MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 29 February 2016

ALL HAIL DI KINGS AS EKITI STATE DON WIN DI AWARD FOR DI HIGHEST NOMBA OF PIPO WEY DEY SHIT FOR PUBLIC FOR NIGERIA


Evribodi get wia dem for be speshalist.
Why Usain Bolt na speshalist for 100mita race,Olamide na speshalist for street miuzik.
Why Wole Soyinka na speshalist for bookuru mata,David Beckham na frikick speshalist.
Why matimatikal Segun Odegbami na futbol matimatishian,Olajumoke Orisaguna na speshalist for bread selling until Baba God pick up her call.
Until yestaday,I nor know say pipo wey dey throw shotput,dat is and pipo wey dey shit for outside pass,get speshalist.
Out of di 36 states for naija,Ekiti state don carry di first position for shitting tins.
Akordin to di study wey dem carry out,1.8million pipo out of 2.7million Ekiti population,stil dey throw shot put or bend yansh shit for public.
Ekiti state Gofnor,Ayo Fayose
Ogakpatakpata for di Kominiti-Led Total Sanitation and staff for Rural Water Sanitation for Ekiti state,Mrs Lanre Ayeni yarn say,e dey pain nam say ova 1.8billion pipo for di world stil dey use dose kain water wey dem don shit put bicos dis water dey giv dem diziz.
She say anybodi wey drink water wey dem shit put go get ten million virus,one million bacteria and one hundred tausand parasite eggs for een bodi.
Baba God save yor shidren.

WATCH MAHEEDA BIUTIFU DAUGHTA AS SHE DEY SOAK GARRI (VIDEO)


Maheeda di goddess of x,as dem nickname her,don tish her fine pikin many naija tins.
E show for hia as di smallie dey soak garri for her birthday.
Di smallie fine finish sha.
Watch di vidio for bottom Hia...



Sunday 28 February 2016

EYAH,SEE DI LION WEY HUNGRY DON REDUCE TO SKELETON


Dis na di first time wey I dey see lion wey hungri won kill be dis.
Akordin to tori wey dey rish us,na zoo for Jos,Plateau state di lion dey and di lion don turn skeleton bicos of hungri.
Hungri dey faint am like three times a day instead of three square meal a day.
Weda make I piti for dis lion or not I nor kon know but if lion see human being,foget piti.
Giv di lion 2minutes,e go wack di pesin finish and grind een bones chop.
Na een gud foram.
Dem too wicked.

YAR'ADUA AND JONATHAN REGIME NOR BUILD ONE SINGLE NEW ROAD FOR DIS KONTRI AKORDIN TO VICE PRESIDO,YEMI OSINBAJO


Yemi Osinbajo,di vice presido,on Friday yarn say Federa Gofment nor build any new road for di past ten years bicos koropshon don enta pipo blood and dem nor kon dey respect demsef.
He yarn dis one for di pastors and lidas joinbodi activiti of di fountain of life church for Ilupeju.
If Yar'adua and Uncle Jona regime nor build any new road akordin to vice presido,Yemi Osinbajo,I hope dey demsef go rememba build new ones?
Nor be to yarn full ground.
Dis news bin soprise me but as he say na new road dem nor build make I nor argue but I know say Goodluck Jonathan renovate some roads like Benin/Ore road even tho dem nor complitam.
Abeg if dem build any new road for yor area let us know so dat we go know weda na lie Osinbajo dey yarn or not.

OYA KISS YOUR BRIDE!SEE AS MONALISA CHINDA AND HER HOSBAND DEY DIGAM FOR DIA WEDDING


Love na biutifu ting as dem yarnam.
Wia I for dey tire na wen Wahala don show face for di marriage,u nor go biliv say na two pipo wey dey kiss demsef be dis.
My prayer for dem na make evritin go sililiwelelen,make evritin go smooth for dem bicos I nor won Hia tori of say she won marry nomba three hosband.

