MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 30 October 2014

MANCHESTER UNITED SIGNS CONTRACT WITH CHI LIMITED AS OFFICIAL SOFT DRINK IN NIGERIA




20 times English premier league champions, Manchester United, don sign multi million naira contract wit Chi limited,makers of caprisone, superbite sausage roll and plenti oda product as dia official club soft drink for naija.

MECHANIC KIDNAP AND RAPE 13 YEARS OLD FOR 5 DAYS


Pipo wey dey feel say na only mechanic work naim Abdulkadir Salihu for Agbai street for Lokoja dey do beta tink again as di guy don add to dey rape join.
Abdulkadir Salihu kidnap one 13 years old small geh for good five days and kon dey torchlight di smallie website for dose 5 days.
One Mrs Joyce Abdulmalik for one sinior magistrate court for Lokoja don say make dem still live di guy for prison for dis offence wey im comit till November 10 wen dem go judge di case again.
Kidnapping and raping naim dey charge am for and di police officer Corporal Ubi Ubana wey dey in charge of di mata tell court say, na one Adama Ibrahim of Galilee street naim kon report di mata for 'A' division police headquotars and department of criminal investigation for Lokoja on di 23 of Octoba.
Akordin to Ibrahim, he say na okro dem send di smallie go buy around 1 : 25pm on di 16 of octoba for Adankolo new layout market wen Abdulkadir Salihu disiv am wit biscuit enta im house for Agbai street for Lokoja.
He also yarn say during dis period wey di smallie dey im house, he dey do steady kerewa wit her till Octoba 20 bifor he reliz her.
Corporal Ubana say dem still dey investigate di mata.
Meanwhy, di judge, Mrs Joyce Abdulmalik say make dem still live di guy for prison for dis offence wey im comit till November 10 wen dem go judge di case again.

Wednesday 29 October 2014

SIMON MBAM COMMIT SUICIDE BICOS OF N1, 000


No be small tin for Izzi local govment area for Ebonyi State as one Mr Simon Mbam kill imsef afta di kpokpo wey some villagers give di guy bicos of 1k wey im tiff from one woman shop.
Simon go buy drinks in di evening make im and im frends take coolu dia mind.
As he buy di shack dey chilax wit im bobos,naim di woman raise alarm say somebodi tiff 1K from di carton wey she dey kip moni.
Like pesin wey mess for church,evribodi wey come buy sontin for di woman shop dat moment deny say dem no take any moni.
Di villagers wey later carry di mata for head like lakpalakpa,give dem till di next day to return di moni back.

AYIRI GIVE HIM SISTER 250K BICOS SHE COOK BETA EGUSI SOUP FORAM


Good soup dey make some pipo lick plate, good soup can make pesin bite im finger,good soup dey even make some men confess dia sins to dia wife.
Di tori now be say, di good Egusi soup wey Stella Emami cook for her sinior bros, Warri billionaire, Ayiri Emami, don land am beta moni.
Ayiri bless her wit two hundred and fifty K ( 250K) bicos she arrange beta soup wit plenti orishirishi and gwongwon for inside.

Tuesday 28 October 2014

CRISTIANO RONALDO, LIONEL MESSI, ARJEN ROBBEN NOMINATED FOR 2014 BALLON D'OR

DEFENDING CHAMPION
Favourite for dis year world player of di year Cristiano Ronaldo must battle against im biggest rival  Lionel Messi for di past 6 years,to know weda im go win dis year Ballon D'or award.
Na January 12 dem go announce di winner for Zurich, Switzerland and dem go still reduce di 23 players wey dem announce to 3 bifor dat day.
Oda players wey go battle am out wit 2 of football greatest players for now, na Arjen Robben, Neymar, Yaya Toure, Ibrahimovic.
Out of di 23, six na from di Germany world cup winning squad.
Captain Philpipo Lahm, Toni Kronos, Muller,Mario Gotze, Bastian Schweinsteiger and goalkeeper Manuel Neuer.
To see di complete list, make u check am for bottom hia:

