MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 1 October 2014

TIME UP! TIWA SAVAGE DON SACK HER HUSBAND AS HER MANAGER

TIWA SAVAGE AND TEE BILLS
E be like say to dey sack family membas for bizness naim dey reign for town now.
Three Months afta Burna Boy sack him mama as him manager,Tiwa Savage sef don sack her husband as her manager too like say dem dey try to tell di world say,live family out of bizness.
Pipo don dey see di hand writing for wall since wen Tiwa no quick wish her husband Tunji Balogun aka Tee Billz 'happy birthday on di 26 of Septemba for instagram' until pipo kon dey remind her bifor she kon manage sendam one kain unromantic happy birthday shout out.
Di rumors wey we dey hear now why Tiwa sack her husband be say di bobo dey use blow dey san paper her face and even dey do kelekele love for outside.
Dem say di kain beating wey di bobo dey giv di eminado singa,Tiwa Savage,no get part two and di tori wey we even dey gada now be say,she don pack comot for dia house few months afta dem marry.
MEKKA MILLIONS
As we dey yarn like dis,na her assistant manager bifor,Mekka millions, don take ova Tee Billz role as manager.
ICEBERG SLIM 
Mekka bin dey work unda Tee Bills bifor Tiwa appointam as di new manager.
Mekka millions naim also be di manager to di rapper wit mohawk hair style,Iceberg Slim.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...