Saturday 27 February 2016

YBNL SINGA,ADEKUNLE GOLD,DON PICK ORENTE AS HIM BEST SONG SO FAR


Talented singa Adekunle Gold,don skip Sade,Pick up,and pick 'Orente' as di best song wey him don sing.
Di bobo wey don alreadi dey win plenti awards,yarn say he dey veri hapi say di three jams wey een don reliz for market dey do well.
Adekunle Gold wey dey unda Ybnl Records,say di way wey 'Pick up' take dey skata evriwia and di way wey pipo take resivam na gud news foram but na Orente dey buss him brain pass.

BETA PIKIN: FLAVOUR NABANIA DON BUY MIUZICAL INSTRUMENTS DASH DI CHURCH WIA HIM BREAKTHROUGH FOR START FOR ENUGU

You see wetin I dey talk about?
Na dis kain tin I want make supastars and celibritis dey do for di world so dat pipo go look dem wit beta eye.
As a popular pesin,pipo sopose to copy beta tin or copy beta exampo from you.
Di king of Afro highlife for naija,Flavour don buy miuzical instruments dash di church wia him stori for start.

Akordin to Flavour of Africa,he say he hapi and dey tankfu for di position wey God givam to touch pipo lives wit positive tins.
He say make we nor give up our dreams even tho di road dey always dey roff.
He attend Church of God mission Enugu tanksgiving service and show dem beta love.
Di bobo say na dia evritin for start and na dia he for develop strong interest for miuzik and naim make am kon giv tanks to di church comuniti.

HUUH! PAUL, DI OGA FOR RUDEBOY RECORDS DON SIGN LUCY AS SHE POSE WITH JUST PANT AND BRA


Some pipo don resiv di pant pichors of Lucy di new First Lady of Rudeboy Records wit soprise why some look am as one of dose tins wey u fit see for dis kain bizness.
Some pipo say at list she for give us one koret jam bifor she give us her naked pishor.
Na di oga of Rudeboy Records,Paul go ansa all di queshons wey pipo go ask for dis style wey di geh take enta di market.
Early dis month,Rudeboy Records sign Muno as dia first miuzishan and na Lucy bi di sekond one wey dem sign.
Lucy,u don show us suntin,time to show us say u fit sing.


Friday 26 February 2016

'AY TILL I DIE!' MABEL DON YARN SINCE RUMOR COME OUT SAY SHE DON LIVE HER HUSBAND,AY


Who dey fool who?
Three days ago rumor broke out say Mabel wey be Ay wife,don cut out livam.
Today di same Mabel don write on top her Instagram page say,na she and Ay go dey run package til thy kingdom come.
She put one foto of she and Ay for Instagram and na dose love nwantiti words she take drive her mesage.
Dis one show say notin dey appun to dia mariage as Ay and Mabel na stil '5 and 6'.
Abi na plan work?
Who dey fool who now?

AFRICA! SEE AS STUDENTS SLEEP FOR GROUND DEY LEARN BOOK FOR GHANA


I don find out say na our lidas dey make di lidas of tomorow wicked wen dem finalli get di opotuniti to rule for di future.
Wen u sofa dem like dis,dem go won suck dia kontri account dry bikos dem ova sofa wen dem small.
Nor be say all dis Africa kontris poor rish dat level wey be say dem nor go fit arrange some kain simple tins for dia citizins but wickedness nor dey allow dem see road.
Imagine how dis tisha take dey tish dis primary school shidren for Kperisi M.A. Primary School for upper west regional capital for Ghana.
No chair and table to len book.
Some sidon why some sleep for ground.chai!
For Ghana rite now bikos of dis pishor,many pipo don dey talk aboutam on top twita until e go rish gofment notice.
I nor get plenti tins to yarn about right now,my own na just to enkorrage dis shidren make dem no loose focus.
Aftaraw,forma Naija presido,Goodluck Jonathan nor get shoe but he stil bikom president of big kontri like dis.
Make dem allow pipo like us wey get beta mind for dis kontri rule,na lie.
Wia pesin go see beta political godfada sef!

