for fuel like mad.

Friday 22 December 2017

OSUN STATE WORKERS DON READY TO GO ON STRIKE FROM DECEMBER 27 OVER HALF SALARY WEY Di STATE GOVMENT DEY PAY DEM


Workers for Osun don't dey para beta para wit di Osun state gofment ova salary mata.
Dem say do govment resiv about N6.3 billion Paris club refund yet dem dey pay dem half salary.
Di workas don't already choose December 27 as Di day wey dem go start Di strike.

Thursday 21 December 2017

DAVIDO FORMA MANAGER 'KAMAL AJIBOYE' DON TALK SAY NAiM SACK HIMSELF NO BE DAVIDO SACKAM AS MANAGER


Kamal Ajiboye wey be Davido forma manager,don yarn tori pipo say,di news of say na Davido sackam as him manager na lie.
He say naim him sack imsef afta he find out say di Big tings wey him want for Davido different from wetin Davido want for imsef.
He say make pipo no dey talk say na sack dem sackam.

Wednesday 20 December 2017

REEKADO BANKS DON YARN SAY,2017 NA GOOD YEAR FORAM BICOS AT 24 YEARS,HIM DON GET LEXUS,BENZ,BUILD HOUSE FOR HIM MAMA AND HE DEY BUILD SCHOOL RIGHT NOW


Mavin records bobo,Reekado Banks don yarn tori pipo say,at 24 years him dey proud of wetin him don achieve.
He say him get two cars Lexus and Benz,he don build house for him  mama and right now,him dey build school.
If nobody praise you,Abeg praise yasef bros,you try.

Tuesday 19 December 2017

YEMI OSINBAJO Di VICE PRESIDO DON YARN SAY,Di N1.5 MILLION AND Di N1.75 MILLION WEY HIM AND PRESIDENT BUHARI DEY COLLECT EVERY MONTH NA CHICKEN CHANGE


Many workers money if dem join evritin from January to December nor rish 300k not to talk of 500,000 as year end salary.
Wetin make I dey yarn dis one be say,Vice presido Yemi Osinbajo don yarn say,di N1.5million wey him dey resiv and di N1.75 million naira wey Buhari dey resiv for one month na chicken change.
He yarn dis one wen he dey yarn for di joinbodi sidon wit di state house tori pipo for di presidential villa for Abuja.
Mr Man,1.5 milla for a month no be small money.


Monday 18 December 2017

DAVIDO DON FINALLY BEG OGA DELE MOMODU SAY MAKE HE NO VEX AFTA HE YABAM TIRE DURING Di QUARREL BITWIN HIM AND SOPHIA MOMODU,Di BABE WEY BORN FORAM



Davido don use him church mind settle wit him baby mama uncle Dele Momodu afta dia quarel for almost two years.
Dele Momodu and Davido bin kwanta afta Davido bin won carry dia daughta travel out without di pikin mama knowledge.
Since dat time Na so so quarel.
Even sef Davido call Uncle Dele him boy for Humble Smith miuzik,Osinachi.
E dey nice say dem settle bifor di new year.

Sunday 17 December 2017

BOB MARLEY AND WIZKID BIG BUT I GO DEY BIGGER THAN DEM ONE DAY WIT MY MUSIC - 'SUGARBOY' OF G-WORLDWIDE NAiM TALK DIS ONE


If you ask me,I go prefa make pipo do dia work and pray to God to bless dem instead of to dey talk wetin go make pipo dey weak for ya mata.
G worldwide records miuzishan Sugarboy,don boast full ground say,one day him go large for name and dey bigga than both Wizkid and Bob Marley.
He yarn tori pipo dis one yestaday and he dey sirios about am.
No be bad dream sha but e for beta make u just dey do ya work dey go and kontiniu to pray make God bless ya hustle as naim get pawa to arrange all mata.

Saturday 16 December 2017

POLICE DON FINALLY ARREST BURNA BOY AND DEM GO CARRY AM GO COURT ON MONDAY AFTA DEM SAY NAiM SEND ARM ROBBERS GO ATTACK MR 2KAY FOR EKO HOTEL



Burna Boy don finalli dey ansa police queshons afta dem arrestam base on di attack wey arm robbers attack Mr 2Kay.
Some weeks ago,afta 2Kay pafom for finish for 2face show,robbers follow am enta him hotel room and dem niali beat am die.
Akordin to di Nigeria police,dem say pipo wey dem katch confess say na Burna Boy send dem to show Mr 2Kay pepper.
Since dat time,police don dey look for Burna Boy but now he don finalli show face for station.
And tori wey dey rish our tori room be say,dem go carry go court on Monday.
How dis mata go end last last,we go let una know.

