MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 30 September 2016

NAIJA VICE PRESIDO,YEMI OSINBAJO,DON YARN SAY,YOU BE MADMAN IF YOU ENTA GOFMENT AND YOUR PLAN NA TO THIEF Di KONTRi DRY


Our Vice President,Yemi Osinbajo don yarn say,if di only tin wey anybodi wey enta gofment dey tink  na to go make money,naim be say di pesin dey mad.
Akordin to Osinbajo pasona pesin,Mr Laolu Akande,he say di vice presido yarn all dis one for inside di presidential villa,Abuja wen he do small joinbodi meeting with Christian Ministas Welfare Initiative wey dia oda name na Pastors Forum,Taraba state.
He say wen u get opotuniti to lead di pipo,u sopose tink of how u go work to make dia life beta.
He say him oga,Muhammadu Buhari,don telam tire say,at his age,notin him dey tink about for gofment dan yo make Nigeria great again.
Yemi Osinbajo don beg evribodi say na dat kain spirit he want make evribodi carry enta gofment,dat is,do somtin for di kontri nor be to tiff somtin from di kontri.

RUGGED MAN! SEE PICTURES OF HOW MINISTER LOOK LIKE FOR SOUTH SUDAN





Ol boy,dis guy face fit boil rock o.
Konpia Fashola,Amaechi,Adeosun looks wit dis South Sudan minista,you go know diferens dey bitwin akara and bons.
Mabior Garang De,na di minista of water mata for South Sudan and South Sudan brake out from Sudan afta many years of war.
Di way wey dis guy dey dress and behave,you go know say di bobo fight for war and dem use dis water minista position take kool hin tempa down.
Jaguda rili get oga.

Thursday 29 September 2016

LUCKY BOY! CRISTIANO RONALDO PLANE DON CRASH!




Di Landing Gear wey skata

Real Madrid and Portugal baller,Cristiano Ronaldo private jet don crash land for Barcelona El Prat airport.
Di luck about di mata be say Ronaldo nor dey inside di plane as he dey Dortmund dey prepia for dia match wen di plane get fault on Monday.
Di plane landing gear,brake and e skata and as dem land.
Di emagensi pipo wey dey on ground,rush go hep di pilot bifor water pass garri.
Dem later treat di pilot for minor injuries.
Cr7 put di private jet on hire for konpinis and na one of di konpini dey use am wen he take crash.
Ronaldo buy di jet for £15 million last year.

CHOi! RWANDA PIPO DON FALL 2FACE HAND AS NA ONLY '40something' PIPO NAIM ATTEND 2BABA SHOW FOR INSIDE KIGALI WEY BE DiA KAPITAL CITY




Big name,2face Idibia land for Kigali,Rwanda to play show for dia but wetin him eye see,he mouth manage to talk am.
Less dan 50 pipo naim attend di show as di rest pipo dey house jejeje dey tink dia life.
Di exkiuz wey dem dey give us be say,dem nor promote di show welwell.
Dem nor do beta advat for radio and television so dat pipo go ginja to attend di show.
Di show promotas sef nor try.
Na Rwanda wey Neva stil rekova from di war wey dem fight some years ago,naim dem carry show go?
Dem kon even forget say 2face don dey reign dey go.
For dat kain kontri,na few miuzishans bodi odour fit draw pipo comot for dia house go watch show.
Maybe pesin like Wizkid,base on say di bobo na di biggest Africa miuzishan right now for di world.
And I nor even dey sure say dem go like come.

CAMERA DON KAPCHOR PREGNANT JANET JACKSON FOR LONDON




Michael Jackson junior sista Janet,don appia for London pregnant.
Akordin to di rumor,e be like say she go buy baby tins.
Fear tori pipo camera o,my broda.
If you like hide for inside hole,dem go still snap you pishor and show you wetin you dey do for inside di hole.
Di 50 years old singa dey marry Arab man Wissam Al Mana and e be like say di bobo don transfer somtin givam to kip for 9 months.
We dey watch.