The 23-man list for di Ballon d’Or
Gareth Bale (Real Madrid/Wales)

Karim Benzema (Real Madrid/France)
Diego Costa (Atletico Madrid/Chelsea/Spain)
Thibaut Courtois (Atletico Madrid/Chelsea/Belgium)
Cristiano Ronaldo (Real Madrid/Portugal)
Angel Di Maria (Real Madrid/Manchester United/Argentina)
Mario Goetze (Bayern Munich/Germany)
Eden Hazard (Chelsea/Belgium)
Zlatan Ibrahimovic (PSG/Sweden)
Andres Iniesta (Barcelona/Spain)
Toni Kroos (Bayern Munich/Real Madrid/Germany)
Philipp Lahm (Bayern Munich/Germany)
Javier Mascherano (Barcelona/Argentina)
Lionel Messi (Barcelona/Argentina)
Thomas Mueller (Bayern Munich/Germany)
Manuel Neuer (Bayern Munich/Germany)
Neymar (Barcelona/Brazil)
Paul Pogba (Juventus/France)
Sergio Ramos (Real Madrid/Spain)
Arjen Robben (Bayern Munich/Netherlands)
James Rodriguez (As Monaco/Real Madrid/Colombia)
Bastian Schweinsteiger (Bayern Munich/Germany)
Yaya Toure (Manchester City/Côte d’Ivoire).


BEN MURRAY-BRUCE DECLARE FOR SENATE, BLAST NIGERIANS WEY DEY BUY PRIVATE JETS ANYHOW


Mr Ben Murray-Bruce,di chairman and chief executive officer of Silverbird, don declare imsef fit and ready to represent Bayelsa East Senator district For national assembly.
To talk am nor be im be di tin o, na weda Ben Bruce fit challenge and win Senator Barigha Amange and Clever Ikisipo wey dey eye di sit like am too.
Di gud tin about di mata be say,Bruce come from Akassa language area of Brass local government and na dem, dem zone di Senator seat to.
Ben Bruce say wetin make am won contest be say, he won come re-arrange tins for dia area like poverty,children wey dem dey rape,society wey no get law.he say law get to dey di land.
He say too many pipo dey live life unda bridge and naija rich pass dat level.
He say to worsen mata,most rich Nigerians no dey pay dia tax.
Ben Murray-Bruce also yarn say, like say dem dey pay dia tax, only one pesin nor go get 3 private jets.

Sunday 26 October 2014

FEDERAL GOVERNMENT DON CONCLUDE PLAN TO BAN OKADA


Many states like Lagos, Akwai ibom, Delta,Kaduna, Rivers,wey don ban okada go soon get 100% backing from federal government to make sure dem ban dem wellwell without looking uche face.
Since di 80s naim dem stat to use okada dey do transport for naija and since den, e don provide job for ova 20 Million pipo weda young or old nationwide.
Dis news to ban okada for naija go come as big shock and he go pepper okada riders for bodi as di National council for transport don propose for dia join bodi meeting wey dem hold for Enugu to ban okada.
Di meeting last for one week and all di state commissioners of transport,permanent secretaries, directors and officials for di states ministries of transport across naija naim attend dis meetings and di council give dem di low down say make dem go scrap okada for dia states.

To pepper okada riders di more for bodi, di minister of transport,Senator Idris Umar wit cup of juice for im hand say im support di ban wit di best part of im heart.
Akordin to tori wey di council bring come out on Saturday, dem say okada transport no dey safe and dem kon advice all di states for do kontri and Abuja make dem from now on dey discourage okada transportation for naija.
Di council also yarn say, make all states develop master plan and get koret public transport system wey go dey safe, wey go dey secure, wey go dey work veri well.
Dem also advice all Danfo,molue, and oda transport motto dem to register properly so dat dem go fit join hand give naija pipo beta transport system wey go work.

