MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 28 March 2019

THE MAMA OF EGYPT SUPERSTAR FOOTBALLER 'MOHAMMED SALAH' DON DEY PARA SAY,SALAH FALL HER HAND AFTA PICTURE OF WIA SALAH HUG ONE FEMALE FAN SHOW FACE FOR INTANET


Mohammed Salah mama don dey para foram base on di picture wey come out online wia evribodi see wia Salah hug one female fan.
Salah mama say like say Salah papa eva do dis kain ting,not in for make her no comot for di marriage.
You know say moslems no dey like all dat kain ting espeshali wen di pesin no be ya wife.

Wednesday 27 March 2019

HIGHLIFE SINGER FLAVOUR, DON BUILD SCHOOL FOR BLIND PEOPLE FOR LIBERIA TO TAKE CELEBRATE HIM BLIND FRIEND 'SEMAH'


Eva since Flavour Nabania turn friend wit dat Liberia small boy Semah G. Weifur,he neva look back to see how he go take add value to di boy life.
He dey go Liberia go visit di boy,sometimes he go carry di boy come Nigeria come stay witam.
But now,Flavour don close eye build school for blind pipo for Liberia.
Flavour post dis tori on top him Instagram page.
Why some don dey say,blind pipo no dey him kontri?some don dey praise am for di beta job.

Monday 25 March 2019

NAIJA SINGA 'WAJE' DON CRY OUT SAY,MUSIC DON MAKE HER BROKE AND SHE NO GET MONEY TO PUT FOR HER MUSIC BIZNESS AGAIN



Waje, di auntie wey sing 'Do me,Do me' for Psquare song dat year,don cry out say,miuzik don finish all her money.
She say she don broke on top miuzik mata and she no get money to dey push her miuzik bizness again.
For inside the video wey dem don dey play for evriwia she say,her daughter school fees alone dey givam headache so diafor,make miuzik dey one corner.
Watch di video for bottom hia...


Sunday 24 March 2019

PATIENCE OZOKWOR a.k.a 'MAMA G' DON YARN TORi PIPO SAY,E STILL DEY PAIN AM SAY HER FAMILY NO ALLOW HER MARRY Di MAN OF HER CHOICE WEN SHE YOUNG


If you dey follow up,you sopose know di no nonsense Mama G of nollywood base on di way she dey show pipo pepper for all her films.
Mama G wey her real name na Patience Ozokwor don yarn tori pipo say,she still dey bitter say dem no allow her marry di bobo wey she plan to marry wen she still dey young.
She say in those days na arranged marriage dey reign welwell as most times na ya famili dey choose who you go marry for you.

Friday 22 March 2019

DAVIDO DON YARN SAY,ONE DAY HIM GO TRY HIM ACTING SKILLS FOR INSIDE NOLLYWOOD AND NA JAGUDA ROLE HIM GO LIKE TO DEY ACT


Supastar Davido don yarn tori pipo him dey nollywood wit corner eye.
He say him get mind to enta film acting one day but sha him no say na bigina for dat kind mata.
He say if he finally get di chance,him go like to dey act jaguda part.

Tuesday 19 March 2019

MAKOSSA MUSICIAN 'KOFFI OLOMIDE' FROM CONGO DON RECEIVE 2 YEARS PRISON SENTENCE AFTA HE RAPE 15 YEARS OLD GIRL


One of di most popular voice for Makossa miuzik 'Kofi Olomide' don  enta wahala afta court find am guilty onto say he rape 15 years old girl.
Dem givam two years suspended jail sentence for France and dis one mean say,dem no go waste time to arrestam if he enta any kind of wahala again.
Koffi Olomide wey be graduate of matimatics, get many of kerewa case wey dey hang for him head.
Even di girls wey dey dance and sing foram don bin confess say di man dey force dem sleep wit dem.

Monday 18 March 2019

GOVMENT DON GIVE PROMOTION TO THE CUSTOM MAN WEY REJECT OVER N150 MILLION BRIBE FROM Di MAN WEY WAN SMUGGLE 41 CONTAINERS OF TRAMADOL ENTA NAIJA


As pipo wey bad plenti rish for naija,me and some few good ones still dey.
Di custom man from di Apapa area command Lagos,wey reject $420,000 bribe,don get promotion from gofment.
$420,000 for Nigeria naira na ova 150 millions.
Di bribe come from pipo wey bin won shift 41 containers of tramadol enta naija but dis man stand gidigba say no way! I can't allow una pass.
Many pipo don dey vex for di man say him for collect di money bicos di money too handsome.
Some say di money wey dem go add join him salary fit no pass 50k.
If na me be di man I for rejectam too.
I know say una no go won biliv.

Saturday 16 March 2019

VICE PRESIDO AND PRESIDENT BUHARI SECOND IN COMMAND 'YEMI OSINBAJO' DON YARN TORi PIPO SAY,OGA BUHARI DON POOR PASS Di WAY WEY HE POOR BEFORE FOR 2015


Vice presido Yemi Osinbajo don yarn tori pipo say, President Buhari poorness level don pass church rat own.
He yarn dis one during di joinbodi groove wey him arrange wit pipo wey carry 'vote for APC campaign' for head during di elections wey just finish.
Akordin to Osinbajo he say,Buhari don poor pass di way wey him poor for 2015 wen he turn president.
Na wa for politishans sef!
Weda you dey support APC or PDP,all of us know how Oga Buhari look like di first time wen he enta Aso Rock.
Even I Go Dye neck dey learn for wia him neck dey.
Fast forward to today,di man don fresh like fresh bons wey dem just fry finish.
So Mr Osinbajo we nor undastand you at all,
Abi yarns don finish for ya mouth like comedian wey dey start work new?

