MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 17 November 2014

THE WORLD GO RUN OUT OF COCOA BY 2020




For those of una wey love chocolate and love to dey drink light or thick tea, dis news no go sweet una for ear at all bicos di world go likely run out of cocoa by 2020 akordin to di report wey dey reach our table.
Di biggest chocolate company for di world, Barry Callebaut, wey base for Switzerland,don add dia voice join di talk of say, di world fit dey short of cocoa by 2020.



Dem say dem dey bow for di way wey Asia pipo take dey consume chocolate, even cocoa butter sef.
Nor be only Asia wahala dey come from concerning cocoa as Brazil wey be one of di world biggest cocoa manufacturers bifor,don dey rely on imported cocoa to take plasta dia mata for yonder.

To add salt to injuri, di Ebola wahala no hep mata at all as price of cocoa dey go up anyhow even though West Africa kontris like Ghana and Cort d'voire na two major cocoa manufacturers for di world.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...