Friday 15 December 2017

BIG BROTHER NAIJA STAR BISOLA,DON TALK SAY,SHE PREFER TO FOLLOW MAN WEY GET PLENTi MONEY THAN TO LOVE AND FOLLOW MAN WEY BE KEREWA CHAMPION


Bisola,shebi you rememba her for 2017 Big Broda Naija?
She don yarn tori pipo say,she prefa to jump like tolotolo follow man wey get bastard money dan to love man wey be champion for bed and man wey fit use kerewa skata her waste for ground.
You don hiaram o.
If u dey love Bisola bifor bicos say u get sharp kerewa skills,she don talk say dat kain love no go work but if u holit like Dangote,she fit die for your mata.

Thursday 14 December 2017

MISS KEDIKE,CHIDINMA,DON YARN TORi PIPO SAY,SHE DEY BLIND FOR SOME MONTHS WEN HER MAMA FIRST BORN HER



Chidinma di miss kedike singa,don tell tori pipo say,she dey always get di mind to help shidren wey get eye ploblem bicos she pass thru di same ploblem.
Akordin to Chidinma,she say dem born am blind and e take some months bifor she start to see.
Di 2010 Mtn project fame winna yarn all dis ones for di joinbodi intaviu wey she and Guardian Life sidon do.

Wednesday 13 December 2017

CENTRAL BANK OF NIGERIA,CBN DON WARN PIPO SAY,ANYBODY WEY ABUSE OUR NAIRA ANYHOW FROM NOW ON GO ENTA JAIL SIX MONTHS AND PAY N50,000 AS FINE


Make e no be like say I no do my work,Di Central Bank of Nigeria CBN,don dey warn pipo say, 6 months jail and N50,000 fine dey wait anybodi wey abuse di Nigeria naira from now on.
One of di tori pesin of di Currency Operation Department Mr Shuaibu Samuel naim yarn dis one for Calabar,Rivers state for di CBN fair wey dem arrange to take coach pipo make dem stop to trit naira anyhow and handle ram wit care.

Tuesday 12 December 2017

ONE MAN KINGSLEY ORIAKU FOR LAGOS,DON SELL HIM PIKIN AND HIM NEIGHBOUR PIKIN TO TAKE GADA MONEY FOR BURIAL OF HIM IN-LAW


Anoda one do appun again o.
Di kain stori wey man dey wake up see for dis kontri,na only God go take kontrol.
For Meiran area for Lagos,Mr Kingsley Oriaku yarn say he sell one of hin shidren Chimamanda.
No be only dat one o,he also konfess say him sell him neighbor pikin just to fit do di burial of him father in law,dat is him wife papa.
He sell him daughta for 190k to orphanage home for Arabia and also sell him neighbour pikin for 120k.
Di spesha anti robbery squad,Ikeja command Lagos na dem parade am for dia station.

Monday 11 December 2017

IMO STATE GOVNOR OKOROCHA DON YAB FEDERA GOVMENT SAY,DEM NO TRY AT ALL AS POVERTY DEY USE NIGERIA PIPO EYE DEY SEE PEPPER


Rochas Okorocha don use yabis to finish Buhari gofment as he say ova 89% of pipo for dis kontri dey suffer.
He yarn dis one thru him Chief press seketri Mr Sam Onwemeodo wen di Nigeria Air Force carry waka visit dem for Govment House for Owerri,Imo state.
I nor undastand dis pipo.
Dis na di same Rochas wey don use Imo state money build statue finish?
He build statue of Liberia president,Ghana and South Africa presidents and many oda statues and di same Rochas dey form holy holy.
Wetin man no go see.

Saturday 9 December 2017

MANY PIPO DON START TO YAB CRISTIANO RONALDO AFTA HE CALL iMSEF Di BEST FOOTBALLER WEY Di WORLD DON EVA SEE


Cr7 don fall him own hand afta he call imsef di best footballer for di world.
Just some days ago,Ronaldo win FIFA world best player di ballon d'or again afta he difit him biggest rival Lionel Messi and Brazilian bobo Neymar.
Dis one no be news again but di news wey dey town right now be say Ronaldo during one joinbodi intaviu wit France magazine afta he kolet him award he say,naim be di Best playa for di world both for pipo wey dey alive or wey don die.
Some pipo agree witam why many don dey yabam say him no try for di yarns.
Akordin to England footballer Joey Barton,he say Ronaldo good but even dis generation,he no even good rish Messi.
No be only Barton,many footballers and fans for di world just dey para foram say na yanga and proudness go killam.

