MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 30 November 2014

IBORI DAUGHTER WIN HOUSE OF ASSEMBLY PRIMARIES ELECTIONS.


Di Odidigboigbo of Africa,James Ibori,di forma Govnor of Delta State don show say him grip on Delta politiks still dey strong gidigba as im daughter,Miss Erhiatake Ibori don win Ethiope West constituency for PDP house of assembly primaries for di state.
We still dey try to find out di reason why liver fail di rest guys wey sopose challenge her as nobodi contest against her for di election.
James Onanefe Ibori wey rule Delta State from 1999 to 2007, dey serve for london jail as dem find am guilty of tiffing money.
Check out di list of oda winners for PDP primaries for di house of assembly elections for Delta State for bottom hia:

Oshimili south-Peter Onwusanya
Warri south constituency I-Godwin Abigor
Warri south constituency II-Dennis Omovie
Warri north-Michael Diden
Ndokwa west-Friday Osanebi
Bomadi-Pius Labo
Burutu south-Kennedy Daubry
Ika south-Isaac Ulebor
Isoko south-Mrs Oreze Esievo
Uvwie-Efe Ofobruku
Aniocha north-Uzomah Idabor
Udu-Moses Odibo

CHAi! SEE WETIN SOUTH AFRICA ACTRESS, TIWA SAVAGE, SEYI SHAY WEAR GO CHANNEL O AWARDS

Na crime to born girl pikin again?
Many celibritis dey make pipo feel say na crime nowadays to born girl pikin but di truth be say no be crime.
Imagine di dress wey Pam Andrews wear,na lace material naim cover her nipples and website if not,na evritin she don show di world be dat.
Di kain dress wey South Africa actress, Pam Andrews wear go di 2014 channel O awards and even di one wey our own Tiwa Savage wear perform on top stage for di awards, fear go catch pesin and we no get choice dan to tell oursef di truth say, we get a lot of work to do about our gehs pikin.

SEYI SHAY FOR CHANNEL O AWARD

EMMA NYRA FOR CHANEL O AWARD


Saturday 29 November 2014

BUSTA RHYMES FALL FROM STAGE AND BREAK HEAD

America rapper,Busta Rhymes don fall yakata from stage and brake head wen he dey on stage dey soport one of him new artiste wey he song dey reign for America right now.
O.t Genasis di name of di new artiste wey Busta Rhymes compini,conglomerate records sign,dey perform for one concert for New York wen im oga, Busta, joinam dey rap all di rapping.
Busta Rhymes wey di real kontri wey hin come from na Jamaica, hold one big bottle of shack wey resemble hennesee and one big cigar for hand dey nod head follow di jam.
Bifor u go say,"bingo is a noun", di guy don fall from stage and brake im head and na so blood kon dey rush out.
Even wit di fall sef and blood wey dey rush from di head,di big havana cigar no gree comot for im mouth.
Busta Rhymes later yarn on top twitter say him salute all di calls wey im get from family and friends just to know weda he dey ok.
Busta Rhymes assure hin fans dem say im bodi don dey kamkpe and he kon also salute O.T Genasis for making dat kain powerful song wey nearly make am die for notin.
Check all di picture of how im take  brake head for di show for bottom hia:

BUSTA RHYMES and O.T GENESIS

Friday 28 November 2014

SHOCKER! FEMI KUTI SAY NO BE HIM GET TWO OF HIM CHILDREN


Afro beat prince, Femi Kuti, di pikin of di Afrobeat king,Fela Anikulapo Kuti, don get di biggest shock for him life as DNA test don show say two of im children no be own.
Out of di 5 children, Made,Afolabi, Dupe, Tosin and Ayomide wey di world don biliv say na Femi Kuti blood, Dupe and Tosin no be him children after all.
Femi wey dem don pick three times for Grammy award but neva still win anyone, say,dis na veri sirios mata bicos wen he do DNA test for him children, he shock to find out say Dupe and Tosin no be im pikin.
He say dis world na funny place bicos im no biliv say somebodi wit her korokoro eyes go fit give you wetin nor be your own.
Bicos of dis tin wey appun so,Femi don return di children dem to dia mama.
Funke, Femi Kuti forma wife naim born im fest pikin and fest son, Made.dem say Femi love dat one pass di way wey dog take love bone.
MAMA AND PIKIN
FUNKE AND MADE( 100% FEMI KUTI PIKIN)
Bisi Ajala nai born Ayomide and one of di pikin wey di DNA result catch.
We neva hear anytin about di third woman name and how di mata take involve am.
Di new album of Femi Kuti di Afrobeat king afta him papa Fela die, don ready and dem go release am veri soon.
But no mata how di album sweet reach, dis kain DNA test wahala, go give Femi Kuti some sleepless night.

