MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 31 October 2015

ABEG MAKE U NOR COMPARE ME WITH FEMALE MIUZISHANS,COMPARE ME WITH MALE MIUZISHANS-CYNTHIA MORGAN

As a she,she get evritin wey woman get but if you see di reggae and dancehall queen Cynthia Morgan, make u no go do mistake call her female artiste.
Just call her,"musician."
Na so she yarn.
Akordin to di Edo born chikito wey dey sing wit plenti power, she say,she no dey di same class wit di rest female artiste dem bicos none of dem dey do di kind music wey she dey do.

Cynthia Morgan, di Northside records first lady say,if u listen to her jammingjamming,u go know say she no dey sing soft di way wey oda gehs dey sing.
She say she don reach dat stage wey be say, pipo no dey borda to compia her wit girls again but dem dey compiaram wit men wey sabi.
She say make all her fans and music lovers expect her album by God's grace veri soon bicos she stil dey try to add salt and maggi to di music wey she dey cook.
She also yarn say,she go work and do collabo wit some oda top musishans including P-square dem wey she say na must for di album.
Cynthia Morgan release one latest song dis month wey she call,"baby mama"and e don dey totori many pipo and many radio stations alreadi.

Friday 30 October 2015

YOU GO SPEND ONE YEAR FOR PRISON IF YOU CIRCUMCISE ANY GIRL AGAIN-OGUN STATE GOVERNMENT


Mrs Elizabeth Sonubi
Di quickest way to spend one year now for Ogun State now,na to circumcise yor daughta.
Di comisiona for women affairs and development for Ogun State,Mrs Elizabeth Sonubi naim yarn dis one for Abeokuta for one join bodi conference to celebrate "16days activities to take remove women oppression kpatakpata".
Sonubi say di law against female circumcision for di state still dey kamkpe.
So diafor, if dem catch anybodi wey carry razor blade, Jack knife, dagger, cutlass or any sharp tools take near dat tin sake of say dem won comotam, na jail di pesin go find imsef for one year.

Di comisiona say female circumcision na harmful traditional practice for women and girls bodi.
She also yarn say Ogun state don put eye for ground to make sure dia is no more oppression against women.

Eliza say oppression no good at all at all and na dis one make dem don put forward and propose di Domestic Violence Prohibition Bill.
My Ogun State pipo,make una nor say I nor warn una o!

Thursday 29 October 2015

OGUN STATE:WETIN KEKE NAPEP AND OKADA RIDERS DO POLICEMEN SEF?

No be small tin appun for Ogun state last week as police pipo wit big big wipons go skata meeting wey dem oganise for keke napep and okada riders.
Di rizin for di meeting na to diskors ''How dem go take dey prevent asident,how dem go take control and stop di abusement of drugs as e take concern di riders."
Di pipo wey oganise dis join bodi na,National Commercial Tricycle and Motorcycle Owners and Riders Association,NACTOMORAS.
As di meeting jos won start,naim ekelebe wit dia guns enta di hall and drive di ova 2000 pipo wey don alreadi siddon.
Pipo wey attend di join bodi meeting na,Federa Road Safety Corps,FRSC membas,Traffic Compliance and Enforcement Corps,TRACE,Pyrates Confra,NDLEA and some oda pipo wey dem invite.
Na wa for wire road.
Dis na naija,di kontri wia anytin fit appun.

Tuesday 27 October 2015

SHARRAP DAVIDO!!! WHY U GO TALK SAY NA LIL KESH BE Di BEST NEW ARTISTE FOR 2015?-CYNTHIA MORGAN

Cynthia Morgan don tell Davido make he go siddon for one place,few days afta she tell tori pipo say, na Davido be one bobo wey be say, if dem giam chance,she go leak him ear.
Kasala don buss out bitwin dem two,four days afta she yarn say,among all di celibritis,na Davido she dey trip for pass.
Di hole wahala start wen Davido hand skratcham go write for twita say,na Lil Kesh go win di best new miuzishan for di Headies Awards wey go appun veri soon.
Akordin to Davido,he say na Lil Kesh be di MVP dis year make evri oda pesin chill for di boy wey sabi.
Quikquik mazamaza,naim Cynthia Morgan reply say,make Davido go siddon for wia containam bicos evribodi wey dia name appia for dat list na MVP.
Apart from di German Juice singa and Lil Kesh,oda artist wey di oganisers choose for dis award na,Reekado Banks,Kiss Daniel and Korede Bello.
Like follow come battery for phone,di next rated award go follow come wit brand new motor.
So anybodi wey win di award,go win di motor join.
Issorait,make I go prepia for di next tori.
Gudluck to all of dem.

