MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 31 December 2016

YEMI ALADE STORY DEY CHANGE EVRiDAY AS Di ORGANIZERS OF Di WORLD BIGGEST MUSICAL AWARDS, 'GRAMMY', DON INVITE HER TO Di 2017 GRAMMY AWARDS FOR AMERICA



Di Grammy Awards go appun on di 12 of February for Los Angeles,America and one pesin wey we nor soprise say dem giv invitation to attend di awards na Yemi Alade bicos of wetin di oyoyo babe don achieve since 2015 kon rish today.
For dem to recognaiz her all di way from Yankee,naim be say she get wetin she dey do right and dis one go surely make di rest miuzishans put in plenti hard work.
Beta pikin,na yor time but nor allow success turn yor head upside down.
More fire.

Friday 30 December 2016

WEN POVERTY CATCH GOVMENT AND PIPO Di SAME TIME,DEM DEY CALL AM RECESSION BUT 'SEKEM' SINGA, 'MC GALAXY' DON YARN SAY HIM GET PLENT MONEY PASS RECESSION


Sekem singa,Mc Galaxy don yarn say,if recession like make e hold evribodi for did KONTRi,nor be bicos of am.
He say him money long pass third mainland bridge so diafor povati nor reach wia him dey.
He show tori pipo vidio of plentiful money and he say,nor be bicos ofam recession build manshon for Nigeria.
Watch Mc Galaxy yarnings for bottom hia...


Thursday 29 December 2016

DOG CHOP DOG AS POLICE DON ARRREST 21 POLICE ESCORT WEY DEM ATTACH TO GOVNOR WIKE OF RIVERS BICOS DEM SHOOT DEY WASTE BULLETS DURING ELECTION


If u tink say dog nor dey chop dog,tink again as police don arrest 21 police escort wey dem attach to govnor wike of River state afta dem dey shoot and waste bullet anyhow during di elections wey dem do for di state some weeks ago.
Dem din carry di 21 police go Abuja to go ansa dia case file.
Na wa o.
For dis recession una dey waste bullets anyhow.
Wot if di bullets go touch innocent pesin?
Nor be wahala be dat?
We need to dey reason wit our head sometimes.

Wednesday 28 December 2016

KING OF AFRO JUJU MUSIC,SHINA PETERS JUNIOR BRODA,YOMI PETERS,SAY Di REASON WHY HE PACK HIM LOAD GO AMERICA GO STAY NA BICOS SHINA PETERS CALL AM ARM-ROBBER


Di king of Afro juju miuzik,Shina Peters broda,Yomi Peters,don tell tori pipo say,di reason why he relocate to America,na bicos Shina Peters call am Arm-robbers bicos of dia papa propatis.
Akordin to Yomi wey also be miuzishan,he say,America embassy nearly NOR givam visa to travel bicos of di mata.
But out of pity dem later givam köret Visa wey fit make am stay America for long.
Yomi also yarn say di tin sirios so tay na only once him and Shina Peters don talk for four years.
Dis one sirios o!
We hope say dem go try settle diasef.

Tuesday 27 December 2016

ARM-ROBBERS DON ROB PLENTi PIPO AND SUPASTAR KISS DANIEL FOR 'CALABAR CHRISTMAS VILLAGE' AND E HAPPEN WEN HE DEY SING FOR STAGE


As u dey plan to enjoy di holiday na so some pipo dey plan to to tiff.
Nor be today arm robbers don dey but trust naija pipo dem go putam for recession head.
How norma human beings go carry gun,carry weapons say na arm robber work naim dem won to dey do?
Imagine as pipo dey selibrate holiday and Jesus birthday for Calabar Christmas Village,arm robbers enta dia go attack pipo and kolet dia propatis and money.
One of Naija biggest artiste for dis 2016,Kiss Daniel,dey stage dey sing dat time as Dem robam also.
Dem pull hin clothes from hin bodi.
Na wa o.
So Dem go kon wear di clothes dey waka afta?
Arm robbers and dia karata sef.

Monday 26 December 2016

MANY FANS NOR GO LIKE DIS ONE AS OGA DEM FOR 'MAN U' DEY PLAN TO INKRiZ MOURINHO CONTRACT TO 10 YEARS UPON SAY DEM DEY PLAY LIKE PRIMARY SCHOOL SHIDREN RIGHT NOW


If u dey find club wey dey play primary school football right now,na Manchester United.
Dia coach,Jose Mourinho dey lost why he players nor dey deliver even on top say,he spend plentibmoney take buy players.
For di past five match dem don improve small but many Man U fans nor dey hapi wit Mourinho and him boys.
Wetin go vex some of di fans pass now be say,di OGA dem for di club dey plan to inkriz Mourinho contract to 10 years sake of say dem don tire to dey sack coach afta one or two years.
Well,na Mourinho wey dey yarn about so.
Dat guy can do magic wen u nor xpet.
Make we Sidon dey look wetin di OGA dem go do.