Thursday 25 February 2016

BREAKING NEWS! OLISEH DON RESIGN AS COACH OF SUPER EAGLES


Super Eagles coachee,Sunday Oliseh,don resign akordin to di tori wey dey enta our yard.
Di bobo make sure NFA pay am all di salary wey dem dey owe am bifor he resign.
Who be fool?
Akordin to Oliseh on why he resign,he say di kondishons wey him dey work unda,nor go fit produce di kain result wey him want for di national team.
Many pipo wey dey para say Oliseh nor dizav di job in di first place,go don dey drink plenti gulder full dia face just to celibrate.
Akordin to dem,Oliseh wey neva even coach any sundaysunday team bifor,nor sopose smell dat position.
Di Super Eagles next match na di nations cup kwoli fire wit Egypt for kaduna next month but we neva know who go sidon for bench as coach dat day.

CHAi! FIRE DON BURN DOWN ONE ASHAWO JOINT AND THREE ODA HOUSE FOR RIVERS STATE

One popular ashawo joint for Choba wey dem dey call Akamas for inside Obio/Akpor local govment dey among four haus wey fire burn down on thursday.
Wen di building dey burn,some of di costomas nor rememba to wear dia trauza as dem run come out wit dia JohnThomas .
Wen dem see strong tin,dem no care weda pipo see dia nakedness.
For yawa race mata,o'boy foget.
U don see wia dem for advise who won cook to buy maggi?

Akordin to di tori wey rish our yard,e be like say na cooking gas even cause di fire.
Di delay of di Fire fightas wey dem call nor hep mata as di Fire affect three oda haus dem.
Just in case u foget,na Choba di univasiti of port harcourt dey.

DANIEL DADA OF PSYCHOLOGY DEPARTMENT,DON BREAK RECORD AS DI STUDENT WIT DI BEST RESULT FOR DI HISTORY OF UNILAG


Dis Daniel Dada boy dizav klapin for di book wey he know so espeshali dis piriod wey plenti bois head don knock like motor engine.
Even gehs too to read na problem.
Facebook,twita and Instagram don take ova.
Pipo dey find money wit torch and candle and dis Daniel Dada kon krate rekord as di best student wit di best result for di history of Unilag.

Di bobo rating na 5GP and na di highest for di 54 year old history of di school.
Unilag VC,Profesor Rahamon Bello take time praise di bobo and he say na di department of psychology Daniel dey.
Akordin to di forma VC of di skul,Profesor Ibidapo Obe,he say Daniel achivment na beta rekord.

Wednesday 24 February 2016

BUHARI DON REJECT INVITATION TO JOIN ASSOCIATION OF ISLAMIC STATE AGAINST TERRORIST BICOS NAIJA NOR BE MOSLEM KONTRI


Naija Presido don skor one beta one against di kontris wey call demsef association of Islamic States as he reject dia invite for naija to join dia group.
Buhari wey dey for one week travel to Saudi Arabia,tell dia King Salman Bin Abdul-Aziz say,naija nor go join dat kain group instead naija go soport di group.
Thank u Buhari.
I nor know who tell dem say we be Moslem kontri.
Na Christians and Moslems na make up dis kontri so make dem kpror for di mata wey dey ground so.

COMEDIAN JULIUS AGWU DON GIVE AREA FADA 'CHARLY BOY' ONE OGBONGE REPLY BICOS HE SAY JULIUS JOKES NOR FUNNY


Born again comedian,Julius Agwu don attack forma Gbagada badboy,Charly Boy afta di area fada say di show wey di bobo organaiz for Abuja on valentine day dey veri boring.
Akordin to di bling bling fada,he say Julius spend plenti time dey preach instead offam to crack jokes wey dem take know am.
Nor be evribodi dey fit witstand dis kain advice as Julius don attack di area fada back.
He post one guy yoyo pishor and di guyman wia big big ring for all him fin gas and he say na dis kain pesin naim dey giv Oga Charlie inspiration.
He also write on top di Guyyoyo pishor say #AnyblingblingWeyDeyShineNaZinc.
Anyway,me I just dey hia di monitor wetin area fada go yarn next.

