MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 31 March 2017

PRESIDENT BUHARI DON DEY PREPIA TO TRAVEL TO LONDON AGAIN TO SEE DOCTORS FOR TREATMENT 3 WEEKS AFTA HE COMEBACK


President Muhammadu Buhari wey come back from London from him sick leave three weeks ago,don dey prepia to go back for follow up tritment.
We nor know who we go biliv again.
Di same Aso Rock tell us some days ago say dem go bring di doctors come Naija to come trit Buhari but today now,na Buhari go enta yonda again.
Well,e nor kuku konsign me.

Thursday 30 March 2017

MAYORKUN,ONE OF DAVIDO BOYS DON YARN SAY,HE FIT SLAP HIM MAMA BICOS OF N350 MILLION NAIRA IF YOU PROMISE TO GIVAM



Mayorkun di eleko singa and one of Davido DMW Records artiste,don tell tori pipo say,to slap him mama bicos of 1million dollars wey be ova N350,000 million for Nigeria money,na small ting.
During di joinbodi intaviu wit Nancy Osime of sound city,Mayorkun say,he mama go vex slapam if him nor slap him mama bicos of dat kain plenti money.
Wetin money go cause ehn,we neva see the end.
Oya watch di video for bottom hia...


Wednesday 29 March 2017

BREAKING NEWS: ALMIGHTY BRAZIL DON BECOME Di FIRST COUNTRY TO QUALIFY FOR RUSSIA 2018 FIFA WORLD CUP AFTA DEM WIN PARAGUAY 3-0


Marcelo,Miranda,Neymar,Coutinho,Paulinho,Firmino don joinbodi wit oda membas of di Brazil national team to giv Paraguay 3 kondo to make dem di first kontri wey kwolifai for Russia 2018 FIFA World Cup.
Na Coutinho,Neymar and Marcelo skor di 3 goals for dem early dis morning against Paraguay and dis one make dem di first kontri to kwolifai for di 2018 World Cup.
Make we see wetin dem go play afta Germany show dem pepper for di 2014 World Cup wey di world gada play for Brazil.
Germany win dem 7-1 and na dia worst eva result be dat.

OLD NEWS: IGBO PIPO ABEG MAKE UNA REDUCE Di BRIDE PRICE OF OUR GIRLS..DAT NA Di BEG WEY FORMA GOVNOR OF ANAMBRA STATE MR ROBERT AKONOBI DEY BEG BE DAT


I neva know how some papa and mama wey come from igboland go resiv dis news.
Di forma khaki uniform Gofnor of Anambra state Colonel Robert Akonobi,don kneel down dey beg igbo pipo make dem take am easy wit di big bride price wey dem dey kolet on top girls head.
He say make dem try reduce di bride price so dat boys go fit dey marry dem.
He yarn dis one for Nnewi,Anambra state during di marage serimoni of bizness man Louis Onwugbenu daughta,Onyinye and her hosband Bosah Chukwuogo.
Nor be news say girls from di east bride price dey veri costli.
So make we see weda e go change as true true many men dey run from Igbo girls bicos of large bride price.

Tuesday 28 March 2017

AFTA WIZKID AND SKALES LIVE BANKY W GANG GO START LIFE FOR SOMEWHERE ELSE,SHAYDEE DON ALSO COMOT GO CANE HIM OWN LINE


E don favour some pipo why e affect some pipo afta dem live dia oga to go arrange dia life for some wia else.
Afta Wizkid live Banky W and EME Records,di bobo don hama sotaaay,Yankee carry him mata for head.
Skales nkor,he nor dey do bad since he live Banky W.
And now Shaydee don waka.
Make we dey see how hin mata go be.

Monday 27 March 2017

Di BABE FOR IBADAN AYOMIDE LABINJO WEY SAY NA DAVIDO BE Di PAPA OF HER 3 YEAR OLD DAUGHTER DON TALK SAY,SHE ADVICE DAVIDO TO WEAR CONDOM BUT Di BOBO NOR GREE


E be like say we neva hear di last word for Davido and di babe wey say naim giv her belle born her 3 year old daughta.
Akordin to di babe Ayomide Labinjo,she say wen Davido come Ibadan,dem two enta one hotel and Davido sleep witam witout condom.
She say she advice di bobo to use condom but Davido say him nor like condom at all.
Na wa o,dis konji na pure bastard!
What if...

