MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 3 February 2016

ARREST GOODLUCK JONATHAN NOW! ONE MAN DON WEAR BANNER FOR NECK AND HE WANT MAKE DEM ARREST OGA JONA

Evribodi wit dia tinking and dis man right now tinking cap dey showam only one ting;Arrest Goodluck Jonathan!
Di man stand outside dis  National Assembly dey do one man pol protest.
Moskito dey use some of di men wey work wit Uncle Jona dey do shege for prison now sake of say dem use money wey dem sopose take buy wipons take play pasona kalokalo.
Dem die $2.1billion dollars and shiaram among demsef.
Di man wey Jona put di money unda him care,Sambo Dasuki,dey prison and he don sing song wey EFCC dey enjoy.
As u dey read dis tori,u go dey pray make he nor call yor name among pipo wey chop for di money.
Some pipo don dey say boys kant use money wey oga take sendem mesage witout say oga nor giv dem orda and na dis one naim make dis man wey dey protest for National Assembly want make dem arrest Oga Jona make he kon yarn wetin he know about di money wey grow wings all of a sudden.
Well make we dey wosh weda dem go take dis guy sirios or e dey on he own.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...