MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 24 October 2014

FOLLY COKER DON DENY SAY HIM NO DEY DO ANY KELEKELE LOVE WITH TIWA SAVAGE

FOLLY COKER
MR and MRS BILLZ ???

Pipo wey dey expect breeze to blow make fowl yansh open, go dey disapointed especially dose anti- Tiwa Savage pipo bicos di pesin wey dem dey suspect say she dey do kelekele love wit, don come out to yarn say, make world pipo live am alone say im and Tiwa Savage no get anytin togeda.
For di past few weeks, rumors dey fly like kite say, Tiwa Savage and her husband, Tee Billz marriage foundation dey shake like weak leaf wey won fall.
Di guy,Folly Coker, wey be pasonal asistant to Lagos State Govnor, Tunde Fashola,don come out to yarn say, im no even get Tiwa Savage phone numba.
Even one pesin wey dey close to Folly Coker, di son of Chief Folarin Coker, talk say dis two pipo no be friend at all so how dem won kon take date demsef?
No be only dis rumors dey fly like helicopter wey dey look for wia to land as dem even dey say na Folly Coker naim get Mavin records di record label wey Tiwa, D'ija, Dr Sid, D' Price, Korede Bello, Reekado Banks and dia leader Don Jazzy dey.
Akordin to di same pesin he say all dis rumors,no single truth dey inside.
Dis same Folly Coker mouthpiece say, di pipo wey form all dis rumors, go soon appia for  court to defend demsef.
From our own end, make we just siddon dey look and wait for scores.
Woteva appun bitwin Tiwa, Tee Billz,Mavin records, Folly Coker, we go bringam to una.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...