Sunday 26 March 2017

SINGA 9ice DON YARN SAY,NO BE BY FORCE TO MARRY AND IF YOU NOR MARRY,E NO MEAN SAY GOD GO PUNISH YOU


9ice,one of di supastar wey him miuzik skata evriwia for inside and outside naija,don yarn say,God no go punish who no marry bicos no be by force to marry.
Di baddest bobo wey get four shidren right now from three diferen women,yarn dis one wen tori pipo askam weda he go marry any of dem.
Akordin to 9ice he say di most impotant ting na happiness and dia is no garanti say na evribodi wey marry dey hapi.

Saturday 25 March 2017

DAVIDO DON ADVICE PIPO MAKE DEM NO LOOK DOWN ON NEW MUSICIANS BICOS NAIM BRING TEKNO AND RUNTOWN COME OUT AFTA HE JOIN DEM SING WEN NOBODY KNOW DEM


Davido wey him new jam "if" dey skata evriwia right now,don yarn say,make we nor look down on upcoming miuzishans bicos nobodi know tomorow.
He say naim make Tekno and Runtown miuzik dey reign today afta dem fichoram for dia first real tracks.
Davido joinbodi for Tekno song,Holiday and today di bobo na one di biggest Naija miuzishan.
Also,he join Runtown sing Galardo and today,di bobo sef don large.
Davido yarn all dis one on top him Snapchat page.
Nice one but Davido forget to tell us who make he imsef blow too if na by last ke dat.
Davido first real song,"Back When" naim blow am afta he joinbodi singa wit Rapper Naeto C.

Friday 24 March 2017

LAFF WAN KEE ME! SEE Di INITIATION CEREMONY FOR NEW SUPER EAGLES PLAYERS (VIDEO)


Super Eagles players dey London right now sake of di two frendli match wey dem get against Senegal and Burkina Faso.
Dem play Senegal yestaday and di match end for 1-1 draw but bifor dem play di match,dem do welkom serimoni for di new playas wey Super Eagles Coachee Gernot Rohr invite.
I nor fit laff alone,
Watch di video for bottom hia...


OLD TIME MUSICIAN EEDRIS ABDULKAREEM,DON TELL 2FACE MAKE HE SHUT UP BICOS NA BLACKFACE MAKE AM WHO HE BE TODAY


Afta 2face cancel Di protest wey him plan to do against Buhari gofment last month,some of him old frend like Eedris Abdulkareem still dey vex foram.
Akordin to Eedris,he say na love songs dem know 2face for and to give girls belle.
He wonda wetin pusham say he won protest against Buhari gofment wen he know say him pawa nor carry am.
Eedris also yarn say anoda ting wey pain am be say,2face disapoint Daddy Showkey afta he fail to show up make dem record for studio togeda.
No be only wetin Eedris yarn be dat o,he also blast 2baba say,na Blackface make am who he be today since na di bobo write all him swit songs foram.
So diafor,make 2face dey respect pipo.
Oya watch di yabis vidio for bottom hia...


Thursday 23 March 2017

MR IBU SAY,KIDNAPPERS KIDNAP AM TIRE AND DEM USE AM TAKE DO CUSTOMER BICOS DEM FEEL SAY HIM NA RICH MAN


Pipo like Davido wey dey boast say he get 30 billion for him account,make sombodi telam to read dis tori as Mr Ibu di biggest Mumu for nollywood don yarn say,kidnappers use hin eye see pepper as dem kon dey feel say him na rich man.
He yarn tori pipo say,from now on,him nor go dey show di world say him get fine cars or build fine house bicos na wetin make kidnappers use am do customa be dat.
Good for you Mr Ibu as you don learn from your mistakes.

BASE ON LOGISTICS,MEET Di POPSIE AND MUMSIE OF BIG BROTHER NAIJA EFE


For local palace yarnings,dem say Warri nor dey carry last kpatakpata na draw.
We go know by next month weda Efe, one of di major bobo wey pipo dey tip to win dis year Big Broda Naija,go win true true.
Di bobo free dis week as he nor go dey among di pipo wey dem go remove from di house dis Sunday bicos naim be head of house.
Many pipo don dey yarn since say Efe get strong face wey fit make pikin dey cry but we sef nor know who he use am rezembo.
Anyhow meet Efe Maale and Paale for dis foto as dem dey expect dia pikin to carry di N25 million wey dem dey fight for Put for Ghana must go bag come house.

