MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 3 October 2014

IKPEBA DON BLAST SAY KESHI NO BE DI RIGHT COACH FOR SUPER EAGLES



KESHI
VICTOR IKPEBA

Forma Super Eagles and Monaco of France player,Victor Ikpeba don yarn say time for Stephen Keshi to waka leave Super Eagles don reach.
He say if Keshi no blame players today,he go attack forma players tomorrow sake of say dem advice am and meanwhy,naim dey cause eagles downfall.
Ikpeba say Keshi don lost am.he go invite players wey no too sabi and meanwhy he go dey follow naija best players dey quarel.
Ikpeba yarn all dis one for Warri wen dem carry waka go di oil city go choose di new Nigeria futbol federation,NFF chairman wey Amaju Melvin Pinnick later win to bicom di new chairman.
He say him no undastand di kain bricklayer wey Keshi be bicos na so so build he dey build since 2012 and na so so experiment he dey experiment sotay for Super Eagles to qualify for ordinary nations cup wey go shele for Morocco next year,na problem bicos dem loose,2 goals to 3 against Congo for Calabar and draw zero zero against South Africa and dat one means say,out of 6points we get only 1point,Congo don get 6points and South Africa,4points.
Victor Ikpeba also yarn say,no be only Keshi naim make Super Eagles win di nations cup wey dem win last year,he say na evribodi put head togeda winam.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...