Friday 8 December 2017

DEM DON GIVE AYO BALOGUN a.k.a WIZKID CHIEFTAINCY TITLE FOR UGANDA


Starboy Wizkid year neva still end wit beta beta as dem don carry chieftaincy title give di bobo for Uganda.
No be small razzmatazz don follow di bobo since he enta Uganda dis week.
Di show wey carry Wizkid go

Thursday 7 December 2017

NOLLYWOOD STAR 'MERCY AIGBE' FORMA HUSBAND 'LANRE GENTRY' DON TALK SAY MARRYING OF BAD WIFE DEY KILL PESiN QUICK PASS POVERTY


Lanre Gentry,di forma hosband to nollywood big name Mercy Aigbe don talk say,poverty na bad ting but bad wife worse pass poverty.
Akordin to Lanre,bad wife dey kill fast pass poverty.
Dis one dey clear finish.
E dey veri clear say na Mercy Aigbe dis man dey talk to afta two of dem break up as hosband and wife some months ago.






















Wednesday 6 December 2017

NO BE SMALL INSULT AND YABiS GOVNOR ROCHAS OKOROCHA DON RECEiVE FROM LEFT,RIGHT AND SENTA AFTA HE MAKE HIM BLOOD SISTER KOMISHONA OF HAPPINESS FOR IMO STATE


Notin we no go hear for naija espeshali funny funny stori from Imo state gofnor Rochas Okorocha.
For some time now,di man don dey behave zabuzabu as he build statu of south Africa, Ghana and Liberia presidents for Imo state.
Akordin to di tori wey enta town dem say,each of di statu cost N500 million to do and mean why, alarm dey tia pipo for di state.
No work,no industri, no food.
Now since yestaday,Rochas don resiv over one billion insults and yabis from pipo.
Even Uncle Jona padi dat year Ren Omokri yarn say,Rochas na nonsense and yeye pesin afta he make him sista Mrs Ogechi Ololo 'Komishona of Happiness' for Imo state.
Dis na di first time wey dis kain tin don appun for dis world.
Dis one weak me pass dodo.
If dis one no weak you naim be say notin fit weak you for dis world again.

Tuesday 5 December 2017

COMEDIAN 'I GO DIE' DON YAB ATIKU WEY DEY TRY TO BE PRESIDENT FOR 2019 SAY HE DEY AMONG PIPO WEY GIVE NIGERIA BAD NAME SO DiAFOR,MAKE PIPO NO VOTE FORAM


Big name komedian 'I go dye' don finish Atiku Abubakar for ground say him dey among di pipo wey spoil Nigeria for ground.
I go dye yarn all dis ones on top twita say make Atiku go sidon one corner wit him plans to be president of Naija for 2019.
He also yarn say make he allow youths rule Nigeria bicos nothing remain wey he won tell us afta he be Gofnor of Adamawa and also spend 8 years as vice presido of Naija.

Monday 4 December 2017

UTI,Di BIG BROTHER AFRICA WINNER DON TALK SAY,HIM NO GET TIME TO WASTE FOR NOLLYWOOD AGAIN BICOS Di MONEY WEY DEM DEY PAY WEN HE ACT FILM TOO DEY SMALL


Nwachukwu Uti don tell tori pipo say him no get time for nollywood film too much again bicos di money wey dem dey pay no risham to take dey do anything.
Akordin to Uti he say him no fit form die wen he be say na money he find go Lagos.
He say bifor him go show face for any film now di film must make brain.
Di bobo also yarn say na to dey MC groove and do show for teli dey givam beta money no be nollywood.

Sunday 3 December 2017

ATIKU DON TALK SAY,AMERICA BAN BUHARI FOR 15 YEARS MAKE HE NO ENTA DiA COUNTRY BICOS HE DEY SUPPORT SHARIA BUT FEMI ADESHINA,BUHARI TORi MAN SAY,NA LIE


To bikom president you must turn your friend to your enimi.
As Atiku Abubakar don dey eye President Buhari position for 2019,he don dey sing for us.
He don clear tori man Dele Momodu say,America ban Buhari make he no enta dia kontri bicos say he dey support sharia law.
Dat yarns no go down well wit Buhari and him pipo as him tori man Femi Adeshina don yarn say,na big lie Atiku dey lie.
Politishans we hail una.