Monday 26 October 2015

NOTIN DO UNA VOTE,WE GO STILL REDUCE FUEL PRICE-YEMI OSINBAJO

I nor sure say naija get time to biliv any politishan again bicos dia eye don see nhwi for di ones wey dem  manage biliv.
NEPA say dem won inkriz light bill middle of novemba by 40% or even more and Vice President,Yemi Osinbajo say dem won reduce fuel price.
Wich one pipo go biliv?
For di fuel reducement,Osinbajo say gofment dey do evritin posibo to make sure dem reduce di price.
Osinbajo wey travel go Uk for one join bodi meeting to sign paper of how di light wahala go improve,tell tori pipo,Bloomberg say,wen private refineries start,e go reduce fuel importation.
He also yarn say dem don get 30 ogbonge refinery license wey go make di fuel price soft lastlast.
E good make pesin biliv say naija go beta but as for me,I go siddon for fence dey watch so dat I go dey tell una how di mata dey go.

Sunday 25 October 2015

HURRAY! STEPHENIE OKEREKE DON BORN BOUNCING BABY BOY PIKIN

Nollywood actress and film maker,Stephenie Okereke Linus, don born a bouncing baby boy.
She announcesam for facebook and oda tori site dis wikend.
Stephenie bin marry forma Super Eagles difenda,Chikelue Iloenyosi and afta sometime, di marriage crash like pack of cards.
Three years ago,she kon later marry Edo boy,Linus Idahosa and dem don welcome dia first pikin togeda.
Congratulabia Linus and Stephenie,for una new bomboy.

Saturday 24 October 2015

SINCE DRAKE REMIX MY SONG,NA BETA BETA I DEY SEE-WIZKID


Wizkid don hail baddest rapper,Drake as di man wey make pipo espeshally pipo for obodo oyibo,dey respect him talent.
For July,Drake and British-Nigerian born rappa,Skepta sing on top Wizzy Ojuelegba song as dem do di remix.
Since den many pipo don know about di bobo talent.
Today na Drake betday and Wizkid kon troway salute givam on top instagram say na Drake make him levels change wey make pipo like Swizz Beatz and him wife,Alicia Keys dey praise am.

HURRAY! STEPHENIE OKEREKE LINUS DON BORN BOUNCING BABY BOY


Nollywood actress and film maker,don born a bouncing baby boy early dis morning,24 of Octoba.
She announcesam for facebook and oda tori site.
Stephenie bin marry forma Super Eagles difenda,Chikelue Iloenyosi bifor di marriage kon crash.
She kon later marry Edo state born Linus Idahosa and dem don welcome dia first pikin togeda.
Congratulabia.

WE GO REDUCE FUEL PRICE-VICE PRESIDO,YEMI OSINBAJO

I nor sure say naija get time to biliv any politishan again bicos dia eye don see nhwi for di ones wey dem  manage biliv.
NEPA say dem won inkriz light bill middle of novemba by 40% or even more and Vice President,Yemi Osinbajo say dem won reduce fuel price.
Wich one pipo go biliv?
For di fuel reducement,Osinbajo say gofment dey do evritin posibo to make sure dem reduce di price.
Osinbajo wey travel go Uk for one join bodi meeting to sign paper of how di light wahala go improve,tell tori pipo,Bloomberg say,wen private refineries start,e go reduce fuel importation.
He also yarn say Dem don get 30 ogbonge refinery license wey go make di fuel price soft lastlast.
E good make pesin biliv say naija go beta but as for me,I go siddon for fence dey watch so dat I go dey tell una how di mata dey go.

BREAKING NEWS!I NEVA SEE Di RIGHT MAN WEY DEY MAKE MY HEAD SWELL-GENEVIEVE

Genevieve dey tink of you,Nor carry last.
All di bobos una dey hear o!
Make u nor shout tomorow say I no yarn u o!
Nollywood supastar,Genevieve, don dey ring agogo rite now say she neva stil see dat man wey fitam.
She neva see di man wey she fit die for him mata.
She neva see stil see di rite man wey she go settle down wit.
Make una no allowram tink die o!
Any man wey she don frend bifor na do and go yor own jeje.
Even D'Banj,na only am naim waka come.
Koko masta come, and he waka hin own comot jeje.
Remain u.
Nor fear,go and try yor luck.
Dis na Nigeria,anytin can appun.

