MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 12 February 2016

KAKA TINS: SEE AS PHYNO DEY RECORD SONG FOR INSIDE TOILET

Well,dem say for u to remain popular for di industri,u nid to dey do som kain crazy tins sometimes.
Dis one wey Phyno carry vocal boot enta toilet go sing so,I hope all is well.
He post dis pishor on top Instagram and write followam say een dey shit for dia head.
Di bobo say make I yarn una to xpect new song.
As Phyno dey record dis new song for toilet,I hope say di song nor go smell wen e enta market?
Di shit is real mehn!

Comot joke,all Ibo pipo nid to dey proud of dis guy bicos di bobo don diliva well wit een mother tongue.
He dey creative and een talent dey clear.
If oda pipo wey nor dey hia di language dey enjoy di man of di year miuzik,Ibo pipo sopose to dey carry am like egg or else we go Un-Biafra dat pesin.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...