Saturday 25 October 2014

PRESIDENT JONATHAN AND PATIENCE PHOTO BACK IN UNIVERSITY

President Ebele Jonathan and wife Patience Jonathan don come a long way sha o.
If u see dis picture wen two of dem take for dia univasiti days u go know say dia is difence bitwin banga soup and banga rice.
Jona na Lecturer dat time and Payshi na student den.
How u see  President Azikiwe Jonathan baggy traouza?
Di only tin wey dey disturb my head now be say i no see Jona leg to know weda im wear shoe or not.lol

EBOLA WAHALA! ENYEAMA WANT CAF TO CANCEL AFRICA CUP OF NATIONS

ENYEAMA:CAF i DEY WARN UNA Oooo!
Super Eagles captain and goalkeeper,Vincent Enyeama, don beg Confederation of Africa Football, CAF, to  cancel next year Africa cup of nations afta Morocco withdraw as host bicos of fear make Ebola no dey go show imsef and spread anyhow.
Enyeama yarn dis one afta im club Lille and Everton play zero zero for dia europa cup match.
Ebola virus don kpai ova 4,500 pipo for Africa alone since dis deadly sickness buss out early dis year.

Enyeama say make CAF hold on fest until wen Ebola don reduce wellwell bicos anytin can appun since plenti pipo go dey move around and to avoid dis sickness, yor bodi must not touch pesin wey getam bodi.
He say evribodi go dey at risk bicos pipo go won hug u and shake yor hands and u no go fit do anytin about am.
But Enyeama say im be notin for wia CAF dey since na dem go decide anytin about di tournament and he also yarn say, altho if Nigeria qualify im go play.
Nigeria get to win dia remaining two matches against Congo and South Africa to qualify for di tournament.
Even di president of Uefa,di bodi wey dey kontrol football mata for Europe,Michel Platini, don advice CAF to use dia church mind too bicos na fly wey no hia word dey follow dead bodi enta grave.

Friday 24 October 2014

OIL BOY! AYIRI EMAMI DON BUY CUSTOMIZED ROLLS ROYCE FOR HIM WIFE TO CELEBRATE HER BIRTHDAY


Warri Big name,billionaire,Ayiri Emami, don plasta mata for im  honey pie as he don arrange her One strong customised Asba Rolls Royce to mark her birthday.
Dis no be di fest time wey Ayiri dey spoil he wife for her birthday as some years ago na America he celebrate am foram.
Baba Oloye as many pipo dey call Ayiri na di forma chairman of Delta Waterways Security Comiti.
Naim be di CEO of A&E petrol.naim also be di boss of A&E group of compinis and he dey deal on oil mata, construction and also di boss of 911 hotels and 911 entertainment.
Present adviser to Govnor Oshiomole of Edo State for enetertainment mata,Maleke, na forma 911 entertainment label artiste.
Many naija miuzishans and actors don benefit from Ayiri windfall most espeshali 2face.
Wen dem snatch 2face ride like 7 years ago,we hia say na Ayiri replace am and nor be small millions he spend for 2face and Annie Idibia wedding For Dubai.
Check out more photos of di Rolls Royce wey him buy for him wife for bottom hia:




FOLLY COKER DON DENY SAY HIM NO DEY DO ANY KELEKELE LOVE WITH TIWA SAVAGE

FOLLY COKER
MR and MRS BILLZ ???

