MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 13 November 2014

LEBRON JAMES SAY NO AMERICAN FOOTBALL IS ALLOWED IN HIS HOUSE


LeBron James, di badoo basketball player and one of di owners of Liverpool futbol club,don yarn ESPN say di rizin why he no dey allow im children play America football be say di sport too strong and he too dey risky.

King James wey don win di NBA two times wit Miami Heat bifor he go back to im forma club and home town club, Cleeveland Cavaliers, say im no dey allow America futbol for im house except di normal futbol wey dem Messi and Ronaldo dey play, baseball and also basketball.
Wetin make James imsef stop football wen im stil dey Saint Vincent-Saint Mary high school for Akron, Ohio in dose days, na bicos he brake he hand for training.
LeBron James, one of di best basketball player of all time,say,im 7 year old son, Bryce Maximus, dey play futbol and oda sports why di sinior boy,LeBron Jr.  don focus on basketball.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...