Wednesday 22 March 2017

BETA PIKIN: OBAFEMI MARTINS DON BUY WHEELCHAIR AND CRUTCHES GIVE SOME NAIJA PIPO WEY NEED AM




Naija futbol star,Obafemi Martins,don buy wheelchairs and crutches giv pipo wey legs and hands dey pain.
Martins wey don play futbol for Italy,England,Spain,America,China,do dis one tru him foundation.
Him frends and workas for di foundation na dem waka go drop di gifts for dis pipo.
Na dis kain good dey make God mind dey swit.
God bless u obagol.

Tuesday 21 March 2017

PAUL PSQUARE DON TALK SAY,HIM DON TIRE FOR NAIJA PIPO BICOS IF YOU HELP PESIN FOR PUBLIC,PIPO GO TALK,IF YOU HELP FOR SiKRiT PIPO GO STILL TALK


One of di Psquare brodas,Paul don talk say,him nor dey undastand naija pipo.
He say if you epp pipo wey dey in need for publik,pipo go say you dey show yasef and if you epp for sikrit,dem go say,you too stingy.
Wich way Naija?

Monday 20 March 2017

COMEDIAN BASKET MOUTH,DON TALK SAY,HIM NOR GO EVER CRACK YEYE JOKE ABOUT Di NIGERIA POLICE AGAIN AFTA DEM HELP AM RECOVER HIM PHONE


Big name Komedian Bright Okpocha a.k.a Basket Mouth don yarn tori pipo say,him nor go eva crack any rotten joke about di Nigeria police again afta di good work wey dem do foram.
Dem eppam rekova him phone wey dem tiff and also hin propatis wey arm robas come tiff some months ago.
Akordin to BasketMouth he say,him nor biliv say he go fit get him phone back but di Nigeria police force soprise am and so diafor,him nor go eva insult police again thru him joke.
So if you nor gain from police again pasonali,you for kontiniu to crack jokes to insult dem?
Yeye dey smell.

Sunday 19 March 2017

TONTO DIKEH DEY SMOKE IGBO AND DRINK OGOGORO LIKE MAD AND SIX MEN NOR GO FIT HOLD HER IF SHE DEY VEX-HUSBAND


Nor be news say Tonto Dikeh and her hosband Churchill kwanta don rish boiling point.
Dia quarel dey worse evriday.
Tonto Dikeh don call Churchill plenti names like woman beater,419 since dia quarel start.
And now Churchill don clear tori pipo say,she dey lie too mosh.
He say Tonto Dikeh don destroy like N66 million propatis for him house plenti times.
Churchill say Tonto Dikeh dey smoke igbo and shack alkohol to pieces.
He also yarn say if Tonto Dikeh vex,six pipo nor fit hold her down.
So how he won take beat dat kain pesin?
Trust Tonto,she go reply di hosband again.
We dey wait.

IYANYA DON YARN SAY,Di REASON WHY HIM AND ACTRESS YVONNE NELSON BREAK UP NA BICOS,HIM NOR GO FIT DEY PURSUE MONEY AND LOVE Di SAME TIME


Kukere masta Iyanya,don yarn say,him break up wit Ghana babe and actress Yvonne Nelson bicos to dey pursue two rats at di same time,nor be beans.
He say wen hin miuzik kukere dey reign,him dey get like four shows evri week and he also dey get like N2 million for dat week.
Meanwhy,di babe dey stay Ghana and him dey stay Naija.
Di distance akordin to Iyanya nor epp matas.
Instead to dey fly evri week to see Di babe for Ghana,he kukuma choose to dey fly go kolet him N2 million for diferen diferen shows.
But Iyanya,I bin hear say,love nor dey ask why dat year now.
Dat girl readi to pack come meet you for anywia you dey stay.
Anyway,Iyanya we don hear,we dey wait for wetin Yvonne Nelson go yarn for dis mata.