Wednesday 28 September 2016

FOOD DON COME! Di CHAIRMAN OF SENATE COMITEE ON TOP ABUJA MATA,DINO MELAYE,DON YARN SAY MAKE PIPO KILL ANY MALU WEY DEM SEE DEY WAKA ANYHOW FOR ABUJA MAIN TOWN


Dis Fulani and dia malu wahala nor go cause war for dis kontri so?
Many town and villages for naija don dey konplain since about how dis cow ownas dey chop dia farm products and destroy dia farm.
We don see and hear tori of how upon all dis ones,di Fulani boys stil dey kill and rape di villagers wey konplain join.
Nor be only dat one,di cow don take dia shit and any how waka waka dey disturb Abuja politishans.
Dis dia waka waka dey cause traffic too.
Now di senate komiti on top Abuja mata wet dia oga na Dino Melaye,don yarn say,if u see any cow wey dey wakawaka like mumu for inside Abuja main town,make u killam chop.
Dem also say dem go fine di malu owna 50,000 naira if dem brake di law again.If yor pawa carry am,kill any malu wey u see for Abuja city.
If na suya or pepper soup u won use am prepia,no wahala.
But my advice to you make u look well bifor u kill any malu bicos dose Fulani boys knife sharp pass anytin.
Nor let dem kill u take do suya.
But come o,Shey na odnari shit and traffic wey dis malu dem dey cause naim our gofment kon wake up from dia sleep?
Dis Fulani Cowboys don kill thousands of pipo for Enugu,Delta,Benue,Imo,Edo and many oda places.
Wen di pipo konplain to gofment to hep dem gofment quiet but now e don reach Abuja,dem don carry di mata for head like lakpalakpa.
Yeye dey smell.

Tuesday 27 September 2016

FOOD DON COME! Di CHAIRMAN OF SENATE COMITEE ON TOP ABUJA MATA,DINO MELAYE,DON YARN SAY MAKE PIPO KILL ANY MALU WEY DEM SEE DEY WAKA ANYHOW FOR ABUJA MAIN TOWN


Dis Fulani and dia malu wahala nor go cause war for dis kontri so?
Many town and villages for naija don dey konplain since about how dis cow ownas dey chop dia farm products and destroy dia farm.
We don see and hear tori of how upon all dis ones,di Fulani boys stil dey kill and rape di villagers wey konplain join.
Nor be only dat one,di cow don take dia shit and any how waka waka dey disturb Abuja politishans.
Dis dia waka waka dey cause traffic too.
Now di senate komiti on top Abuja mata wet dia oga na Dino Melaye,don yarn say,if u see any cow wey dey wakawaka like mumu for inside Abuja main town,make u killam chop.
Dem also say dem go fine di malu owna 50,000 naira if dem brake di law again.If yor pawa carry am,kill any malu wey u see for Abuja city.
If na suya or pepper soup u won use am prepia,no wahala.
But my advice to you make u look well bifor u kill any malu bicos dose Fulani boys knife sharp pass anytin.
Nor let dem kill u take do suya.
But come o,Shey na odnari shit and traffic wey dis malu dem dey cause naim our gofment kon wake up from dia sleep?
Dis Fulani Cowboys don kill thousands of pipo for Enugu,Delta,Benue,Imo,Edo and many oda places.
Wen di pipo konplain to gofment to hep dem gofment quiet but now e don reach Abuja,dem don carry di mata for head like lakpalakpa.
Yeye dey smell.