Sunday 25 December 2016

PLAYING OF TOO MUCH P SQUARE AND OTHER NAIJA SONGS FOR GHANA,DON MAKE ONE OF DiA MUSICIAN WEY HE NAME NA 'BULLET', DEY FIGHT DiA SHOW ORGANIZERS


Nor be our fault say our miuzik dey reign enta evri kona.
Na sign of GOD favour and sign say Naija miuzishans dey work hard.
Ghana miuzishan,Bullet, don start fight wey he nor go fit finish against dia show oganaizas and promotas bicos dem too dey play Naija songs.
Akordin to di bobo,for dis vidio wey he for dey para,he say na so so P Square miuzik and Naija miuzik dia pipo dey play why Ghana miuzishans dey suffer for dia own kontri.

Where me,you dey wen NEPA no gree to shine dia light?

Wemi U dey wey man no sleep dey work all night?

Oga Bullet,calm down and listin to Reekado Banks song Oluwa ni,you go know wia we dey come from.

Watch di vidio of how di guy dey para for bottom hia...

Saturday 24 December 2016

CHAi! SEE AS WIZKID DODGE RAPPER 'EVA' HUSBAND TO BE HANDSHAKE (VIDEO)


For di Headies Awards wey appun yestaday for Eko Hotel,Lagos,Africa biggest artiste for 2016,Wizkid,avoid Caesar handshake like say lakpalakpa dey di bobo hand.
Instead Wizkid kon hug di bobo babe,Eva di rappa.
But to be fair,na bicos Eva and Caesar won hug Wizzy di same time naim make Wizzy choose to hug one pesin out of dem two.
I nor sure say he purposeli do am.
But come o,wich boy go live babe kon hug boy wen di two of dem won hug u di same time?
Anyway,watch di vidio for bottom hia...


iPHONE 7 YANGA BOYS AND GIRLS DIS STORY NA FOR UNA..NAIJA BILLIONAIRE, FEMI OTEDOLA ATTEND ONE GROOVE FOR LAGOS AND WE Siam DEY MAKE CALL WIT PHONE OF N1,000

All those shakara and yanga boys and gehs s wey like to dey smart like say dia life dipend on say tomorrow nor dey get to learn.
E make sense say u get N300,000 for your bank account and at di end of di day u use N250,000 and u dey left wit 50k bicos u won impress?
 Imagine billionaire and Forte Oil owna.,Femi Otedola,play enta di Rhythm unplugged show for Lagos and di man carry three one,one tausand naira phone take dey make call.
Those 3 phones na three  tausand naira.
Shakara pipo make una resiv sense.
Your mama need money for village,you need to start life like who get sense.

Friday 23 December 2016

AFTA Di REGGAE PLAY Di BLUES,HARRYSONG BADDEST SONG DON WIN Di BEST POP SINGLE OF Di YEAR FOR 2016 HEADIES AWARDS

Ogbe Ijaw most valuable player Harrysong don win di best pop single for dis year Headies award wey appun for Eko Hotel,Lagos.
hin song,Reggae Blues wey plasta evri kona for naija defeat other artiste like Wizkid,Kiss Daniel,D'Banj to win di best pop single for di year 2016.
Congrats Baba for di gehs.

Thursday 22 December 2016

FANS DON DEY WARN GHANA ACTRESS,YVONNE NELSON TO BEWARE OF FLAVOUR NABANIA BICOS FLAVOUR FIT TURN HER TO ANODA BABY MAMA


Well,wen fans don dey advice girls to dey giv u chance sake of say dem don see you as pesin wey nor dey use eye see girl waist,naim be say you riri need dilivrance.
Ghana big name actresss Yvonne nelson,Post vidio of she and highlife miuzishan,Flavour on top Instagram and her fans kon dey advice her say make she dey kiafu wit Flavour.
If not,di bobo go giam belle one time as he don alreadi giv two girls belle.
Sandra and Anna Banner don born two daughtas giv Flavour and Dem don turn popular baby mama for town.
Di advice right now to Yvonne from her fans na make she nor go end up as baby mama nomba three for Flavour hand.
Na her life if she nor like di advice,dat one konsign her.
We must all learn from pipo mistake.
See Di vidio of Yvonne Nelson and Flavour wey make fans dey shout for botom hia...



