MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 5 October 2014

DEM DON OFFER ITALIA 90 WORLD CUP HERO, ANDREAS BREHME, TOILET CLEANING JOB

ANDREAS BREHME
To fall from grace to grass no be beta tin at all as forma Germany player wey skor di only goal for Germany against di Argentina national team wey Maradona captain for italia '90 world cup,Andreas Brehme, don see toilet klina job  from di kompini of one boy wey him coach bifor for spVgg Unterhaching.
Di boi,Olivier Straube,say make him forma oga comot shame for eye accept di job say na so life dey be some times.
BREHME
He say Andreas Brehme fit dey klin bathroom too and he kon yarn say hep no pass like dat since right now he don broke finish like church rat and even sef, he go soon appear for court for di 50 million naira debt wey him dey owe pipo.
Di 53 years old Andreas Brehme, play 86 times for Germany and na also regular player for Inter Milan and Bayern Munich during im playing days.
Him forma coach for italia 90 world cup, Frank Beckenbauer, don beg di futbol community make dem hep Brehme comot for dis kain condition wey him find imsef.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...