MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 4 November 2014

BREAKING NEWS! BOKO HARAM TAKE OVER ASHAKA CEMENT FACTORY


Like play like play, di terror group, Boko Haram don dey capture some towns and villages for north.
Di tori wey dey reach our table now now now be say, dem don take ova Ashaka cement factory for Gombe state.
Days afta Dangote cement and some oda cement compinis reduce bag of cement to one thousand naira,Boko Haram wit dis attack,don make statement for di industry.
If u check and balance am, dis one fit carry cement price back to 2K plus again bicos e go surely affect production.

Afta Boko kill 5 pipo including one Sheikh ( leader), naim dem buss enta di cement factory for Gombe state and soranda di whole  compound.
Akordin to workers for Ashaka cement factory, di Boko Haram rambos enta dia yard wit heavy heavy weapons and dem begin shoot anyhow and shoot anytin at sight including di workers afta di main guard dem run for dia dear lives.
As at di time wey we take write dis tori, we neva get any report say anybodi die for di take ova attack.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...