MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 31 August 2017

INSTEAD OF HANDSHAKE AS REWARD WEY OBASANJO INTRODUCE,BUHARI DON SHOCK MANY PIPO AS HE GIVE N1 MILLION EACH TO NAIJA WOMEN BASKETBALL TEAM WEY WIN AFRICA CUP


President Buhari don dash each player of Nigeria women basketball team wey win di FIBA Africa basketball cup for Senegal,N1 million each.
Di money small if you konpiaram to wetin dem bin dey give most of our team and players anytime dem do us proud for kompetishon.
But during Obasanjo second coming as president from 1999 to 2007,na handshake and kpof kpof naim dem dey resiv afta dem win cup.
Since we know Buhari as pesin wey hate to spend money anyhow,we feel say di handshake govment go kontiniu but we shock say he still give each of dem N1 million naira.

Wednesday 30 August 2017

ONE BABE 'CHIOMA PIUS' DON TELL TORi PIPO SAY,SOME POLICE MEN FOR RIVERS STATE BEAT NONSENSE COMOT FOR HER BODY JUST BICOS SHE DRAW TATTOO



Chioma Pius don report policemen for Rivers state on top di beat wey dem beat her wen she dey travel from Bayelsa to Port Harcourt.
Dem stop her taxi for Elebrada junction,Emohua,Rivers state.
Akordin to Chioma,Di reason why police pipo beat her wit koboko and cane na bicos she draw tattoo for bodi.
And now she dey wonda weda to get tattoo for bodi don turn crime?

Tuesday 29 August 2017

POLICE DON ARREST PASTOR WIFE FOR AKWA IBOM STATE BICOS SHE ARRANGE HER OWN KIDNAPPING SO DAT CHURCH MEMBAS GO PAY N3 MILLION FOR HER RELEASE


Police for Akwa Ibom state don arrest one Victoria Elijah Ndu wey be pastor wife for Nsit Atai local gofment area,sake of say she plan her own kidnap.
Police reskiu her for Imo state but dem later find out say,na she plan her own kidnaping wit her junior broda Victor Okon Akang and dem don arrestam too.
Mrs Victoria bin plan her own kidnap so dat church membas go raise di N3 million wey dem put for her head.
We too wicked for dis world.
Imagine a whole pastor wife bicos of money.
Akwai Ibom state police command for Ikot-Abia don dey gada her konfeshon wey dem go take nail am last last.

Monday 28 August 2017

BIG BOY ACTOR,MOFE DAMIJO (RMD),DON YARN SAY,WETIN HIM HATE PASS FOR HIM LIFE NA TO SHAVE HIM BIA-BIA..HOPE SAY HIM DEY REMEMBA TO DEY SHAVE HIM ARMPIT SHA



Mofe Damijo nollywood fine man,Mr RMD,na beta lazy man bicos he don yarn tori pipo wit hin own mouth say,him lazy for one area and dat area na to dey shave him bia-bia.
He say,anytime wey work nor dey,he go just allow di bia-bia kuku grow.
He yarn say no be say him dey poposeli dey live di bears make dem grow but bicos e dey tire ram to shave.
If  RMD dey lazy to shave odnari bia-bia for face,you sure say if he show us hin armpit,man no go fain

Sunday 27 August 2017

FORMA MAN UNITED BADDEST DIFENDA,PATRICE EVRA, DON USE TUBABA EVAGREEN SONG 'AFRICAN QUEEN' TAKE SELIBRATE HIM MAMA AND ALL MAMAS ALL OVA Di WORLD


African Queen,di ogbonge song wey still dey put 2face for map till today,don kontiniu to kolet beta mention home and abroad.
Di latest pesin wey use di jam take selibrate na forma Man U and forma Juventus great difenda Patrice Evra.
Evra use di song take selibrate Mama dem all ova di world as he advice pipo make dem no use dia mama take play.
He even dey sing follow di song line by line.
He say him no dey like shidren wey no get respect for dia mama.
He yarn plenti tings and he say he love him mama plenti plenti.