Thursday 23 October 2014

JAY JAY OKOCHA NA DI 93RD BEST PLAYER FOR ENGLISH PREMIER LEAGUE HISTORY


Di forma Super Eagles skippo, Jay Jay Okocha wey di press give many guy names like, mercurial, skillful,dribbling machine,talented, bag of tricks,don get anoda recognition from British newspaper, Telegraph as di 93rd best player out of 100 for di past 28 years for premier league history.
Pipo like Pele of Brazil, Roger Milla, Arsene Wenger, don praise Okocha as one of football's finest talent.
During OKocha playing days for England with Bolton Wanderers, he even win di 5th best player for di  2002,2003 season.
OKOCHA CELEBRATE A GOAL WITH BOLTON TEAM MATES

Di forma Bolton captain, carry dem from relegation team to mid table team and also hep dem enta di final of di 2004 league cup.In fact e get one time wen he dey win di player of di month award anyhow like say tomorow no dey.dis one kon make di fans dey alla him name say "so good they name him twice".

Even di polo for dis "so good they name him twice" sell like pure water dat period.
Many pipo even dey argue say Okocha suppose dey di top 20.
Alan Smith,Jason Burt, Henry Winter, Jeremy Wilson, Mark Ogden, dey among di pipo wey choose dis list.
Jay Jay Okocha skor 14 goals for 124 matches for Bolton Wanderers.

To see di best 100 players for premiership history akordin to di Telegraph, make you check am for bottom here:

 (1)Ryan Giggs
(2) Thiery Henry
(3) Roy Keane
(4) Alan Shearer
(5) Paul Scholes
(6) Cristiano Ronaldo
(7) Patrick Vieira
(8)Eric Cantona
(9) Dennis Bergkamp
(10) Frank Lampard
(11) Steven Gerrard
(12) John Terry
(13) Peter Schmeichel
(14) Wayne Rooney
(15) Didier Drogba
(16) Ashley Cole
(17) Rio Ferdinand
(18) Luis Suarez
(19) Yaya Toure
(20) Tony Adams
(21) David Beckham
(22) Gary Neville
(23) Andy Cole
(24) Vincent Kompany
(25) Robert Pires
(26) Robbie Fowler
(27) Robin Van Persie
(28) Nemanja Vidic
(29) Gary Speed
(30) Gianfranco Zola
(31) Jaap Stam
(32) Gareth Bale
(33) David Seaman
(34) Matt Le Tissier
(35) Sergio Aguero
(36) Ian Wright
(37) Cesc Fabregas
(38) Teddy Sheringham
(39) Ruud Van
Nistelrooy
(40) Jamie Carragher
(41) Claude Makelele
(42) Michael Owen
(43) Xabi Alonso
(44) Edwin Van Der Sar
(45) Dwight Yorke
(46) Dennis Irwin
(47) David Silva
(48) Sol Campbell
(49) Emmanuel Petit
(50) Les Ferdinand
(51) Mark Hughes
(52) Fernado Torres
(53) Pablo Zabaleta
(54) Sami Hyppia
(55) Patrice Evra
(56) Ledley King
(57) Jurgen Klinsmann
(58) Marcel Desailly
(59) Lee Dixon
(60) Branislav Ivanovic
(61) Gary Pallister
(62) Peter Cech
(63) David Ginola
(64) Ole Gunnar
Solskjaer
(65) Carlos Tevez
(66) Steve Bruce
(67) Marc Overmars
(68) Luca Modric
(69) Nicky Butt
(70) Dimitar Berbatov
(71) Nicolas Anelka
(72) Steve McManaman
(73) Peter Beardsley
(74) Tim Cahill
(75) Ricardo Carvalho
(76) David Batty
(77) Michael Carrick
(78) Lucas Radebe
(79) Jimmy Floyd
Hassel-baink
(80) Paul Ince
(81) Joe Hart
(82) Martin Keown
(83) Gus Poyet
(84) Graeme Le Saux
(85) Nigel Winterburn
(86) David James
(87) Roberto Di Matteo
(88) Pepe Reina
(89) Paolo Di Canio
(90) Shay Given
(91) Chris Sutton
(92) Robin Keane
(93) Jay-Jay Okocha
(94) Kevin Phillips
(95) Michael Ballack
(96) Freddie Ljungberg
(97) Tim Howard
(98) Phil Neville
(99) Scott Parker
(100) John Barnes
.