NO! NO! NO! NO! FLOOD DON TAKE OVER GOODLUCK JONATHAN TOWN OF OTUOKE AS MANY PIPO DON COMPLAIN TO TORi PIPO

Flood don take ova di Otuoke/Onuebum road for Ogbia local gofment area for Bayelsa state as pipo for di are dey pass tru hell to comot.
Inshot,na elebele road wey far die naim motors dey pass now and I case u don forget,na dat area mama peace hosband,Goodluck come from be dat.
Dis flood worse for 2012 and dem nor do any sirios tin to stopam.
If kia is not taken,water go take ova di classrooms of students of di Federa univasiti bifor dem go back to school veri soon.
 Many soportas of forma Presido,Goodluck Azikiwe Jonathan don alreadi come out dey yarn say,flood nor be wetin u fit kontro bicos na nachora disasta.
Pure robish talk!
If u nor fit build beta drainage for your own small town for six years as president,na me wey dey manage small rabbit farm go do am for u?
Abi na Buhari wey don make frend wit Fulani Cowboys won come do am for you!
Oyibo go say 'misplaced support'.
If you choose to soport robish na yor headache be dat nor be my own.

Monday 26 September 2016

POLITICIANS! UNA DON START ABI?


So na akara who na won take bribe pipo na abi?
Edo elections don near ground and now pipo wey make democracy be like craze for dis kontri don dey find way to take gada voters.
Akara bribe banner for Edo state don enta tori pipo hand and na APC dem write put.
But wot if na dia enimi PDP naim go print dis banner make dem for dey laff dem?
Well,dat one konsign dem.

"STOPAM! I NEVA DIE!" Di RICHEST BLACKMAN FOR AFRICA AND Di WORLD,ALIKO DANGOTE,DON SHOUT BACK GIVE Di AMEBO PIPO WEY DEY CARRY RUMOR SAY HIM DON DIE


Who be di pesin wey sell dis rumor give pipo wey carry am.
Abi na Dangote enimis?
Make Dangote find out dat one by imsef and tell tori pipo.
We go hepam spread am.
Naija pipo wake up kon dey hia dis yeye rumors but Dangote imsef don come out yarn say,make we nor mind dem say he body dey strong kakaraka.
He yarn dis one on top twita.
If u rememba,Dangote join some world leaders like Barrack Obama for di United Nations General assembli joinbodi meeting for New York.

Sunday 25 September 2016

BAYELSA STATE GOVNOR WIFE,MRS RACHAEL DICKSON,DON BORN FOUR PIKINS AT ONCE FOR AMERICA.MEANWHY,DEM DEY BEG GOD FOR ONE SINCE AND NOW GOD DON BLESS DEM WIT FOUR.



God way nor be man way.
Even Gofnor Seriake Dickson and him wife Rachael,nor go biliv say,God go bless dem wit four shidrens at once afta dem don dey look for just one since for many years.
Na so God dey do hin own.
Soprise,soprise,soprises.
She born dis four shidren for Americaoon Friday.
Congratulabia.

OLD MAMA YOUNGIE: Di MOTHER OF FLAVOUR NABANIA BABY MAMA,NA CORRECT SWEET 16

Anna Banner

Anna Banner,Flavour baby mama nomba two,don sampo di pishor of di mama wey born her on top Instagram to take selibrate her birthday.
She fine nor be small and she kon be like young Diana.
Choi!beta sweet 16 of life.
I nor sure say di Flavour wey I know see dis woman bifor he meet di daughta.
If not,na two differen tori una for dey hear.
If u nor know say Flavour na di real 'Bad,Badoo,Baddest' for Nigeria entertainment,naim be say u nor dey follow up.

Saturday 24 September 2016

WIZKID DON CALL CANADA MIUZISHAN 'THE WEEKEND' 419 BICOS HE NAME HE NEW ALBUM 'STARBOY' AND STARBOY NA WIZKID COMPANY NAME.