Saturday 26 August 2017

MAJEK FASHEK DON YARN SAY WETIN MAKE DEM NO DEY USE AM PLAY FOR OBODO OYIBO NA BICOS OF Di TRAINING AND EXPERIENCE WEY HIM GET FROM FELA


Supastar Majek Fashek want make u know say,him no be odnari miuzishan but intanashona star.
Majek wey go selibrate him 30 years on stage on Septemba 10 wit ogbonge show,don yarn say,di Majek brand strong both for local and intanashona bicos of pipo like Fela wey train am.
Majek go also reliz him new album wey him call 'Weep not child' on di same day of di show.

Friday 25 August 2017

RAYMOND,Di ONLY PIKIN OF ONE OF Di BIGGEST ACTRESS FOR NOLLYWOOD,EUCHARIA ANUNOBI,DON DIE


Bad news no be wetin dey make pesin happy at all.
We join millions of Nigerians to say sorry to Eucharia Anunobi,one big Nollywood actress on di loss of her son.
Her only pikin,Raymond die on Monday at di age of 15 and akordin to tori wey we gada,Raymond dey suffer from sickle cell anemia.
May hin soul Rest In Peace.

Wednesday 23 August 2017

JARMIE VARDY,LEICESTER CITY FOOTBALL CLUB PLAYER SAY,HIM DON DEY LEARN NAIJA PIDGIN ENGLISH


England and Leicester city top striker Jarmie Vardy,don yarn tori pipo TheCable say,him don dey learn Nigeria Pidgin bicos na wetin Naija Leicester players Kelechi Iheanacho,Wilfred Ndidi and Ahmed Musa dey always dey yarn be dat.
Jarmie dey di same club wit dis three Naija bobos and he say dia Pidgin dey difficult foram to learn but base on say ogoro(frog) must jump,him don dey learn our Pidgin.
Akordin to Jarmie,he say Pidgin inglish hard to speak but him don dey go far for di language.
Nice one Jamie Vardy,remain amala,fufu,ogbolo soup wey dem go teach you.

ASSOCIATION OF NAIJA RATS DON WIN Di BATTLE OF WHO GET BUHARI OFFICE AS DEM DON DESTROY TINGS AND STOP BUHARI FROM USING Di OFFICE AFTA HE COMEBACK FROM LONDON


Rats don chase Buhari comot from him office as dem don take ova di president office.
Association of Naija Rats argument be say,na dem be di real owners of di office bicos Buhari abandon di office for a long time.
Dem say anytime dem come for visit dem no dey see di President for him seat and any office wey pesin live for ova 3 months,don automatikali turn dia own be dat.
Di sinior special assistant to di president on top tori mata,Shehu Garba,confam di tori as he say,yes na true say rats don take ova di office but dem don buy bombs,guns and rat poison wey dem go take kill di rats dem in three months.
For dis three months akordin to Garba Shehu,Buhari go dey rule di kontri and operate from hin house.
We dey wait to hear from di President of Di Association of Naija Rats about di bad plans wey Federa Gofment get for dem.
We go bring una any new tori wey come out as e take konsign di Presidency and di Rats association.

Tuesday 22 August 2017

PRAY FOR OLAMIDE AS DEM FIT PUTAM FOR PRISON AND ALSO PAY FINE OF 3 MILLION BCOS HE DON BREAK Di 2015 TOBACCO LAW AS HE ENKORRAGE SMOKING FOR HIM NEW SONG "WO"


All Olamide fans,make una fast and pray bicos he be like say he don enta Gofment wahala.
If Federa Gofment law for di 2015 Tobacco Control Act gbab Olamide,naim be say dem go troway am for prison for one year and he go also pay fine of N3 million naira sake of say,he promote smoking for di video of him new song "Wo".
Di Federa Ministri of Health some days ago don dey ago dey yarn say Olamide new song "Wo" wey don enta evriwia like fever,no good for public health reasons.
Law na Law and we don see wia laws of many kontris land pipo for ploblem.
Although Dem neva charge am to court but we wey know efritin about Naija law,don dey beg Olamide loyal fans make dem bigin 40 days and 40 nights prayers and fasting bicos di law fit sink dis shakiti bobo.

Monday 21 August 2017

BURNA BOY DON YARN SAY,WETIN MAKE AM NO GET FRIEND FOR Di INDUSTRY BE SAY,MANY OF DEM HATE TRUTH..DAT IS WHY HE LIKE TO DEY DO TINGS ALONE


Burna Boy one of Naija baddest Reggae and Dancehall miuzishan,don yarn tori pipo say him no be dat rain miuzishan wey dey like add salt and pepper join stori.
He say di kain life wey him dey live be say,him dey yarn mata di way wey mata be.
Burna say all dis one naim make am no get frend for di industri.
Akordin to Burna Boy,he say if u offend am,him go tell u to your face say u offend am,and afta dat he don waka.
But he say for dis industri,if u yarn truth,he go be like say na you be di bad pesin and dat is why,he no get plenti frends for di industri.