Wednesday 21 December 2016

AFTA SICKNESS STOP ALL WIZKID KRISMAS GROOVE,TEETH SICKNESS DON ALSO STOP TIWA SAVAGE KRISMAS GROOVE AS DEM GO RETURN MILIONS WEY DEM PAY DEM TO SING DIS HOLIDAY



Na wa o.
Dis na season of groove canceling as Tiwa Savage don join Wizkid as di two major Naija artiste wey sickness don stop dia krismas groovement.
Wizkid cancel him shows three weeks ago inkluding di big money show for Uganda wey dem don pay am for.
Last week sef Uganda court giv dia police order make dem arrest Wizkid any wia dem siam bicos of di show.
Now teeth dokta,dentist, don pull Tiwa wisdom teeth full plate as she postam on top Instagram.
She say she go rest for dis holiday like Wizkid.
Make we dey wait to see if dem go arrest her too on top show promoters money.
God forbid sha but make dem settle wit di promoters.

Tuesday 20 December 2016

NO FOOD,NO WATER! NAIJA SOLDIERS DEY USE EMPTY STOMACH DEY FIGHT BOKO HARAM (VIDEO)


Boko Haram boys go don laff una kontri tire afta di vidio of how hunga dey finish Nigeria soldiers show face on top intanet.
Akordin to di sojas for di vidio,Evri day naim like 70 sojas dey faint.
Boko Haram dey use chicken do toothpick but di men wey dey hep us fight dem,dey use empti belle run shows for inside forest.
Right now,dem don dey beg Buhari make he reskiu dem bifor hunga go use dem play kalo-kalo.
Odnari water for dem to shack na wire.
Five naira biskit na gold for wia dis sojas dey as hunga don use dia eye see pepper.

Watch di vidio for bottom hia and you go shame for our leaders


NA BETA EXAMPLE BE DIS AS NAIJA YOUNG MUSICIAN,SKALES,DON BUILD HOUSE FOR HIM MAMA


Wen u see beta tin,e good make u talk am.
Forma EME bobo,Skales wey dey unda Baseline records now,don finish di house wey him dey build for him mama.
Skales yarn tori pipo on top Instagram about dis köret exampo wey any normal human being go dey proud of.
Di bobo say e don get dis dream for head since to build house for momsi and Baba God don true true show imsef for di mata as he don konplit di bunk.
Mama Skales abeg enjoy di gains wey evri mama dey pray for.

Monday 19 December 2016

PLEASE HELP! WATER GO CARRY Di FAMILY HOUSE OF FORMA VICE PRESIDENT,DR ALEX EKWUEME TROWAY FOR ANAMBRA DURING NEXT YEAR RAINY SEASON AKORDIN TO EXPERTS


Akordin to obodo oyibo expert from United Kingdom,Trevor Jewitt,he say if gofment nor do somtin about am bifor next year raining season,erosion water go carry di family house of forma vice presido,Dr Alex Ekwueme troway as di same erosion don alreadi swallow him grandpapa house.
Jewitt yarn dis one wen he carry waka go di area wit house of rep komiti memba on ecological mata,Obinna Chidoka.
Chidoka wey lead di joinbodi waka say,him go take di mata go meet Buhari seketri,Babachir Lawal so dat dem go do somtin about am bicos di mata na veri veri sirios mata.

Sunday 18 December 2016

DOUBLE CELEBRATION AS PRESIDENT BUHARI 74 YEARS OLD BIRTHDAY AND DAUGHTER ZAHRA MARRAIGE WITH AHMED INDIMI,HAPPEN Di SAME DAY




No wonda dem postpone di wedding bitwin Buhari daughta,Zahra and her billionaire pikin boyfriend,Ahmed Indimi wey sopose appun some weeks ago.
Dem finalli do di marage yestaday Di same day wey Buhari selibrate hin 74 years old birthday.
Congratulations not only to Buhari and him daughta but to evri oda pesin wey selibrate somtin yestaday.