#BIGBROTHERNAIJA: FINALLY WE DON KNOW Di GUY WEY GET Di BIG VOICE BEHIND BIGGIE



Afta weeks of guessing who get di voice behind Big Broda Naija,"Biggie",we don finalli know who di pesin be.
Many pipo bin feel say,na Nollywood actor Yemi Blaq get dat voice.
Some also feel say na me but not until sombodi talk say na Frank Idoho of 'Who wants to be a millionaire' naim be biggie bifor di truth kon come out.
Frank Idoho naim later leak di sikrit on top twita afta he read di bobo message.
Him name na,Ejike Ibedilo,Nollywood actor and forma prezenta for Cool Fm Radio Station for Lagos.


Saturday 18 March 2017

E DON HAPPEN AGAIN AS ONE BABE AYOTOMIDE LABINJO FOR IBADAN,DON CLAIM SAY NA DAVIDO BE THE FADA OF HER THREE YEARS OLD DAUGHTER

Sophie Pikin and Labinjo Pikin Resemble For dis pishor Welwell
Di way wey di tin dey go nawadays,no week wey u no go hear say Davido giv girl belle.
If he nor dey fight on top twita wit Sophie him pikin mama,he dey pop champagne wit plenti girls for video.
Last week,rumor enta town say,he don giv one Amanda belle for America and di babe go soon born.
Him kukuma neva deny yam.
Now since yestaday,one girl for Ibadan Ayotomide Labinjo,don come out to say Davido naim be di fada of her three years old daughta.
Akordin to Punch Newspapers wey bring out di tori,di babe say di two times wey Davido don play enta Ibadan for groove,dem two don use di two night do kerewa for hotel.
Although Davido don deny say nor be him be di papa.
Even di test wey dem do bifor dis tori come out,also show say nor be Davido be di papa.
Meanwhy,Labinjo and her mama say na fake result di hospita wey do di test bring come out.
But make we talk truth,di girl pikin rezembo Sophie pikin finish if you check dis pishor wey carry di two daughtas.
Who kon dey lie for di mata?
Davido and di hospita?
Or di girl and her mama?
We know say we neva hear di last word for dis mata.
Always check back as Ogakpatakpata go bring una more tori as e take konsign dis mata wen e come out.

Friday 17 March 2017

EKITI STATE GOFNOR,AYO FAYOSE DON TALK SAY,OBASANJO NAIM BE FADA OF CORRUPTION FOR NAIJA BICOS HE DON KOLOBI PLENTi OF OUR MONEY TO MAKE IMSEF VERi RICH


Oboy,dis kain Obasanjo and Fayose fight tire me o.
Nobody know wia dis dia fight come from.
I wonda Wetin be di root of dis dia fight.
Di latest one now be say,Fayose di Ekiti state gofnor say,Obasanjo don kolobi our Naija money to make imsef rich pass world bank.
Fayose Abeg kpror.
Wich of una nor dey kolobi Nigeria money?

Thursday 16 March 2017

MAJEK FASHEK DON CALL TIMI DAKOLO LAZY THIEF WEY NOR FIT WRITE HIM OWN MUSIC BUT DEY THIEF SONG WAKA


Di rain maker and send down the rain singa,Majek Fashek don blast Timi Dakolo again afta he say Timi na lazy miuzika tiff.
For some time now,Majek and him manager dey vex for Timi say he remix 'send down the rain' witout dia pamishon.
Timi imsef don show us receipt of N500,000 wey him pay bifor he sing Majek song.
But Majek Fashek nor won hear any of those exkiuz.
Na only God know wich manager he pay to.
Abi dem don skamam?
But come o,
Timi u get heart o!
You pay N500,000 for one of Nigeria biggest song and dem dey pay Wizkid N10 million bicos he sing Daddy yo.
All dis boys una nor get conscience o.
Watch Wetin Majek yarn for di video for bottom hia...


Wednesday 15 March 2017

KOGI STATE GOVNOR YAHAYA BELLO DON APPOINT DAUGHTA OF Di SOIL AND NOLLYWOOD ACTRESS MERCY JOHNSON AS SENIOR SPECIAL ASSISTANT TO HIM GOFMENT


More jobs don dey come Nollywood madam Mercy Johnson life but dis time around nor be script from home vidio.
Her State Gofnor Yahaya Bello,don appoint her as di Spesha Adviser on top entertainment mata for her state.
Dis one na more responsibiliti as she need to take kia of her three shidren,her acting and now her new job.
She nor need to share her bodi,na just propa planning.
Ogakpatakpata dey wish u luck for yor new position.