Sunday 20 August 2017

EVERYDAY NAIM I DEY CRY BUCKET FULL AFTA MY WIFE RUN LIVE ME - EMEKA IKE,NOLLYWOOD ACTOR


Nollywood actor,Emeka Ike wey him marage to him wife Suzanne Emma,don skata for sometime now,don confess say,afta di wife live,na evriday him dey cry like pikin.
Emeka say,no be say to put anoda woman for house naim hard am but he need to do di right ting bicos Di woman na mother of dia four shidren.
He say him still love him wife but he biliv say di wife no know wetin him dey do.
Akordin to Emeka,wen he meet him wife for street,she telam say she no get papa and tins roff  but he givam hope say make she no worry him go be him papa,him go take kia of am.
Since den,him don build house for her famili for Lagos and also for Isoko,Delta state.

Saturday 19 August 2017

AY COMEDIAN JUNIOR BRODA,YOMI CASUAL,DON YARN SAY,HE ENTA KEKE NAPEP FOR Di FIRST TIME FOR HIM LIFE DIS WEEK BUT WE NO KNOW WEDA HE DEY LIE SHA


Yomi Casual,Ay Maku di comedian junior broda,don yarn tori pipo say,him enta keke napep for Di first time for him life dis week wen he visit Warri.
He post dis tori on top Instagram and nor be small yab dem don yabam say na lie go killam.
Wen Ogakpatakpata visit him Instagram page,he don alreadi comot di pishor but bifor he removam,we don copy di foto take.

Friday 18 August 2017

GHANA DON BAN BLEACHING CREAM BICOS Di CHEMICAL WEY DEM TAKE DEY DO DIS CREAM,DEY AMONG WETIN DEY CAUSE SKIN CANCER



Our neighbors Ghana,don ban bleaching cream.
Di CEO of di Food and Drugs Authority (FDA), Mrs Mimi Darko,yarn say,dem don even stop to regista any konpini wey dey dia bizness na to sell bleaching creams.
Di reason why dem banam be say,Hydroquinine wey be di chemical wey dem take dey do am,dey cause skin cancer.
To make sure di mata no end for dia,Ghana FDA don dey go from place to place dey teach market women and oda pipo why bleaching cream no good for dia bodi.
Sista caro,sista Abigail and all Naija girls,Una don hear about skin cancer bifor?
Try Go write am down bicos black is biutifu.

Thursday 17 August 2017

Di RICHEST BLACK MAN FOR Di WORLD ALIKO DANGOTE DON YARN SAY,IF HE BUY ARSENAL,Di FIRST TING WEY HIM GO DO NA TO SACK ARSENE WENGER


Aliko Dangote,di richest man for Africa and di richest black man for di world don yarn tori pipo say,if he fit buy Arsenal football club one day,Di first ting wey him go do na to sack dia coach,Arsene Wenger.
Akordin to Dangote,he say no be say di coach neva try o,but him go sackam so dat oda pipo go try dia luck bicos dem no plant Arsene Wenger placenta for dat seat.
Dangote don dey arrange plans to buy Arsenal for future and he dey hope say,afta he finish him refinery wey him dey build,him pocket go large reach to buy di club.
He also dey hope say,wen he don readi,God go touch di owners heart to sell di club toram.

Wednesday 16 August 2017

I LIKE TO MARRY HUSBAND WEY BE SAY,IF I MESS HE GO TELL ME SAY,THANK YOU MY LOVE EVEN IF Di MESS DEY SMELL...DAT NA WETIN NOLLYWOOD ACTRESS,ANITA JOSEPH TALK


Nollywood starbabe,Anita Joseph,don yarn tori pipo say,she go use mess kill her husband for house.
Akordin to Anita wey her yansh big pass katapilla,she say she go like to marry hosband wey be say,if she mess for house,di husband go tell her say,thank you madam for di wondafu mess.
She say she dey veri kiafu about di man wey she go spend di rest of her life wit bicos of tings like dis.
She say she and her husband go dey do messing kompetishon for house.
Una fit do annivasri join sef if una like nobodi go arrest una.