Saturday 17 December 2016

UGANDA COURT DON GIVE ORDER MAKE DEM ARREST WIZKID AND HIM MANAGER BICOS WIZKID CANCEL HIM SHOW FOR DIA KONTRi AFTA DEM PAY AM MONEY


Imagine Wizkid for inside Uganda prison for 11 years.
E fit appun as Uganda court don giv order to dia police say make dem arrest Wizkid and Sunday Arè wey be hin manager.
Di tori be say Wizkid kolet show promota money for Uganda to show face for di kontri dis krismas piriod but di bobo nor go.
If u rememba some days ago,Wizkid announce say,hin doctor say make he rest him bodi dis decemba and he use di opotuniti apologize to him Naija and Uganda fans.
But e be say di Uganda pipo nor won hia any excuse o.
Abeg Wizkid if dia money dey yor hand Abeg return am back to avoid tori dat touch.

Friday 16 December 2016

SUPER EAGLES PLAYER,OGENYI ONAZI DON DASH OUR GIRLS FOOTBALL TEAM SUPER FALCONS,ONE MILLION NAIRA AFTA NFA AND OUR GOVMENT WAN USE HUNGRY KILL DEM


Play play play play,E don dey turn crime to come from Naija.
Since our Super Falcons girls beat Cameroon girls to win di Africa Cup,cobwebs don gada dia pockets bicos shishi nor gum dem.
Wetin our billionaires like Dangotes,Otedola,Adenuga nor fit do,soccer star and small boy Ogenyi Onazi of Super Eagles don do am as he don arrange N1million for di gehs make dem take see front.
Nor be only dat one o,Onazi also dash one of di player,Onome Ebi wey injure N200,000 make she use for tritment.
God abeg plasta tins for Ogakpatakpata staffs so dat we go dey do pass Onazi.

Thursday 15 December 2016

NAIJA COMEDIAN,MC ABBEY,DON YAB PIPO WEY SAY MAKE DEM STOP TO CRACK JOKES FOR CHURCH SAY,NOBODY FIT STOP WETIN GOD DON APPROVE


Naija comedians wey dey crack jokes for church eida to make money,for fun or for free,last week get message from Mike Bamiloye say make dem stopam bicos church nor be wia dem sopose to carry dia jokes go.
But Mc Abbey one of di comedians wey dey run tins for church somtimes say,no way,God don sign am and bless comedy for church.
Akordin to Abbey,he say na so dem dey against drama for church in dose days but today evribodi dey do drama for church.
He say now dem don carry am come wia comedy dey but dem nor go succeed bicos God don bless comedy for church.

Wednesday 14 December 2016

CHRISTMAS GBEDU: JINGOLO BELL,Di NUMBER ONE PIDGIN ENGLISH KRISMAS KAROL,DON LAND FOR YA ZONE AND YA EAR



Yes o!
Jingolo Bell na di first eva pidgin inglish krismas Karol for Naija and dis joliment matiria na to vibrate di Africa spirit wey dey inside us.
E don tay wey we carry obodo oyibo jams for head like ringworm.
Pipo like Bonney M,Abba and oda miuzishans white krismas Karol,don bicom part of us for a veri long time but me and you know say di only tin wey white about our krismas for Africa na di white rice and stew.
Jingolo Bell na di krismas karol wey me and you don know about bifor but di only diferens be say dem don fine tune and sing dis one wit di language wey me and u sabi,di language wey our mama nor dey use dey play,di language wey dey sweet oyibo man for ear like mad.
Krismas Karol for köret pidgin inglish:nor let dem tell u di tori.
Abeg,oyibo krismas Karol,comot for road....JINGOLO BELL DON LAND.

To getam and to use am take do your ringtone for yor phone,Oya click www.jingolobell.com

DiS NA WHITE RICE AND EWEDU MIXTURE O,AS INTANASHONA GOSPEL MUSICIAN DON MOEN DON TALK SAY,HIM AND D'BANJ FIT JOIN BODi DO COLLABO TOGEDA


Circular miuzik and gospel miuzik go soon do joinbodi as intanashona gospel miuzishan Don Moen from America don tell tori pipo say,him and D'banj fit do kolabo togeda one day bicos him just like di koko masta.
But he say,him go pray about am first since he need confam from God weda He soportam.
Well,who be me to judge.
I hope say D'banj nor go dey shout koko masta and kokolets for di song?
Anyway,I just dey ask sha bicos I know wetin full he mouth.
You fit nor hear Jesus for hin mouth bifor di song go end.
Watch wetin Don Moen talk about D'banj for di vidio...