Thursday 27 November 2014

ARM ROBBER SAY NA ONLY ON SUNDAY HIM DEY THIEF

If you neva hear dat proverb wey say ,"evriday for di tiff, one day for di owner", naim be say you are on a long ting.
No be small comedy for Lagos State police command as pipo burst laff wen one bobo, Kelechi Ikechi, confess say na only on Sundays him dey tiff.
Di same Sundays wey God create as rest day.
Luck run against am for Ejigbo wen he go rob for one Peter Ibeh house for im area.
Bifor dat day,Peter Ibeh don dey complain to pipo say im don notice say dem dey break enta im house to tiff evri sunday.
So one Sunday he kon set trap for di tiff as he arrange somebodi to pam for corner wen he dey go church.
Imidiately Kelechi brake enta di house, naim di guy wey pech for corner lock di door against am from outside.
Di guy raise alarm imidiately and neighbours kon gada catch di guy and hand am over straight to police.
Kelechi Ikechi also yarn say why he dey tiff on Sunday days na bicos pipo dey spend plenti hours for church and im start to dey tiff wen he loose im factory job.

FEDERAL GOVERNMENT DEY PLAN TO BUY SLOW COOKER AND STOVES FOR N9.2BN FOR WOMEN

STOVE

WONDER BAG
For dose men wey no dey fit bear hungry especially wen dia wife food dey fire and e dey take time to don,una sorry o,bicos, una go learn how to bear hungry like never bifor as federal government don conclude plans to buy one slow cooking machine for our rural women free of charge.
Dis slow cooker wey dem dey call"wonder bag", na cooker wey no dey use electricity and na South Africa company,Sarah Collins naim make am.
Na 9.2 billion naira government won take buy dis wonder bags and cooking stoves and na di Federal executive council( FEC), naim approve am on Wednesday.
Di pipo wey yarn FEC dis mata, na di supervising minister of information, Dr. Nurudeen Mohammed and im colleagues dem for ministry of environment and federal capital territory, Mrs.Lawrecia Mallam and Bala Mohammed.
Some pipo dey argue now say, wen oda kontri dey talk about cooking gas, Nigeria still dey dream about cooking stove for 2014.
For inside di meeting, di council also approve 60billion naira contract to one local compini, Kakatar CE Limited to take buy engineering equipments for Kyami district, Zone C for Abuja.
Di pesin wey chairman dis meeting na, Vice President,Namadi Sambo and for inside di meeting, dem expect Messrs Integra Renewable energy Services limited to deliver dis stoves in 12 weeks.

Wednesday 26 November 2014

DIS NA MESSI WEEK BUT NA RONALDO YEAR BE DIS?


I wonda if di debate of who be di beta playa bitwin Messi and Ronaldo go eva stop since dis two footballers don swear say na so so records dem go dey brake for dia life.
Messi carry record breaking dis week for im head like lakpalakpa( ringworm) as he bicom di highest goalscorer for Spain la liga history on sunday.
As if dat one neva reach, just last nite Messi brake Raul record to bicom di highest goalscorer wit 74 goals for di UEFA champions league wit di 3 goals wey him skor against Apoel Nicosia of Cyprus.
Ronaldo on di oda hand, brake di highest goalscorer record for a single champions league season wen he skor 17 goals to win di Champions league wit Real Madrid for may.
He also break Isindro Langara 79 years old record for di highest goals scored for a La liga first 10 games.
Ronaldo score 17 goals for di first 10 matches dis season and naim be di world best player for 2013 and many football lovas dey feel say naim go still winam for 2014 bicos naim best ever year be dis.
Di ting right now be say dis two players, na fire be di oda name for dem bicos of di football wey carry fire wey dem dey play.
If I say make i bigin talk about di records wey dem don break, day go break you here just to read am finish.
But bitwin you and me, who you tink say get dis year?
Na Ronaldo don finish work pass dis year? or na Messi wey break two strong records dis week?

