MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 11 October 2014

GENEVIEVE SAY SHE NEVER FORGET SINGING

Dem sat di best way to expand quick and gada riches na wen you put hand for plenti tings.
Apart from say Genevieve na big name actress for naija, she don also try her luck for oda bizness like singing and now, fashion.
Una remember say last week, nollywood star and home vidio goddess , Genevieve Nnaji launch her clothing line and plenti pipo follow her jollificate for di day of di launching.





Di name of dis her fashion line na St. Genevieve and di baby no new to dis kain bizness bicos she don fest stat for 2008 bifor she take small break.
Dis one no be news again bicos  bizness don stat full time for Genevieve but di news now be say she fit still go back to miuzik.
Akordin to di tori wey we gada wen she follow channels television yarn during di launching, she say na on only one condition go make her do miuzik again.
She say,"if di right song come at di right time, she go singam".
For dose of her fans wey won hia her voice again,Oya time for prayer don rich so dat God go givam di right song.
For 2004, Genevieve reliz one hiplife jam, 'No more' and many pipo curse di song but na plenti dJ's favorite song back den for party.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...