MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 5 October 2014

CHIDI MOKEME, EEDRIS, RUGGEDY BABA, IYANYA DON BLAST MTV BASE OVER NAIJA 20 SONGS OF ALL TIME LIST

CHIDI MOKEME

 Nollywood star and actor,Chidi Mokeme, Eedris Abdulkareem and oda Nigerians don blast MTV base for dia list of top 20 naija greatest songs of all time.
Chidi Mokeme yarn for twitter say make Mtv base pack well for one kona for Fela name not to dey di list.
EEDRIS
He say although 2face African queen and D'banj oliver twist no bad for dia list but e beta say make dem change Di title to 'top 20 naija songs for now' bicos di list no represent di truth as na so so nowadays miuzik full inside.
He also yarn say make Mtv base go boil rock chop bicos nobodi go even do Top 20 Africa greatest songs without Fela name no dey inside.
Anoda pesin wey dis list pain enta im bone marrow na Eedris Abdulkareem di bobo wey don sing plenti jamming wey don reign wella like jagajaga and Mr Lecturer.
He say na God go punish anybodi wey im hand dey for dat selection of di Mtv naija greatest 20 songs of all time.
RUGGED MAN
Even Rugged man finish dem for ground too as he say if mtv base know di meaning of greatest songs of all time, dem for do dia homework well bifor dem go bring dat kind yeye list come out.
He say even songs wey neva even reach one year,dey there and you dey call dem greatest songs of all time.
IYANYA
Iyanya sef blast dem say im jam Kukere wey scata evriwia suppose dey di list.

To see di full list of Mtv base top 20 greatest naija songs of all time so dat u go judge for yorsef,
Make you check am for bottom here:

1.2FACE-AFRICAN QUEEN
2.9iCE-GONGO ASO
3.D’BANJ – OLIVER TWIST
4.P SQUARE FT.WAJE – DO ME
5.WIZKID – HOLLA AT YOUR BOY
6.DAVIDO – DAMI DURO
7.ICE PRINCE – OLEKU
8.D’BANJ – WHY ME
9.M.I – SAFE
10.OLU MAINTAIN – YAHOOZE
11.NAETO C – KINI BIG DEAL
12.DAVIDO – SKELEWU
13.BANKY W – LAGOS PARTY
14.WIZKID – PAKURUMO
15.ASA – JAILER
16.P -SQUARE – CHOP MY MONEY
17.WANDE COAL – BUMPER TO BUMPER
18.DR SID – SURULERE
19.FLAVOUR – NWA BABY REMIX
20.KCEE –LIMPOPO

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...