FROM PARTY RIDER TO HORSE RIDER: 9ICE SHOCK EVRIBODI AS HE RIDE HORSE GO SUBMIT NOMINATION FORM

He bin dey call imsef "Party rider" but now you fit also call am "Horse rider".
Abolore Akande, A.k.a. 9ice, don add style join im dream to bicom memba of di house of rep,Abuja.
Na small tin remain dem for say na cowboy style 9ice take go somit im form for APC party secretariat for yemetu, ibadan like say na hat he wear.
Di Gongo Aso hitmaker,9ice,add style join im waka to di secretariat as na horse im ride take go somit im nomination form to represent Ogbomosho north and south federal constituency for di 2015 general election for naija.
9ice dey hope to follow di footstep of di fest entatayna wey win election for Nigeria, Tony "one week" Muonagor wey be memba of di Anambra State house of Assembly.
Tony one week go put im popularity to test as fellow nollywood star and ex- gulder ultimate search host, Bob Manuel Udokwu don conclude plans to challenge am for di next election for Anambra.

Tuesday 25 November 2014

TWO YEARS AFTER DIA MAMA DIE,P SQUARE PAPA DON DIE


Dis na veri sad news again as P Square don turn orphan.
Dia papa don die two years afta dia mama die.
He die yestaday afta he undago successful knee operation and wen he dey go hospital for follow up naim he collapse and die.
No be beta year at all for di P Squares as na small tin remain kwanta nearly make Peter and Paul break up bifor dem later settle demsef.
May his soul rest in peace.



Monday 24 November 2014

NICKI MINAJ DON ENDORSE NIGERIA RAPPER, CHILLY B


Numba one female hip hop star, Nicki Minaj, don notice and endorse one of her biggest Nigerian rapper fan, Chilly B for twitter.
Chilly B wey get wicked CocaCola bottle shape,release her fest jam,"wine am go down" and since den she never look back like Lot wife for bible.
She don dey sing for sometime now and na she be di musician wey open di stage for Africa biggest carnival, di Calabar festival.
Just dis week for twitter,di queen of di south south, Chilly B, get beta praise from Nicki Minaj wey she no go eva forget for her life.
Nicki write for her time line say Chilly B dey big and bold and just like am, she get veri sexy, biutiful hot bodi.
Congratulabia Chilly B, you fit chill now wit one bottle of champagne to celebrate yor fest worldwide recognition.
See wetin Nicki Minaj talk for bottom hia:


Saturday 22 November 2014

HARRY SONG DON HAMMER HUMMER



Anybodi wey tink say na only millitant life ijaw pipo sabi, make he reset im mind bicos anoda ijaw pikin from Ogbe-ijaw,Five star music representa, Harrysong,don hammer one tear rubber hummer to take oppress di devil.
Di brand new 2009 Hummer H2 SUV wey worth 20million naira, na anoda way to count im blessings one by one.
Since he join Five star music from Question mark, na so so beta beta tins don dey appun for im life.
Just di oda day, he take plenti moni take do pillow for bed.
Di music wey blow Harrysong na di hailings song for di late Nelson Mandela and all di money wey im oda song, Beta pikin don givam,reach to take buy 'Suya' for one full local government and im pocket no go dry akordin to one guy wey dey stay dia area.

BREAKING NEWS!!! CHAZ B IS DEAD!


Nigeria don loose one of her best radio presenter, Charles Bruce ( Chaz B) early dis morning to di sickness wey him dey battle with for some years now.
He survive kidney transplant over two years ago but sickness no still allow am rest as he dey shuttle abroad and naija for over two years now to kip up wit im bizness.
Chaz B wey dey handle di veri popular programme "Sharing life issues" on Inspiration Fm, Lagos, leave di station last year and start his own independent show with di same sharing life issues as name,for Rhythm Fm.
As my forma boss,to avoid rumors, im wife confamam on phone say her husband die early dis morning.
We never know how him children for abroad go take di news.
He wife and daughter also dey Nigeria witam bifor he die.
May his soul rest in perfect peace.

