MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 6 February 2016

YORUBA TRADITION DON MAKE 78 YEARS OLD OBASANJO POSTRATE FOR 41 YEARS OLD OONI OF IFE

If dem get any tribe wey like to dey postrate for elders for naija,dat tribe na Yoruba.
Any small tin Yoruba pipo don postrate flat for elda as mark of respect and dat na veri gud tin.
Yestaday for Ibadan,forma civilian and khaki presido,Olushegun Obasanjo visit di new Ooni of Ife,Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi Ojaja II and he slip for ground flat to grit di 41 years old Oba.
Obasanjo imsef wey be 78 years old respect di yoruba tradition even tho many pipo see am as jaguda oga.
Obasanjo carry waka go visit di Oba to gritam for all di effort wey een don bring to take unite di yoruba nation.
See more of di pichors for bottom hia..





No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...