MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 6 November 2014

WOMEN NA BETTER POLITICIANS THAN MEN-OBASANJO


Forma khaki and civilian president, Chief Olushegun Obasanjo, don say forget say im na man, di truth be say women beta pass men wen it come to politics and rulership.
He say,if woman say no shakement I dey wit you, naim be say true true she dey wit you but if man say he dey wit you and you catcham for anoda meeting, he go say no vex na politics, all join.
He say if politiks na all about promise and fail, naim be say water don pass garri and dat one don turn anoda tin be dat. He say politicians weda man or woman sopose to respect demsef and dey veri truthful to di pipo.he say to build beta kontri, na both man and woman di mata involve.

Obj yarn all dis one on wednesday wen di national executives and membas of Nigeria Association of Women Journalist, NAWOJ, carry waka go see am for im Hilltop haus for Abeokuta Ogun State.
Baba iyabo also yarn say women don suffa abusement,religiously and culturally and dis one don deprive dem di oportuniti to show demsef say dem be women of timba and caliba and also show di world wetin dem can does for politiks.
Obj also tell dem say, one of di best journalist wey ever work witam na woman and na di late Mrs Oluremi Oyo.
Di national president of NAWOJ, Mrs Ifeyinwa Omowole, say why dem go see Obj na bicos of im strong bilif of one naija.
Omowole say all di bad bad nonsense wey dey appun for naija of recent, na bicos say di diferent tribes no dey united.
Dem also let di forma khaki presido know of dia plans to build 500 housing units for all di states for naija.
Bifor di women journalist carry waka comot for Abeokuta, dem present di "Father of The Nation Award" give Obasanjo.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...