Tuesday 13 December 2016

MMM, Di MONEY DOUBLER,DON SPOIL CHRISTMAS FOR PIPO WEY PUT MONEY FOR Di BIZNESS AS DEM DON BLOCK PAYMENT FOR Di NEXT 30 DAYS


MMM don join to skata pipo apiness for dis December as dem don block all cash withdrawals for 30 days.
Di maga don pay konpini diside to take brake bicos of di crowd,bicos of bad belle from gofment and some oda reasons.
But dem don assure dia costomas say no shakement,say dis set back na for only 30 days so dat dem go fit arrange di konpini welwell make evribodi for enjoy.
If Dem nor open dat site back,pipo go kolo o.

Sunday 11 December 2016

LIKE SAY Di PLANE WEY SHE BOOK TO UYO NOR CANCEL DiA WAKA,ACTRESS,INI EDO FOR DEY AMONG Di OVER 100 PIPO WEY DIE FOR INSIDE Di CHURCH WEY FALL PRESS PIPO



Ini Edo get beta luck as na small tin remain,she for kpai for di kolaps church buiding for Uyo.
As Dem CANCEL her flight naim be God wey save her.
She post di tori of how God take save her on top Instagram.
May di soul of di pipo wey die Rest In Peace.

DAVIDO DON CRY OUT SAY,SOMEBODY DEY TRY USE JUJU WINSH AM DOWN BUT E NO GO WORK BICOS BABA GOD BLANKET COVER RAM



Wen Baba God blanket cover you,you nor dey worry about babylon bad plans against you.
Dis na wetin African star,Davido biliv on 100%.
Akordin to di tori wey di bobo post on top on top snap chat as he say,sombodi dey try use juju on am but him dey Kämpe bicos Baba God dey by him side.
He also yarn say,di pesin wey dey try do otumorkpor on top hin head,know imsef.
Una don hia o,
Di skelewu singa get juju-detector.
So make una giam chance.

Saturday 10 December 2016

SHUO! MAKE UNA SEE O! FEDERA GOFMENT DON AGREE TO PAY SWITZERLAND N25 BILLION AS COMMISSION FROM Di N125 BILLION ABACHA LOOT WEY DEM RETURN BACK TO OUR GOFMENT


Bizness plenti o.
You don hia about kontri to kontri MMM bifor?
If you neva hiaram naim be say you late come class.
Switzerland don Hama N25 billion komishon from di N125 billion Abacha loot wey dem return give federa gofment.
Na di agreement wey di two kontris don rish be dat and na di Chairman of di Civil Sosaiti Network Against Koropshon,Mr Olanrewaju Suraj naim yarn dis one for one joinbodi sidon wey dem do for Abuja.
Abacha,you nor try for di mata wey dey ground so o.
Any moment from now,Dia gofment go send dia account nomba to Central Bank Of Nigeria,CBN for di online transfer.
O boy,see money.
If I resiv dis kain alert ehn,dem don die for my hand.
I go plasta skata.

NEW PICTURES OF PAPA AJASCO AND BOY ALINCO SHOW SAY PAPA AJASCO DEY PREGNANT


Just wen I just dey tell mysef say,e don tay wey I hear from Papa Ajasco and Boy Alinco,dem just reliz dia latest pishor to take oppress.
Alinco don dey fresh small small o but dis Papa Ajasco pregnancy naim I nor kon undastand.
See as di old boy belle dey grow like say dem plant fatalaiza for him belle.

CONFAMENTO! SOLDIERS DON CONFAM OSITA IHEME a.k.a PAWPAW AS Di "NEW CIVILIAN GENERAL"


To be star for dis life na di koko i swear.
See sojas wey be say you nor need look for dia trouble bifor dem go bigin flog u,just dey hapi to hang out wit small motor big engine,Pawpaw of Nollywood.
Get money,get fame,get life,anyone you fit get,getam and u go soprise say,even kings go give u dia daughta to marry for free.

Friday 9 December 2016

WIZKID DON TAKE Di ADVICE FROM HIM DOCTOR TO REST HIM BODi AFTA TWO YEARS OF WAKA-WAKA AS Di BOBO DON CANCEL ALL SHOWS FOR DIS YEAR TILL NEXT YEAR



Wizkid don beg all him fans make dem undastand why he kanso evri show wey him get to play dis year as doctors don advise am to rest him bodi afta 2 years of wakarin upandan, all ova di world dey play shows.
Even di home coming show wey fans sopose enjoy dis decemba for Eko hotel and Africa shrine,no go appun again.
He beg all him fans make dem no vex as he get to bounce back veri strong next year afta he don rest.
Di bobo need di rest,bodi nor be firewood.