I follow sombodi dey diskos dis mata,di pesin kon yarn say,the weekend,fit nor know wizkid as starboy.
Na true talk be dat but my argument be say,why e be say na wen wizkid break enta dia market,naim he kon name he album starboy?
Bicos bifor now,nobodi dey shout starboy, starboy except wizzy.
Wot if di bobo don watch one wizzy video wia he for dey shout starboy?
Nor be only dat one,wizkid always dey write starboy for all him video and nor forget say di bobo don popular for di world since he follow Drake sing 'one dance'.
Well,make dem two settle dia mata.
I dey cross road go buy akara to punish did hot fresh bread.

Friday 23 September 2016

CAN U IMAGINE? ICE PRINCE PIKIN SAY HE DON GET GIRL FRIEND! (VIDEO)


I go dye rili talk am say,if u like hide ashawo talk from shidren,some of dem go still know wetin deyfor pipeline.
Who know wia  Ice Prince and him pikin dey drive dey go bifor dem kon enta hosting levels.
At his age,so dis  boy don get gehfrend?

Oya klik and watch di vidio for bottom hia make you hear wetin dem dey diskors..


Thursday 22 September 2016

I NOR FIT FORM! NO MATA HOW MANY TIMES I TRAVEL GO YANKEE,I GO STILL DEY BEHAVE LIKE PROPER NAIJA PIKIN-TIWA SAVAGE


Tiwa Savage don yarn tori pipo,Vibe Magazine say,she nor fit form for some kain tins wey some pipo dey form ova.
She say wen some Africa miuzishan don get chance to play enta yankee,dem go just dey form.
Dia tongue go change ovanite.
Mama Jamil don yarn say she nor go join dem.
She say she dey reprezent Africa and nobodi fit negotiate dat one.
Nice one babe.

Wednesday 21 September 2016

CHIBUZOR a.k.a FAZE,DON PRAISE HIM FORMA OGA FOR PLANTATION BOYS,BLACKFACE,AS Di PESIN WEY MAKE AM BE WHO HIM BE TODAY BICOS HE BILIV HIM TALENT FROM Di BIGINNING


Faze,2face and Blackface,na di three bobos wey make up di plantation boys but di band don skata for some years now.
Even on top di skata,Faze stil find time to praise Blackface as di pesin wey biliv him talent from day one.
He yarn tori pipo say,nor be small enkorrage Blackface givam.
Di blackman go telam bifor he go any singing kompetishon say,he go carry first and true true Faze go win evribodi.
Di same Blackface naim addam join di plantation boys as he biliv say if Faze join,he go add more bite to di group.
Me and u know about di bite and di skors wen di three of dem bin run shows togeda.
Dem skata evri ear dat time wit beta jammingjamming but now evribodi don carry dia cross and dem stil dey di industri dey do dia tin.

Tuesday 20 September 2016

IMO STATE GOFNOR,ROCHAS OKOROCHA,DON TELL IMO PIPO SAY,ANYBODi WEY CIRCUMCISE ANY GIRL AGAIN,GO SPEND PLENTi YEARS FOR PRISON

My pipo my pipo,if u neva hear,Gofnor Rochas Okorocha of Imo state don warn pipo of di state say,anybodi wey carry knife near any girl website say dem won circumcise am,dat pesin go enta prison.
Rochas yarn dis one on top di joinbodi campaign wey him wife Nkechi and United Nations dey do to take diskorage pipo from circumcising dia gehs shidrens.
Mrs Okorocha gada ova 500 gehs student and women and dem waka round some street to krate awareness.
She say,dem nor go rest until dem stop dis circumcising karata for di state.

Monday 19 September 2016

NAIJA SINGA JIDENNA WEY BASE FOR AMERICA,DON YARN SAY,HE NOR FIT FOLLOW ANY WOMAN WEY NOR SABi COOK JOLLOF RICE AND ANY WOMAN WEY NOR GET BIZNESS SENSE


If u be woman,you nor sabi cook jollof rice,Jidenna di naija Singa wey base for America say,make u nor near wia him dey.
To make mata worse,Jidenna say,if u nor kon get bizness sense join,make you giam long distance.
He yarn tori pipo all dis one and I nor dey soprise.
Nor be evri man fit stand woman wey nor sabi cook and Jidenna don show say him na one of dem.
If you like carry all di baddest style enta bedroom,di ibo boy don tell u say,you must sabi cook join to make yor talent konplit.