Tuesday 14 March 2017

BUHARI DAUGHTA ZAHRA BUHARI,DON TALK SAY Di LOVE WEY HIM PAPA GET FOR NIGERIA,NOR BE MOIN MOIN LOVE BUT CORRECT LOVE


Biutifu daughta of President Buhari,Zahra,don yarn tori pipo say di love wey her papa get for Naija nor be beans.
She say Buhari too love Nigeria.
Akordin to Zahra,if u listen to Baba dey yarn about dis kontri,u go dey soprise say di love na from di bottom of hin heart.
Na wa o.
Who go say hin mama soup nor swit?

Monday 13 March 2017

SINGA OMAWUNMI DON YARN SAY,FELA MUSIC CAN NEVA DIE


Singa Omawunmi don yarn tori pipo say,di King of Afrobeat miuzik Fela fit don die since but hin miuzik can neva neva die.
She yarn dis one base on di Fela show wey dey come up dis Easter and na Smooth Fm Lagos naim dey arrange di show.
Omawunmi also yarn say,dat kain pesin wey use di only weapon wey him get miuzik,take make beta name for di world,dat kain pesin name nor fit die lai lai.

Sunday 12 March 2017

BABA IBEJI: REAL MADRID STAR CRISTIANO RONALDO DEY EXPECT TWINS,TWO BOYS VERY SOON FROM ANODA SiKRiT BABY MAMA


Four times world player of di year,Cristiano Ronaldo,akordin to tori wey dey rish our yard,don tell close frends say him go soon turn Baba ibeji as him dey xpect twins boys from him sikrit America babe.
If u rememba,na di same sikrit way Cr7 take get him first boy as till today nobodi know who di mama be.
Akordin to di tori,Ronaldo fil say time don rish for him first son to get brodas wey him go grow up wit.
Ronaldo mama Dolores,go take kia of dem afta di America babe born dem.
Trust me,money for pampas nor go be ploblem since dia papa bank accounts large like mad.

Saturday 11 March 2017

DAVIDO DON CONFAMAM SAY HIM GIRLFRIEND FOR AMERICA DON GET BELLE AND HIM DEY EXPECT HIM SECOND PIKIN


Afta Sophie Momodu born di first pikin Imade for Davido,di Dami duro singa,don dey xpect anoda pikin from Amanda him babe for Atlanta,America wey him don giv belle.
Maybe he won do konpetishon wit 2face,Flavour and Wizkid.
2face get seven shidren from three differen women,Flavour get two from two women,di same tin wit Wizkid wey also get two from two diferen women.
Davido,Welkom to dat strong klob of baby mama and baby paparism.
Diaris God.

CHANGE: SAMUEL ETO DON WITHDRAW SUPPORT FROM HIM KONTRi MAN ISSA HAYATOU WEY DEY PLAN TO KONTINIU AS CAF PRESIDENT AFTA HE DON DEY DIA FOR 29 YEARS


If you ask many Naija pipo weda dem go like give dia pikin "change" as name,dem go tell u say,Tufiakwa!
Di reason nor hard to know.
But one man,Samuel Eto'o di four times Africa footballer of di year,say di CAF Presido don try but time don rish foram to step down for anoda pesi afta 29 years wey him mix evostic and supa glue take gum hin yansh for di sit.
Di Confederation of African Football (CAF) president Issa Hayatou na from Cameroon,Samuel Eto na from Cameroon too but di bobo nor kia about di same kontriman yarnings as he don settle for "Change".
Ahmad Ahmad
Next week March 16 for Addis Ababa,Ahmad Ahmad from Madagascar wey don gada plenti soport from plenti Africa kontris inkluding Nigeria,go challenge Issa Hayatou to see weda he go bikom di new CAF president.
Di only ting wey I see for di mata be say,Samuel Eto and oda Cameroon pipo inkluding dia President Paul Biya,only witdraw dia soport for Issa Hayatou afta dem study di handwriting for di wall say,many kontris Don readi to vote dia man out.
Well sha,na election and anybodi fit still win.
We go bring una di scores all di way from Addis Ababa,Ethiopia next week.