Oga Charlie

Tuesday 23 February 2016

HAA! COMEDIAN AY WIFE DON RUN LIVAM?


I hope say dis tori wey we dey hear no be true o.
All di serenren wey we dey see for intanet and newspapers don turn lie?
AY and een wife dey always dey hapi togeda anytime wey u see dia pishor for aproko site.
Dem dey even dey make us dey jealous dia marriage.



Now di rumors wey dey reign for town be say Ay wife,Mabel don pack comot for di bobo house sake of say she dey resiv enuff beating.
Dem say Ay don turnam to punching bag akordin to di tori.
Di two of dem don get one dota togeda alreadi.
We also hear say Mabel don delete all her pishors for Instagram.
All dis once na stil rumors as we dey wait make Ay yarn for di mata as he dey London right now dey shoot one televishon program,Lodgers.

AFTA WIZKID,PRAIZ DON JOIN TO ATTACK LINDA IKEJI


Na wa o.
Dis week na week of attack for Linda Ikeji?
One lawyer first blastam say na poverty mentality dey worry dis week.
Wizkid read di lawyer tori and he say een enjoy ram.
Yestaday di same Wizkid say Linda na almost 40years,she dey lonely and dey bita.
Just now now,Praiz don attack her too.
Praiz yarn on top twita say wey di Govnor of Minnesota for America,Mr Mark Dayton honoram on 6th of February,tori queen,Linda Ikeji nor carry di tori and dem be naija togeda but wen di state of Carlifonia honor comedian Kevin Hart,Linda Ikeji rush carry di tori like say dem pay her to carry di tori.
Praiz say na God go hep us for dis kain karata.

RADIO STAR,TOKE MAKINWA SAY HER FORMA BOYFRIEND BREAK UP WITH HER BICOS HER PAPA POOR PASS CHURCH RAT


Hmmm.
Di kain stori wey we dey hia about love nor go eva end bicos na evriday u must hia freshfresh ones weda good or bad.
Di latest lovu nwantiti tori wey I want make u hia na wetin Toke Makinwa yarn us konsigning her expirience.
Radio prezenta,Toke Makinwa say e pain am enta bone some years ago di tin wey love use her eyes see.
She say her forma boyfrend wey come from rich famili,knock her bicos her own famili too poor.
Di day wey di guy tell her say she nor want again,she kon gada mind ask di guy say why?
She say di bobo telam say een famili dey expect am to follow geh wey dia famili holit too and not sombodi like Toke.
Toke Makinwa say she cry sleep dat nite but even inside di cry she tell hersef say na to succeed for life or notin else.
Since dat time she nor look back again as she don double up her hustling.
Today now,Toke don dey rob sholda wit her mate as her hustling don pay and her bank account dey swell up like bread wey dem soak for water.
She say she neva even start but baba God dey move her up step by step.
She also take time to advice pipo make dem nor loose hope in God bicos nobodi wey nor fito make am.

Monday 22 February 2016

ANNIE IDIBIA,2FACE WIFE,DON DRAW EAR DEY WARN ONE BABE FOR INSTAGRAM SAY MAKE SHE NOR TRY SKATA HER FAMILY


E nor dey clear wetin di babe do Annie Idibia but we dey suspect say she dey try carry 2face go kona go teach 2baba some lesins.
From di way wey Annie take attack di babe for instagram,u go know say somtin dey pipeline.
She even call di babe rich kid and family home recka.
She say make di make pipo hep her carry di news until e go reash di geh famili pipo bicos she dey worry her own famili.
Annie say if she start to release di geh message for public,pipo go shock but she nor won do am.so diafor make di geh give her famili chance.
Annie sef for try yarn us di koko of di mata so dat we go know wot to yarn.
If na about 2baba,dat one nor be news bicos 2baba futbol team neva complit.


UNA DON HEAR?ACCESS BANK DON CLEAR KANYE WEST SAY DEM GO GIVAM DI N10billion WEY HE DEY FIND

America rappa and Kim Kardashian hosband,Kanye West don receive reply on top twita and een yarn say him need $53million to take settle debt and krate some biutifu ideas for di world.
Access Bank wey nor fit borrow me common N50,don dey beg Kanye West say make he let dem know wetin dey pipeline as dem readi to givam di N10billion naira wey he dey find.