Sunday 18 September 2016

ONE WAY CLOSE ANODA ONE OPEN: DAMMY KRANE DON LIVE 2FACE HYPERTEK RECORDS,AS DAVIDO DON SIGN AM ENTA HIM WORLDWIDE MUSIC GANG




Davido don announce di signing of Dammy Krane enta Davido miuzik worldwide(DMW).
Bifor now,Dammy bin dey wit 2face konpini,Hypertek.
I be pesin wey dey praise good tin if I see one.
Oya rizinam.
Many old miuzishans wey we don attend dia shows,buy dia CDs,dem nor even dey give back to di sosaiti.
No label,no workshop,not even palm wine for di boys,no grooming di young ones upon di whole endorsement wey big konpini endorse dem.
Davido,you be man.
I fit don vex for you ova some of di tins wey u don do bifor,but no man dey perfect.
Dis ova five artiste wey u don sign and give voice to,you don earn my respet foreva.
At yor young age u don give back like dis,make baba God grow u bigger.
Abeg,make di upcoming and some sinior ones learn from di young boss.

Watch Davido and Dammy Krane hapi moments afta di signing for bottom hia...


Saturday 17 September 2016

FOR DIS KAIN HARD CONDITION,OYO STATE GOFNOR DAUGHTER DEY SPRAY DOLLARS FOR INSIDE PARTY


For state wey dey owe workers six months salary,can u imagine gofnor pikin attend party and she kon dey spray dollars.
Na wetin Abiola Ajimobi gofnor of Oyo state daughta do be dat.
For dis kain harsh hungry period?
  1. My broda  yawa dey o.
I nor won yarn too much,watch di party wey  she for crase di crase for hia ..


Friday 16 September 2016

AFTA POLICE ARREST Di ARM ROBBERS WEY ROB SUPER EAGLES PLAYER,OGENZI ONAZI PAPA,DEM DON CONFESS SAY,NA BICOS Di PAPA DEY STINGY NAIM MAKE DEM GO ROBAM


Police don finali katch di boys wey go rob super eagles midfielder Ogenyi Onazi papa.
Dem tiff hin white Toyota highlander and 5k,and na for Lagos area of Ajamgbadi wia dem run go lodge naim police for arrest dem.
Di area pipo naim report say some boys dey invite different pipo to come dey price di car.
Base on say dem no trust dem,naim make dem invite police.
Dem be area boys to Onazi old man and dem don confess say na bicos di man dey stay alone and he also dey stingy naim make dem go robam.
Na wa o.
If he dey stay alone nko?
Na una papa?
I expect di police to deal wit dem akordin to di law.

Thursday 15 September 2016

ONE OF GHANA BEST MUSICIAN,STONEBWOY,DON TELL PIPO WEY SAY NA JUJU HIM DEY USE TAKE MAKE HIM CAREER SHINE SAY,NOR BE JUJU BUT HARD WORK


You know say for Africa,e dey always dey soprise pipo if you dey shine wit speed.
Dat na exactli how plenti pipo don dey soprise weda Ghana afropop,reggae and dancehall miuzishan,Stonebwoy,dey use juju to make him karia rise and rise.
Stonebwoy say notin like dat dey appun.
He say na siriosness,hard work and dedikayshon putam for wia him dey today.
Stonebwoy wey him real name na Livingstone Etse Satekla,tell tori pipo say,otumorkpor or magic nor dey among at all.
He say bicos him dey focus naim make joliment full him karia.