DSTV MUST RESPECT NIGERIA PEOPLE POCKET-HOUSE OF REPS


Di house of representatives for naija don come out for dia join bodi sitting say,South Africa company, DSTV of Multichoice,must be checkmated.
Dat is to say, dey must stop di rough play wit naija pipo moni.
Dem say di kain big moni wey dem dey charge no make majority of naija pipo fit dey watch am.
Dem say lack of competition from oda stations no even dey hep mata.
Di lawmakers say wetin dey vex dem pass na, as DStv take dey charge pipo weda you watch or u no watch, weda u dey house or u no dey house, weda u on yor tv or you no on am.
Di pesin wey carry di mata for head like lakpalakpa na, di house memba from Adamawa state, Mrs  Aisha Dahiru_Modibbo.
AISHA DAHIRU
Mrs Aisha, for di bill wey she sponsor, talk say, she no dey against foreign pipo coming to do bizness for hia o, but she say she dey against bringing bizness wey go pepper naija pipo bodi.
Di house membas say NBC, National Broadcasting Commission must amend dia laws to favour Nigerians and crate competition.
Di second in command for di house, Mr Leo Ogor, say, why DStv no dey tritment naija pipo well di way wey dem dey trit oda Africa kontris?
He say na we dey patronise dem pass yet dem dey trit us like nama.
Anoda pesin wey chuk mouth put for dis mata for di house, na di house memba from Lagos State and ogbonge broadcaster,Abike Dabiri-Erewa.
ABIKE DABIRI
She say she agree to wetin her colleagues talk and he good make all dis company wey dey enta naija come do bizness give us price wey go make us call dem our friends.

BOKO HARAM KIDNAP 60 WOMEN AGAIN


Six days afta dem say Federa govment and Boko Haram officials meet for Saudi Arabia and dem don agree to stop di fighting for northern Naija, pipo don dey ask say'' na wich kain agreement dem reach wey be say di fighting kon dey worse day by day?" 
Just yestaday for Adamawa, di tori wey we gada be say Boko Haram don kidnap anoda 60 women join di ova 200 Chibok gehs wey Dem kidnap since April. 
Dem kidnap 40 of di women for Waga Mangoro and dem kidnap di remaining 20 for Garta. 

All dis area for Adamawa especially Garta, dem say na Boko Haram dey rule am for some months now,no be President Jonathan govment.
Akordin to pipo for dose area, dem say dem don kill many men, kidnap some women.we also hear say, di operation stil dey on as Boko Haram dey use motto take carry di women dem dey enta forest.
Boko Haram dey enta pipo compound, dey brake enta dia house and kidnap di women.
Di local govment chairman of Madagali,di area wey Garta and Waga Mangoro dey unda,Mr. James Watharda, say since Boko Haram take ova dose area, him don relocate go Yola di capital of Adamawa, so him no too know wetin dey happen. 

RITUALIST AGAIN! DEM KILL PAPA, REMOVE PIKIN EYE


No be small tin for Toro local govment area for Bauchi as about 10 ritualists don kill one man,Yakubu Ubandoma and comot him pikin eye.
 Di ritualists brake enta di man house wit dangerous weapons, stabam for neck and cut him hands comot.
As if dem neva satisfy, dem also comot di eye of Ishaya Yakubu,di man pikin and he later die for hospital too.
As if dat one neva reach dem, dem even give anoda pesin,Yakubu Almadu sirios head injuri for di house wit cutlass.
Di State Police Public relations Officer,Haruna Mohammed, confam di tori and kon talk say, dem go do evritin to make sure dem find and arrest di ritualists.
Haruna Mohammed say dis bad tin happen for di house of Yakubu Ubandoma, 10 kilometres from Rimin Zayam village for di same Toro local govment.
Mohammed kon also yarn say anybodi wey get any information on how dem go take catch di ritualists, make he enta di nearest police station and yarn dem.

