MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 2 February 2016

Lol..SEE WETIN BOVI USE DEMUREN AND TOOLZ FOTO TAKE DO AFTA DIA WEDDING

Dis Bovi guy na one of di few crase wey neva stil get cure for naija comedy.
Di wedding of di year for now,radio babe, Toolz and pilot, Demuren,appun ova di wikend and some few pipo nor get chance play enta di groove as dem go run dia parole wey dem don alreadi arrange.
One of di few pipo wey nor show face for di ground na Bovi but he stil get time to read meaning to di  pishor wey Toolz and Tunde Demuren snap.
He trow di joke on top di pishor for Instagram and di bobo try to imagine wetin dey run tru many men mind during bride price wahala.
Nor be small tin.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...