MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 11 October 2015

LEPACIOUS BOSE: FROM OROBO TO LEPA TO BAAD!

If Sound Sultan dey look for fans wey go love dat him jam "OROBO" more,make una warn am make he no near wia Lepacious Bose dey bicos dat babe dey para for anytin oroboism.
If u know about Naija comedy welwell,u go know say,even sef say lepa dey inside Lepacious Bose name,she nor lepa for one kobo?

Wia her joke for start,na di Lepacious wey dey inside di name.
Na di comedy be dat,na her catchpoint be dat and e dey work wella for her.
Di tori hia be say,di babe fat finish nor be small.
In short,na times five(x5) of Buhari, Lepacious Bose be.
Di babe fatness nor be here.
But now,if u see Lepacious,u fit tink say na somebodi else u dey see.
Di babe don turn Lepa finish and na only she go fit tell us how she do am pass.
Di tori wey dey reash our office now be say,she say she no go stop to watch her weight until she lepa like Dija of Mavin Records but we neva confamam weda truth dey di tori.
Now,if u see her new pishor u sef go hala say,shuo!dis change wey dem dey talk about,so na true?
Even her smile sef don change.
Na through Lepacious Bose I take know say pesin smile dey fine.
My broda and sista,make we no yarn too much,check out di bifor foto and now foto,for bottom hia weda di babe nor get plenti tori to tell.




No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...