Tuesday 15 August 2017

VEXi VEXi PLAYER,DIEGO COSTA DON TALK SAY,HE NO WON PLAY FOR CHELSEA AGAIN BICOS Di CLUB AND Di COACH ANTONIO CONTE,DEY TREAT AM LIKE CRIMINAL


Diego Costa of Chelsea,don blast di club and him Coach Antonio Conte say,dem dey tritam like say him kill pesin and like say him thief biskit.
He say him no be kriminal,he no undastand why Chelsea dey tritam like krimina.
He say di coach na wicked pesin and him no wan play for Chelsea again and he dey use God beg dem make dem try sellam to Athletico Madrid wey don show am say dem like am.
Diego still dey Brazil dey enjoy him holiday as he don vex say him no wan play for Chelsea again bicos of how Dem tritam.
Chelsea sef don kukuma telam say,until he rezoom dem no go pay am salary again.

Monday 14 August 2017

NOLLYWOOD LOVERBOY EMEKA IKE,WEY JUST COMEBACK TO ACTING,DON YARN SAY,NA BEG DEM BEGAM FOR OVER TWO YEARS BIFOR HE AGREE TO COMEBACK


I nor know who neva hia about Emeka Ike for Nollywood but in case u neva hia about am bifor,na popular face wey form lovaboy tire and use girls eyes see shege for nollywood.
If u dey put eye for ground welwell,u go notice say Emeka Ike no dey appia for home vidio nawadays.
Emeka wey turn 50 years dis year,don yarn tori pipo say,wetin make am agree to comeback to acting na di pressure wey him get from one producer wey begam tire for ova two years to show face for him film.
No wahala we don hear.
We bin tink say your pocket dey leek naim ma

Sunday 13 August 2017

OGA BUHARI SAY HIM NEVA READY TO COME BACK FROM LONDON BICOS HIM DON LEARN TO DEY RESPECT AND OBEY HIM DOCTORS ADVICE


If you dey expect President Buhari to comeback from London veri soon to come do di work wey dem vote foram to do,naim be say you dey disiv yasef.
Buhari wey travel go London go trit sickness,don spend 97 days for yonda.
Many pipo feel say,fear go katcham run back to Naija bifor our house of rep pipo go use law take remove vam.
But for wia!
Di man say,him doctors say make him no rush comeback since di sickness for him system neva clear.
He yarn dis one afta him padi like Lai Mohammed,Femi Adesina,Garba Shehu,Abike Dabiri and others visitam for London .
My ploblem wit Buhari and oda of our leaders wey nor dey use dia nomba six be say,how much di owners of di hospita take build and buy tings for di hospital for London?
E pass N50 billion for example?
So we nor get N70 billion to take build our own hospita wey go beta pass di London hospita for our kontri?
Yeye rili dey smell.
Dis kontri don cast.

REEKADO BANKS: EVERY MAN GET WETIN GO KILLAM,ME NA BREAST GO KILL ME


Some pipo say na tea kill M.K.O Abiola for prison and dem say na sickness kill Yar'Adua but one man don talk wetin go killam.
Him name na Reekado Banks and he don tell tori pipo say,na breast go kilam.
Di singa yarn dis one on top twita.
From tori wey we gada di bobo no dey use eye see breast.
Girls,Una don hear o.
For those of una wey dey eye di boy,make una use iron bra protect una breast o.
if not,Reekado get bad plans for una Bobbi o.

Saturday 12 August 2017

NOLLYWOOD LOVERBOY EMEKA IKE,WEY JUST COMEBACK TO ACTING,DON YARN SAY,NA BEG DEM BEGAM FOR OVER TWO YEARS BIFOR HE AGREE TO COMEBACK


I nor know who neva hia about Emeka Ike for Nollywood but in case u neva hia about am bifor,na popular face wey form lovaboy tire and use girls eyes see shege for nollywood.
If u dey put eye for ground welwell,u go notice say Emeka Ike no dey appia for home vidio nawadays.
Emeka wey turn 50 years dis year,don yarn tori pipo say,wetin make am agree to comeback to acting na di pressure wey him get from one producer wey begam tire for ova two years to show face for him film.
No wahala we don hear.
We bin tink say your pocket dey leek naim make you comeback.

