MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 16 November 2014

NA WA o! HOMOSEXUAL ARRESTED IN IKOTUN WITH 14 YEAR OLD BOY

One Gideon Harrison and one 14 years old boy( no name),go still spend sometime for prison for homosexual activities until dem work on dia bail conditions.
E be like say di 14 years jail term for man wey dey date man or woman wey dey date woman no be threat to gay pipo for naija as police don arrest two young boys over dis mata wey di Nigeria senate don confam as crime for naija.

Di Nigerian senate pass di bill some months ago say man must not date or marry man and woman must not date or marry woman or else dem go spend 14 years for prison.
Di Nigerian police don arrest two boys for Ikotun for dis offence and dem don even appear for young pipo court to defend demsef or face di penariti.
Di 14 years old say im no dey guilty but Harrison agree say im dey guilty of di offence.
Wetin appun be say,20 years old Gideon Harrison bribe di 14 years old boy to sleep witam, but di boy refuse and call pipo for di area attention to di mata.
For station, di smallie from Abia state say Harrison wey come from Delta State naim dey forsam to do am.
Harrison imsef also yarn police say no be today im statam as he don dey give oda smallie for di area N200 to N300 to bribe dem to sleep wit dem and he say no be only im dey involve for dis mata.
Di court don approve di bail money to be N200,000 with two sureties and di court also order dis two sureties to deposit di N200,000 to di Chief Registrar Account until di mata end.
Di court later postpone di mata till Novemba 17.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...