179 YEARS WORLD OLDEST MAN,SAY, HE DON LOOSE HOPE TO DIE


E get how poverty or sickness go cramp some pipo reach, dem go tell you say, "dem don loose hope to live", but for di case of Mahashta Mùrasi di oldest man for di world, him say, "he don loose hope to die" bicos of old age.
Di world oldest man,179 years old,Mahashta Mùrasi from India akordin to di Guiness World Records, don yarn say "death don forget about am ".
Akordin to Mahashta Mùrasi, he say dem born am for January 6th,1835 for Bangalore, India and he work until he retire for 122 years for 1957,di year wey dem born my mama( no pun intended).
He say im don live for life sotey,him don loose hope to die.
He also yarn say im no undastand wetin dey appun again bicos him grandchildren don die many years ago and e be like say death don forget about am.

Friday 21 November 2014

MY MAMA WANT TO FINISH ME WITH JUJU AND OTUMAKPOR-ADEBAYOR


Tori pass tori and dis tori, na one tori wey go make u wonda for tori.
Di tori wey dey reach our backyard since morning be say,Tottenham hotspur and Togo attacker Emmanuel Seyi Adebayor, don tell one Ghana radio station say,why he abandon im mama na bicos she dey do juju to winshy im career.
Adebayor say, "why I no go mind my bizness and dey on my own jejeje, wen e be say na my own mama dey tell evribodi say my hussle no go pay".
He say make im maleh stop to do juju against am if dem want make dem settle dia quarel.
Akordin to wetin im sister,Mageret tell Peace Fm for Accra, Ghana , she say Adebayor don abandon dia momsie and drive dem comot from im hause and na padlock and polythene bag di mama dey sell now for Togo and Ghana border.
Maggie also say if no be dia junior broda for Germany, Kola Adebayor wey rent house for dem to stay, maybe na undabridge dem for dey sleep now.
Di Togo captain deny am and say na only im mama use her leg waka comot for di hause.
Di forma Africa footballer of di year also yarn say,im family no value all wetin he dey do for dem since including di 35,000 tausand dollars car wey im buy for di junior sista,Lucia and even di hause wey im build for dem for East legon.
He say dia own na to dey spoil im name and do juju do kill im destiny.
Dis season, Adebayor no dey form at all as he don score only one goal out of ten matches wey he don play for spurs.
Di Adebayors, na beg we dey, make una try settle unasef.

Thursday 20 November 2014

MRS MUGABE PLANNING TO SUCCEED MR MUGABE


PRESIDENT ROBERT MUGABE AND MRS MUGABE
Jaguda get oga.
Zimbabwe president, 90 years old Robert Mugabe, di numba one oga jaguda for Zimbabwe, wey don get kwanta wit almost all America president and wey don rule Zimbabwe for almost 40 years, don dey hatch anoda hidden agenda, as  he don almost conclude plans make him wife,Grace Mugabe succeed am if he decide to step down akordin to reports.
Who no know go feel say na him wife Grace Mugabe be vice president as she don almost won take over di position of di vice president to her husband, Mrs Joice Mujuru .
LEAVE ME ALONE! VICE PRESIDENT, JOICE MUJURU DEY TELL MRS MUGABE

She tell Mujuru to resign bicos akordin to her, she no like di Mugabe's family.
49 years old Mrs Mugabe,also dey accuse Vice President, Joice Mujuru say she dey plan to kill her husband make she bicom Zimbabwe presido.
Wit di rally dem wey she dey hold all ova Zimbabwe now and di kain tins wey she dey yarn di crowd, u go know say Grace Mugabe don make up her mind to take over di role of her husband and her husband go take over di role of di first lady.
For one of di rally, she yarn di pipo say,time don reach for her to show di pipo wetin she be.she say she be no won enta politiks bifor but since pipo dey force am, she don ready to serve dem.
She say,"some say i won be president.Why not?no be Zimbabwe I come from too?
Di oposition to her husband no like her behavior as dem get one guy name foram, "Dis Grace".
Dem say na she dey force her husband not to step down bicos of she won kontiniu her large life of travelling abroad to dey shop for expensive jewelleries, gold, diamond and oda shakara tins.

