MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 8 October 2014

GENERAL BABANGIDA SAY DI SICKNESS FOR HIM BODI DON GO AND HIM BODI DON STRONG CHIMCHIMCHIM.

FORMA KHAKI PRESIDOS, IBB and ABDULSALAM WITH
GOVNOR ALIYU MUAZU SOMETIME BACK
Forma khaki wearing president of nigeria, General Ibrahim Badamosi Babangida, don yarn from obodo oyibo say, di sickness wey make am travel don go kpatakpata.
We bin yarn una 2 weeks ago say IBB dey sick siriosly and dem don fly am go Germany for tritment.
SORRY SIR, GET WELL SOON
But wen anoda forma khaki president, General AbdulSalam Abubakar call am yestaday for di house of Niger state govnor, Muazu Babangida Aliyu for phone, IBB talk say im bodi don strong kakaraka and say im go soon come back bicos him don miss home and all of dem welwel and he dey wish dem happy Barka de Sallah.
Nor be only Abdusalam and di govnor dey there as he also follow di journalist dem wey dey around talk too.
IBB also yarn dem say,no shakement say him go come back anytime from now.
Last week, Govnor Muazu Aliyu send some pipo go visit IBB.
Di two forma khaki president, AbdulSalam and Babangida dey always visit di govnor evri year for sallah celebration period.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...