Friday 11 August 2017

FELA FIRST DAUGHTER,YENI KUTI,DON TALK SAY,WE SUPPOSE TO DEY FORCE OUR LEADERS TO SWEAR WIT JUJU SO DAT FEAR NO GO MAKE DEM DEY THIEF OUR MONEY WEN DEM DEY RULE


Fela daughta Yeni Kuti don yarn say we need to introduce juju enta our gofment.
Akordin to Yeni,she say bifor our leaders enta gofment,if dem swear wit juju,fear no hope allow dem to dey thief our money again.
She say dis juju go stop koropshon and make Nigeria beta.
Yeni Kuti yarn dis one during one joinbodi talku talku show for Classic Fm 97.3,Lagos.

Wednesday 9 August 2017

NOLLYWOOD BABE,TONTO DIKEH,WEY HER MARRIAGE TO CHURCHILL DON SCATTER LIKE DADA WEY DEM NO COMB,DON TALK SAY,SHE GO MARRY ANODA MAN WEN SHE SEE TRUE LOVE


Drama and home vidio babe Tonto Dikeh,don yarn tori pipo say,she go marry again anytime wey she see true love.
If u dey follow up,you go know say for ova three months now,Tonto Dikeh marriage to Churchill Oladunni Olakunle don krash but di babe don yarn say she don enta market again.
But dis time she say if she wan marry,it must dey base on true love.
Na wa o.
Make God lead us to wia we go get evalasting appiness for dis life.

Tuesday 8 August 2017

TODAY TORi: YOU DON HEAR SAY LAGOS WAN ORGANIZE BEER FESTIVAL FROM SEPTEMBA 25 TO OCTOBER 1,2017 FOR Di FIRST TIME FOR NIGERIA?


If u neva hear,lagos state don dey arrange plans to add anoda festival join New yam festival and oda types of festivals wey dey appun for dis kontri.
Di name of di festival na Beer Festival.
Akordin to di organaizas,di festival go appun from Septemba 25 to Octoba 1 wey fall for indipendens day and entatayment go berekete.
Di general manager of 001 limited wey dey arrange dis Beer and alcohol festival,Mr Akinola Oluwaleimu yarn say,dis show go bring plenti pipo to visit Lagos from different part of di world bicos for Germany wey dis kain festival for start,ova 50,000 pipo dey visit dem to jolificate.
Now many kontris for di world for Europe and America sef don dey arrange dis festival.
During dis festival for Lagos,alcohol and beer kompini go get chance to bring dia shacks come di venue and krate awianess.
I hope say pipo no go dey use dia head waka go house wen dem don drink beer full face?

Monday 7 August 2017

BIG NAMES! NICKI MINAJ AND WIZKID FOR DIS FOTO FOR STUDIO,JUST CHILL OUT TOGEDA (PHOTOS)




Dis boy Ayo Balogun a.k.a Wizkid don waka far.
Biggest hip hop female artiste for world Nicki Minaj for dis foto,hang out wit Starboy Wizkid for wia we biliv say na studio.
And for studio like dis,na miuzik pipo dey record.
So e dey posibo say somtin dey unda pipeline from dis two supastars.
We dey wait jejeli but we neva know how Wizkid bigest rival Davido go feel if he see dis pichors bicos for some time now,dis two bobos dey form cat and rat.
Di swit ting for dis Mara be say,na Nicki Minaj use her hand post dis pishor for her Instagram page.

SURPRISE AS ONE SHOOTING STARS FOOTBALL CLUB FAN AND STADIUM WORKER,FAINT YESTADAY AFTA GOMBE UNITED SCORE GOAL AGAINST Di IBADAN CLUB


Shooting stars football club(3SC) fan and steward,faint yestaday during dia match against Gombe United for Ibadan stadium.
Imidiatli Gombe United score,Na so di bobo faint but thank God say pipo dey dia as dem wake am up  bifor he go kpoof troway bicos of football.
Di match later end 2-1 in favour of Shooting Stars football Club.