Saturday 2 December 2017

79 YEAR OLD BILL OXLEY DON CONFESS FROM HIM SICK BED SAY,NAiM KILL BOB MARLEY AND NA AMERICA SENDAM GO CHOOK MARLEY WIT NAIL WEY DEM PUT CANCER POISON


Bill Oxley wey get just few weeks to live,don konfess for him sick bed for Mercy Hospital, Maine say naim give Bob Marley Converse Canvass wey dem hide nail wey dem poison.
And as Marley shook leg for di canvass,di nail just shook him leg and from dia,di cancer poison pass dia enta him bodi.
Akordin to Bill Oxley na Central Intelligence Agency CIA na dem sendam.
He say America use am kill 17 pipo and out of all of dem Bob Marley own naim pain am pass.
He say America feel say Bob Marley dey spoil market for dem wit him miuzik naim make dem take him life.
Bob Marletvlater die from cancer May 11,1981.

Friday 1 December 2017

TODAY NA WORLD AIDS DAY,WE DEY BEG EVRiBODi MAKE WE TRY DEY KIAFU BICOS AIDS NO BE MALARIA,AIDS NA Di MOST WICKED SICKNESS FOR Di WORLD


As today na WORLD AIDS DAY, we for Ogakpatakpata dey beg all our readers and evribodi for di world make dem dey kiafu bicos dis sickness neva stil get cure.
To avoid AIDS,you need to face only ya wife,only ya hosband,only one boyfriend,only one gehfriend.
Kpatakpata if konji hold you,bad as e bad,use condom or no do at all.
Na stoborn fly dey follow dead bodi enta grave.
God bless you.
Una good morning.

Thursday 30 November 2017

FOR LONDON,DAVIDO AND WIZKID DON MAKE US PROUD AGAIN AS DAVIDO WIN BEST AFRICA MUSICIAN AND WIZKID WIN Di BEST INTERNATIONAL MUSICIAN FOR 'MOBO AWARDS'


Davido and Wizkid don kontiniu to make naija proud even though say dem be cat and rat.
For di MOBO Awards wey appun for London yestaday,Davido win di best African artiste why Wizkid difit pipo like Drake,Jay Z and Cardi B to win di best International artiste.
We no say dis two guys don turn enimis but we need selibrate dem as dem don kontiniu to put dis kontri name for map.

Wednesday 29 November 2017

COMEDIAN AY,DON TELL GIRLS WEY DiA BRAIN EMPTi SAY DEM NEED BETA BRAIN TO SEE CORRECT HUSBAND,NO BE TO DEY PACK MAKE-UP FULL FACE


Comedian Ay don yab all those girls wey dey carry make-up full face from morning till night just to look fine.
He say,if dem no know book naim be say to see beta man marry na ploblem.
No amount of make-up and aso-ebi wey you buy fit give you hosband to marry.
Akordin to Ay,if your brain empti koret men go dey use and dump you.

Tuesday 28 November 2017

PRESIDENT BUHARI DON GIVE ORDER TO ALL GOVNORS,MAKE DEM MAKE SURE SAY DEM PAY WORKERS WEY DEM STILL OWE SALARIES BIFOR CHRISTMAS


E be like say dis krismas go swit o as Uncle Buhari don tell all Gofnors say make dem no owe any worker salary bifor krismas.
If e get salary wey dem neva pay,Buhari don tell dem say make dem pay bifor di krismas selibrayshon.
Nice one,only say di money nor go still rish dem use as price of food stuff and evritin don double since Buhari enta pawa.

Monday 27 November 2017

CHECK OUT NIGERIA NEW JERSEY WEY DEM GO WEAR FOR Di FIFA WORLD CUP,RUSSIA 2018


Just like as e dey appun bifor evri World Cup wey we dey go,Nike don reliz new jersey wey di Super Eagles of Nigeria go wear for Russia 2018.
Few pipo wey I talk to for street gree say,dis one fine skata and e plasta finish.
Me sef agree.
How u siam?