Thursday 22 October 2015

ARUMBA STYLEE!YO MEN! YO! IBB WEAR CANVASS TAKE ROCK AGBADA AS HE ATTEND COUNCIL MEETING


Forma khaki president,General Ibrahim Badamosi Babangida,don kill fashion wit bow and arrow as he nod blue agbada kon nack one blue canvass join.
Na di council of state meeting for Abuja di guy man wear ram go.
For dis dressing,IBB try to tell us say,dem fit tell u say,nor wear dis,wear dat,for real fashion sense but at di end of di day na u get yor clothes and na u know how u won do di combination pass.
Na u get yor shoe,na u know wia e dey pinsh u,na u get yor cap if u like u wiaram face back.
Yo men!,Yo me! Livam like dat notin dey appun.
What it do men!
IBB stylee!
Ina Aromba stylee!

Wednesday 21 October 2015

ONE SOUTH AFRICA BABE SAY DEM USE WORWOR SWEAR FOR NIGERIA WOMEN


I nor know who ofend dis South Africa babe o but she write for her twita page say all naija women ugly finish.
Abi one smart Ekiti babe don snatch her bobo?
Di babe wey her twita name na, @dinnyaphane yarn say,di kain worwor wey our women worwor enh!,E no get part two.



Di South Africa geh wey dey yarn dis one so,i don look her pishor but wetin i dey see for hia shock me enta my biskit bone.
She be like who chimpazee use daga dey porshoe wit worwor.
Abi my eyes dey disiv me?
Check her pishor yorsef too,make u judge for yasef.

WHO SAi! RUGGEDMAN NOR SLEEP WIT MY FORMA WIFE,NA LAZYMAN WIFE DEM FIT SNATCH-9ICE

Di present spesha asistant for youths mata to Abiola Ajimobi di Oyo State Govnor,9ice,don yarn say for wia!who born monkey to smart pass di owna.
He say na onli laziman wife dem fit snatch.
If u rememba some years ago,rumors bin come out say 9ice forma wife,Tony Payne dey do touching bodi wit Ruggedman and na dat one make 9ice put full stop to dia marriage.
And also di way wey di tori dey dat time,9ice know Tony Payne tru Ruggedman.

But di Alapomeji singa don come out to say,Ruggedman nor fit sleep wit him.He say na lie all dis rumors be bicos dog nor fit snatch lion wife.
He say him neva forgive rappa Ruggedman on less he apologise bicos di root of wetin cause dia quarel,dem neva uproot am.
He yarn all dis one on top TVC program,'Entatayment Splash' and wen dem askam wetin appun bitwin dem two,9ice say "Ruggedman go chook mouth for anoda man mata instead ofam to mind him bizness."

Monday 19 October 2015

UNA BYE BYE!!! I NO GO EVER VISIT SWEDEN AGAIN - SNOOP DOGG

America rappa,Snoop Dogg,don tell all him Sweden fans say make dem blame dia police pipo for di swear wey him swear say,him no go eva visit dia biutifu kontri again.
Snoop yarn dis wan on top twitta on sunday afta Sweden police stopam for road,arrestam go station and force am to piss for cup sake of say dem won do test wit di piss to know weda igbo(marijuana) dey him system.
Snoop bin go do show for di university town of Uppsala Stockholm,Sweden.
Snoop later yarn say na bicos him na black man naim make dem tritam like dat but di police pipo say na lie bicos na dia work dem just dey do.
If u check and balance am,u go blame Snoop?
For police to arrest am go station from him car and force am to piss for cup and no be say dem catcham wit igbo,naim be  say dat wan pass opression.

But sha o,bifor dis wahala for Sweden appun,Snoop carry smoking for head like lakpalakpa.

