MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 4 November 2014

MAJEK FASHEK TO JOIN POLITICS FOR 2015


Day no dey brake again witout u no hia say one naija entertainer won enta politics.
Di latest pesin to announce im movement into politics na di send down di rain singa, Majek Fashek.
His ''Royal Freshness'', di guy name wey we dey call am in dose days bicos di guy fresh finish and e skin dey shine like ororo dat year but if u see am now, Majek don dry wellwell. Some say na igBo smoking naim do am like dat why some say na spiritual attack but woteva di case be,dat one na tori for anoda day so dat we go talk about im new found love, "Politics".

HIS ROYAL FRESHNESS..back then
One of di best miuzishan to come out of Africa, Majek yarn say,come sun come rain, naim and politiks next year and he say di rizin why he dey enta, na to join PDP and soport President Goodluck Azikiwe Jonathan and also to soport di govnor.wich of di govnor,na dat one naim we no kon know bicos im state, Edo State,na Adams Oshiomole be govnor and na APC he dey and Majek say he won join PDP.Although sha, im papa na yoruba.
Him say from im experience for America mata, im no like to be President bicos di chair and di wahala wey dey full president head big passam and naim make he own na to soport di president.
Majek say to be President no be im calling.he say im na miuzishan wey dey sing about change and wetin im go do wit di power wey God givam,na to soport di govment  so dat dem go fit rememba di poor pipo.
He say like Obama,so far so good,Goodluck deserve second term to try his best.
He say anywich way, if na Jonathan or somebodi else, no shakement.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...