MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 11 November 2014

I LAUGH WHEN PEOPLE SAY I'M LAZY-EMMANUEL ADEBAYOR


Forma Africa footballer of di year, Emmanuel Adebayor of Tottenham Hotspur, don yarn say he no undastand why pipo dey say him na lazy playa and he no sopose dey first team.
He say if he make mistake and if he miss some chances during match, e no mean say im na lazy player.
Di Nigerian born Togolese, say anytime wen im hear say im na lazy player,him go just laff.
He say although all dose kain talk no dey pain am for bodi again bicos for 13 years as a professiona, him don dey use to di curses and praises.


Adebayor say even if tins no dey go as e plan sometimes for field, im still dey do im best and im still dey do him normal running around for field, him still dey do di jumping, di heading and play im futbol.
He say he no be lazy player but a winner bicos anytime wey im enta field he dey make sure im play im best for di team.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...