Sunday 18 October 2015

MONEY PALAVA: NAIJA MUSICIANS NOR GET SHISHI,NA FORM DEM DEY FORM-DAVIDO

Nobodi know wetin appun wey Davido decide to fall im felow miuzishans hand.
I bin tink say dog nor dey chop dog but Davido don show say if dog para,e fit chop im felow dogs,drink water and klin mouth.
Davido leek one kain sikrit wey many pipo nor know about as he yarn say na fake life naim many miuzishans dey live.
Davido say,di form wey dem dey form say dem be big bois and big gehs, na sign say dia leg no strong for ground.he say dem no get shishi for bank.
Davido yarn all dis one on top twita.
Sake of say na me dey hep pipo kip dia sikrit,i go see how e go take dey posibo make Davido tell me di sikrit of who make am vex and yarn all dis tins.
If he tell me di sikrit,i go tell una but make una nor tell anybodi say na me tell una sha o!

WHO DEY DIA? LINDA IKEJI DEY LOOK FOR HUSBAND SIRIOSLi!

Forget say she be babe,di king of amebor tori,Linda Ikeji,dey look for hosband siriosly.
All di bobos wey dey find malawi wey dey do veri well to marry,God don ansa una prayer.
Linda Ikeji wey jost buy ova N500 million haus for banana island write on top twita say,"sometimes God go poposeli dey delay u for some kain tins to bless oda part of yor life.she say anytime wey di man wey won marry her ready,she sef don ready too.as she yarn all dis one,she kon ask anybodi wey read dis tori say,who go like to marry her"?
I no sure say na joke she dey joke o!
Anywia wey she hide,make u find her see and marry am quik quik bifor anoda bobos go first u marry am.
Hurry up o,bicos as she write dis tori on top twita,if u see di crowd wey won die for her mata,u sef,fear go catch u.
Oya,read wetin she write and all some reply wey she get for bottom hia:


Saturday 17 October 2015

PASTORS,WITCHES AND WIZARDS NEARLY DECEIVE US TO VOTE FOR GOODLUCK JONATHAN-JULIUS AGWU

Naija comedian,Julius Agwu,don yarn say him know how many Nigeria pastors forma presido Ebele Azikiwe Jonathan dash money make dem pray foram so dat he go win Buhari during di April general elections.
He say but baba God nor ansa dia prayers.
He also yarn say why e be say,na only witches and wizards na dem rili want make Jonathan win?
Julius di genius Agwu,yarn all dis one for one join bodi siddon wey dem call,'Red Summit Gala' and e appun for Harbor point, off Ahmedu Bello way,Victoria Island for inside Lagos.
Di bobo wey sorvive brain surgery some months ago,say di so call asosiation of witches and wizards yarn labalaba full ground say Goodluck na dia man and he go win again but God pass dem.
He kon use joke beg say,make Buhari no joke wit di God wey putam for Aso Rock.
Infact,he say we need to troway dat first part of our national anthem wey be 'Arise  O Compatriot',bicos di compatriot neva stil rise since naija get indipendense.
He say e beta make we kuku choose di second national anthem wey be,'O God of creation,direct our noble cause'.
Julius say make we put God for front like Amerika wey biliv say na 'In God Dem trust' bicos e dey work wella for dem.


PASTORS,WITCHES AND WIZARDS NEARLY DECEIVE US TO VOTE FOR GOODLUCK JONATHAN-JULIUS AGWU

Naija comedian,Julius Agwu,don yarn say him know how many Nigeria pastors forma presido Ebele Azikiwe Jonathan dash money make dem pray foram so dat he go win Buhari during di April general elections.
He say but baba God nor ansa dia prayers.
He also yarn say why e be say,na only witches and wizards na dem rili want make Jonathan win?
Julius di genius Agwu,yarn all dis one for one join bodi siddon wey dem call,'Red Summit Gala' and e appun for Harbor point, off Ahmedu Bello way,Victoria Island for inside Lagos.
Di bobo wey sorvive brain surgery some months ago,say di so call asosiation of witches and wizards yarn labalaba full ground say Goodluck na dia man and he go win again but God pass dem.
He kon use joke beg say,make Buhari no joke wit di God wey putam for Aso Rock.
Infact,he say we need to troway dat first part of our national anthem wey be 'Arise  O Compatriot',bicos di compatriot neva stil rise since naija get indipendense.
He say e beta make we kuku choose di second national anthem wey be,'O God of creation,direct our noble cause'.
Julius say make we put God for front like Amerika wey biliv say na 'In God Dem trust' bicos e dey work wella for dem.