Wednesday 22 October 2014

SMALLY SAY POLICE MUST ARREST DI DOGS WEY NEARLY KILL AM WITH BITE

Omonigho Abraham
No be small mata for Igando area for Lagos state as two useless dogs nearly take di life of 4 years old boy, Omonigho Abraham.
Di dogs buss enta dia bunk wen him and him broda dey play but naim no kon get luck as di dogs ovapower am.
As we dey talk so, di boi dey di burns and plastic ward for di Lagos state univasiti teaching hospital, LASUTH,Ikeja, dey resiv tritment.
Di dogs dem bite di kanda wey cover him head and he skull sef kon dey show.
Dem don arrest di dogs dem but police need permission from Omonigho popsie bifor dem go reliz dem give di owner.
Now Omonigho Abraham don yarn say, im no go go back to di house if dem no kill di dogs.
Di TWO GERMAN SHEPHERD DOGS FOR POLICE HEADQUATERS, IKEJA
Rumors wey we dey hear be say, e be like say na dem Omonigho landlord naim get di dogs.
Police come wia di dogs for dey bite di boy but fear no allow dem enta di house akordin to di boy mama.
She say wen she tell one policeman make dem rescue her pikin, di police tellam say she try wellwell, weda naim fit to die?
Di mama say na dis one naim givam mind to rescue her pikin by hersef.
Police public relations officer, DSP Kenneth Nwosu, carry waka go visit di boy for LASUTH and beg di family make dem no vex for di police pipo bicos wetin mata now na say di boy dey alive. He say dem go try test and do check up on di dogs to know weda dem dey Kolo.
Although Omonigho state govnor, Dr Emmanuel Uduaghan send im personal doctor Mr Ufuoma to check on di bobo.
Mr Ufuoma kon yarn say di way wey im dey see di mata, e be like say di boi go need beta tritment for abroad.
Lagos state ministry of health don also come out to assist di boy as dem don give dem back all di moni wey dem don spend for tritment and dem also promise to take kia of all oda expenses.

Tuesday 21 October 2014

BABA GOD DON SMILE ON ORITSE FEMI AS HE DON MOVE ENTA 200 MILLION NAIRA HOUSE FOR LEKKI


From Ajegunle to Ikeja, from Ikeja to him own house for Lekki.
Dis na di stori of di rise and rise of Oritsefemi.
Anybodi wey say God no dey, he's on his own as baba God don show Oritsefemi him mercy.
Mercies of di Lord, dat ogbonge jamming jamming wey blow Oritsefemi solo career,don really dey show for di bobo life as he don move enta him ova 200 million naira house for Lekki and he even support am wit  24 million  2014 Range Rover Evoque wey he also buy for imsef.

Wen i go intaviu di forma Junglist group lead singa for him house for Ajegunle for 2008,him yarn say even di devil cannot stop him shine.
Also last year wen di Manchester United fan,Oritsefemi,yarn us say im dey build house for Lekki, many pipo take am as comedy but today di bobo don show say "him be talk na do".
Dis one na pure Mercies of di Lord indeed.

HARRYSONG DON TAKE PICTURE WITH PLENTY NAIRA FOR BED


Harry Song if u no know am,naim break di higest downloads record for a day for naija wit him tribute song for Mandela.
Ordinarily dat one na more money for di Ogbe ijaw,Warri south west born miuzishan as di bobo don show him kpai numba wit plenti moni for bed and e be like say he dey try tell pipo say anybodi wey no like him style make he go boil rock.
He put di picture for him instagram account dis afternoon and he kon write say,"make pipo see di picture wey him take wit him best friend(money)".
Abeg if any OLE dey read dis HarrySong tori for dis blog,make una no take am personal o,na my brodaOoo!

