MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 9 October 2014

BISHOP OYEDEPO NA DI RICHEST PASTOR FOR THE WORLD

NO 1.OYEDEPO

NO 2.CHRIS OYAKHILOME

NO 3.BENNY HINN

Di way wey pastors take dey make moni nowadays fear man.
Na pastors dey wear di most expensive bling bling now, finest cars, na dem get di biggest compinis, ogbonge houses evriwia,finest wives, some get 4 to 5 private jets,dia shidren dey go di best skuls and dem dey live large, even sef na dia skuls dey collect di highest skul fees for di world nowadays.
Inshort, pastors don take ova di entatainment industry wit dia life style.
Dis one na tori for anoda day.
Anyway, dis one go sound like comedy for una ear but no be joke at all as Bishop David Oyedepo wey get The Living Faith World Outreach Ministry,aka Winners,don top di list of di richest pastors for di world.
For di list of di 10 richest pastors wey Richestlifestyle.com bring out,5 of di pastors na from naija.
Benny Hinn and even TD Jakes moni sef, dey learn for wia Oyedepo  raba dey.
No be only Oyedepo be di naija pastor name wey dey di top ten as TB Joshua, Chris Okotie, Oyakhilome and Mathew Ashimolowo also make di list.

To see di names of di top 10 richest pastors for di world and how much dem worth, Make you check am for bottom here:

1) David Oyedepo - worth: 150 Million dollars (Nigeria)
2) Chris Oyakhilome-worth 50 million dollars (Nigeria)
3)Benny Hinn-worth 42 Million dollars (America)
4) Creflo Dollar-worth 27 Million dollars (America)
5) Billy Graham-wort 25 Million dollars (America)
6)TD Jakes-18 million dollars (America)
7)TB Joshua 15 Million dollars (Nigeria)
8)Mathew Ashimolowo 10 millions (Nigeria)
8) Chris Okotie 10 millions (Nigeria)
10)Joseph Prince 5 millions (Singapore)
NO 4.CREFLO DOLLARS
NO 5.BILLY GRAHAM
NO 6. TD JAKES
NO 7. TB JOSHUA
NO 8. ASHIMOLOWO

JOINT 8.CHRIS OKOTIE


NO 10.JOSEPH PRINCE

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...