Friday 16 October 2015

MIKEL OBI DON RELEASE NEW PISHOR OF DI TWINS WEY HIM RUSSIA BABE BORN FORAM

Chelsea and Super Eagles midfida,Mikel Obi,don strike pose wit him twins and him Russia geh frend and baby mama,Olga Diyachenko.
She born twins for Mikel last month and since den dem dey always dey reliz new new foto of di twins.
Rumors wey our tori pipo also gada be say,Mikel don get four year old son and anoda one year old geh pikin from oda women but di bobo Neva come out to confamam.
Oya check out some of di twins pishor,dia popsi and dia momsi.


Thursday 15 October 2015

CARLOS TEVEZ DRAW 'ANGELS' AS TATTOO TAKE COVER EVERYWHERE FOR HIM BACK

Abeg, hep me phone Wiz Khalifa and Lil Wayne dis morning say, make dem pause and wait to find out who apart from Tonto Dikeh don join dem for di tattoo madness.
Dia new memba na Argentina soca star,Carlos Tevez, wey don draw tattoo take cover everywia for im back.
He put di picture of im bodi tattoo for twitter and na angels naim he draw for di back.
Di forma Manchester United and Manchester City player, wey carry im bag waka comot for England and enta Italy go kontiniu im football career with Juvey and from Juvey,he carry him bag again enta Argentina back,pose wit one man wey we biliv say naim draw di tattoo as he write for unda di picture say,
"tank you my frend for dis wondaful tattoo wey u sketch for my back.na you be di baba of all baba for dis tattoo job".

Tuesday 13 October 2015

BAD EXAMPLE: CYNTHIA MORGAN DEY SMOKE CIGAR,KON CARRY PIKIN FOR HAND TAKE SNAP FOTO

Nobodi know how Okorowanta craze take stat but di guy kain craze nearli winam award.
E be like say Cynthia Morgan dey read some of Okorowanta books bicos di way wey she dey go wit her life right now,she dey five seconds away from grade A madness if she no stop her yeye bihavior.
Di naija reggae and dancehall star,post one kain annoyin pishor for Instagram of how she dey smoke cigar,kon draw her jaw enta like say her life depend on topam.
As if dat one no reash,she kon carry one naked inosent pikin for hand take snap di pishor.
Yeye mesage naim she pass and many modas wey go see dis foto,go para for her no be small.
Pipo dey try to be celebriti wey dey show beta example,Cynthia Morgan dey won be celebriti wey dey turn yeyebriti.
My pipo don tire to len bad tin,abeg Cynthia Morgan,stay one place.

2FACE SAY MAKE GOVERNMENT INTRODUCE PIDGIN ENGLISH ENTER SCHOOLS

2baba don yarn say make govment use dia church mind and introduce pidgin langua enta naija skuls espeshally all dose skuls dem for villa.He yarn say,all dose smallie for villa na pidgin english be most of dem second language,so for dat rizin,e good make govment introduce am to develop dia yarnings and to use am transfer knowledge to dem since dem undastand di language like a,b,c.
2face yarn all dis one on top one join bodi talk for MTV Base wey dem dey call #ChooseOrLoseRoundTable.


2face yarn say,dem fit employ some pidgin professors like you and me,pipo wey sabi di pidgin langua reach ground.
He say dis na di only way wey dem fit take reduce di gap bitwin pipo wey dey use big big grammar and pipo wey dey soak pidgin language.


Sunday 11 October 2015

SEE DI LIST OF 37 PLAYERS WEY CAF CHOOSE FOR AFRICA FOOOBALLER OF DI YEAR AWARD

Confedration of Africa football,CAF, don choose 37 players from wich dem go pick di winna for di next Africa futbola of di year.
Of di 37,na only two Naija players CAF chuz.
Vincent Enyeama and Ahmed Musa,dis two naim make di CAF list.

Oya check out di names of all di 37 playas for A,B,C order for bottom hia:

African player of the Year: Name, Club, Kontri.

