MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 1 October 2014

KCEE GET LUCK SAY NO BE ME HE MARRY-ADOKIYE KYRIAN

ADOKIYE KYRIAN
Miuzishan and Imo state youth ambassador,Adokiye Kyrian, don yarn say na only for naija pesin go hama finish and di next tin wey im go do na to turn di wife to slave.
Why she yarn dis one na bicos of Kcee di limpopo Singa wey deny him wife for one intaviu wit baby oku, Toolz for di tv program 'Di juice'.
She say she no dey happy at all wit di way wey Kcee dey use im wife dey do rag for pages of newspapers and differen differen site for intanet.
Adokiye Kyrian wey dey claim virgin say, di way wey some kain naija men dey do sef like say skoinskoin dey dia head dey make am dey wonda and get double mind weda she go get anytin to do wit dem wen e come to love and marriage.
She also yarn say Kcee get luck say no biam he marry say she for don call on her village juju to finisham for ground bicos she cannot take robish from any man.
She say anybodi wey dey deny him wife for public na slave she dey use him wife do be dat.
ADOKIYE
She say she hear say Kcee marry and wed im wife, Ijeoma Okonkwo propali and dis kain tins kon make am dey wonda weda na di kain pipo wey won rule naija be dis? since dem dey say na we be di leaders of tomorow.
She say any man wey dey responsible no go deny him wife for public.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...