JUDGE THOKOZILE MASIPA DON SENTENCE OSCAR PISTORIUS TO FIVE YEARS IN PRISON

OSCAR PISTORIUS
Judge Thokozile Masipa don sentence South Africa runner, Oscar Pistorius to prison for 5 years sake of hin girlfriend, Reeva Steenkamp wey hin shoot die.
No be small cry di guy don cry and no be small vomit di guy don vomit for court since dem stat di judgement some months ago.
Na two offence di guy commit akordin to di judge.
One be say u kill pesin u kon act like say u no mean to kill di pesin and Pistorius get 5 years for that one and dem also give am 3 years jailing suspension bicos of gun wey no get license wey hin use.
Di judge also yarn say, evribodi know wetin Pistorius do and if dem no judge di case like dis e go be like say na separate law naim dey guide poor pipo and different one for popular celibrities and rich pipo.
Di judge Thokozile Masipa, say Oscar Pistorius bad for shooting finish  as hin cock hin gun reach mouth.
She say he use di gun shoot him babe no be once, no be twice but plenti times until di babe lego.

Monday 20 October 2014

AYO ORITSEJAFOR IS INNOCENT-PASTOR ADEBOYE


Di General overseer of di Redeemed Christian Church of God, Pastor Enoch Adeboye don yarn for facebook say,di Christian Association of Nigeria(CAN) President, Pastor Ayo Oritsejafor, dey innocent of di heavy money wey dem see for inside hin private jet for South Africa.
Di south Africa govment naim seize di jet wey carry 9.3 million America dollars of raw cash.
Two pipo naim dey inside di jet,one na naija pesin and one israel man.
Akordin to di federal govment of Nigeria, dem say yes,na Ayo true true get di jet wey dem hire but di money na govment own and na weapons dem be wan use di money buy.
But di tori now be say some pipo say Pastor Ayo know about di moni and na runs dem use hin private jet dey do but he deny yam.
PASTOR E.A. ADEBOYE
Pastor Adeboye don come out na to defend The Word of Life Bible Church General Overseer, Pastor Ayo say,him fit swear wit him life say Ayo dey innocent and na charter govment charter di jet use.
Adeboye say him know Pastor Ayodele Oritsejafor as a real man of God and he cannot just dey blow lie anyhow.
Baba say he dey sure say Pastor Ayo no dey aware of wetin dem charter hin jet for and God go kontiniu to build hin church and di gate of hell cannot do am anytin in Jesus name.

Saturday 18 October 2014

SINCE I DATE PRESIDENT, I DEY FIND AM HARD TO DATE ORDINARY PESIN-ELLA MARTINS


Sexy Benin Republic miuzishan and actress, Ella Martins,  don yarn say, since she date president of a kontri, to follow ordinary pesin no dey hungry am again.
She say even tho di president later brake her heart,she enjoy di relationship wellwell bicos she learn many good tings inside.
Although she no mention di name of di president but Ella yarn say she learn how to dey do tins in a mature way and akordin to more tori wey we gada, she say di president dey veri caring and mature.

She say if she stat to dey yarn all wetin happen bitwin she and di president, day go break and naim make she won use her experience wit di president take shoot one film wey she don alreadi stat to work on.
Ella say, to date president no be moinmoin  bicos u must dey bam and sexy too.
Wen tori pipo askam weda he good to sleep wit man bifor pesin marry, she say yes bicos,e go make u know who u dey friend weda na good or bad pesin bifor una marry.

Friday 17 October 2014

DAVIDO HANG OUT WITH OBASANJO FOR KENYA

Omo babolowo,OBO,  Davido and OBJ jam demsef for Kenya and dem no waste time to enta picture togeda.
2014 na di most successful year for Davido career as he dey travel round di world for shows and awards and na one of such waka carry am enta Kenya.
We know OBJ for some kain funny dance steps like wen he cane us dat Gangnam Style dance for Ghana for 2012 but weda he dance small skelewu wit Davido, na dat one we no fit confam right now.
Dem jam for  Jomo Kenyatta international airport for Kenya and Davido put di picture for instagram wey him snap wit di forma civilian and khaki president of Nigeria, General Olushegun Obasanjo.
Apart from OBJ and OBO, Shina Rambo, Davido cousin, also dey di picture.