Ahmed Musa CSKA Moscow, Russia Nigeria
Andre Ayew Swansea City, England Ghana
Aymen ABDENNOUR FC Valence, Spain Tunisia
Baghdad Bonjah Étoile du Sahel, Tunisia Algeria
Bassem Morsi Zamalek, Egypt Egypt
Chrisitian Atsu Bournemouth, England Ghana
Dieu Merci Mbokani Norwich, England D.R Congo
El Arbi Hillel Soudani Dynamo Zagreb, Croatia Algeria
Faouzi Ghoulam Napoli, Italy Algeria
Férébory Doré Angers, France Congo
Gervais Yao Kouassi Rome, Italy Cote d’Ivoire
Ibrahima Traoré Borussia Mönchengladbach, Germany Guinea
Javier Balboa Al-Faisaly, Saudi Arabia Equatorial Guinea
Héldon Ramos Rio Ave, Portugal Cape Verde
Mame Diouf Stoke City, England Senegal
Max Alain Gradel Bournemouth, England Cote d’Ivoire
Mehdi Benatia Bayern Munich, Germany Morocco
Modather Al Tayeb “Karika” Al Hilal, Sudan Sudan
Mohamed Salah As Roma, Italy Egypt
Nicolas Nkoulou Marseille, France Cameroon
Pierre-Emerick Aubameyang Borussia Dortmund, Germany Gabon
Robert Kidiaba T.P Mazembe, D.R Congo D.R Congo
Rudy Gestede Aston Villa, England Benin
Riyad Mahrez Leicester City, England Algeria
Sadio Mané Southampton, England Senegal
Serge AURIER Paris Saint Germain, France Côte d’Ivoire
Seydou keita Rome, Italy Mali
Sofiane FEGHOULI Valence, Spain Algeria
Stéphane Mbia Trabzonspor, Turkey Cameroon
Thievy Bifouma Granada, Spain Congo
Victor Wanyama Southampton, England Kenya
Vincent Aboubakar Porto, Portugal Cameroon
Vincent Enyeama Lille, France Nigeria
Yacine Brahimi Porto, Portugal Algeria
Yannick Bolasie Crystal Palace, England RD Congo
Yasine Chikhaoui Al-Gharafa, Qatar Tunisia
Yaya Toure Man City, England Cot d’Ivoire


LEPACIOUS BOSE: FROM OROBO TO LEPA TO BAAD!

If Sound Sultan dey look for fans wey go love dat him jam "OROBO" more,make una warn am make he no near wia Lepacious Bose dey bicos dat babe dey para for anytin oroboism.
If u know about Naija comedy welwell,u go know say,even sef say lepa dey inside Lepacious Bose name,she nor lepa for one kobo?

Wia her joke for start,na di Lepacious wey dey inside di name.
Na di comedy be dat,na her catchpoint be dat and e dey work wella for her.
Di tori hia be say,di babe fat finish nor be small.
In short,na times five(x5) of Buhari, Lepacious Bose be.
Di babe fatness nor be here.
But now,if u see Lepacious,u fit tink say na somebodi else u dey see.
Di babe don turn Lepa finish and na only she go fit tell us how she do am pass.
Di tori wey dey reash our office now be say,she say she no go stop to watch her weight until she lepa like Dija of Mavin Records but we neva confamam weda truth dey di tori.
Now,if u see her new pishor u sef go hala say,shuo!dis change wey dem dey talk about,so na true?
Even her smile sef don change.
Na through Lepacious Bose I take know say pesin smile dey fine.
My broda and sista,make we no yarn too much,check out di bifor foto and now foto,for bottom hia weda di babe nor get plenti tori to tell.




Friday 9 October 2015

BUHARI CARRY GO,JONATHAN TOO SOFT NAIM MAKE AM NOR FIT FIGHT CORRUPTION-CHIEF EDWIN CLARK

Forma minista of Information,Chief Edwin Clarke don yarn say make President Muhammadu Buhari carry go wit di way wey he take dey fait koroption wit soja hand bicos forma presido,Goodluck Ebele Jonathan,weak like dodo naim make am nor fit fait koropshon.
He say Goodluck na complit gentleman and to fight koroption no be play play mata.
Clark say nor be evritin wey yor rival do naim must dey wrong.
So diafor,him go soport anytin wey go make naija beta.
He also yarn say Jona mean well for dis kontri but he too gentle for some kain tins wey need gragra.
Di Chief from Ekiagbodor say many pipo wey serve unda Jona dey live like king now for dia big big haus wey be like palace.
He say for beta kontri and sosaiti wia dem dey use dia sense,if pesin salari na N20,000 pa month,bifor daybreak di pesin kon buy N100,000 tin,dem go make sure dem find out how he take get di money but if na naija,insurance go cova dat pesin.
Edwin Clark say dat one wey call imsef Obasanjo,soport koroption for 8 years wen hin be president and naim dey sharp mouth pass about koroption.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...