MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 8 October 2015

BETTIN PALAVA:MAN U FAN,USAIN BOLT FORCE TO WEAR ARSENAL JERSEY AFTER HE LOOSE BET

One of Manchester United biggest fan for di world,Usain Bolt,don wear Arsenal jersey for di first time for him life sake of say Man U loose to Arsenal last Sunday for Emirates.
Wetin di betting dey about bitwin him and him frend be say,if yor team loose,u go wear di winna jersey.
Him frend name for Instagram akordin to Bolt na, Patty Lopez Delac and na Mexico Tv star.
And as Arsenal kon give Man U three kondo,Usain Bolt no get choice as he kukuma nod di gunners jersey.
As di guy wear di jersey,he squeeze him face like pesin wey dem use mess stone.
He imsef even confamam say he no happy at all say him wear di Arsenal jersey.
Sorry Bolt,sometimes u loose,sometimes u win.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...