Sunday 6 August 2017

BREAKING NEWS! POLICE DON CONFAM Di KILLING OF 8 PIPO DIS MORNING BY ONE GUN MAN FOR ANAMBRA DURING SUNDAY MASS FOR SAINT PHILIPS CATHOLIC CHURCH


One gun man dis morning,don shoot 8 pipo die and oda injured for Saint Philip Catholic Church for Amakwa Ozubulu,Ekwusigo local govment for Anambra state.
Akordin to di komishona of police for di state,Mr Garba Umar,he say,di man wey shoot dem wear mask and he dey speak strong Ibo language as he dey shoot.
We neva hear dis kain ting bifor say Ibo man or any oda tribe enta church go shoot pipo die for dis kontri.
Di only pipo wey dey do dis kain ting wey we know na Boko Haram and oda groups wey no biliv in di Christian religion.
We dey wait to hear from di church membas and dia priests to confam weda wetin police yarn na true.

Saturday 5 August 2017

AMERICA DON FINALLY AGREE TO SELL WAR PLANES GIVE OUR COUNTRY NIGERIA SO DAT DEM GO FIT FIGHT TERRORISTS WEY DEY GIVE NAIJA PROBLEMS



Finalli finalli,di America gofment don agree to sell war planes give Naija gofment so dat dem go get plenti pawa and weapons to take fight Boko Haram and ISIS West Africa branch.
Bifor now,dem bin no send us again espeshali afta our Air Force bomb innocent pipo by mistake instead of Boko Haram for Borno state.
Dis weapons go cost Nigeria gofment $593 million dollars to buy.


Friday 4 August 2017

REEKADO BANKS Di 23 YEARS OLD BOBO AND DON JAZZY BOY,DON TELL TORi PIPO SAY,HIM DEY BUILD PRIMARY AND SECONDARY SCHOOL FOR LAGOS


Don Jazzy boy and one of di Mavin Record crew memba,Reekado Banks,don yarn tori pipo say him don start to build school for Lagos.
Akordin to Reekado,he say him no dey for 'groove and die type of lifestyle' as him don dey build primary and secondary school for Lagos.
Him no wan hear say him dey katch winsh tomorow if hunga start dats why him dey plan him tomorrow,today.
Unlike many miuzishans wey dey buy club dry and buy di latest cars take oppress street and at di end of di day dem go broke lastlast.

Thursday 3 August 2017

YORUBA ACTRESS RONKE OSHODI SAY,IF SHE GET MONEY PASS HER HUSBAND AND NA SHE DEY TAKE CARE OF DiA HOUSE NAiM BE SAY,SHE CAN NEVA ENTA KITCHEN COOK FOR Di MAN


Make God no allow pesin wife get money passam for dis life if not,di man go chop shit if she marry pesin like Oshodi Oke.
Di Yoruba actress naim use her mouth talk am say,if she dey pay house rent and her hosband fold hand dey look and if na she dey bring money to take kia of di house,naim be say,she can neva enta kitchen cook for dat man.
All bobos,make una double una hussle if una no want make woman take u turn slippas and rag for house.
Watch di Ronke video for bottom hia....


Wednesday 2 August 2017

FORMA MTN PROJECT FAME WINNER MONICA OGAH TALK SAY,HER PAPA DON WARN HER NOT TO CARRY IGBO MAN COME HOUSE FOR MARRIAGE BICOS HE NO GO SUPPORT DAT KAiN MARAGE


Monica Ogah di Benue state shenkess wey win Mtn project fame some years ago,don yarn on top twita say her papa say,if she bring Igbo man come house,na be say she dey on her own.
Her papa no want make she marry Ibo man and Monica her sef dey soprise as she kon dey ask her fans say wetin dey wrong wit Ibo men.
Di queshon be say,anytin dey wrong to marry anoda tribe?
Na her papa sopose ansa dis queshon.

Tuesday 1 August 2017

WIZKID WEY DEY NAIJA DEY CHILL RIGHT NOW FOR HOLIDAY,DON SETTLE WIT Di BOY WEY HIM FOLLOW FIGHT FOR CLUB SOME DAYS AGO FOR LAGOS


Some days ago,video of Wizkid wey dey getam hot wit one bobo wey try to snapam foto,come out.
For di video,Wizkid dey fight di boy afta he try to take am foto and many of him fans no hapi witam at all.
But afta about two days,Wizkid don hang out witam and dem don settle dia fight.
Na so e suppose be espeshali wen u know say u no try for some kain tings.
Oya watch di video of dia settlement for bottom hia...


LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...