MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 5 October 2015

LOCAL RAPPER:ANYBODi WEY DEY EXPECT TO HIA YORUBA RAP FOR MY MOUTH DEY WASTE HIM TIME-MODENINE

Modenine,di naija rappa wey dey rap fire,don yarn say,if u stil dey dream to siam to dey rap wit yoruba language,naim be say fowl go grow teeth fest.
If dem say pesin dey rap,na Modenine, bcos di boi dey rap wella like say him papa na Amerikana.
But for naija,rapping like Amerikana no go give u beta money to take buy origina kpofkpof but wit di kain money wey rappas like Olamide,Reminisce don make thru dia yoruba rappin,dem fit buy 90 trailers of akara for full communiti and millions go stil remain for dia bank account.
Nigeria na kontri of ova 250 language and if u be rappa wey dey rap well wit any of dis language for dem,dem readi to come yor show and buy yor CD but if u dey rap like Amerikana,dem no go too send u.
Di rizin wey Modenine give be say,di kain level wey Phyno,Olamide,Reminisce don reash for local rappin,e go hard to beat dem.
So he say fear dey even catcham sef.
Abeg make una no vex,make una allowram to kontiniu him Amerika rappin.
God dey.

1 comment:

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...