Wednesday 14 September 2016

OLD SKOOL NOLLYWOOD ACTRESS,ANN NJEMANZE a.k.a DOMITILLA,DON ACCUSE ADUNI ADE OF THIEFING HER HAND BANGLES WEN DEM DEY SHOOT ONE FILM FOR IKEJA


I be tink say hand bangles nor to cost o but dat nor be di case  as old skool nollywood actress Ann Njemanze a.k.a Domitilla,akiuz Aduni Ade say na she tiff her hand bangles for Weston hotel di place wia dem for shoot di film for Ikeja.
Nor be small para Aduni para as she say wetin she won use hand bangles do.
Di botomline now be say,di bangles loss and na sombodi for dat place tiffam.
Wetin be hand bangles wey pesin dey tiff.
EFCC dey akiuz Patience Jonathan of tiffing ova $31million dollars and sombodi dey dia dey tiff odnari hand bangles.

SEE Di BABE WEY SOME HAUSA PIPO SAVE FROM RITUALIST FOR DELTA STATE


Make God nor let pesin wake to hear bad news.
Dis harsh piriod plus bad news join,na die.
Ritualist for Obiaruku,Delta state use dis babe eye see shege.
If not for God wey use some Hausa pipo take save dis babe,her life for don end like football match.
Why ritualist nor fit use malu or fowl take do dia rituals.
Suegbe pipo,na thunda go fire dem!



Tuesday 13 September 2016

HUNGER BAD AS POLICE DON ARREST FADA OF 5 SHIDREN FOR AKWA IBOM STATE BICOS HE THIEF PLANTAIN


Wetin di spirit of tiff and hunga dey make some pipo do for dis kontri,nor be small.
Imagine Victor Okon for Uyo,Akwai ibom state,wey be fada of five.
Di man tiff bunch of unripe plantain and dis one don land am for police station for Ifaha Atai,Akwai ibom.
Make hunga nor make pesin go do wetin nor dey God book.
Baba God save your shidren.

Monday 12 September 2016

SAD NEWS! KANU NWANKWO MAMA,MRS SUSAN KANU IHEME,DON DIE AKORDIN TO TORi WEY WE GADA

Two times Africa footballer of di year and forma Super Eagles captain,Kanu Nwankwo mama don die on di 7th of Septemba akordin to Tori wey we gada.
As at di time wey we take enta studio to bring una dis tori,di famili neva reliz di burial plans.
Rest in peace mama.

Sunday 11 September 2016

DEM SAY IF NOBODi PRAISE YOU MAKE YOU PRAISE YOURSEF AS AYO FAYOSE,DON PRAISE HIMSEF AS Di BEST GOVERNOR WEY EKITI STATE DON EVER GET


Na wa o.
First of all,dis money wey dem take dey do work for dia state wetin dem sopose use am do if not to take develop dia state.
I just say make I let una know,di gofnor of Ekiti state,Ayo Fayose,don yarn say naim be di best gofnor wey Ekiti pipo don eva get since dem create di state 20 years ago.
He say di work wey him don do,none of di forma gofnor get sense do like am.
If you ask me,make he work and stop all di sef praise.
Let pipo sing yor praises if you rili dey work.

BUHARI MUST SEE DIS PICTURE! SEE WETIN HUSBAND DO TO WIFE BICOS SHE PRAISE BUHARI




I neva talk for dis mata,di tin don alreadi tire me.
Dis na wetin one man do him wife just bicos she say Buhari dey work.
Abi di man drive trailer enta di woman?
Dis beating nor be here o.
Shuo!
Di only tin wey I get to talk for dis mata be say,make Buhari and him frends check diasef weda dem dey rule well.
Some pipo go tell u say Buhari dey work fire why some go tell u say,Buhari know nothing.
Journalist sopose intaviu like 5,000 pipo and ask dem weda Buhari dey rule well or not.
Buhari and di man wife go dey one side and di man go dey di oda side.
Anybodi wey hin vote plenti pass naim win bicos dis mata don pass be kiafu.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...