MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 13 October 2014

JOURNALIST AND FANS SAY KESHI MUST GO

AMAJU PINNICK
Di NEW NFF CHAIRMAN
Many pipo feel say day no go break bifor dem go sack Super Eagles coach Stephen Keshi afta dem loose to Sudan one kondo for nations cup qualifier and don get only one point out of nine.
But di big boss as dem dey call Keshi stil kack for chair as Eagles coach even tho rumors come say dem don sack am.
Di guild of sports editors for naija don come out now say di new NFF wey Amaju Pinnick dey lead must sack am bifor di return leg match for Abuja on wednesday.
Akordin to di yarnings wey dem bring out,di presido of di association, Mr Tony Ubani,say make NFF no allow Keshi yansh smell dat bench for di day of di match bicos he fall ova 100 million pipo hand for di match.
KESHI
Dem say  he dey do like agbero, he dey insult pipo anyhow, he no dey take advice and sometimes na players wey dey clear grass for dia clubs he dey like invite.
Dis jounalist association kon advice NFF say make dem no follow Keshi talk  "con" not to talk of "tract" as he cup don full dey troway and he no deserve new contract.
Even kpakpa sef many football fans no won hear Keshi name for dia ear.
Out of 11 pipo wey I follow yarn Keshi mata afta di match,9 say make dem sack am bicos he don run out of ideas.
Super Eagles naim dey carry last for di group wit 3 matches to go.
South Africa get 7 points, Congo get 6 points, Sudan get 3 points and Nigeria get just 1 point.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...