I NO DEY CHARGE FOR COLLABOS-ICE PRINCE ZAMANI

Ice Prince don join di list of few artiste wey don yarn say, dem no dey charge any money bifor dem go do collabo wit oda musicians unlike Wizkid wey report confam some few weeks ago say,he charge Saeon N1.5milla to feature for her song "Boogie down".
Wizkid even yarn say if craze enta him head, he fit charge 10 million naira for collabo.
ABOKI, ICE PRINCE
But for one sharp tongue twisting to wetin Wizzy yarn, Chocolate City superstar rapper, Ice Prince Zamani, don yarn say,him no dey collect shishi to sing for pesin song but he say sha,di pesin music must sweet foram to get interest.
He yarn all dis one wen he dey answer questions wey radio and tv celebriti,Olisa Adibua dey askam for im show, The Truth.
Ice Prince say although evribodi get dia own laws on how dem dey run dia show but for him,he no dey charge any penny to do collabo.
He even say anybodi wey doubtam, make he ask di pipo wey im don feature for and dem go yarn dem di same tin.

Wednesday 19 November 2014

3RD WORST HIT EBOLA COUNTRY DON QUALIFY FOR AFRICA CUP OF NATIONS

GUINEA FOOTBALL TEAM
I hope say dis one no go be a case of yanga dey sleep trouble go wake am as Equatorial Guinea, di new host of di Africa Cup of Nations get a lot to do afta dem agree to replace Morocco wey withdraw from hosting di tournament for fear of Ebola spread.
One of di kontri wey Ebola case for plenti pass, Guinea, don qualify for di tournament wey go take place for Equatorial Guinea for January 2015.
Infact dis latest Ebola wahala wey later spread enta Sierra Leone, Liberia, then Nigeria, na Guinea e for start last Decemba.
As at Novemba 11, na 1,919 Ebola case naim dem don report for Guinea out of wich, 1,166 pipo don die.

FOOTBALL FANS
Di tori now be say, how Equatorial Guinea go take fight dis war wey dem buy wit dia own hand as tausands of fans go travel enta di kontri wen di nations cup stat.
Since di quickest way to catch dis Ebola na thru handshake and sweat from bodi contact,Equitorial Guinea get a veri worryment work to do.
I wish dem and Africa di veri best of luck.

BYE BYE STEPHEN KESHI

Afta failing to qualify di defending champions, Super Eagles for di Equatorial Guinea 2015 nations cup with dis 2-2 draw with South Africa,i dey sure say dis na Keshi last match for Eagles.
Amaju pinnick over to you.

BETWEEN MAHEEDA,KIM KARDASHIAN, HUDDAH MONROE,...WETIN DIS WORLD DEY TURN TO? 18+ ONLY

Wetin dis world dey turn to?
For sometime now,many celebrities like Nicki Minaj, Kim Kardashian, Rihanna, Huddah Monroe and Vera Sidika from Kenya and even our own Maheeda,dey see am as normal ting to dey show dia kpekus for di world to dey see.
One tin come my mind and i dey ask, bifor dis pipo dey show dia nakedness and dia website, wey suppose to dey veri private, who dey give dem di go ahead?
Na dia husband/boyfriend or dem dey wake up and decide to craze on dia own?
Dia papa and mama no dey vex for dem at all?




Monday 17 November 2014

THE WORLD GO RUN OUT OF COCOA BY 2020




For those of una wey love chocolate and love to dey drink light or thick tea, dis news no go sweet una for ear at all bicos di world go likely run out of cocoa by 2020 akordin to di report wey dey reach our table.
Di biggest chocolate company for di world, Barry Callebaut, wey base for Switzerland,don add dia voice join di talk of say, di world fit dey short of cocoa by 2020.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...