Many pipo dey find loan of just N60,000 to take start small bizness,dem no see and Access Bank dey show dia kpai nomba for sombodi wey nor send dia papa mesage.
If u folow up,last week,Kanye West bin dey beg Facebook owna Mark Zuckerberg say een need money make di yong bobo hepam.
I nor know who dey craze pass bitwin Access Bank and Okorowanta.

DIS CHARLY BOY DAUGHTER MATA NOR BE HERE O,SHUO!


Like papa,like dota.
Like mama,like dota.
Di last dota of Charly Boy and him America wife Diane,don cut rope giv us some kain wicked pikchors,di same karata wey we take know her papa and mama.
Dominique Oputa AKA Princess Dewy, show us her hot bikini bodi and breast and now, many mehn don dey come out from wia dem hide dey shout,'okokobioko!
Di 22 year old babe,carry waka go kack for cacun beach and pack di foto dem wey she take for dia on top Instagram to take disturb di boys wey nor dey use eye see beta tin.
Dis area fada dota sha, take am easy on us o,make crowd nor go get hypertenshon bicos of yor load.



Sunday 21 February 2016

BUHARI GO SOON ARREST OBASANJO BICOS NAIM CARRY CORRUPTION ENTA NATIONAL ASSEMBLY AKORDIN TO SENATOR USENI


Akordin to Senator Jeremiah Useni wey also be di forma gofnor of Bendel state,he say dis one wey forma khaki and civilian presido,Olusegun Obasanjo dey yarn say di National Assembly pipo koropt so,Buhari go soon carry di fight reach een door mot.
He say why bicos,na Obasanjo naim start koropshon for National Assembly wen he dey bribe di house sake of say he won rule anoda 4years join di 8years wey him don rule.
But naija pipo nor gree make e appun.
J.T USENI
Useni say,e get one yarns wey Awolowo dey yarn dat time say, wen you carry new wood on top old ones,if u won use the wood,u go first remove di new ones on top bifor u go reash di old ones.
Meaning say,Obasanjo naim start dis old habit wey be koropshon and afta Buhari don deal wit dis new ones finish,he go reash di turn of di old ones.
Na una naim know.
Make una nor fight sha o.

Saturday 20 February 2016

AKORDIN TO YES INTANATIONAL MAGAZINE,DEM SAY BUHARI MINISTA,AISHA-ABUBAKAR GET STRONG BODY ODOUR


Bifor,dem say Buhari body odour dey make our rest lidas dey bihave demsef.
Meaning say di fear of Buhari,na di biginning of, 'Oya rule well'.
But now,akordin to Yes magazin intanashona,dem say President Buhari minista of state,trade,industri and investment,Mrs Aisha Abubakar get di real bodi odour wey fit kill fish for river.
Dis na wetin pafume go fit solve as far u dey spray am almost evritime but madam nor kukuma gree to use her brain.

Dem say for meeting nobodi dey hapi to sidon near her.
Pipo wey reali dey sofaram na pipo wey dey work wit her as fear nor let dem telam.
Di only choice wey dem get na to dey swalow di odour like dat.
U know say bad news dey sabi dey spread quik bifor u go know wetin dey appun,Obama go hia di tori.

CHECK OUT PHOTOS OF CELEBRITIS WEY ATTEND SENATOR BEN BRUCE 60YEARS BIRTHDAY GROOVE FOR EKO HOTEL


Common sense senator,Ben Murray Bruce celibrate him 60 years birthday for Eko hotel last nite and many big names turn up make e for nor loss.
Bovi,2baba,Wizkid,D'banj,M.i,Dare and plenti oda Stars play enta di ground.
Even politicians like Dele Momodu,Peter Obi,Nuhu Ribadu also enta di ground too go show dia jersey nomba.
See more foto dem for bottom hia...



LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...