I BE BOXER BIFOR BUT I STOP AFTA ONE DELTA BOY USE BLOW SCATTER MY FACE LIKE SAY KATAPILLAR JAM ME - MR IBU


Funny actor John Okafor a.k.a Mr Ibu,don yarn tori pipo say,if no be di film industri wey snatcham,he for kontiniu him work as a boxer.
Akordin to Ibu,him stop boxing di day wey one Delta boy use blow draw map for him face.
He say dem go one boxing kompetishon for Delta but dem niali killam for ring.
Di nollywood actor say,wen he rish house and see him sef for mirror,naim he tell imsef say,boxing bye bye.
Mr Ibu say di guy na idiot and he niali blind one of him eye wit blow and e take am sometime bifor he start to see wit di eye again.

Sunday 26 November 2017

GOODLUCK JONATHAN DON TELL ATIKU ABUBAKAR SAY,IF HE WAN BE NAIJA PRESIDENT FROM PDP,FIRST OF ALL,HE MUST GO BEG OBASANJO


Goodluck Jonathan don advise Atiku Abubakar make he go apologize to Ogakpatakpata of Naija politiks Olusegun Obasanjo,if he won be president of Naija for 2019.
Atiku naim be Obasanjo assistant,Vice President and nomba two man wen he be president from 1999 to 2007 but two of dem later turn cat and rat bifor dem comot for Aso Rock.
Now forma president Goodluck don advise Atiku say,if he want make PDP choozam as dia nomba one man for 2019 election,he must go beg Obasanjo to forgivam onto say,Baba still dey vex foram.
Akordin to Goodluck Obasanjo stil get say for who go be president.
Na wa for our leaders o.
No be we go vote to choose who we want again to be president?
Na only Obasanjo?
Ok o,we dey watch.

IKEBE DANCE COMPETITION,ENUGU 2017 FOR PHYNO SHOW (VIDEO)


Duncan Mighty put Enugu girls ikebe for high jump during di Phyno Fest groove.
Wen di bobo come out to sing Na so he do Ikebe konpetishon for di girls to choose di Enugu best Ikebe,2017.
All kind of yansh naim do di groove.
Slim,fat,stone yansh,soft and even water water yansh come stage for di konpetishon.
Watch who win Enugu Ikebe,2017 for hia...


Saturday 25 November 2017

CONFAM! DAVIDO DEY BUY MOST OF HIS SONGS AS 'TENI' SAY NA SHE WRITE DAVIDO NEW SONG 'LIKE DAT'


For abroad na norma tin for pesin to write miuzik and hawk dey sell.
Pesin like Davido nor send anybodi message as he don bring yankee style enta naija on top say he dey always buy most of him hit tracks from writas hand.
We bin hear say na General Pype naim sell 'Gbagbe Oshi' for Davido and Peruzzi wet just join him gang naim write 'Fall and Fia' foram.
Now, one of di new star 'Teni' don tell tori pipo say na she write 'Like dat' for Davido.
Na Davido new miuzik wey just come out yestaday.
Nice one Teni,all na bizness.
Make I enta street go find song buy.

Friday 24 November 2017

AFTA NEWS ENTA TOWN SAY TIWA SAVAGE DON DEY PREGNANT AGAIN,SHE DON COME OUT SAY DAT ONE NA BIG LIE FROM AMEBOR PIPO


Mama Jamjam and Tee Billz wife Tiwa Savage, don deny di rumors wey dey evriwia say she don carry belle of her second pikin.
She say na lie say she no dey pregnant.
She say if Tee Billz giam water drink she go let evribodi know.
If you dey follow up,last week Tiwa say she no mind to carry belle for 2018.

Thursday 23 November 2017

AFTA APC GOVNORS SAY NA PRESIDENT BUHARI DEM GO VOTE FOR 2019 ELECTION, BOLA TINUBU DON TALK SAY DAT ONE NO GO WORK..2019 NA FOR ANYBODY NO BE ONLY BUHARI


National leader of APC Bola Ahmed Tinubu don yarn tori pipo say anybodi wey get dream to bikom president of Nigeria, get di right to come out for 2019.
APC gofnors for naija bin talk few weeks ago say na President Buhari dem won soport for 2019 again but Tinubu no agree wit dem.
Akordin to Tinubu,he say even Buhari biliv in democracy.
He biliv say evribodi get right to come out for 2019.
He yarn all dis one wen he carry waka go Ondo state for one joinbodi meeting wit di govnor of di state Mr Rotimi Akeredolu on top di Afenifere meeting.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...