SHINA RAMBO, OBJ and DAVIDO
FOR JOMO KENYATTA AIRPORT, KENYA.

Thursday 16 October 2014

2FACE SAY NA MUSIC STOP AM TO BE GOALKEEPER

2BABA and HIS HYPERTEK GANG
Naija mega superstar,2face Idibia, say na small ting naim remain e for be goalkeeper bicos him like football welwel dat year.
Akordin to di tori wey we gada,2face wey win di award for di 2005 Mtv Europe Best African Act, yarn say, im like football die but he no be fanatic.
Dat is to say,no be do or die affair and he no fit do robish ting bicos of football.
2baba, di new name wey he don adopt, say, e no be like dose pipo wey dey comit suicide, dose pipo wey dey fight, dey argue and dey kill demsef bicos of Man u, Chelsea, Barcelona,Real madrid and west brom mata.
He say im own no reach like dat.

2face say im just like football and like say e no dey do miuzik, im for be anoda Peter Rufai or Fabian Barthez or Wilfred Agbonavbare or Oliver Khan or even Abiodun Baruwa in di making.
We no dey sorprise about 2baba love for football bicos, for 2008,he form him own football club wey him name "Hypertek FC".

OSHIOMOLE SAY HE DON READY TO TAKE OVER FROM GOODLUCK JONATHAN FOR 2015

GOVNOR ADAMS OSHIOMOLE
Anybodi wey get President Goodluck Jonathan phone numba or wey know how to reach am one on one,make he tellam say make he watch him back bicos di forma Nigeria Labour Congress,NLC President and di Govnor of Edo State,Adams Oshiomole don talk say he dey eye di Aso rock numba one seat for 2015.
Oshiomole don write letter give APC leaders to know say him get him eyes on Jonathan sit.
He don also dey yarn forma presidents and pipo wey mata across naija about him plans.
Dis no be di fest time wey Oshiomole dey say him won contest to bicom president as he don fest talk am for 2006 wen he retire from di Nigeria Labour Congress.
But he no kon later stat wit di election to bicom president but he contest for Edo state govnorship and he win for 2007.

CONFIRMED! AMAJU PINNICK AND GANG DON SACK KESHI! AMODU TO TAKE OVER

FORMA EAGLES COACH DEM,
FROM LEFT:SHORUNMU, AMOKACHI and KESHI
Call am forma Super Eagles coach if u like, di tin be say u no lie bicos di Nigeria football federation don finally sack Stephen Keshi as Eagles coach afta he get only 4 points out of 12 for di qualifiers for Morocco 2015 Africa nations cup.
NFF praise him and he asistants, Daniel Amokachie and Ike Shorunmu and even tell dem make dem go learn more coaching skills for abroad say di NFF go pay.
Imidiately afta di match wit Sudan wey Super Eagles win by 3 goals to 1 yestaday, NFF enta one quick join bodi meeting and na dia dem for announce Keshi sack.
For di remaining matches against Congo and South Africa, dem kon apoint forma Super Eagles coach too, Amodu Shuaibu to coach di bois.
NEW CARETAKER COACH, SHUAIBU AMODU
Pipo wey go assistam na, Salisu Yusuf, Gbenga Ogunbote and forma Eagles goalkeeper Alloy Aguwey loose one of him teeth wen he stil dey keep for naija.
Garba Lawal naim be di new coordinator of di team, Toyin Ibitoye di new media officer, Godfirst Chike di new equipment manager and di team secretary, Enebi Achor go stil dey dia to work wit dis new pipo As he no dey among pipo wey dem sack.
Di NFF comitee also apoint Samson Siasia as di new unda 23 coach and Fatai Amoo as him asistant.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...