Friday 15 March 2019

FOR EKITI STATE,GOVNOR FAYEMI DON SIGN THE LAW WEY GO MAKE DEM PUT ANYBODY WEY THIEF NEPA PROPATiS FOR PRISON FOR TWO YEARS


If you be jankoliko and you speshalise to dey tiff NEPA equipment and propatis,my broda,na inside prison for two years dem go throw you put.
Akordin to Ekiti state gofnor Kayode Fayemi wey just sign dis law for di state,if dem gbab you for di state dey tiff NEPA wire,na inside prison you and moskitos go dey romance una sef.
Na di message wey di gofnor say make I yarn una be dis.

Wednesday 13 March 2019

VICTOR AD,THE BOBO WEY SING DAT OGBONGE JAM 'WETIN WE GAIN' DON YARN SAY BY DIS TIME LAST YEAR HIM NO GET PASSPORT BUT TODAY HE DEY GO DUBAI LIKE SAY NA BACKYARD


Wen grace of God arrive your life,e no get anytin wey anybodi fit do about am.
Dis na di stori of di bobo wey sing 'Wetin we gain' if we no make money.
Him name na Victor AD.
Last year dis kain time di guy say,him no even get travelling passport not to talk of to dey travel to obodo oyibo but today,him dey go Dubai anyhow like say naim backyard.
Baba we thank God for ya life as I dey beg evri naija pesin make dem kontiniu to pray for grace as one day na one day evriwia go stew.

Sunday 10 March 2019

FOR PARAGUAY,'LIBERTAD DE PARAGUAY' DON SACK DIA COLOMBIA COACH (LEONEL ALVAREZ) WEY SLEEP WIT HIM PLAYER (EDGAR BENITEZ) WIFE


As women plenti rish,na your player wife kon enta your eye!
Well,if you neva hear,Colombia born coach Leonel Alvarez wey dey coach Libertad de Paraguay of Paraguay don resiv sack leta just like dat afta dem find out say he dey sleep wit him player wife.
Edgar Benitez naim be di player wey di coach dey sama him wife but di wife don dey cry out say na lie say nothing like dat dey appun.
Na wa o,di thickness of dis tori dey give me fever.
Sirios ogberaga tori.

Saturday 9 March 2019

AKPAKO MASTER AND DADA BOY 'TERRY G' DON YARN SAY,UP TILL TODAY HIM PAPA AND MAMA STILL DEY VEX SAY HE CARRY DADA FOR HEAD


Terry G di bobo wey Naija know as Akpako masta,don yarn tori pipo say,him papa and mama still dey vex foram till today say he carry dada put for head like pineapple flawa.
Dem don buy scissors kip since but di way wey di mata dey go so,e be like say dem neva fit pin Terry G down to take di dada down once and for all.
Terry G parents bin want make di bobo be pastor but a Terry G head no carry am.

Friday 8 March 2019

DAVIDO DON BOAST SAY HIM DEY SPEND N36 MILLION EVERY WEEK


Omo babolowo imsef Davido don yarn say him dey spend nothing less than $100,000 dollars evri month.
For naija naira dat na about N36 million.
Davido wetin dey wida?
Dangote wey worth billions of naira can't come out come tell us say him dey spend 36 million evri week.
Di only ting wey go make biliv naim if he yarn day na salary for him workas.

Tuesday 5 March 2019

GOOD NEWS AS NIGERIA DON OVERTAKE EGYPT AS AFRICA NUMBER 1 RICE PRODUCER


Akordin to di Direktor-General,Africa Rice Center,Benin Republic,Dr Harold Roy-Macauley,Nigeria don ovatake Egypt as Africa nomba 1 rice producer wit 4 million tones a year.
Egypt bin dey produce 4.3 million a year but e reduce wit ova 40% afta Egypt gofment limit dia rice cultivation so dat dem go fit save water resources.
No be lie dis one be at all as na so so local and home rice without stones naim full our market but di only ting be say e neva rili cheap to buy.
To show say dis our overtakement no be scam,make dem try comot small money on top di price of rice.
E go make sense.

Monday 4 March 2019

PASTOR ADEBOYE DON YARN HIM RCCG CHURCH MEMBERS SAY,E GET ONE MORNING WEY HIM AND GOD DRINK TEA TOGEDA


The Redeemed Christian Church of God GO Pastor Enoch Adeboye,don yarn say,e get one morning wey him say make him drink tea,bifor he say make he start to shack di tea,God just appear from heaven and join am.
He say na two of dem kon drink di tea togeda laslas.
Hmmm,make I no yarn anytin.
Make I just kwayet.
Make me sef go find tea drink too,anytin can appun.

Sunday 3 March 2019

TOP COMEDIAN 'ALI BABA' DON YARN SAY,FROM NOW ON,NA THUNDER GO FIRE ANYBODi WEY THIEF NIGERIA MONEY AGAIN


Ali Baba don dey swear for naija politicians say thunder naim go fire any of dem wey thief our money from now on.
Afta di comedian post thunder wey skata tree on top him Instagram page,he kon yarn say na dat kain thunder naim go fire any politician wey go chop govment money again.
But Ali Baba,dis politicians dey contract you to do MC work for dem.
What if na stolen money dem take dey hire you since?

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...