MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 2 November 2014

BOB MANUEL UDOKWU AND TONY ONE WEEK IN A FIGHT FOR ANAMBRA STATE HOUSE OF ASSEMBLY SEAT


Dem say if two elephants fight, na di grass dey sufferam.
Nollywood friends don enta agreement to test dia popularity for Anambra state house of assembly for di 2015 general elections.

Honourable Tony Muonagor aka Tony one week, naim be di current pesin wey dey di seat and he dey represent Idemili North Constituency, di same constituency wey Bob Manuel come from.
Tony one week dey APC why Bob Manuel go contest unda APGA.
Bob Manuel na Special adviser to di Govnor on nollywood and entertainment matas presently but im say he won serve him pipo and he want to join to transform and develop Anambra and Idemili North.
Dis one no be film trick and dis one no be home vidio.
We go dey watch and see who go win di battle bicos dis na one of di election wey pipo go follow up wellwell bicos of di way wey di mata be.
Tony one week or Bob Manuel, whoever win, na still victory for nollywood and di entatainment industry.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...