Thursday 8 December 2016

OUR WOMEN FOOTBALL TEAM,THE SUPER FALCONS,DON SEIZE Di AFRICA CUP WEY DEM WIN FOR CAMEROON LAST WEEK UNTiL GOVMENT PAY DEM DiA MONEY


Play,play,play,play,
Dis Buhari gofment  don dey turn somtin else o.
Wich one be say dem nor get money to pay for di gehs wey suffer,stroggle win di Africa women cup for Cameroon some days ago.
Dem carry ova 170 million Nigerians mata for head yet dem dey gidem stori.
Nff chairman Amaju Pinnick,don beg and xplain him mouth tear for di gehs but dem say no way Dem nor dey comot for di hotel wey lodge for Abuja until,dem pay dem.
Na wen dia sweat don dry bifor gofment go arrange dem dia small tin?
Na wa for dis pipo.

Wednesday 7 December 2016

OUR LEADERS GET TO DO SOMETHING ABOUT OUR KONTRi AS UNITED NATIONS DON PICK 'KIGALI' WEY BE Di CAPITAL OF RWANDA AS Di MOST BEAUTIFUL CITY FOR AFRICA



Two years ago,Wen my forma oga comeback from Kigali wey be di capita of Rwanda,he tell us say dat place neat die.
And now wey United Nations don choose am as di most biutifu city for Africa,I nor dey soprise.
Na only bad tins we for dey carry first.
Last year,na Port Harcourt airport win di most worwor airport for di world.
War niali skata Rwanda for ground and dia Lida's still get mind like dis.
E be like say na to sell dis kontri naim remain.

Tuesday 6 December 2016

IF U WAKE UP AND HEAR SAY GOVMENT DON BAN SUYA AND ISI-EWU ONE DAY,NOR SURPRISE BICOS MINISTA OF HEALTH,ISAAC ADEWOLE SAY ALL DIS FOOD DEY KILL NAIJA PIPO EVRiDAY


Na wa o!
Dem Don carry rish wia enjoyment dey?
I nor sure say dis one go work o,as many Naija pipo don disagree wit di minista of health professor Isaac Adewole say eating of suya,isi-ewu,kilishi,nkwobi,ngwongwo dey kill.
Akordin to di minista,all dis food nor good for bodi bicos dem dey add plenti salt and salt nor too good for bodi.
Also Mineral and all dis chocolate nor good for bodi too bicos of plenti sugar wey full inside.
He say all dis tins dey cause highpatenshon wey fit result to heart and stroke ploblem.
Di minista yarn all dis one for Lagos during di joinbodi sidon wey dem call,"first annual black tie gala" wey Tristate Heart Foundation organaiz.
Dem organaiz dis joinbodi sidon to raise N500 million naira wey dem go fit take dey trit pipo wey get dis ploblems.
But talk true Oga minista,
You nor dey eat all dis wackis wey u talk say make all mehn stop to eat?

Monday 5 December 2016

"SHUT UP YA MOUTH! KOREDE BELLO DON MAKE OVER N100 MILLION"..DIS NA WETIN DON JAZZY TELL ONE AMEBO BABE FOR INSTAGRAM WEY SAY KOREDE BELLO NA YEYE MUSICIAN



Some pipo own na to dey look for cheap populariti by fire,by force.
E nor tire you?
Don Jazzy don reply one babe on top Instagram wey say Korede Bello na di worst investment wey di Mavin Oga don sign.
Jazzy nor waste time to carpet her as he tell her to shut up her mouth and respet pipo wey dizav respet.
He say,Korede Bello wey she dey call worst investment don make over 100 million naira so make di babe show us her own worst investment wey don make dat kain money.
Di Mavin Oga also yarn say,nor be beans for Korede to get 1.9million followas for Instagram if he nor tight.
But Don Jazzy u for ask yor boy make he look di babe pishor weda na one of dose gehs wey he don break dia heart.
Dem nor dey know finish.
Worst investment ke!

Sunday 4 December 2016

HALLELUYA! UGANDA PROSTITUTE DON SURRENDER PACKET OF CONDOMS FOR CHURCH AS SHE GIVE HER LIFE TO CHRIST



Dis babe ashaworism bin strong bifor o!
Omo!
See as condom full ground.
Dis Uganda babe Niisima Allen,repent afta she attend Robert Kayanja Ministries Crusade for Uganda.
Dis one show say,even tho u be badoo for bad bizness,e nor dey late for you to giv yor life to Christ.
For you to make heaven akordin to di biliv of kristians U must give yor life to Jesus and dat na exactli wetin dis babe don do.
So wetin you dey wait for?

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...