Friday 10 March 2017

DON JAZZY ADVICE TO WOMEN: IF YOUR FELLOW WOMAN FIT SNATCH YOUR HOSBAND,NAiM BE SAY DAT MAN NOR BE Di MAN WEY GOD CHOOSE FOR YOU


Wicked produsa Don Jazzy,don advice women say if any oda woman fit snatch yor hosband,naim be say dat man nor be yor man at all bicos di real man wey God choose for you go stay.
Since actress Tonto Dikeh pack comot from her hosband house afta he tell di whole world say her hosband na wife beater,her hosband na ashawo,her hosband na liar,her hosband na dis and dat,many pipo don dey talk di one wey dem fit talk for di mata.
So we nor soprise say Don Jazzy add hin voice join dis kain mata.

Thursday 9 March 2017

OSUN PIPO UNA DON HEAR?UNA GOVNOR RAUF AREGBESOLA SAY MAKE ARSENA SACK ARSENE WENGER AFTA BAYERN MUNICH WIN DEM 5-1..HOPE SAY HIM DEY RULE UNA WELL?


Bayern Munich of Germany disgrace Arsenal on Tuesday night for dia champion league match nor be small.
Two weeks ago dem win Arsenal 5-1 for Germany and on Tuesday hia,dem win Arsenal 5-1 again for Arsenal stadium.
In fact many of dia fans don dey shout make dem sack dia coach Arsene Wenger afta di disgrace.
One of dia fans for Naija,Gofnor Rauf Aregbesola of Osun State don join dey para for Wenger as he say 'Wenger must go'.
He yarn dis one on top him Instagram page.
Can you imagine!
If anybodi won talk dat kain ting,e no sopose be di Gofnor at all bicos he imsef sopose to don comot for office too since he owe Osun workas ova two years salari.
Kettle calling pot black naim be dis case.

Wednesday 8 March 2017

COMEDIAN ALI BABA WIFE,MARY,DON GET SUSPENSION FROM HER COMPANY HERITAGE BANK AS DEM DON TELL HER MAKE SHE GO RECOVER Di LOANS WEY SHE BORROW PIPO


Akordin to Sahara reporters,Di wife to di King of Comedy Ali Baba,Mary Akpobome,don get suspension from di bank wia she dey work as dem don tell her say make she go bring back all di plenti loans wey she don borrow pipo.
E be like say di bank dey xpiriens hard times so dem dey do efritin posibo make dem for no fold up.
As di mata stand so,na indefinite suspension dem givam and dat one mean say,dem fit sack her from dat suspension or manage to call her back.
I hope say nor be some of dis loans her hosband take dey organaiz him January 1st shows.
No! Nor get me wrong.
I only say "I hope say"!
I nor won hia tori bicos I dey enjoy dat show.
Efribodi eyes dey red now and even banks nor dey smile again.

Tuesday 7 March 2017

FROM TOMOROW,IF ANY AIRLINE TELL YOU TO PAY MAKE YOU ENTA DIA PLANE GO ABUJA,MAKE U KNOW SAY NA 419 BICOS,GOVMENT DON CLOSE Di AIRPORT DOWN FOR SIX WEEKS


Gofment don finalli announce say from tomorow Wednesday 12 a.m,dem go close Abuja intanashona airport for six weeks make dem for fit do sirios mentaynance wey go benefit efribodi.
Dis one no be rumor or lie at all bicos,na Di minista for infomayshon,Lai Mohammed naim announce dis one for Abuja.
Di minista of transport,Rotimi Ameachi also yarn say,make we dey use di Kaduna airport for now until dem finish work for Abuja airport.

Monday 6 March 2017

ZIMBABWE HIGH COURT DON STOP TEACHERS FROM FLOGGING SHIDREN FOR SCHOOL FOR DIA KONTRi




Afta one woman konplain about di injuri wey tisha giv her 6 year old pikin wey dey class one,Zimbabwe high court don ban tishas from flogging shidrens for dat kontri.
Linah Pfungwa say just bicos dem nor sign for di daughta book to confam say she don do her homework,naim make tisha bulala di pikin niali die.

