MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 9 February 2016

DI BABE WEY RIVERS UNIVASITI DRIVE FROM SCHOOL BICOS SHE NOR DEY HEAR WORD AND TALK WELL,DON CARRY DI SCHOOL GO COURT FOR 20MILLION


Jane Ihuoma-Ottah,di babe wey Rivers State Univasiti of Science and Technology(RUST) drive comot for school bicos her yarnings nor too clear and she nor dey hear word well,don carry di school go court. and she want make dem pay for damages of 20 million naira.
Akordin to her popsie and Momsie,dem nor born her deaf.
Dem say na from primary six she for get di problem.

From primary skul,she enta secondary skul and she pass all her papers for WAEC di first time wey she write tam.
Now RUST won skata her plans of to bikom lechora for di fiuchor,dem say e nor go work.
So make we dey watch wetin court go talk for di mata.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...