Sunday 5 March 2017

WONDAMENT! SPAIN GOVMENT DON APPOINT MINISTER OF KEREWA AFTA DEM FIND OUT SAY HUSBANDS AND WIVES NOR TOO GET TIME FOR DIA SEF AGAIN

Edelmira
E nor get one day wey news wey fit make your jaw drop nor dey appun.
Di Spanish gofment don krate new ministri and dis ministri na Ministri of Sex.
Why bicos,dem say dia population don dey rediuz evri year.
Hosband and wife nor dey gree born too much for yonda again.
Di exkiuz wey some of dem give be say,dem dey tire afta dem don spend plenti hours for work and late nite waka sef kon join.
Wen dem finalli rish house,dem go don tire and weak like dodo.
Na dis won kon make di gofment for Spain krate dis kerewa ministri.
Di minista of kerewa akordin to di Spain gofment na Edelmira Barreira.
Dis woman naim go do evritin posibo to make sure hosband and wife go carry kerewa for head and produce shidrenses.

Saturday 4 March 2017

TONTO DIKEH HUSBAND FAMiLi PESiN DON TALK SAY,TONTO DON BOAST BIFOR SAY,SHE GO SPOIL HER HUSBAND NAME BICOS OF DiA QUARREL


Nor be news again say Tonto Dikeh and her hosband Churchill get kwanta for dia marage as di babe don pack comot from dia house for ova a month now.
Di rumors wey we hear be say,di bobo dey do touchingbodi bizness wit one of di girls wey dey work foram.
Since she remove from di marage,she don yarn many tins about di hosband.
She say most of di tins wey she bin take dey boast say Churchill buy foram,na lie she dey lie dat time.
She even yarn say Churchill giv her bedroom disease.
Now of one of Churchill famili pesin don defend him broda say,make anybodi nor take Tonto Dikeh yarning sirios bicos,she bin don boast say,she go show her hosband pepper since dem start dia kworel.
From di way wey tins dey go so,we go see more drama on top dis mata as Tonto Dikeh don say she go yarn more tins wey appun for dia marage.

Friday 3 March 2017

LAGOS COURT DON FINALLY SKATA AND END EMEKA IKE MARRIAGE AFTER HIM WIFE TALK SAY SHE NOR WANT TO MARRY AGAIN


Lagos court don end Nollywood star,Emeka Ike marage to him wife Susanne Emma finally.
Di wife bin pack comot from dia house afta she say Emeka Ike take her dey do punching bag and di tin kon tire her.
She don carry di mata go court since and now court don finalli judge di mata.
Akordin to wetin di Lagos court talk,dem don say make Emeka be Di pesin wey go dey baff and take kia of di shidren but di woman get right to visit di shidren too.
Na wa o.
Wetin dey appun to Nigeria selibritis marage sef?

Thursday 2 March 2017

MILLITANTS FOR NIGER DELTA DON GIVE SOUTH AFRICA COMPANIES 30 DAYS TO PACK COMOT FOR NAIJA BICOS DEM DEY FIGHT AND KILL NAIJA PIPO FOR DIA COUNTRY


Di xenophobia madness wey South Africa pipo carry for head go soon land dia konpinis for heavi wahala.
South Africa Boys dey kill kill oda Africa pipo for dia kontri gor years now and na diferen diferen excuse we dey hear dem dey give.
Now,militants don say dem give Dstv,Mtn,Shoprite 30 days to comot from Naija.
Nor be only Niger-Delta militants dey vex right now as National Assembly and National Association of Nigerian Students(NANS) don warn say South Africa konpinis naim go use head carry am if Dem nor stop di nonsense wey dem dey do for dia kontri.

Wednesday 1 March 2017

FANI KAYODE SAY HIM GO EXPOSE Di NAMES OF PIPO WEY DEY BEHIND Di COLLAPSE OF TB JOSHUA CHURCH BUILDING WEY KILL OVER 120 PIPO FOR 2014


We don hear one ogbonge tori about one of di building of Pastor TB Joshua Synagogue Church of All Nations for Ikotun,Lagos wey kolaps and kill ova 125 pipo for 2014.
Di tori wey we gada be say,forma minister of Airport mata and PDP chief,Femi Fani-Kayode,don yarn say,him go soon xpose di pipo wey make dat building fall.
He say if u rememba for di video of how he take fall,you go see say,one eroplane dey fly around di building.
Fani-Kayode say dat plane nor be odnari plane as na pipo naim sendam.
He say na TB Joshua dem bin dey plan to kill.
Akordin toram he say,him still dey investigate di whole tori and wen he finish,he go yarn he mind.
So diafor make una kontiniu to visit ogakpatakpata to hear dat Fani-Kayode tori wen he dropam.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...